Pages:
Author

Topic: Nah lack of common sense or greed?? (Read 830 times)

member
Activity: 289
Merit: 29
January 10, 2024, 05:01:20 AM
#64
I say make I bring this mata come here make we discuss. I wan hear our different opinions on how we fit stop this menace. We no be strangers to the dangers wey tanker wey dey carry fuel come get accident dey cause. The issue of bad roads nah another thing to consider and also, sometimes carelessness of the driver becos him go dey drive like say nah sports car him dey use.

But where the gbese dey nah on how people go dey rush to go collect fuel wey dey spill, not minding the possible danger to life wey if small spark happen, dem fit roast.
Recent incidence wey happen for Ondo state of how tanker wey dey carry fuel get accident and people go rush to pack fuel, e no end well as 15 people kpai for the ensuing explosion wey take place not too long after..

Some go say na due to the fuel scarcity nai make them rush, others go say dis na opportunity to take get money after them sell am, but my question be say how we fit stop out loved ones from this sort of risky movement? You feel say our government dey partly to blame or nah just lack of common sense dey worry us so??

But wait oo, if you mah sef get oil business and you dey transport oil like that, common sense no go tell you say the road suppose good first ? This kind thing, no be to help fix the road or if na national road complain to the legit governmental body make them fix am?  Everybody get fault for the death of those people oo. Government weh no gree do their duties , owner of business weh no do him SWOT analysis well and people weh see opportunity no know say na death dey call them.

Naija normally, like to dey do this kind thing. Even when some supermarkets go catch fire weh people go dey run, na there you go see Naija dey enter dey carry free things.

As to keeping my family and relatives safe,na only prayer oo, cause me sef no know watin I wan tell them. " No enter place weh get fire or no go fetch oil from spilling truck"  shebi dem suppose already know all this one. Na only God fit save us for this country ooo
member
Activity: 322
Merit: 70
January 08, 2024, 08:07:01 AM
#63
Normally pipo for Naija sabi take risk.Make we leave the government first from dis mata but we go also blame dem becos na refineries wey we no get nai make fuel scarce.To me na lack of common sense.Even oyibo man talk say common sense is not common.How person go hear say fuel spill from tanker,come get mind carry him bucket some go even carry their jerrycan go fetch the fuel wey them know say explosion fit take place anytime.Nobody go tell me say e no know say fire dey burn.My country pipo normally we know say to make am for life we go bear risk but risk dey pass risk,some pipo wey dey go take the fuel wey spiil na sell dem wan sell am take meet up their needs but dem ignore the risk behind am.Make we remember say life na one oh........
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
December 07, 2023, 05:41:01 AM
#62
For this matter en, I go say we nor suppose blame the government. Even if we wan blame them, na to blame them for bad road, because many of these accident na bad port holes dey cause am. If I go rate the percentage of the cause of this kind of accident I go say 30% na to the government for bad roads, then 20% na to the driver wey dey drive like say na fast and furious without watching the road well or slow down for bad place, because every company wey dey deal with road movement supposed get required speed limit wey truck drivers nor supposed exceed for express or for inside town. Then 50% of the blame dey go to the individuals wey carry thief for mind to take go collect wattin no be their own, why human being go even think of to go collect fuel from tanker wey get accident and fuel dey pure. The one wey come dey vex me pass na the foolish ones wey go come go try to smoke around there, or cause fire for there. Sometimes I dey imagine if na send Dem even send Dem to do that kind of thing, or abi na suicide bomber wey see another opportunity.
member
Activity: 364
Merit: 89
Reward: 10M Shen (Approx. 5000 BNB) Bounty
November 28, 2023, 06:34:27 PM
#61
People are suppose to be considering both negative and positive aspect of something but it is now obvious that people only have thought of the positive outcome of things and sometimes it is not like they're not aware of what would possibly happen if reverse is the case but yet they still involve themselves. Well I think government  should be taken out of this because someone  who is really  reasonable and satisfied with what he/she has will never involve himself/herself and most of the people that are always fall victim are poor people.
full member
Activity: 160
Merit: 84
October 17, 2023, 05:38:11 AM
#60
This matter, I go say na "lack of fear of death" person wey dey fear death no go near that kind place. Even the stories we've been hearing and videos of this kind of incident and how it ends should be enough to teach people but no, them ready to die put for how much.
The only thing I would blame the government for is the poor state of the country but this very act by an individual should never be blamed on the government. It's pure greed on their part. I pray my loved ones have sense so they won't find themselves in that kind of situation.
hero member
Activity: 2660
Merit: 630
Vave.com - Crypto Casino
October 17, 2023, 05:27:30 AM
#59

For Me, I feel say the best thing we fit do for this matter na Sensitize and teach pipo the dangers wey surround accident tankers. Especially for individuals wey dey live for communities along the Expressways. Working together with the communities development committee/council and Youth. As statistics don show say na youth dey be the victims of this explosion.


E no get how you want take sensitize people wey someone no go still fall victim, in fact plenty people. Some people go always feel say them smart pass others so when dem go scoop Dem go escape before anything go happen but the unfortunate thing be say e no dey give sign for that to happen.

So sensitization fit still dey go on but people go still dey want help demselves by deir own means while some people will never try go there and that is the difference. This kind death no be news again but people go still dey fall on it.

For government side, na to build better road, create enabling environment for jobs for the youth so that if you remember say you get where you go from feed yourself, you go relax if that kind thing happen. However, some people go still enter go risk their lives even if Dem get jobs.
member
Activity: 181
Merit: 39
October 16, 2023, 10:43:32 PM
#58

For Me, I feel say the best thing we fit do for this matter na Sensitize and teach pipo the dangers wey surround accident tankers. Especially for individuals wey dey live for communities along the Expressways. Working together with the communities development committee/council and Youth. As statistics don show say na youth dey be the victims of this explosion.
My guy, my pipo dey tok say "fly wey not dey hear word go folo dead bodi enter grave". E no get as e wan be, if you like put am for news or anyhow you wan take pass the message on the dangers of taking fuel from a fallen tanker, pipo go still pay deaf ear rush go when anoda opportunity come. You know wetin e be? A litre of fuel now nah #630. Calculate am by say 25litres wey dem fit fill and no be just one jerrican Dem go fill o. The idea of the moni wey them stand to gain go outweigh the risk to their lives and nai make everytime we still dey get scores of casualties.
full member
Activity: 560
Merit: 161
October 15, 2023, 04:05:00 PM
#57
For Me, I feel say the best thing we fit do for this matter na Sensitize and teach pipo the dangers wey surround accident tankers. Especially for individuals wey dey live for communities along the Expressways. Working together with the communities development committee/council and Youth. As statistics don show say na youth dey be the victims of this explosion.

My brother even for school wey we go, no be everything wey dem dey teach us, for dis matter I no sure say dem need any lecture concerning fuel and explosion.
Nobody go tell you say fire dy burn even if e never burn you at least you don see am or hear how e dy burn people so all dese things no need teaching and all before people for dat community to get sense say fuel and fire no be the same road dem dey follow.
For this matter nah just greed and stupidity nai dy cos am seriously, nothing more.

I go agree with you because I believe say you know fit learn everything for school, church even for house self rather some things person gats use em own initiative or akonuche as some people dey call am. I believe say poverty self no be wetin dey make some people dey do some kind bad things na just mumu and foolishness including greed wey dey dia body if not, how person go open eyes go near tanker wey carry explosive product like fuel and others? I no dey pity any youth wey die as a result of and tanker explosion again for naija because I believe say anybody wey see tanker wey fall go dey rush carry fuel death dey hungry the person.
People wey dey see tanker when e fall and run to it to get petrol know say this liquid is explosive but them no just care about their life, greed has taking over them and make them to not reason say e fit cause explosion. I no really blame this people why dem they pit their life at risk because if to say the government they do the right things people for they fear to go close to tanker when fall. If the system is working fine for the youth dem for no dey go break pipeline containing crude oil just to make a living . Because of how the government don keep the country,  youth no dey fear wetin go fit kill dem.
full member
Activity: 952
Merit: 232
October 15, 2023, 11:17:10 AM
#56
This thread have been here for months but I never make comment, na because I no dey tok matter wey cryptocurrency related e no dey. I dey only discuss topics wey get cryptocurrency related matter dem. Dis matter na very serious matter and if you bring dis matter to real life situation, my mate you no go fit stop am because there are different things wey dey make people to go there dey collect fuel in respective of the danger and if you tell them to stop. Some people will even tell you say it is better they die than living because there living is not better than dead pesen.

Me I blamed di government for two things in dis matter like this. Number is bad road. And number two na unemployment. Dis two things na dey make people to go such place for survival. As you op tok am some dey go there ey take I fuel to on gen because dem no get money to buy while di other dey collect am to sell because dem no get money. And I no believe say anyone wey dey work go do dat kind thing.
Even work get levels. Anyone wey dey work wey get mind go scoop fuel from fallen tanker, get the kind work wey e dey do wey make am get that kind mind.

The funny thing is that it happens every time. Ones tanker fall, scoopers or scavengers must gather. Not only tanker self, even cargo carrying trucks dey exposed to this kind of incident too.

I think if the roads dey repaired to some extent this issue of fallen tanker and scoopers go reduce. Also, if you see the people wey dey drive the truck, besides the fact say some dey high on hard drugs, some are just small kids in their early 20s. Dem no suppose dey handle such consignment in the first place. Adults responsible enough should instead be allowed to drive these trucks/tankers.

I also think this na why sensitization workshops and campaigns on the introduction of Bitcoin and also the dangers of such practice of scooping fuel from fallen tankers to children from primary schools and even to those on the street go help the next generation dey aware and go make dem smart enough to avoid such scenario from happening.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Hire Bitcointalk Camp. Manager @ r7promotions.com
October 15, 2023, 10:37:24 AM
#55
This thread have been here for months but I never make comment, na because I no dey tok matter wey cryptocurrency related e no dey. I dey only discuss topics wey get cryptocurrency related matter dem. Dis matter na very serious matter and if you bring dis matter to real life situation, my mate you no go fit stop am because there are different things wey dey make people to go there dey collect fuel in respective of the danger and if you tell them to stop. Some people will even tell you say it is better they die than living because there living is not better than dead pesen.

Me I blamed di government for two things in dis matter like this. Number is bad road. And number two na unemployment. Dis two things na dey make people to go such place for survival. As you op tok am some dey go there ey take I fuel to on gen because dem no get money to buy while di other dey collect am to sell because dem no get money. And I no believe say anyone wey dey work go do dat kind thing.
sr. member
Activity: 756
Merit: 454
October 15, 2023, 05:36:30 AM
#54
For Me, I feel say the best thing we fit do for this matter na Sensitize and teach pipo the dangers wey surround accident tankers. Especially for individuals wey dey live for communities along the Expressways. Working together with the communities development committee/council and Youth. As statistics don show say na youth dey be the victims of this explosion.

My brother even for school wey we go, no be everything wey dem dey teach us, for dis matter I no sure say dem need any lecture concerning fuel and explosion.
Nobody go tell you say fire dy burn even if e never burn you at least you don see am or hear how e dy burn people so all dese things no need teaching and all before people for dat community to get sense say fuel and fire no be the same road dem dey follow.
For this matter nah just greed and stupidity nai dy cos am seriously, nothing more.

I go agree with you because I believe say you know fit learn everything for school, church even for house self rather some things person gats use em own initiative or akonuche as some people dey call am. I believe say poverty self no be wetin dey make some people dey do some kind bad things na just mumu and foolishness including greed wey dey dia body if not, how person go open eyes go near tanker wey carry explosive product like fuel and others? I no dey pity any youth wey die as a result of and tanker explosion again for naija because I believe say anybody wey see tanker wey fall go dey rush carry fuel death dey hungry the person.

Ok nah as dem wan blame am on government and poverty or even no food I believe say as dem don roast now dem dey chop d food wey dem no get even d lack of job dem don get am and d rest of d suppose cos of wetin make dem go carry fuel.
People no wan learn how to survive instead dem ready to go d easy wey of making it which is d result dem get so, unnecessary death.
Like dis now I know say tanker wey go fit explode at any time nai I go carry my one life wey God give say I wan go carry fuel say I dy craze? Which kind money wey better pass life na, even tanker wey pass moto wey I enter e dy do me to come down make d moto pass before I continue my journey nai go rush go carry fuel, God forbid.. Like dis common sense don finish for this contri.
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
October 15, 2023, 04:02:15 AM
#53
For Me, I feel say the best thing we fit do for this matter na Sensitize and teach pipo the dangers wey surround accident tankers. Especially for individuals wey dey live for communities along the Expressways. Working together with the communities development committee/council and Youth. As statistics don show say na youth dey be the victims of this explosion.

My brother even for school wey we go, no be everything wey dem dey teach us, for dis matter I no sure say dem need any lecture concerning fuel and explosion.
Nobody go tell you say fire dy burn even if e never burn you at least you don see am or hear how e dy burn people so all dese things no need teaching and all before people for dat community to get sense say fuel and fire no be the same road dem dey follow.
For this matter nah just greed and stupidity nai dy cos am seriously, nothing more.

I go agree with you because I believe say you know fit learn everything for school, church even for house self rather some things person gats use em own initiative or akonuche as some people dey call am. I believe say poverty self no be wetin dey make some people dey do some kind bad things na just mumu and foolishness including greed wey dey dia body if not, how person go open eyes go near tanker wey carry explosive product like fuel and others? I no dey pity any youth wey die as a result of and tanker explosion again for naija because I believe say anybody wey see tanker wey fall go dey rush carry fuel death dey hungry the person.
sr. member
Activity: 756
Merit: 454
October 15, 2023, 01:37:04 AM
#52
For Me, I feel say the best thing we fit do for this matter na Sensitize and teach pipo the dangers wey surround accident tankers. Especially for individuals wey dey live for communities along the Expressways. Working together with the communities development committee/council and Youth. As statistics don show say na youth dey be the victims of this explosion.

My brother even for school wey we go, no be everything wey dem dey teach us, for dis matter I no sure say dem need any lecture concerning fuel and explosion.
Nobody go tell you say fire dy burn even if e never burn you at least you don see am or hear how e dy burn people so all dese things no need teaching and all before people for dat community to get sense say fuel and fire no be the same road dem dey follow.
For this matter nah just greed and stupidity nai dy cos am seriously, nothing more.
full member
Activity: 448
Merit: 163
October 14, 2023, 12:25:06 PM
#51
I say make I bring this mata come here make we discuss. I wan hear our different opinions on how we fit stop this menace. We no be strangers to the dangers wey tanker wey dey carry fuel come get accident dey cause. The issue of bad roads nah another thing to consider and also, sometimes carelessness of the driver becos him go dey drive like say nah sports car him dey use.

This your matter need to be reason seriously not only by ours here is government that supposed even considering this kind of matter you brought here. Because is due to bad road that we have in Nigeria na him dey make does tanker dey fall any how, is not that the drivers are driving careless. Because their some situation that they have to drive it like that, to be honest does tanker drive are really try their best if not is not an easy work them o, if government will think wisely and consider does big truck and trailer and provide better roads for them I think it will be good ideal, so that they won't be distop the small cars and they will actually save it will even avoid to much of accident.
Quote

But where the gbese dey nah on how people go dey rush to go collect fuel wey dey spill, not minding the possible danger to life wey if small spark happen, dem fit roast.
Recent incidence wey happen for Ondo state of how tanker wey dey carry fuel get accident and people go rush to pack fuel, e no end well as 15 people kpai for the ensuing explosion wey take place not too long after..

Some go say na due to the fuel scarcity nai make them rush, others go say dis na opportunity to take get money after them sell am, but my question be say how we fit stop out loved ones from this sort of risky movement? You feel say our government dey partly to blame or nah just lack of common sense dey worry us so??

If no be some people that are out of their common sense how will you see what will destroy your life and still you push yourself in to there, just because them see that the tanker had an accident nai make them rush go there so that they go see fuel pack, imagine something wey no belong to them o what of in process of packing the fuel and the tanker catch the fire na so they are going die for nothing. Because immediately the tanker catch fire I don't think dey will ascape.

This your matter make me remember one incidence that happened for our side, exactly this can of issues happened to one guy him was sent to town then on his way going E saw one tanker had an accident, na so the guy take pack his machine o for side and go direct to were people are pack the fuel and join them too at the end day after him don finished pack the fuel him came back to were he drop the machine he saw empty place dey stole his machine. E cause big problem for him self because of small fuel wey e get pack, that's is good for us to be avoid this can things.
newbie
Activity: 1
Merit: 0
October 14, 2023, 02:01:52 AM
#50
I say make I bring this mata come here make we discuss. I wan hear our different opinions on how we fit stop this menace. We no be strangers to the dangers wey tanker wey dey carry fuel come get accident dey cause. The issue of bad roads nah another thing to consider and also, sometimes carelessness of the driver becos him go dey drive like say nah sports car him dey use.

But where the gbese dey nah on how people go dey rush to go collect fuel wey dey spill, not minding the possible danger to life wey if small spark happen, dem fit roast.
Recent incidence wey happen for Ondo state of how tanker wey dey carry fuel get accident and people go rush to pack fuel, e no end well as 15 people kpai for the ensuing explosion wey take place not too long after..

Some go say na due to the fuel scarcity nai make them rush, others go say dis na opportunity to take get money after them sell am, but my question be say how we fit stop out loved ones from this sort of risky movement? You feel say our government dey partly to blame or nah just lack of common sense dey worry us so??

For Me, I feel say the best thing we fit do for this matter na Sensitize and teach pipo the dangers wey surround accident tankers. Especially for individuals wey dey live for communities along the Expressways. Working together with the communities development committee/council and Youth. As statistics don show say na youth dey be the victims of this explosion.
full member
Activity: 322
Merit: 211
October 13, 2023, 06:38:06 PM
#49
From this yarn you drop, e show say no lives were lost and I happy for that one but the Koko be say when govt fail to attach importance to these little areas, small small e go become big problem. How fire department no go get the necessary tools to take quench fire?
In another sense, this senseless act of scooping fuel go stop if govt bring back subsidy sef?
  Subsidy or no subsidy naija no go see opportunity leave am, we day always use the predicament of others to our advantage, na watin the county don turn us into to day feast on one another. I no day support the scooping of fuel from tanker, because things like this no fit sup for civilize countries. Our government don day fails us they come and no be today e start. First of all, all this tankers them no suppose day use residential roads, if the governmental get the ot they for create another special lane for them tankers and big trucks ee no go only free up the small roads we get, he go even make am last well, all this road congestion we day always get we no go day see am again, if all this tankers and big trucks get their own lane. Or better still make them day commot for night when road don free. Our lapses too much for this our country, government day fuck is up, even we sef the civilians we bo day even help matters. Na watin our government turn us into, they turn us to survivors. We no even day do second thought, some to say na opportunity to chop government money wen be say their life day at risk. All this for no day if we day properly civilize, na the system way we find ourselves be that.
hero member
Activity: 966
Merit: 620
October 13, 2023, 06:04:34 PM
#48

My brother, this fire service matter me self get first hand experience. Dis one happen some years back for school, me and one of my departmental guy dey go lecture hall when see sight thick smoke for girls hostel. Naso we jog reach there, on getting there we come see few persons wey dey try to break into the building to safe some properties. Small small, crowd come gather, some people dey pour sand, some dey pour water with buckets, while others dey cry.

After like 15 mins we come dey hear siren, naso fire service take land, very clean truck as you dey take see am for oyibo movies. Boys come dey happy as we see them. This men park their truck, dem no use the hose release water into the fire, dem go open one side tap wey water dey come out. After dem pour like 2 buckets of water into the fire, dem say water don finish say dem wan go fetch water. Naso boys leave building wey dey on fire dey chase the truck with stones and clubs, dem chase the truck comot from school enter major road, those men get luck to escape death. The fire bring the building down but my state governor been come intervene, build another hostel.
From this yarn you drop, e show say no lives were lost and I happy for that one but the Koko be say when govt fail to attach importance to these little areas, small small e go become big problem. How fire department no go get the necessary tools to take quench fire?
In another sense, this senseless act of scooping fuel go stop if govt bring back subsidy sef?
full member
Activity: 434
Merit: 202
Duelbits.com
October 13, 2023, 04:17:38 PM
#47
Firstly anything wey dey happen for this country dey always get trace to government and Tru Tru no be lie somehow government get hand for almost every gbese wey dey happen, no b like say I dey try blame government for everything but then if to say government been dey do well e for dey prevent somtins even before them happen so that's y I dey blame dem.

But the main time be say we suppose dey get sense to dey help oursef no be everytin we go wait till government do am well before we go com say make we dey alright. Now numba one d issues of bad road dat wan na government get the full blame we no need to drag dat wan, den country pipo wey go dey rush dey Carry fuel, we know say hunder dey wey fit dey cause am but den some risk no worth am no mata d excuse, common sense suppose tell dem say e dey too risky but d hunger go cover dia eye so tae dem go forget. But if government dey help regulate dis tinz well, make road safety dey active wen timz like dis happen dem stop pipo from going close and also dey educate dem about d dangers, many many ways dey Sha but I no fit talk all now.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
October 13, 2023, 03:38:09 PM
#46
Nah so news put am say the fire department come to the scene speedily but if say we get person as eye witness wey for like tell us wetin happen you go find out say fire service waste time. Wetin make me tok like this? E get when fire outbreak bin happen as a result of illegal hoarding of fuel for my side; nah so we wait fire services sotey properties come dey followndet destroyed. Nah boys for the area put off the fire, after 20mins nah we see them dey stroll to come put out fire. I no fit para.
My brother, this fire service matter me self get first hand experience. Dis one happen some years back for school, me and one of my departmental guy dey go lecture hall when see sight thick smoke for girls hostel. Naso we jog reach there, on getting there we come see few persons wey dey try to break into the building to safe some properties. Small small, crowd come gather, some people dey pour sand, some dey pour water with buckets, while others dey cry.

After like 15 mins we come dey hear siren, naso fire service take land, very clean truck as you dey take see am for oyibo movies. Boys come dey happy as we see them. This men park their truck, dem no use the hose release water into the fire, dem go open one side tap wey water dey come out. After dem pour like 2 buckets of water into the fire, dem say water don finish say dem wan go fetch water. Naso boys leave building wey dey on fire dey chase the truck with stones and clubs, dem chase the truck comot from school enter major road, those men get luck to escape death. The fire bring the building down but my state governor been come intervene, build another hostel.
hero member
Activity: 966
Merit: 620
October 13, 2023, 01:08:36 PM
#45
Another tanker carrying fuel goes up in flames this morning at the Otedola bridge, Berger area of Lagos.  According to reports, there's no news of any casualty but the one wey dey pain me nah say despite the fire, people still dey go scoop fuel Roll Eyes..why e still be say people Neva dey get sense? We dey always test fate, abi nah when this kind tin wipe major part of a city before them go get sense? See more for here...https://www.channelstv.com/2023/10/12/just-in-tanker-explodes-at-iganmu-bridge-lagos/
Another man stupidity fit cost the lives of several others. When e happen now we go begin to blame Satan. I know no why some people dey get this kind mentality, we don hear stories of how fatal fuel tanker explosion dey be, but dem go choose to dey test fate. De fuel wey dem dey scope na how much wey dem want sell am and how e go take improve their lives? Well, I thank God no life was lost and also for the quick response of fire service and other emergency response teams. My life too dey important and if I get shop or office, around the place wey the tanker fall, I don close for that day.


Nah so news put am say the fire department come to the scene speedily but if say we get person as eye witness wey for like tell us wetin happen you go find out say fire service waste time. Wetin make me tok like this? E get when fire outbreak bin happen as a result of illegal hoarding of fuel for my side; nah so we wait fire services sotey properties come dey followndet destroyed. Nah boys for the area put off the fire, after 20mins nah we see them dey stroll to come put out fire. I no fit para. Make govt try to dey put moni for these bodies to help encourage them. Some of their equipments don spoil or e no dey work again. Some of the workers no get joy to even dey come work because who knows, some of them fit never collect pay.
 But as for this mata of people scooping fuel when tanker fall, nah only God go fit save them.
Pages:
Jump to: