Pages:
Author

Topic: Is English language really necessary in our local board? - page 2. (Read 218 times)

hero member
Activity: 966
Merit: 620
 According to your question nai I go give my answer. Inasmuch as here na our local board and we suppose represent, make you know so say no be everybody here wey Sabi nack the pidgin well and instead of that one to be barrier for these people to no dey able to pass the info or knowledge wey dem get, nah make for me I feel say the ogas for here put am as rule for here, so if you dey ask if English dey necessary, my broda I go say yes. If you check am, here nah out local board which means, we suppose dey use different dialects dey communicate for here so since that one no go work, pidgin nai we dey use but I really no see any biggie for there as this pidgin we dey back here nah a by product of English broken down.
newbie
Activity: 19
Merit: 1
Your suggestion is a good one, but make you know say no be everybody dey fluent with this our pidgin. So when they speak, them go likely mix am with English. I will say pidgin is a common language  that some counties might find it easier to understand with the rate at which our citizens they go viral
sr. member
Activity: 378
Merit: 285
We are truly representing the Nigerian way of life here in this forum. If you check very well in our society we are mixing English and pidgin language in our day to day life and that's exactly what is happening in this place. Those local boards you see that they are only using their local language check very well in their country it's only that language that is widely spoken every day.
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
Happy new year everyone.
~
The early members of our local board chose English and Pidgin as the languages, and this has been a big issue over the years. In Nigeria, where almost everyone speaks English and Pidgin, these languages were chosen to avoid confusion. I remember someone suggesting using other tribal languages, when writing about the history of the local board but that could have made things worse.

Currently, only Naija and the India board use English alongside their local language. The local board wasn't created solely because of language.it was a way to unite Nigerians and discuss country-related issues.

It would have been more stressful creating a topic strictly for Nigeria in the general board, and having other English members who know nothing of what is going on debate for us how to go about. So that's the whole idea about the English and PIDGIN it does necessary mean we have to write in pidgin but as a way to bring us together.
full member
Activity: 266
Merit: 120
OP Your suggestion dey good o but wetin you go understand be say e get some senior men Dem wey dey come from outside our local board wey dey come check how we dey do for our local board and sometimes Dem dey award merits to quality posts wey Dem jam for our local board, so if we say make we make pigin official language dat means say if dose people come our local board e go dey hard for them to know wetin we dey talk or discuss therefore Dem go find am difficult to merit post them wey get good quality so na in be d disadvantage wey go dey there if we decide to make pigin language official for our local board so make we just dey mixed both pigin and English language as we dey do am before na in be my own opinion.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Feel free to use Pidgin English as people like me use English. Do you know that we have local board rules?

1. Only Naija Pidgin and English is allowed

Did you know that few topics in English posted on English board are moved to local board if it is strictly pertaining to Nigeria?
sr. member
Activity: 462
Merit: 355
The great city of God 🔥
So should we continue mixing English language with pigin language base on the fact that we don't have a common language that everyone can speak and understand or we should just make pigin language official in our local board?
To me mixing pidgin and correct English no change anything atol, because na the message you dey pass across Naim Matter. The problem we get na the too much language we get for Nigeria. Like as I been talk before here na place wey foreign people dey always visit and dem dey try read wetting people dey post because Nigerians dey become more interesting this days. and if you dey lucky enough them see your post worthy enough dem fit merit am with the English you speak because pidgin no get Google translator. so anything wey get advantage also get disadvantages. while the disadvantage na the English wey you speak, if na something wey dey implicating and you dey see am as say na local board say dem no go fit trace you, dem go catch you when you speak am for Pure English Naim be the disadvantage.
sr. member
Activity: 420
Merit: 253
Happy new year everyone.
I took time to go through the local boards in this Bitcointalk forum and I found out that almost all the local board apart from India and Nigeria are the countries that speaks English in their local board as all other countries speaks their own languages rather than English language so I now begin to wonder that is it really necessary for us to be speaking correct English in our local board while we can just be speaking pigin language since we don't have a unified language as a country.
So should we continue mixing English language with pigin language base on the fact that we don't have a common language that everyone can speak and understand or we should just make pigin language official in our local board?

Though for me I prefer make we use pigin as official language so that e go help those of our people here wey no too know how to speak correct English and when e be say if other people dey speak correct English Dem no go understand wetin Dem dey talk so that e go dey easy to carry everybody along for d local board. Although e get people wey dey use pigin dey write always for our local board but when other people dey take correct English dey discuss you go see say dose people wey dey use pigin write no go understand wetin Dem dey discuss.
Pages:
Jump to: