Pages:
Author

Topic: Investment be like farm work - page 2. (Read 231 times)

jr. member
Activity: 66
Merit: 7
December 17, 2023, 01:04:10 AM
#7
U get valid point investment be like farm work at first you go plant during the planting season then you go wait make e germinate from ground then e go letter big reach when you go harvest wetin you plant na so investment be you gats dey patient and some times no be every farming season wetin you plant go yield better result sha but no give up there are many challenges also in farming sometimes you go experience famine e no mean say e no go better 2moro big men like OTEDOLA and the likes if them tell you say them in vest on many things way work and no work you no go believe.
full member
Activity: 280
Merit: 190
The great city of God 🔥
December 16, 2023, 08:26:47 PM
#6

Wetin I dey try talk, make we know say as we dey invest at first e fit no yield result but e no mean say  profit no go come ,,we just need consistency even as we wan enter a new year...I believe say na year wey get positive vibes especially for bitcoin
We all know say farm work no be for the faint hearted likewise to invest too but in all with God our expectations will come through 🙌
Yes investment dey good. E just dey also remind us say when we invest on Bitcoin and the price dey drop make we no give up hope, instead the water we go take water am na to still buy more when the price don dip, sothat when e go rise, all of them go rise up together.

Life is all about consistency, and anybody wey choose say e no wan continue na Problem be that na. Just like who dey work and e dey get paid, come  say e no wan work again how e wan take survive?
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
December 16, 2023, 07:41:03 PM
#5
Wetin I dey try talk, make we know say as we dey invest at first e fit no yield result but e no mean say  profit no go come ,,we just need consistency even as we wan enter a new year...I believe say na year wey get positive vibes especially for bitcoin
We all know say farm work no be for the faint hearted likewise to invest too but in all with God our expectations will come through 🙌

Your story is more about observation and na wetin many of us no dey do when we dey invest. We just dey follow how market be without researching to know how to invest. As you plant those first okoro and dem no grow, if you no been dey observe you no go know say you suppose try again and if e still no grown then you go know say problem dey. Either the land no good or you no water the okoro well for that side, na wetin no come make am no grow. You go come can strategize and e fit reach extend you add fertilizer for the ground to make am better by adding am manual wey go help the okoro grow well.

This na so we supposed treat our investment too, make we no think say we go just invest and all our problems is solve, only a few get lucky with their first investment and they become financially free for life. Others have multiple trials until they finally make it so make we no dey give up very quick. Anything wey we dey do whether na investing oh, trading oh or anything wey involved business and money we need dey very patience with am and always observing too so we no go dey waste money for wetin wey no go favour us.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
December 16, 2023, 07:26:03 PM
#4
Op you don try, I dey like all this rae illustration to take define something because naim go show say you dey really dey understand wattin others dey talk about this Bitcoin matter or investing in crypto,as a newbie e dey always advise make una start with DCA that is, to dey put small small amount of money for inside you Bitcoin investment portfolio, you fit dey do am week by week or month by month, any one wey sweet you or wey your money fit reach. No go rush inside the market oo , take your time make you do small study to understand how to keep you wallet safe from misplacing your deed phrase and private key and how to avoid scams for inside this crypto network, though if you get money to start now e go dey very good if you just accumulate than to Waite  any more longer, but if you fon already start to dey invest for Bitcoin, I go advise make you increase your portfolio before the bull run.
jr. member
Activity: 76
Merit: 3
December 16, 2023, 07:23:10 PM
#3
Of recent I say make I try plant okro around my house ...I come realize say some of the okro no gree grow while others don pick up ..wetin I do I still replant again...and I no only replant but I also water them now I come see say them sef don dey grow and I come dey get joy as them dey do well.
Wetin I dey try talk, make we know say as we dey invest at first e fit no yield result but e no mean say  profit no go come ,,we just need consistency even as we wan enter a new year...I believe say na year wey get positive vibes especially for bitcoin
We all know say farm work no be for the faint hearted likewise to invest too but in all with God our expectations will come through 🙌

Op this one be like say you no water the first one wey you plant and you con get lucky say some grow and the second time wey you con plant you give ahm water na why e grow.
 This one show say you no give am water or maybe enough water na why the first one no grow well. That one mean say you try to make it right this time around, For giving the plant enough water of their satisfaction.

And for the Bitcoin matter you know say if you go invest in bitcoin you gaz make sure say you dea ready for am because no be fast money e go bring but if the money com e fit change your life entirely, and the investment is all about Risk you fih gain or lose but always we dey pray for good result.
member
Activity: 66
Merit: 5
Eloncoin.org - Mars, here we come!
December 16, 2023, 06:59:03 PM
#2
I agree with you, every thing need support and constantly adding to your investment will yield a better result just as you illustrated with your okoro plantation.

Sister, I for like advise you small, if you need to grow well for this forum eeh you no need all this kind post.
Just take your time go to https://learnmeabitcoin.com/ make you read they understand small small, then anything wey you no understand you fit come here ask am people go teach you to understand.

Best regards
Churchill
newbie
Activity: 29
Merit: 2
December 16, 2023, 06:25:28 PM
#1

Jump to: