Pages:
Author

Topic: Make/Announce Ur Rank Up nd Weti U don Achieve plus Merit Here - page 3. (Read 764 times)

sr. member
Activity: 728
Merit: 421
Our adage say person wey like good thing when any thing good happen or take place make you too wey like good thing follow celebrate am because wetin you pray to happen to others God go make happen to you. Make I use this opportunity to celebrate and congratulate our senior comrades them wey dey celebrate their achievement Agbe and Mate2237. A very big congratulations on una achievement. E no easy for this giant strides for this platform. For person to grow through ranks, the hurdles no be here no to talk of the activities wey person dey engage him or herself here for no easy. My prayers be say make God guide us through as we journey this industry, more wisdom to contribute our quota to this platform wey go make us recognized and not the least, make baba God keep us strong and healthy because na only man wey dey strong go fit work well. Once again congratulations mates. We are heading there.
hero member
Activity: 994
Merit: 744
Make I follow congratulate my fellow Nija colleagues here on their achievement, e no actually de easy to come dis far for d forum, but una hard work keep una moving up till this stage, I pray for greater height and more achievement both in the forum and outside d forum.

Congratulations Agbe and Mate2237 on una latest achievement.
sr. member
Activity: 756
Merit: 454
My mouth too small to shout plenty plenty nah, Mate2237 make I congratulate you big big as you struggle like Arsenal go reach greater height wey you no go fit come down, continue the struggle nah God go generate wings for you and other of our brodas and sistas wey dy here... Thank God for una

Me I never fit talk but from newbies to this place I dy now, e even shock me I no fit shout...
Thank una wey see me as person wey no go put sand for una garri...
hero member
Activity: 1008
Merit: 702
Seeing my fellow Naija people rise to greater heights in the forum fills me with joy and happiness. Congratulations, Mate2237 and Agbe, on your new accomplishments; you've both set a new record in the forum. I anticipate you guys accomplishing more in subsequent times to come in the forum.
Wuna two don try wella, make wuna take some time cool off and celebrate wuna selves.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
A very big congratulations to Mate2237 on your senior member rank and to you Agbe on your 1000+ merit achievement. I know it hasn't been all rosy as you must have been confronted by some challenges and discouragement along the way but your resilience and commitment for self improvement, knowledge and contribution to the forum is gradually paying off. Today, I join everyone in raising a glass to you guys. Cheers! 🥂
legendary
Activity: 2184
Merit: 1302
Congratulations Mate2237 and Agbe, una don do wella and una deserve wetin una don achieve, e no they easy at all to earn merits consistently for this forum, the user must they post wetin be quality and constructive posts, and for una to achieve the ranks and merits wey una get now, e show say una follow for users wey they post wetin make sense for forum. Una don try, as una don open this thread so, i know say many other Naija users go also get their own achievements, so them go post am here and we go celebrate with them.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
1000+ Merits Achieved
2day nai dey make three months wen I join dis forum and I bin dey suffer well well, in dis naija board nobody suffer pass me. Bt might be, I know y I dey tok so, on di 7th of December last year, I created dis thread https://bitcointalksearch.org/topic/m.61407689 to celebrate my one year in di forum. In di forum, good name is one of the important thing one must maintain, and I am also trying my best to maintaining dat one. Nd anoda one is the MERITS obtaining nd Ranking Up. I don't know how to say it but God has been faithful to me in di forum.
2day I don achieve 1000+ merits which is di highest merit 2 enter di last Rank in di forum. I am very much excited.
I am also encouraging odas dat want 2 rank up with Merit 2 be patient. Just quality posts den all is done.

I want 2 tanks The Sceptical Chymist, Igehhh now Igebotz,  My Bosses I never fail u nd I will not Di Virus himself. Lovesmayfamilis, Welsh, fillippone, NotATether, EFS, DdmrDdmr, The Cryptovator, Adbitco, JayJuanGee, o_e_l_e_o, Charles-Tim nd Oda names 2 mention. Pls accept my Greetings. The Sceptical Chymist I specially thanks you for your generosity. God bless you.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
For ranking up and other achievements? In my opinion, you can edit this thread for that purpose. Former local thread is now for newbie's introduction and orientation
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Hire Bitcointalk Camp. Manager @ r7promotions.com
Rank up nd weti u don achieve nd u want 2 announce am, do am here 2 avoid repetition of threads nd spamming.
Di way u dey do am 4 there also use Pidgin English 2 do am if want 2. Any rank u aquire, merits, promotion, etc.
Like example:

I Just Entered Sr. Member Rank this Week

Di long waited rank finally open dis week Wednesday. It was not easy 4 di journey, those wey no fit, dem give up, but I no give up 4rom brand newbie 2 newbie, nd newbie 2 Jr. Member nd Jr. Member 2 Member nd Member 2 Full Member nd Full Member 2 Sr. Member nd now there are two ranks 4 me 2 attain. Nd I believe God go do am 4 me. I also encourage newbies, Jr. Member, Member and Full Members 2 post qualitative nd not quantitative so dat dem go rank faster.

Pages:
Jump to: