Pages:
Author

Topic: My experience, a lesson to others. (Read 255 times)

hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
July 11, 2023, 07:49:04 PM
#27
I don get similar experience once like that. I been dey reply everyone wey shook mouth under my post one after the other like say na WhatsApp chat. Na so the moderators just delete all those separate replies come put all of them inside one comment. Na him make to reply comments for my posts dey do me somehow because I nor know how the moderators go react. But then again eh, I don see some other people dey reply one one like that but nothing dey happen. I dey even ask myself say why Dem nor dey remove these kind reply. Anyways forum na the forum.
full member
Activity: 322
Merit: 146
July 11, 2023, 01:28:34 PM
#26
Na so life be. Sometimes when u do 1 mistake u learn plenty tins from am and be more cautious dealing with other things Only when u grab say no be all situations dey give person 2nd chances.

E good make u no let sometin wrong way happen to others happen to u b4 u learn. Yes. Bcos u fit no fit handle am during ur own time.

Make we dey always tank God for every 2nd chance opportunities. Even we humans at times we just feel like yes. Make the person die. No forgiveness on this matter.

Life hard and e really dey teach us lession.

But I go like say.... If u want contribute inside person matter, try make a positive 1 way go boost the person inline according to wetin him lines relate with.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
July 11, 2023, 01:09:57 PM
#25

I have not used Bounty Board so I am not used to the bounty hunt. But question be sae if Bounty Hunting is not something that people will not take you serious, why people still dey do am, though you said , it is not a bad thing but the reputation of the person nai e no go dey like other forum users. Knowledge is needed in all areas and not only on bounty Huntinng but also other boards in the forum. When the person post out  of point from the main thread then moderators use to delete such posts.

The thing wey make that bounty side be say no competition for that side like e be for this bitcoin side which is the foundation of this forum. That bounty side too full of scam and some managers no send self na to collect their own pepper from developers or the team wey bring the project and whether the project exit without paying bounty hunter no be their concern. Back then self some team go use their hand run bounty after you do their work finish dem go waka, so that place no be serious minded people dey there and there knowledge on top btc dey low.
sr. member
Activity: 434
Merit: 500
July 11, 2023, 04:10:17 AM
#24
I have not used Bounty Board so I am not used to the bounty hunt. But question be sae if Bounty Hunting is not something that people will not take you serious, why people still dey do am, though you said , it is not a bad thing but the reputation of the person nai e no go dey like other forum users. Knowledge is needed in all areas and not only on bounty Huntinng but also other boards in the forum. When the person post out  of point from the main thread then moderators use to delete such posts.
Likewise here, me sef no de used to that section so i no too sabi how bounty be like but i don ever go check how the place be before few times and I notice say some bounty de get signature campaign too and most user wey de participate na dem de spam for other sections for forum, because dem no too get knowledge about things and their main focus na just the bounty section. I don’t even know how the earnings there are okay to those participating in bounty, dem go promise to pay after 1 or 2 months wey una don work finish. Abeg i no fit settle for that kind payment oo. I hear people de always talk say bounty no de pay like before and everytime i go con de wonder how much this people don make for bounty wey de make dem de talk say e no de pay again.
I just notice say scam projects plenty for crypto now and since na mostly new projects dem de work for e mean say plenty projects go de scam hunter be dat.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
July 09, 2023, 03:53:49 PM
#23
Bounty hunting is not totally bad but the truth is no one will take you seriously if your post histories are made up of bounty links and all manner of external links, but then if you focus more on learning about the entire cryptocurrency industry and try to find yourself in a position that aligns with your skills and fine such way to offers your services and get paid in either bitcoin or any other crypto coin which Is on of major advantages of cryptocurrencies serving as an alternative payment, so,, in essence knowledge is very important and that is the reason why your posts where deleted because it lacks the basic contents to meet the standard of the forum and I am sure if you can put more efforts to learn more it helps a lot mate.
I have not used Bounty Board so I am not used to the bounty hunt. But question be sae if Bounty Hunting is not something that people will not take you serious, why people still dey do am, though you said , it is not a bad thing but the reputation of the person nai e no go dey like other forum users. Knowledge is needed in all areas and not only on bounty Huntinng but also other boards in the forum. When the person post out  of point from the main thread then moderators use to delete such posts.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
July 05, 2023, 08:15:50 AM
#22
My people, the day wey I notice say this forum pass bounty matter , that day I just dey curious to know more about other boards, na so I just see 'new post' under one particular board like that. Na so hit the button , e carry me go where I go write. Hmmm. I begin write ooo, later I con post am.

After I post am, body they shark me . After small time people they throw away reply give me, body con dey shark me more, the sharking make me reason am say, I dey see people they reply others for their post. So I decide to hit the quote button , boom na ihm be that.

As I know how to reply people, I start to deu reply every single person wey reply for my post.
Make I no lie you, people wey de do bounty get reason for doing that even though we know say the bounty no de pay like before as much project no de legit as before, but I know say one day dem go cash out too.
Abegy we no give newbies hope sae some day dem go cash out for the bounty wey dem d do. Make we dey plain with them by telling them the truth sae nothing d for bounty. The time wey bounty pay don go, I no believe sae such time go ever come again. Even if em go come, the number of people wey participate for am, no go be here. That will somehow reduce the pay wey each peso go get.

All the bounties wey I don do, which one wey don pay me big? Almost all of them no worth a dollar. Even the ones wey promise sae them go worth something in the future never list for exchange sef. Na promise upon promises wey dem d do more than a year now.

But this forum is actually pass bounty  by far because if you de do bounty, you no go know anything we de happen for other sections of the forum, and there some good information about Bitcoin in the other sections.
Na the thing. The forum big pass bounty. If you only focus on bounty you go lack knowledge for crypto and how you go take grow for the forum to be a quality poster. Na wetin bounty d cause for peso side.

OP I no go advice you to keep on with altcoin bounty because na complete waste of time. Am telling you from experience. I no go like make person wey I wan better for to indulge in am at all.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
July 05, 2023, 04:03:16 AM
#21
From what I can deduce here, I see OP was only informed about bounties here that was why he had no knowledge of some forum policies and does not know about other activities too not until he decided to do a research by wanting to expound his horizons. He was lucky he wasn't tagged a shitposter and that would have been the end of his account but since it happened he was granted an olive branch, I think he should make good use of the opportunity so as to remain relevant otherwise any lapses from OP again could be a serious problem for I'm as he has been granted pardon initially.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Always Act Smart and Play Safe With Your Funds
July 04, 2023, 06:24:26 PM
#20
Meh nothing dey bad here sha but e depends on how you carry run ur parole for this industry go matta your longevity because normally I noticed am say we 9ja dey always find shortcut but forgotten say here na international standard place wey be say man supposed stand up to dey read everything ends to ends.

If only we go bring out our mind settle down and develop the habit of reading e go really fasten and enhance your operation here than to dey look for shortcut to bycut reading and the rest, I believe say no be only you don join the forum and I also believe say you no go be the last person as well.
full member
Activity: 1190
Merit: 126
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
July 04, 2023, 02:56:11 PM
#19
Good experience op,I believe u will not try such thing again until you retire from bitcointalk.org. well, every newbies always have experienced to share from their beginning which is always rough for every newbies in this forum.pls u need to be very careful like d advise some of our senior men give to u, so that u will have more opportunities to learn.
member
Activity: 784
Merit: 34
👉bit.ly/3QXp3oh | 🔥 Ultimate Launc
July 04, 2023, 02:27:25 PM
#18
My people, the day wey I notice say this forum pass bounty matter , that day I just dey curious to know more about other boards, na so I just see 'new post' under one particular board like that. Na so hit the button , e carry me go where I go write. Hmmm. I begin write ooo, later I con post am.

After I post am, body they shark me . After small time people they throw away reply give me, body con dey shark me more, the sharking make me reason am say, I dey see people they reply others for their post. So I decide to hit the quote button , boom na ihm be that.

As I know how to reply people, I start to deu reply every single person wey reply for my post.

The shock I later recieved be say when I later logins I recieve message say my quote dey deleted cause some of my quote(reply) just be like, "that's good, thanks, absolutely right". Na den I con realize say unnecessary posting is not needed. I go back to the rule to know what is needed. I go thank lovesfamily for in support as inh take plead for me for some of post wey get mistake as some people dey throw way Banga for me.

Now I don learn my lesson

 Grin Grin Grin oh you think say here na FACEBOOK OR WHATSAPP where you go dey ask person how are you, what are you doing, you don chop, where u dey hahaha you get luck sha, me been don encounter this same thing you encounter when i been first start. you no just come talk any how for BITCOINTALK forum if not na wahala you dey put your self into and you go stand the opportunity to say bye bye to your account.
hero member
Activity: 812
Merit: 560
June 03, 2023, 07:30:18 AM
#17
Beware of this kind of category of mistakes some people made while posting or quoting some one and I've been taking note on this areas while quoting other or making my own post.

1. Don't quote a physhing link, scam post or shitpost because your own post together with their shits will end up being deleted or if lucky on off topic.

2. Don't always quote while posting except if necessary and try to learn how to edit out some contents before posting to make your quote more specific.

3. Don't join in mega quoting always whereby more than four or five quotes have already been made and you're making an additional quote on them.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
June 02, 2023, 12:54:51 PM
#16
My people, the day wey I notice say this forum pass bounty matter , that day I just dey curious to know more about other boards, na so I just see 'new post' under one particular board like that. Na so hit the button , e carry me go where I go write. Hmmm. I begin write ooo, later I con post am.

After I post am, body they shark me . After small time people they throw away reply give me, body con dey shark me more, the sharking make me reason am say, I dey see people they reply others for their post. So I decide to hit the quote button , boom na ihm be that.

As I know how to reply people, I start to deu reply every single person wey reply for my post.
Make I no lie you, people wey de do bounty get reason for doing that even though we know say the bounty no de pay like before as much project no de legit as before, but I know say one day dem go cash out too.

But this forum is actually pass bounty  by far because if you de do bounty, you no go know anything we de happen for other sections of the forum, and there some good information about Bitcoin in the other sections.

The reply wey you de talk na the same thing with the normal proof of authentication and link submission wey bounty hunters de do, but their own na mainly on the same bounty thread.

Quote
The shock I later recieved be say when I later logins I recieve message say my quote dey deleted cause some of my quote(reply) just be like, "that's good, thanks, absolutely right". Na den I con realize say unnecessary posting is not needed. I go back to the rule to know what is needed. I go thank lovesfamily for in support as inh take plead for me for some of post wey get mistake as some people dey throw way Banga for me.

Now I don learn my lesson
Those small small reply de look like spam, na why moderators de delete them.

We de always learn, so na normal thing mate, the ting be say as you don improve make u keep am up and I de assure you say you go get reward for this.
My chairman  no bex say I have to qoute your entire  thread because your writing deserve because I no ean dey quote you small small.
@op I've the fact say  you fey realize your mistakes and you dey build on dem because that actually na the first step to growth and progress  especially for the forum and i don review  your post and you dey do absolutely  well and I wan also encourage you say make you no give up even if the criticisms later plenty and also try to read the profiles of persons like @Charles-Tim, @CryptopreneurBrainboss, @Mpamaegbu @GeorgeJohn and a whole lots of them from local board and also learn from them.
Goodluck
member
Activity: 212
Merit: 12
June 02, 2023, 10:40:09 AM
#15
My people, the day wey I notice say this forum pass bounty matter , that day I just dey curious to know more about other boards, na so I just see 'new post' under one particular board like that. Na so hit the button , e carry me go where I go write. Hmmm. I begin write ooo, later I con post am.
After I post am, body they shark me . After small time people they throw away reply give me, body con dey shark me more, the sharking make me reason am say, I dey see people they reply others for their post. So I decide to hit the quote button , boom na ihm be that.

As I know how to reply people, I start to deu reply every single person wey reply for my post.

The shock I later recieved be say when I later logins I recieve message say my quote dey deleted cause some of my quote(reply) just be like, "that's good, thanks, absolutely right". Na den I con realize say unnecessary posting is not needed. I go back to the rule to know what is needed. I go thank lovesfamily for in support as inh take plead for me for some of post wey get mistake as some people dey throw way Banga for me.

Now I don learn my lesson
Well it's good you have learnt something from what you did ok,so try to always follow up the instructions and make sure you understand what was written there before you can make attempt to contribute or comment on it to avoid this kind of mistake, and to avoid being banned for going against the rules and regulations guiding the certain websites ok, information is very very important in everything we do ok..
hero member
Activity: 896
Merit: 653
May 31, 2023, 12:38:06 PM
#14

The shock I later recieved be say when I later logins I recieve message say my quote dey deleted cause some of my quote(reply) just be like, "that's good, thanks, absolutely right". Na den I con realize say unnecessary posting is not needed. I go back to the rule to know what is needed. I go thank lovesfamily for in support as inh take plead for me for some of post wey get mistake as some people dey throw way Banga for me.

Now I don learn my lesson
It's good you got to realize on time that this forum has got something more of value than bounting hunting, and im happy for you for discovering on time, because the the forum has rules and whenever violated, it is the work of moderators to take action on time, and those rules are listed on this forum which is a must read for every beginners, which if you never read am, here is the link Unofficial list of (official) Bitcointalk.org rules, guidelines, FAQ and this other one Newbies - Read before posting

You just have to note that the forum frown at members writing only 2 or 3 letter words in the comment sections (i.e Thanks you & That is good) as all of these are classified as spam.
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
May 31, 2023, 08:54:32 AM
#13
From my understanding of your post e be like say na the person wey carry you come this forum,na e tell you about bounty. If not how you take know about bounty and come put more interest for am. This forum was created to learn and educate users about bitcoin and other crpytocurrency and you wet come the forum then deviate from this purpose,the management board and other forum members go see you as person wey see the forum as a place to cash out instead of learning. This go make people no send you or to assist you with merit so that make you too grow. Bounty na chasing of shadows because better money dey signature campaign when you don rank up to participate for Sig campaign. I happy say you don realize your mistake and come wake up fast to follow up for the general boards. I beg e good make any new place wey you find yourself,make u know how them dey do things for there either by asking or reading so that you no go do things anyhow wet go fit implicate you.
sr. member
Activity: 574
Merit: 308
May 31, 2023, 07:31:53 AM
#12
My people, the day wey I notice say this forum pass bounty matter , that day I just dey curious to know more about other boards, na so I just see 'new post' under one particular board like that. Na so hit the button , e carry me go where I go write. Hmmm. I begin write ooo, later I con post am.

After I post am, body they shark me . After small time people they throw away reply give me, body con dey shark me more, the sharking make me reason am say, I dey see people they reply others for their post. So I decide to hit the quote button , boom na ihm be that.

As I know how to reply people, I start to deu reply every single person wey reply for my post.

The shock I later recieved be say when I later logins I recieve message say my quote dey deleted cause some of my quote(reply) just be like, "that's good, thanks, absolutely right". Na den I con realize say unnecessary posting is not needed. I go back to the rule to know what is needed. I go thank lovesfamily for in support as inh take plead for me for some of post wey get mistake as some people dey throw way Banga for me.

Now I don learn my lesson
This is how life suppose be na... When you do mistake you should have people to put you through into the right way but majority of our people here like to criticizes rather than to correct. I commend your courage for the trial and heed to correction. If the high rank members here in our midst are ready to help we'll have been more successful in this forum than we are now. Some of them are really are icon and deserves some accolade but some among them are very selfish set of people who don't like others to prosper.
sr. member
Activity: 434
Merit: 500
May 31, 2023, 07:28:53 AM
#11
My people, the day wey I notice say this forum pass bounty matter , that day I just dey curious to know more about other boards, na so I just see 'new post' under one particular board like that. Na so hit the button , e carry me go where I go write. Hmmm. I begin write ooo, later I con post am.

After I post am, body they shark me . After small time people they throw away reply give me, body con dey shark me more, the sharking make me reason am say, I dey see people they reply others for their post. So I decide to hit the quote button , boom na ihm be that.

As I know how to reply people, I start to deu reply every single person wey reply for my post.

The shock I later recieved be say when I later logins I recieve message say my quote dey deleted cause some of my quote(reply) just be like, "that's good, thanks, absolutely right". Na den I con realize say unnecessary posting is not needed. I go back to the rule to know what is needed. I go thank lovesfamily for in support as inh take plead for me for some of post wey get mistake as some people dey throw way Banga for me.

Now I don learn my lesson
Na why dem de always advise say make we read the rules first before we do anything here. I think say you de lucky say you no go mistakenly commit offense. Sometimes we learn through taking risk sha but pls lets all be careful, there is nothing bad in asking questions when you need answers.
This forum large and a lot de happen inside this forum, na just when you de enter inside different sections you go find out say almost everything wey de run for this world dey happen here too. This forum pass just bounty and e get plenty opportunities wey de here.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
May 31, 2023, 04:43:34 AM
#10
My advice to you be sae leave bounty hunter work and focus on building your account. You see this bounties wey you d rush to d do and complete there weekly post no worth am. Many of them na scam, some there tokens na worthless even if em worth something na small amount of the token you go finally get due to the involvement of many bounty hunters participant. I d tell you this because of my past involvement with altcoin bounties.

Having said that there are so many things to learn from this forum if you navigate through other board sections. The more you begin to go through other boards na so em go the open up your reasoning of wetin you need to learn and unlearn for the forum via making posts, replying posts.

You see as your forum account d so, em d like your office. You need to build am properly because you will be rated by what you engage yourself into with it. Your post history is made up of your participation in altcoin bounties. Em no make sense atall if I should advice you
sr. member
Activity: 630
Merit: 420
May 31, 2023, 04:22:27 AM
#9
My people, the day wey I notice say this forum pass bounty matter , that day I just dey curious to know more about other boards, na so I just see 'new post' under one particular board like that. Na so hit the button , e carry me go where I go write. Hmmm. I begin write ooo, later I con post am.
You try ooo, I don even check your post history and I see say e no bad, but make we all still dey careful, incase if you no sabi something local board dey for you wey u go fit ask, nobody go blast you for here, highest dey go correct you. make you try avoid plagiarism, anything wey you wan write and you know say no be you get am make sure say you quote where u copy am from and make sure say you add source link, e dey very important, if you don add source link no body fit talk say u plagiarize again.

Me self na bounty I dey do before, na as I see say bounty no dey pay again na why me self come dey try rank up small small I come enter signature, you self fit rank up, Dis one wey na just rubbish bounties dey now, u no go really make any better money.
hero member
Activity: 896
Merit: 645
May 30, 2023, 07:30:41 PM
#8
My broda, na since June last yr u join dis forum o. Since den, ur matter b lik na bounty chop ur head else, u na old persn 4 d forum way suppose don rch far. Anyhw e be, u don see say better no dey 4 where u bin dey luk nd u don dey try anoda side. Na d better tin u don do b dat.

Watin I go like mak u do now b say, mak u try avoid anytin bounty, commot bodi. U no fit dey that way nd u go xpect say pple 4 here go tak u serious. I jst run tru ur post history nd ur report jst plenty everywhere lik say, u nevr commot hand.
Go delete ur bounty post dem mak pple carri anoda eye dey see u.
Pages:
Jump to: