I create this post after I see say, a post wey Dem create about this board as e wan turn to market place where them dey drop anything them like. E good make we tell ourself truth. D way wey some people dey accuse others for the forum don dey too much, abeg.
If you don grow your account or you don stay for long no mean say anybody with lower rank na trash be their post.
Many newbie go definitely do mistake, that one no means say make we dey tired of them, even you wey dey blame others, I believe you know how many times you do mistake before you con Sabi. Since we no get moderator yet, anybody wey overdo pass in self make Dem let an know with love. I no dey like make person dey address others with hash words just because your rank pass others. I respect all the senior men for the board wey dey show love. Before some of the newbie no the forum, Dem dey live life, even without the forum , Dem go live life. Na hustle everybody dey as the country situation dey hard every day. Make anybody no frustrate another person for here.
As presido talk, let the newbie breadth. Make we allow them breadth before them go give up for the forum. This thread suppose be reply for the thread wey I read but them don lock am. I know dey happy with all this accusation and the rest.
No be everyday person go dey see something talk about bitcoins, so make we know make the board look like burial ground.
Rank aside, everybody deserve respect, make we dey talk with love.
OP you don't expect everybody to react the same, some people can be moderate in their response others can be harsh as well. One thing you should understand is that, Human beings are sometimes stubborn, some of us no dey hear word. Wen senior members tell you say no do this thing, na that time them wan do that thing way them ask them not to do. So sometimes the harsh response dey help reset their brain to normalcy, because as this forum be, if you're not properly guided or handled, you go commit one crime unknowingly, and you go chop suspension or a ban.