Pages:
Author

Topic: INEC: Underage voters will be arrested - page 3. (Read 359 times)

sr. member
Activity: 798
Merit: 388
January 02, 2023, 01:59:53 PM
#2
To me how deh go talk say any underage voter they go arrest am how they go take arrest like some villages.
These wey election don deh come na him INEC deh come with new New rules and regulations some people wey no get parent nko or some people wey no dey vote for there area make they just forget about that underage of something make they allowed everybody to vote for there choice..
If they want to do for some places na war go start because no parent go allowed police or any other uniform person con carry him pikin for him presence definitely people go fight be that na
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
January 02, 2023, 11:59:15 AM
#1


Quote
The Independent National Electoral Commission (INEC) says visibly underage persons who attempt to vote during the 2023 elections will be arrested. Festus Okoye, INEC national commissioner for information and voter education, said this on Monday during an interview on ‘The Morning Show’, a programme by Arise Television. Okoye said in an effort to address issues around underage registration, INEC has summoned all its officers in areas where underage registrations were recorded.
As we dey gear up for the 2023 elections wey go kickstart with the presidential election on 25th february 2023, na him INEC national chairman for information and voter education Fetus Okoye, don come out come talk say any underage person wey come out come vote, dem go arrest such persons. Well...  I like as dem they loud as to our hearing and I know say na naija we dey and there's still going to be defaulters and we know say na for northern part of naija na im this underage voters registration dey common, but INEC go fit really persecute this persons? Also, INEC say dem get 93.5 registered voters and dem go publish the list on 16 January before the election go start... Wetin una think concerning making the registered voters list public?

Quote
The parents will also be arrested for aiding and abetting such a venture.
This one go dey hard to carry out ooo...  As most of the underage voters wey be Almajiri with no parent, wey dey street dey beg with plates... how dem want take arrest the parent? Abi dem just dey talk am so that parents and guardians go advise their wards?

Source: https://www.thecable.ng/visibly-underage-persons-who-attempt-to-vote-will-be-arrested-says-inec/amp
Pages:
Jump to: