Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 150. (Read 1025511 times)

hero member
Activity: 1498
Merit: 702

Happy April fool's day, our oga theymos dun drop another prank although me I no dey too feel am like the last ones. Me I been get plans to run prank for this thread but I just decide last minute to pause. Anyways I welcome una to a new month, happy new month and na better blessings go shower us this month. Anywhere wey we put hand na so so progress go just they comes. We dun finish 3 months and like play like play year dun dey end, abeg make we all seat up.
Happy new month guys, I think the best prank dropped na from our senior man Brainboss when in advertise campaign and that period campaign no too dey only for him to talk say na April fool, regardless this days years are short and we still never forget the last April fool so a new one no the catch everybody off guard.
Regardless na good source of fun for the community and theymos dey do well to they follow am up all the time.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Okay make I dey reply una one by one, this reply na for the two of una. Yes Amaechi get interest and make e no surprise una if e emerge as flag barrier. Na who and who be the Snr man for their na una dey forgot say Amaechi follow for who make APC stand, you know the River money dat man pour for the first campaign to put buhari for seat. Amaechi was so strong dey make am Campaign Manager. Amaechi na slow poison oh, no think say e no dey strategize oh. Dat man dey wait for everything to set before e declare e intentions. People hate tinubu and buhari sabi dat one including other founding fathers. Dem know say dey hi lose with tinubu and are looking for better alternative.
Make I tell you something today, 9ja politics no.be as you think ammm as you see all those political party so e get waiten we.dey call party politics, this thing na system men dey run. Amechi no get that kind levels for APC yes say him be one of those guys were champion Buhari  presidential election in 2015 this APC no get strong party Manifesto and just gang of politicians gather to o overthrow PDP from power but you see when every body abandoned PDP na wike carry ammm for back na why PDP no collapse after 2015 election. Then we're Atiku we're Peter obi if Wike declare baba make Atiku and Obi go seat down because two of them just want use PDP just like they did before.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Wetin I dy see online former rivers state governor Rotimi Amaechi, Wike’s arch nemesis de also come out for presidency both of them na from the south but different party.
My people me I know say wike na strong man and to get PDP presidential ticket dey easy for WIKE, but you see Amechi no fit ever get APC ticket as men were strong pass still dey ground,

Okay make I dey reply una one by one, this reply na for the two of una. Yes Amaechi get interest and make e no surprise una if e emerge as flag barrier. Na who and who be the Snr man for their na una dey forgot say Amaechi follow for who make APC stand, you know the River money dat man pour for the first campaign to put buhari for seat. Amaechi was so strong dey make am Campaign Manager. Amaechi na slow poison oh, no think say e no dey strategize oh. Dat man dey wait for everything to set before e declare e intentions. People hate tinubu and buhari sabi dat one including other founding fathers. Dem know say dey hi lose with tinubu and are looking for better alternative.

I laugh sotey I fall for ground break my phone screen as I see where you talk say Atiku go fit run leave PDP because say Wike declare interest to be president. That statement na joke of the year. E better as the statement come today wey be 1st April, make we kuku call am April fool

You dey do like you no sabi Atiku again, how many times e jump camp, when PDP no give am sure slot, e no run go APC, buhari come win am for primary, again as buhari wan extend his stay knowing say e slot no sure wetin e do no be to run go back PDP. That man no be loyalist for party na selfish interest e get and if South South pressure much for am and PDP decide to zone am to South, Atiku go still change camp or forget about all his intentions.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
My people me I know say wike na strong man and to get PDP presidential ticket dey easy for WIKE

E no get as e go easy for Wike to get that ticket. Peter Obi na more credible candidate than Wike. We know how all this things deh be before we know wetin deh sup some of them go begin say them don step down for others. They just want to cash out and come bear the title of former contestant. To step down for someone na better bribe money na. Atiku no get shame again at all. Na all weather. If he fails to get PDP ticket him go run enter APC. Somebody like Atiku no fit get my vote.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
The other day him smoke go Channel Tv go sleep while Interview dey on dey talk rubbish. Lol

Wike na our trump, e no dey care as e dey him mind na so e dey dish am out. Make we no lie without Wike PDP for no get stand again. All them Atiku, etc all ghost but Wike on his own been dey make people still dey hear PDP voice. Wike dey fight for ticket to come South and I believe north no go get am. I no go shock if Atiku defect go APC to go try ticket hustle because with Wike force na South that presidential ticket they come for PDP
As I see this comment, I trace am come up to see who posterm, me I surprise say na senior man Brainboss yarn this kind thing shaa... Although politics no be crypto  Grin.  Na crypto wey you be Lord, no be for Nigeria politics.

I laugh sotey I fall for ground break my phone screen as I see where you talk say Atiku go fit run leave PDP because say Wike declare interest to be president.  Grin Grin Grin That statement na joke of the year. E better as the statement come today wey be 1st April, make we kuku call am April fool Grin
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
The other day him smoke go Channel Tv go sleep while Interview dey on dey talk rubbish. Lol

Wike na our trump, e no dey care as e dey him mind na so e dey dish am out. Make we no lie without Wike PDP for no get stand again. All them Atiku, etc all ghost but Wike on his own been dey make people still dey hear PDP voice. Wike dey fight for ticket to come South and I believe north no go get am. I no go shock if Atiku defect go APC to go try ticket hustle because with Wike force na South that presidential ticket they come for PDP

The only thing he does is go to other states to drop money from Rivers State. Atiku is the only hope of the PDP regaining power. Even with Buhari's influence in the last election, Atiku still garnered more votes than Goodluck Jonathan did against Buhari. Atiku has the support of the North, South, and East, unlike Wike. PDP needs someone with money, influence, and support, and Gov. Wike is not that man. The North has already endorsed Atiku for the second time, and that is all that matters; Atiku will obtain the ticket without a doubt.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
The other day him smoke go Channel Tv go sleep while Interview dey on dey talk rubbish. Lol

Wike na our trump, e no dey care as e dey him mind na so e dey dish am out. Make we no lie without Wike PDP for no get stand again. All them Atiku, etc all ghost but Wike on his own been dey make people still dey hear PDP voice. Wike dey fight for ticket to come South and I believe north no go get am. I no go shock if Atiku defect go APC to go try ticket hustle because with Wike force na South that presidential ticket they come for PDP
Wetin I dy see online former rivers state governor Rotimi Amaechi, Wike’s arch nemesis de also come out for presidency both of them na from the south but different party. The two men na power house for their respective parties, I go happy any of them win. As campaign don start make we remember when two elephant dey fight na grass dey suffer am. Happy new month Naija
My people me I know say wike na strong man and to get PDP presidential ticket dey easy for WIKE, but you see Amechi no fit ever get APC ticket as men were strong pass still dey ground, 2023 election go tough but I know say e go still pass and politicians go always play their way into power. Our prayer na make futuristic leaders merge together so we fit move the country forward e dey possible.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
The other day him smoke go Channel Tv go sleep while Interview dey on dey talk rubbish. Lol

Wike na our trump, e no dey care as e dey him mind na so e dey dish am out. Make we no lie without Wike PDP for no get stand again. All them Atiku, etc all ghost but Wike on his own been dey make people still dey hear PDP voice. Wike dey fight for ticket to come South and I believe north no go get am. I no go shock if Atiku defect go APC to go try ticket hustle because with Wike force na South that presidential ticket they come for PDP
Wetin I dy see online former rivers state governor Rotimi Amaechi, Wike’s arch nemesis de also come out for presidency both of them na from the south but different party. The two men na power house for their respective parties, I go happy any of them win. As campaign don start make we remember when two elephant dey fight na grass dey suffer am. Happy new month Naija
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Recently lots of people were taking by men of the EFCC some we truly guilty of cyber crimes but also some where just Crypto enthusiast, we are being attacked in this country by lots of things even the people meant to protect us.

Na mumu county wey we dey so na, me I dun talk am. If mistakenly dey carry me anyday spoil my name for wetin I no do  I dun cash out majorly be that because we go go court case tire. We go start from the smaller court and I no go mind if them dey bribe their way out, we go still dey run am Ike that and I no go mind how much e cost. People need teach this guys lesson, away sha God dey.

Happy April fool's day, our oga theymos dun drop another prank although me I no dey too feel am like the last ones. Me I been get plans to run prank for this thread but I just decide last minute to pause. Anyways I welcome una to a new month, happy new month and na better blessings go shower us this month. Anywhere wey we put hand na so so progress go just they comes. We dun finish 3 months and like play like play year dun dey end, abeg make we all seat up.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
I no know if this na true say the federal government dey ask us the citizens to donate money for the terrorist shooting matter make them take arrange things.
I nor know if the story na legit sha I nor go dey surprised, this administration na one of the worst eight years in office I don experience since them born me. During COVID-19, Lai Mohammed publicly ask yahoo boys to donate to Nigeria government to help fight covid.
It's bad to have a bad government it's now worst to feel insecure in your own country.
The insecurity now don dey touch everybody when chibok girls happen we carry am dey joke like say na play. Herdsmen dey rampage farms, villages overnight we still dey carry am play cos we dey city we no understand wetin our people wey dey village dey face. Small small the war don creep to our doorstep
Recently lots of people were taking by men of the EFCC some we truly guilty of cyber crimes but also some where just Crypto enthusiast, we are being attacked in this country by lots of things even the people meant to protect us.
Na who looseguard them dey carry. I don carry am for mind say any officer wey ask me my occupation, never will I ever say crypto trader or forex trader if you try am na cell you go see yourself. Efcc dey on a mission, oga at the top fit don give them target make them 1000 cyber criminals in one month. Na so them go use their mind dey arrest anybody them see for street.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
I no know if this na true say the federal government dey ask us the citizens to donate money for the terrorist shooting matter make them take arrange things. It's bad to have a bad government it's now worst to feel insecure in your own country.
Recently lots of people were taking by men of the EFCC some we truly guilty of cyber crimes but also some where just Crypto enthusiast, we are being attacked in this country by lots of things even the people meant to protect us.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
The other day him smoke go Channel Tv go sleep while Interview dey on dey talk rubbish. Lol

Wike na our trump, e no dey care as e dey him mind na so e dey dish am out. Make we no lie without Wike PDP for no get stand again. All them Atiku, etc all ghost but Wike on his own been dey make people still dey hear PDP voice. Wike dey fight for ticket to come South and I believe north no go get am. I no go shock if Atiku defect go APC to go try ticket hustle because with Wike force na South that presidential ticket they come for PDP

My wife done born baby Satoshi is here.
I greet everybody

Congratulations brother, e no easy oh to bring pikin enter this world. Na better joy u dun bring come like dis. I follow put body celebrate with you. As your pikin dey grown, show am road for the space so she no go be novice when the time comes and go fit dey run one or two based on the cryptocurency level.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
Exxon Mobil Plan using Waste Natural Gas in Mining Bitcoin In Nigeria.

Nigeria is one of the fast groy developing countries in the world and Africa at large, it is said to rank third in the global statistics of bitcoin users and first in Africa respectively, going with the consideration of how fast is the booming of  bitcoin activities in the country and considering the population of user on exchanges from the region, it could be said that Nigeria has a suitable avenue with great potential for bitcoin expansion.

Exxon Mobil, which is an oil and gas company in the United State is determined to set a "bitcoin mining activities in Nigeria using waste from the natural gas" in other to help create an effective maximization of the waste energy realized through the exploration of crude oil thereby converting the energy for use in bitcoin mining rather than constituting environmental pollution of waste energy.

Quote
Exxon Mobil is trying to reduce its carbon footprint by turning excess natural gas, which would otherwise be burned off, and would cause harm to the environment, to become useful in generating revenue for the company in form of crypto mining.
https://nairametrics.com/2022/03/24/exxon-mobil-to-run-pilot-bitcoin-mining-operation-in-nigeria/?amp=1

Better opportunities await Nigerians as it about to set a new record for its first bitcoin mining in the south south region where oil and gas exploration takes place.
I don’t know the environmental impact of this venture. History has taught us manufacturing/ mining companies do not care about the effects of their exploitation on the environment. Back in the 90s, Niger delta was exploited by oil companies from  the west, the after effects are long term.....the polluted areas are polluted and a clean up will probably take a decade with luck.
If this is what they say it is, then it should be adopted by other companies that release such wastes into the environment. Global warming is a real problem.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
If you look your area e get one particular region people wey don migrate to every corner of the country. Na them believe say them get right pass for the country, aboki go use trailer jam person police no go fit arrest am charge am to court, settlement outside court them no dey do. The law for naija dey very bias, na only when we decide to change the narrative nai our country go see better days

Sometime i deh feel like crying when I see how things deh go for 9ja badly. Una sure say this country go ever good again? Everything come worse since this APC people enter for presidency. Hardship and lost of lives come become normal thing for our country now. Life no worth much anymore. Person go just kill another person for small matter weh no reach to stone fowl or goat. Abi na police them own we want to talk about? We deh live like animal kingdom here as Mazi Nnamdi Kanu be talk. Which way Nigeria according to late Sonny Okosun.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Pokapoka my brother I appreciate you, how your side, 2ru 2ru an men dey run ammm and I dey pray for everybody here to experience the same joy, I know say many dey where don enter fatherhood since before but the excitement no be here ooooo,. Such an overwhelming experience e dey come with stress sha but everything an joy 😁. But again I no happy for waiten dey happen for 9ja I dey stadium yesterday to watch Nigeria vs Ghana match and after the match naa so some fan begin scatter things for inside stadium and e no make sense.
Even when we never recover from the terrorist attack on kaduna-Abuja 🚆train🚂  twice within 24 hours things are way to bad now for 9ja.

This image no be Ukraine oooo na 9ja
Federal government nor dey take terrorism seriously, boko Haram dey terrorize the country with impunity. How country wey won fight terrorism go dey give amnesty to "repentant terrorists". This amnesty include scholarship abroad, monthly stipends, them even carry some put for Nigerian army. How you go treat enemy of the state that way. The way fg dey do this matter, e dey obvious say their hand no clean and them get interest for this kasala wey dey hapun. We the masses no dey take our lives and country serious, our spirit of patriotism don die as the country don fail us time and time again. We need to stand up for ourselves even if government no go defend us. If you look your area e get one particular region people wey don migrate to every corner of the country. Na them believe say them get right pass for the country, aboki go use trailer jam person police no go fit arrest am charge am to court, settlement outside court them no dey do. The law for naija dey very bias, na only when we decide to change the narrative nai our country go see better days
hero member
Activity: 812
Merit: 560
My people I greet una make una no vex for me say I no come dey too active for this side, actually my wife born baby last week Thursday so the family responsibility come take too much of my attention but am back, I go read through thread make I see were I fit contribute. My wife done born baby Satoshi is here.
I greet everybody

Congratulations to you, may God bless and keep the child.
Welcome back bro, hope say you don dey ready to shower us with the naming ceremony celebrations here  Grin i guess you did nkt mark attendance to that our match for stadium? Or did you?
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
You no tell us wetin you give birth to finally(wink). Whether na boy or girl.

Satoshi be man and I believe baby Satoshi go be boy na. Congratulations Wiwo my brother. I forget to comment on that your post yesterday to greet you on the thing weh you do weh come result to public showings.

The rate him dey disgrace Rivers People for National TV no good. Must he be on highness everytime him wan talk for TV?

Na this same thing we accused Goodluck Jonathan of when he was president. Too much shakings deh worry people from that riverine areas. Maybe na too much cold deh make them drink ogogoro too much we no know. But I like as Delta politicians deh respect themselves by not showing and displaying it publicly.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
My people I greet una make una no vex for me say I no come dey too active for this side, actually my wife born baby last week Thursday so the family responsibility come take too much of my attention but am back, I go read through thread make I see were I fit contribute. My wife done born baby Satoshi is here.
I greet everybody
Congratulations Boss, God dey by your side. E no easy. I am happy for you. If na man him born, just carry one person here for Naija board name him. E go make sense. But no name him Igehhh o, because I no sabi the meaning Grin

The other day him smoke go Channel Tv go sleep while Interview dey on dey talk rubbish. Lol
Abi make we talk this Wike talk now or later tomorrow. The rate him dey disgrace Rivers People for National TV no good. Must he be on highness everytime him wan talk for TV? Well, this country na cruise shaa, nothing suppose surprise any person again.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
My people I greet una make una no vex for me say I no come dey too active for this side, actually my wife born baby last week Thursday so the family responsibility come take too much of my attention but am back, I go read through thread make I see were I fit contribute. My wife done born baby Satoshi is here.
I greet everybody
I celebrate with you. Congrats my broda, em no d easy at all to be a loving and caring father give your pikin. I know how joyful em d be to see and carry your own pikin. Na joy overboard give you. Your baby go b a shinny light give you and your family, more open doors give unah(amen).

You no tell us wetin you give birth to finally(wink). Whether na boy or girl. Baby Satoshi can be boi or girl. You are doing well sha
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino

My people I greet una make una no vex for me say I no come dey too active for this side, actually my wife born baby last week Thursday so the family responsibility come take too much of my attention but am back, I go read through thread make I see were I fit contribute. My wife done born baby Satoshi is here.
I greet everybody
Good news na we wan dey hear, wiwo my brother na man you be...we rejoice with you. Congratulations bro. Fatherhood is a blessing only God can give. Where the party go dey na. Bitcointalk family suppose show face for there, na privacy matter go make some people no like those events. Congratulations with the latest father in town

Jump to: