Pages:
Author

Topic: Make we talk locally, truely how you dey change your crypto to Naira? - page 2. (Read 315 times)

hero member
Activity: 896
Merit: 653
This na really beta thread you just bring up my Oga, because for me, I don dey use Remitano for more than 3yrs now and since then I can proudly say I never get any issue with them, but no be say I no dey use Binance oh, but i don dey use to Remitano & na him I dey use the most, bcos one good thing about Remitano be say if for instance you try to withdraw Naira now,  in less than 5 minutes you go don see alert for your phone, very fast and convenient.

The steps just dey very simple & here is how to go about it


Step 1: While using Remitano, the first thing you go need to do na to just log in the app, then click on the down side wey they write "wallet" and after that you select the coin you intend to deposit (i.e BTC)



Step 2: After you don click on the deposit button, eh go carry you come this side wey you shown below and all you need to do na to just copy the wallet address wey you go send the coin to and make sure say you deposit more that 0.0001 BTC, if not your fund no go deposit inside your wallet and you no go see am again.



Step 3: So after the BTC don land for your wallet, the next tin to do go be to go swap your BTC into NGN as you dey see below. All you go need to do na to just input the amount wey you go wan swap into NGN, and this process dey always dey instantly.



Step 4: So after you don swap your BTC into NGNR, the next step go be to click the withdraw button as you fit see below, and eh go take you go the next step



Step 5: So after you don click step 4, eh go carry you come this side all you need to do na to just select your bank, input your acct number & in few minutes you go see alert for your phone. Very simple
member
Activity: 322
Merit: 10
Well, for my own case I dey use BINANCE peer to peer P2P 4 short it's very secure if you can follow the rules of not releasing ur escrow until u see alert, or vice versa. You can change from 4k upwards to millions in naira. I use it because it's free and I have no desire to go on another journey of discovery what may or may not serve my purpose.

Like u pointed out, I too was aware wen to change crypto to naira na computer science. Back den I found 2 companies dat help which were xbit now known as luno and xapo.  

I left d crypto space 4 a while, now coming back many new improvements are around. Back den too to bridge from one Blockchain to another na mountain. And in some case pay charges upward $100+ in fees, now tins are easier. A good man talk say that "the suffer him dey suffer today is so dat the future peeps no go see the same suffer."
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
So I just sit down now dey reason how improve crypto dun dey since wey I join the industry around 2015. I fit remember when na Facebook groups I dey sell my Bitcoin and other crypto wey I get then we come move enter WhatsApp groups and scammers use us shine. Today the story different people wey just dey join the industry go think say as e sweet now to sell crypto to Naira na say na so e sweet from the very beginning. Now if I wan sell my Bitcoin or other cryptocurency use hold body, ASAP e go happen and I no even need to dey worried that much. E no matter if na centralized exchange the trade dey happen or na decentralized exchange. The confidence dey there say I go get my Naira for my bank account use run one or twos.

This matter just enter my head I come say make I drop the matter here and maybe our suggestions fit help one or two new users. How far, how una dey, which means wey you dey use sell your crypto (Bitcoin or altcoins) to Naira. How reliable the platform dey and any thing person need know before him use the platform? Abeg I need genuine answers and no go dey recommend wetin you no dey use just so you go sound like say na you e dey body pass. Make we talk Nigerian to Nigerian and leave oyinbo talk first, which platform you dey use sell your cryptocurency?
@Gender, I see say you know follow express your own experience about this discussion. Is like you never sabi post since you be newbie. If na so,wetin you go do be say look for up of the thread wey Brainboss write,you go see reply for the right hand side na there you go click to drop your own point. If you no sabi quote,avoid quoting for now till you don understand the basic things on how to post and reply. For you to quote wetin person write without your own point of view, na spamming charge o.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
Vave.com - Crypto Casino
Well me na 2022 nai I start 2 market ma bitcoin, and na ramotatano nai I take start am. Then late I come dey use p2p with won guy 4 ma yard wey come dey cheat me like Igbo man and later won guy here come dey introduced Binance 4 me, nai I come dey use binance till now. Though I don dey use other platforms dem but those wons are di wons I majorly used. But in 2015 wen I started hearing about bitcoin, and those of ma friends wey key into di business, been dey use p2p very well and dat time dey were buying bitcoin with 5k but I no know di units dey were buying.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
Mehnnn... Like this na Telegram group na im I been dey use run my package. At some point I come try Luno, and I wasn't pleased with their services, imagine transaction of 7 kpali, dos people collect about 1.5 kpali as charges. Dem charge me for deposit, conversion to naira and withdrawal, d thing just tire me. Dis thing happened more than 5 years ago, so I no no how their services dey now and I no want try dem again. For now na Whatsapp crypto group where I dey sell to verified buyers. I dey look Binance one eye, I bin don do tier 1 KYC for long but I neva use their P2P service.

All dis oda platforms wey una mention too I go try check them out know which one go good for me. D Whatsapp crypto group sometimes fear dey catch me because scammers dey there too and if you loosegaurd you go enter one chance.
full member
Activity: 770
Merit: 180
Eloncoin.org - Mars, here we come!
For me, na Remitano win am. Although most times na network go worry transaction.
There was one transaction I remembered doing sometime back.To convert my crypto (BTC) to our local fiat, Naira. It was during the presidential election this year. It took almost 24hours before it dropped in my account. I was really scared that day o. The amount later reflected but I didn't the alert until the following day.
I have been trying to explore Bouex.com. I also tried Kucoin onetime but the navigation seems complex than Binance exchange. That's how I stucked to Remitano finally.
End of story!
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
My own be say na the most convenient one wey dey me very ok I dey use now and na binance but before i begin use binance, na through my brother connect I dey take market my coin and token them. Once I get paid by any of the project doing airdrop then and it starts trading at a good price I call brother to see if he has any available buyer for the token and I am always lucky that any time I call there is always a buyer begging to get the token  and coin I had so I had the opportunity selling it at good price depending on the market price then. After some time binance launched but binance gave me a tough time getting registered in their platform as i had issues with their kyc process but however, I scaled through after a while and then binance is my p2p platform for easy conversion of my coin to naira.
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
As for me na last year,I start to use crypto and na when I join this forum. My first bitcoin wey I change to fiat na my guy buy am.
Na our local exchange na e I dey use Busha,I come to know about this exchange from that my guy wey I dey sell my btc for. Though,I already know about Binance but the process to sign up na die for me. Especially that face scanning, na there I dey fed up for. Since my blood dey hot and I need to change my bitcoin in the absence of my guy. Na so I start to use Busha till today. I never try any other exchange but I know say many good exchanges dey. The first time wey I won use remittano mobile app,bros I no go lie for you,I miss road. So far so good,I know say Busha dey charge high but I dey comfortable with the exchange because I never get any issue with them apart from the last time wey dem lock my account for 23hrs due to say higher amount enter the exchange from my normal amount wey I use start with them. I still dey reason say I go try another exchange and this topic din make me know the next exchange wey I go give a trial.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Chairman, you dey use Bisq trade your Bitcoin or altcoins to naira?
Unlike those smart contract so-called decentralized exchanges, only few coins are listed on Bisq, but exchanging to fiat is possible, which is not possible on those smart contract exchanges.

Bisq is far more complex than just using it to exchange to local currency, you can check the payments supported: https://docs.bisq.network/payment-methods)

There are other payments that are accepted in Nigeria as well. Bisq should be a topic on its own, unlike exchanges that local traders are using to trade with other local traders.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
For privacy, decentralized exchanges are still the best. Among decentralized exchanges, Bisq is the best and most decentralized. Bisq is just a software code, not an organization.

Chairman, you dey use Bisq trade your Bitcoin or altcoins to naira? The question no be about which one be the best, the question na which one wey you dey use trade and for that platform wetin you think say dey good about that particular platform wey you dey use trade and wetin you think say dem fit improve so?  The question na about your personal experience no be wetin people talk, which one you dey use that's the question. Ps: if you no dey comfortable sharing no issue.

Na Remitano I dey use. I know Binance get him own P2P but I never learn that one. Make I give small review about am.

I remember when remitano come out, dem too dey try but I no see any difference between them and Binance exchange. Dem both dey centralized so the features no supposed dey any different. Why remitano dey easy for you na because person show you road on how to use am. If dem show you Binance too e no go hard you. I been dey hear say remitano launch their own coin, how far you benefit from am and e dey trade well abi na another shitcoins wey go soon die comot for market.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Na Remitano I dey use. I know Binance get him own P2P but I never learn that one. Make I give small review about am.
There is nothing hard about any P2P if you follow the right guide. Those exchanges that are highly rated like Binance, OKX and Kucoin have better bitcoin or crypto to naira P2P.

- so far nobody don scam me. I get confidence say once money dey my wallet I fit run without any issues.
If they are centralized exchanges, scam can reduce, but you should be able to avoid scam even on decentralized exchanges.

- them dey help pick the merchant with the highest price. My life dey easy with that one
On the centralized exchanges that I mentioned, you will see 'express', that is the function of express.

- if you use OPAY which I prefer you fit wait until you grow white bear-bear before the money land
Opay transaction is fast, the problem is from Remitano, just like I commented too about Remitano. The first time I use Remitano, the transaction expired or so and it was cancelled. I tried it again, it took 1 to 2 hours before the money reflected on my bank account. Very frustrating. That was the first time I used Remitano. The second time I used Remitano, the transaction was cancelled and cancelled again and again. You see how that can make you leave an exchange forever without visiting it again.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
Make we talk Nigerian to Nigerian and leave oyinbo talk first, which platform you dey use sell your cryptocurrency?
Na Remitano I dey use. I know Binance get him own P2P but I never learn that one. Make I give small review about am.

Why I like Remitano
- so far nobody don scam me. I get confidence say once money dey my wallet I fit run without any issues.
- their platform dey very easy to use but if you ask me, I go say I prefer the mobile app pass the website version
- them dey help pick the merchant with the highest price. My life dey easy with that one
- U fit get multiple accounts . KYC not needed unless you be merchant

Why I nor like Remitano or Wetin I feel say dem fit improve on
- most times, their mobile app dey take too long to load
- their update too dey confuse me
- if you use OPAY which I prefer you fit wait until you grow white bear-bear before the money land
- dem need to improve the way to sellers to fit give proper review to the merchants.

I still dey use dem sha. Maybe later I go learn binance p2p later.

I don talk my own.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
For privacy, decentralized exchanges are still the best. Among decentralized exchanges, Bisq is the best and most decentralized. Bisq is just a software code, not an organization. One of the disadvantages which may make people not to be that using it is because it has only computer software, no software for Android or iOS, except the Android and iOS notification apps. So if comparing the trading volume to those centralized exchanges, centralized exchanges have far higher trading volume. But for anyone that wants privacy, Bisq is the best decentralized exchange to go for, but it has low trading volume.

As for centralized exchanges, those that allows Nigeria P2P that are highly ranked on Coingecko, like Binance, OKX and Kucoin are all having high P2P trading volume. Among the ones that are not there like Luno, Remitano and Quidax. I have used Luno before some years ago, the exchange is very good. I have also used Quidax before, very fast but not advisable to use because of some high hidden deduction of users money. I have aso used Remitano before, I do not like the slow transaction completion time after CBN do not want bank to officially support bitcoin and other crypto transactions anymore.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
So I just sit down now dey reason how improve crypto dun dey since wey I join the industry around 2015. I fit remember when na Facebook groups I dey sell my Bitcoin and other crypto wey I get then we come move enter WhatsApp groups and scammers use us shine. Today the story different people wey just dey join the industry go think say as e sweet now to sell crypto to Naira na say na so e sweet from the very beginning. Now if I wan sell my Bitcoin or other cryptocurency use hold body, ASAP e go happen and I no even need to dey worried that much. E no matter if na centralized exchange the trade dey happen or na decentralized exchange. The confidence dey there say I go get my Naira for my bank account use run one or twos.

This matter just enter my head I come say make I drop the matter here and maybe our suggestions fit help one or two new users. How far, how una dey, which means wey you dey use sell your crypto (Bitcoin or altcoins) to Naira. How reliable the platform dey and any thing person need know before him use the platform? Abeg I need genuine answers and no go dey recommend wetin you no dey use just so you go sound like say na you e dey body pass. Make we talk Nigerian to Nigerian and leave oyinbo talk first, which platform you dey use sell your cryptocurency?
Pages:
Jump to: