Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 154. (Read 1025788 times)

hero member
Activity: 1064
Merit: 501

Una see that thing about greed and shamelessness. See this ex-footballers weh we think say go even deh on the part of the youth don sell themselves give Tinubu. Kanu and Okocha deh there self. Ikpeba shock me too. See as that one called Taribo West deh vibrate there say him deh pray. I sabi say them get right to their choice of politician to support but na with old cargo like Tinubu? This is shameful. Men supposed get class and shame na. See picture of their meeting with Tinubu and the video of Taribo praying below.
You see this our football heroes, their shame the catch me more especially Kanu and Okocha. If you get money, call them both(Kanu and Okocha) dem go come endorse you. Naso both of them go endorse Bello for Presidency last year. I no dey surprise of seeing them both.
All man for this our country d hustle for dia pocket dem no mind wetin tomorrow go be.
It's a pity that the youths longer no longer be the future of tomorrow for this our country since Tinubu go get mind commot as the the president of Nigeria and em expect sae em go win. An wetin d mad me.
hero member
Activity: 812
Merit: 560
The House of Representatives wants automatic employment for first class graduates from Nigerian institutions.



https://www.channelstv.com/2022/03/16/brain-drain-reps-seek-automatic-employment-for-first-class-graduates/amp/

I pray so say dis no go only be on paper news but turn a reality 4 dis awa naija ehnnn, i swear dis na my first time of coming to see d govement reasoning graduates first class 4 dat mata, for this world notin wey no fit change o because I can remember some times back that if a first class graduate apply for employment dem no dey giv am because they themselves know say den no get qualification near 2nd class sef, na d 1st class lahlah graduates dey suffer employment pass 4d contry.

Now wey dey don wake up see say awa guyz bin dey japaa out of d kontri in seeking 4 greener pasture, triger dem 2 offer dis peanut implementation when we have over millions of graduates every year with no adequate plan 4 dia future as a kontri, are the youth not d future of d kontri? if dey can neglect awa graduates wat of the non graduates, is dia a plan 4 dem? Baba God go kuku help us 4 dis kontry.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504

Una see that thing about greed and shamelessness. See this ex-footballers weh we think say go even deh on the part of the youth don sell themselves give Tinubu. Kanu and Okocha deh there self. Ikpeba shock me too. See as that one called Taribo West deh vibrate there say him deh pray. I sabi say them get right to their choice of politician to support but na with old cargo like Tinubu? This is shameful. Men supposed get class and shame na. See picture of their meeting with Tinubu and the video of Taribo praying below.



https://www.facebook.com/803267836/posts/10162301162887837/?app=fbl
Na like this them wan carry scam us! Omo, this men them nor suppose dey do these things abeg. Watin concern football past hero's with matters of politics. I know say them be citizens and all that but, the  endorsing Tinubu for presidency nor mean say Tinubu never show the  least love to push there actions.

I don tire to dey see the same old faces and billionaires dey rule us abeg. People way no even been do well for there previous office cef, team go con feel say, na this new office them go make better impact. If at all I wan support anybody, na one fresh youth or person way en face never too show for the matter I got reason. Make these men them go buy relaxer and chilax for there domain.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
9ja needs a futuristic leader. Leader that can set things right when we go get things right 2023 don come and na time to choose another leader which direction we dey go.

E get when I dey optimistic like you, I bin dey hope say good leaders go emerge, futuristic leaders like you said. But since I put body for politics matter I realise say most of these things na dream wey no go manifest or na for our grand children time e go manifest.
The system was laid on a faulty foundation, hence is faulty.
The system it's is corrupt.
The system has a way to recruit the corrupt to man it.
When a non corrupt eventually emerges, he must turn corrupt.
SEE make I shock you, if Buhari rule finish, all those men wey make Buhari win go still be president finish, and nobody ready carry him slot give youths. So forget am.
Unless na the process we produce bitcoin, go one day help us.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
()
I no dey like do 9ja politics analysis because our politics na just like every other African politics were don dey since the inception of 9ja and Africa as a whole, we get common features for we politics which are:
1. Seat tite syndrome
2. Politics of Rivalry
3. Politics of Blood shedding/ political thuggery.

 One other thing na political party, affiliation better known as (partisan politics)
All this thing done divide our politics for Africa, democracy is not practice in it pour sense for Africa so we no fit talk waiten dey really happen na why people were fit do gragra dey enter power be that.
I get believe say Tinubu go become 9ja President unless God say otherwise and this na my belief base on personal conviction no be any affiliation but make we tell ourselves the truth na waiten we really need? The answer dey your 🙌.
Who order Lekki shooting we don forget END SAR so soon, what about the Twitter ban, even we crypto CBN ban.
9ja needs a futuristic leader. Leader that can set things right when we go get things right 2023 don come and na time to choose another leader which direction we dey go.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
The Number of Crypto Users in Africa Grew By 2,500% in 2021

Despite estimated 45% of adults that owns smart phones and 33% that can access the internet on a stable basis in Africa. Yet, Africa has the highest rate in bitcoin and crypto adoption in general in 2021, even despite 86% in Europe and 81% in US that have access to a stable internet.

The latest data collected by KuCoin reveals that crypto transactions have increased by 1,250-2,670% over the past year in the aforementioned countries. Such growth dynamics are also related to the low values that have been observed during previous periods, as the amount of crypto transactions in Africa constitutes 2.8% of global volumes.

The average number of monthly transactions across African countries has shown a 1,386.7% increase from January 2021 to January 2022. The number of users has also increased significantly, showing a 2,467.2% spike over the same period. The average amount per transaction has, however, decreased, indicating that the adoption of this technology is taking place not only for large transfers, but for small payments as well.

To read in details especially about the countries the rate of crypto adoption has significantly increased, you can click on the link below. Lagos, Cairo and Cape Town are considered to be the engine of digitalization in Africa.

https://docs.google.com/document/u/0/d/1qxfQwmUo0HIA6MRTS_US0UnvsZmgE5LH/mobilebasic

Although, we can get something out there, that the IP addresses are used for the tracking and most pointing to Lagos. Even as I am not in Lagos, my IP address 99% times or more points to Lagos but this does not change the fact that Nigeria is playing high role in crypto adoption in Africa and in the world.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.

I just check this page and I saw some careless talks about our football heroes based on say dem endorse Tinubu. People dey call them shameless and some say dem hungry etc. Make people wey dey involved try get respect for our icons. Okocha and Kanu for instance resemble people wey dey hungry?
Na because na Tinubu dem endorse? If say na Atiku, na una go come here shout Atikulated. I no dey support the politicians but make we try get respect for our image dem wey dey represent us.
No politician is good and I am not expecting any good thing from them, but I personally respect Tinubu because he is a leader. One man define leader as person wey dey empower others. Vice president of 9ja na Tinubu boy, Lai Mohamed na him boy, plenty senior men na him boys  including Fashola to the present governor.
I want make e clear for una eyes say we go need choose between Atiku and Tinubu unless na God interven. Make we no dey act like say we dey sleep
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.

Una see that thing about greed and shamelessness. See this ex-footballers weh we think say go even deh on the part of the youth don sell themselves give Tinubu. Kanu and Okocha deh there self. Ikpeba shock me too. See as that one called Taribo West deh vibrate there say him deh pray. I sabi say them get right to their choice of politician to support but na with old cargo like Tinubu? This is shameful. Men supposed get class and shame na. See picture of their meeting with Tinubu and the video of Taribo praying below.

I dun yarn my mind for that our NFPL thread, you see this our hero footballers dem Sabi fall hands. I no know weda na because during their time money no too dey so now dem wan cash out by any means. You no fit see the recent footballers mumu like this. Another person wey e mata dey tahya me na 2baba. That guy's sabi lick yansh like monkey. Very soon na you go hear say e wan organized protect for youth den as soon as dem wire e AZA, e go just go offline.

For me na dem falz I dey listen when entertainer dey talk about politics. The rest na either money or family affair. We go just dey here hear say tinubu dun win, e go just do us like film. That man dey set e compass loudly and for Nigeria na gra gra people dey win election oh even though the main person slow like buhari, provided e get gra gra people wey day e back, na sure tickets.
Wetin you yarn here na better yarning as e be like this eh me I no fit carry my money go listen to any musician wey say em dey do show if e no be davido and fals. Davido dey help youth them for empowerment unto say em get money em no dey beg like some people wey dom enter studio na wey campaign dom-start dey use one old cargo name dey do praise and worship for em to rub them oil for mouth, fals dey follow em papa wey be falani step as em papa no dey support wuru wuru people wey dey collect wetin no be there own for our obodo naija so em so fals dey vex,  the guy dey use em music take dey blast our politicians wey dey do bad work and dey ones wey dey chop money for project for inside naija. As e be like dis now, dey wey dis old man wey dey claim say em be youth (Tinubu) take dey waka waka for dis em campaign eeh if no stronger person wey em face show come out come challenge am eeeh tinubu go win and our suffering go pass like dis for naija. Na only him dey waka dey meet people wey em feet say go herep am win and person wey wam win election na dis kind tins dem dey do.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
I say every sector fir 9ja nah casted, even footballer's weh me I dey even look up too.
Sha, make them do their thing, crazy ass lickers, now I dey find way be say I no go see this thing my eye done see.
UK rapper J-Hus say, if you move with the opp (enemy) then you're an OPP.
Like this Dem be enemies to 9ja yuths and 9ja..... Crazy ASF
Nigeria gives you less assistance so you just have to do it yourself, we the people has been everyday leaving by harsh economical situations it has gotten so bad that we just laugh over some actions by our federal government.

Although guys make we no dey discouraged, I think many of us here are putting in serious work and helping ourselves the best way we can and thanks to crypto-currency it has given us another chance at self dependancy.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Exactly, majority make use of centralized exchanges. But few bitcoin users are afraid of data leak as well, such people at times can still make use of centralized no-kyc exchanges. Some bitcoin users are afraid of both data leak and not having full control, such people stick to full decentralized means.
Yes, though i am not so sure, but i think the number of people who use completely/solely decentralized means are in the minority, i know everyone tends to go for that which suits them and is more convenient, but from my years in the network i think people need to sacrifice convenience for safety, security, anonymity and privacy, if it will take you some stress to protect yourself and your funds, then i think one should do it, the most convenient means most times in this network is usually the least secure; like for example, when people choose to use weak passwords so it be convenient for them to remember, not knowing it is a very wrong/bad thing to do.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
The endorsement we dey talk about sef, this generation no know who be Okocha or Kanu how many influence them get over people votes. Nobody fit influence my vote na wetin dey my mind I go do. Another thing those men nor see money for ball, wetin na england taxes and cost of living chop their money finish I nor know

Like you talk, those greedy and shamelessness footballers no fit make me too vote person weh I no want to vote for. They no fit influence me anything. They just deh yeye themselves.

Another thing, no be say them no see money the time weh them be deh play football. Na their lifestyle fit affect them because many of them lived large. As I deh so I no fit pity any footballer weh play abroad come deh beg money tomorrow for 9ja shishi. Most of them like to spend on flashy cars and jewelries, women, clubbing and drinks. No be say to live well no go, but first invest before living extravagant life. Na the same thing weh go also happen to this ones still playing now some years later if them no invest wisely now.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
the same politicians and Senate weh pass bill to ban Crypto Currency stuff for we 9ja na them go use am pass.
Not No senator proposed a bill to ban bitcoin and other cryptocurrencies in Nigeria not to talk of passing such bill, Senate are mute about this for now.

CBN banned cryptocurrency transactions, not Senate. Generally in many countries, there is Central Bank anti-crypto criticism, like in Russia, India and some others countries. CBN move to ban cryptocurrencies could begin after EndSARS protest, but saying government ban it in Nigeria is highly a misconception. Yet, with p2p, Nigerians are using cryptocurrencies successfully, even on centralized exchanges which is not beyond the reach of the government to stop them (the centralized exchanges) from providing services to Nigerians, or regulate them to further comply with their AML or CTF.

---snipped---
Exactly, majority make use of centralized exchanges. But few bitcoin users are afraid of data leak as well, such people at times can still make use of centralized no-kyc exchanges. Some bitcoin users are afraid of both data leak and not having full control, such people stick to full decentralized means.

Politics in Nigeria is a game of self-interest; no politician is a saint; they are all the same. I'm not sure what motivated others to support Tinubu, but Kanu stated that Tinubu is the only reason his Kanu Nwankwo heart foundation is still operating today; he stated that Tinubu was the only politician who donated to his foundation, so he has every reason to support him, and I don't see anything wrong with that.
If job is self interest (money making wise), it is said politics is one of the lucrative job in Nigeria. I too will respect the decision of others even if their decision is not in line with mine. If what happened recently did not happen, this does not stop Nigerians to accept ₦10000 and vote for a party that paid them money, this are the majority of people that are voting. Only few people are knowledgeable and wise to know what election is and most of them are not even voting.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
The matter tire me ooooh na the same footballers were endorse Governor Yahaya Bello of kogi state some months ago, same them them still endorse Tinubu, this is indeed shameful. No act of patriotism at all only after brand envelope ✉️ no wonder they could not do the Nation proud all through out their football carrier.
The condition of the country dey make us react to every thing nowadays, even something wey person no suppose dey reason self.

They all did great things for the country in their own way; in this picture, we have two of the greatest captains, Olympic gold medalists, AFCON winners, and the most decorated left-back. Politics in Nigeria is a game of self-interest; no politician is a saint; they are all the same. I'm not sure what motivated others to support Tinubu, but Kanu stated that Tinubu is the only reason his Kanu Nwankwo heart foundation is still operating today; he stated that Tinubu was the only politician who donated to his foundation, so he has every reason to support him, and I don't see anything wrong with that.

I'll say it again: politics is a game of selfish interests; if you're close to the government, you'll benefit more. I'm a proud beneficiary of the APC government, and as an APC cardholder, I'll always support them because that's where my interests lie.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I say every sector fir 9ja nah casted, even footballer's weh me I dey even look up too.
Sha, make them do their thing, crazy ass lickers, now I dey find way be say I no go see this thing my eye done see.
UK rapper J-Hus say, if you move with the opp (enemy) then you're an OPP.
Like this Dem be enemies to 9ja yuths and 9ja..... Crazy ASF
hero member
Activity: 812
Merit: 560

Una see that thing about greed and shamelessness. See this ex-footballers weh we think say go even deh on the part of the youth don sell themselves give Tinubu. Kanu and Okocha deh there self. Ikpeba shock me too. See as that one called Taribo West deh vibrate there say him deh pray. I sabi say them get right to their choice of politician to support but na with old cargo like Tinubu? This is shameful. Men supposed get class and shame na. See picture of their meeting with Tinubu and the video of Taribo praying below.

I understand what you mean, at least it is expected of them all to maintain their integrity because seen with jagaban in the public os a showcase to self devalue. But lets take a look at it from the angle too, most of the guyz sighted were ex naija players and their tenure don pass, they are no more invoke, as per naija mentality wetin u go reason? dey need to survive by doing one or two things, dont be surprised that not all of them are truly in support of tinubu from within, na just to appear and receive honorarium for attending the invitation, no be evri body wey gada sit wt u ar wt u.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555

Una see that thing about greed and shamelessness. See this ex-footballers weh we think say go even deh on the part of the youth don sell themselves give Tinubu. Kanu and Okocha deh there self. Ikpeba shock me too. See as that one called Taribo West deh vibrate there say him deh pray. I sabi say them get right to their choice of politician to support but na with old cargo like Tinubu? This is shameful. Men supposed get class and shame na. See picture of their meeting with Tinubu and the video of Taribo praying below.

I dun yarn my mind for that our NFPL thread, you see this our hero footballers dem Sabi fall hands. I no know weda na because during their time money no too dey so now dem wan cash out by any means. You no fit see the recent footballers mumu like this. Another person wey e mata dey tahya me na 2baba. That guy's sabi lick yansh like monkey. Very soon na you go hear say e wan organized protect for youth den as soon as dem wire e AZA, e go just go offline.

For me na dem falz I dey listen when entertainer dey talk about politics. The rest na either money or family affair. We go just dey here hear say tinubu dun win, e go just do us like film. That man dey set e compass loudly and for Nigeria na gra gra people dey win election oh even though the main person slow like buhari, provided e get gra gra people wey day e back, na sure tickets.
I vex as I get the jerk. I don pause reason am from another angle. Una know say with or without these endorsement Tinibu go still rig election, the footballers know nai make them relax use the opportunity to cash out .The endorsement we dey talk about sef, this generation no know who be Okocha or Kanu how many influence them get over people votes. Nobody fit influence my vote na wetin dey my mind I go do. Another thing those men nor see money for ball, wetin na england taxes and cost of living chop their money finish I nor know
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

Una see that thing about greed and shamelessness. See this ex-footballers weh we think say go even deh on the part of the youth don sell themselves give Tinubu. Kanu and Okocha deh there self. Ikpeba shock me too. See as that one called Taribo West deh vibrate there say him deh pray. I sabi say them get right to their choice of politician to support but na with old cargo like Tinubu? This is shameful. Men supposed get class and shame na. See picture of their meeting with Tinubu and the video of Taribo praying below.

I dun yarn my mind for that our NFPL thread, you see this our hero footballers dem Sabi fall hands. I no know weda na because during their time money no too dey so now dem wan cash out by any means. You no fit see the recent footballers mumu like this. Another person wey e mata dey tahya me na 2baba. That guy's sabi lick yansh like monkey. Very soon na you go hear say e wan organized protect for youth den as soon as dem wire e AZA, e go just go offline.

For me na dem falz I dey listen when entertainer dey talk about politics. The rest na either money or family affair. We go just dey here hear say tinubu dun win, e go just do us like film. That man dey set e compass loudly and for Nigeria na gra gra people dey win election oh even though the main person slow like buhari, provided e get gra gra people wey day e back, na sure tickets.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino

Una see that thing about greed and shamelessness. See this ex-footballers weh we think say go even deh on the part of the youth don sell themselves give Tinubu. Kanu and Okocha deh there self. Ikpeba shock me too. See as that one called Taribo West deh vibrate there say him deh pray. I sabi say them get right to their choice of politician to support but na with old cargo like Tinubu? This is shameful. Men supposed get class and shame na. See picture of their meeting with Tinubu and the video of Taribo praying below.



https://www.facebook.com/803267836/posts/10162301162887837/?app=fbl
The matter tire me ooooh na the same footballers were endorse Governor Yahaya Bello of kogi state some months ago, same them them still endorse Tinubu, this is indeed shameful. No act of patriotism at all only after brand envelope ✉️ no wonder they could not do the Nation proud all through out their football carrier.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co

Una see that thing about greed and shamelessness. See this ex-footballers weh we think say go even deh on the part of the youth don sell themselves give Tinubu. Kanu and Okocha deh there self. Ikpeba shock me too. See as that one called Taribo West deh vibrate there say him deh pray. I sabi say them get right to their choice of politician to support but na with old cargo like Tinubu? This is shameful. Men supposed get class and shame na. See picture of their meeting with Tinubu and the video of Taribo praying below.



https://www.facebook.com/803267836/posts/10162301162887837/?app=fbl
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Depreciated and outdated old fool's, their day of reckoning is coming.
Look now next year election dey come and Efcc dey monitor all accounts in Nigeria, the same politicians and Senate weh pass bill to ban Crypto Currency stuff for we 9ja na them go use am pass.
Them go use BTC well well ehhh next year, I swear.
The matter weak me and it irks me to see no improvement,we all in this together... Hopefully we'll get outa this sit together.
Well I personally feel that bill will not be passed onto law, it's a scheme to keep the Nation poorer, we as a nation already get serious financial issues we need to they tackle , so now as a Crypto enthusiast ma now your useage of Crypto-currency go suppose come in play, if only we can hetore services accepting Crypto-currency as a medium of Exchange.
Jump to: