Na true talk and I totally agree with u, investment no be really the way we dey think or mk I put am like this, investment no dey easy the way we think say e dey, e just be like farm work like u talk, sometimes u go do well, sometimes u no go do well, for example like me, wen I never really understand crypto well, I think na just to put money buy coin dey watch am as e dey grow immediately den withdraw my profit comot but I got it wrong because I no check the market well before buying any coin, na just like that all my money just go o, I no make profits even my capital I no see, na after some months wen my mind no dey der again, na the coin come rise, I make better profits that time o, so even if I never get all the ideas about crypto but at least I understand say Bitcoin investment or crypto investment na just about Patience, e fit be short or long term investment just like the way we dey farm, when we plants things in our farms like cassava, yam, okro, corn, we already know say na okro and corn we dey first harvest before cassava but no be just immediately, e take time na so investment dey too, na e mk dem dey always dey draw us hand for ear say mk we first understand wetin we won sign up for, if we just fall today and e go take like moths or years to rise back. But most importantly be say mk we get patience and self control, this two na e they conquer investment.
Some people go invest in a particular business and when them see say eh no yield profits, the way they want them go leave that one go into another one, eh no make sense at all because at some point they go done spend alot of money and waist their time on different things wey them no benefit from, one thing wey dey help business grow na patients and also consistency. If you notice the OP give reference with farming say em been plant okro but eh no grow, then em come dey patient to retry again and this around em add fertiliser then water the plant and eh grow, that na very good example to let people know say patients and consistency matters alot for a business to dey successful, no be to dey jump jump from one business to another wey you no get knowledge about. Apart from Bitcoin and crypto investment every other aspect of investment or business plan need person to dey patient, you no go fit plant okro or yam or cassava come expect say eh go produce in 2weeks , na so business or investment dey.