I have actually used whatsapp but then we never too open eyes based on how we carry full force enter the industry. To some points we come move go remitiano although me no love there, na one of my guy I dey sell give then him go move am go there to trade.. after some while we come discover say Luno dey try small small, na so we begin dey trade am directly to our bank but at some certain points e come be like say Luno self wan kill us with high fee and them dey buy very low instead of us not to sell we just managed am like that.
For OGs WhatsApp na normal sumthin but no be wetin make me quote you so, na dat Luno wey you mentioned. Brother, Luno do us something I no go lie you. E get when to withdraw money come be problem for that app and if you wan sell, dem go buy from you wetin no good compare to wetin others dey sell but their sellng price na fire. If one Naira na 350 dat time, Luno go sell you am 450. As I dey read I see their name I just remember how the platform frustrated me back then and I dey thank God say dem no be popular brand again to dey use. Dem be get one issue one time belike dem dun close abi dem still dey operate but nevertheless dem na old story now.
OP this headlines wey you just give out about how the bitcoin p2p selling bin be before now just look like na people like una be the John the Baptist for Bible wey first come clear the straight path for men like us wey just dey enter the industry to tread on. And based on the storylines aswr, this time the process soft we'll pass before.
E go make newbies dem wey just dey come understand the struggle wey men be face before industry soft like dis data why I drop the words, I fit remember how much I lose when I be dey find better vendor wey go sell me cheap or buy from me higher than most people been dey buy. Me I start Bitcoin from the days of MMM and na wetin introduced Bitcoin to Nigerians mainly be dat as after that one all those other ponzi schemes dem wey dey use Bitcoin come dey come in. To buy Bitcoin dat time you must buy or sell to your upliners as vendors no plenty but we thank God say today things different.
Another issue with Remitano is that their withdrawal fees are fixed at $30 regardless of the amount you wish to withdraw, and they do not provide segwit addresses.
Belike dis one na new update oh because nobody talk this one since abi na the transaction fees wahala dey cause this one. For segwit address matter, some exchange just recently add am so belike remitano go add their own soon too but the fees na everybody e dey affect and e go reduced when everything calm down.