I just go through the stuff now, and truly him copy the write up, way be say him Don gather small merit him for try calm down,I believe say maybe them don ban him account cause him account they inactive since 23rd,na to start all over again I just hope him no go make the same mistake him make this time.
My dear, you dey mind dem. Pepper body too much for those guys side. Dem nor wan make anything Africa shine. E even worse once dem know sey na Naija.
Haha, ur pidgin dey sweet me 4 belle aswear, you tight.
D tin just taya me for all this oyibo pipo, dem no wan make persin follow dem enjoy, all our yan and mata just dey 4 deir room dey mormor con dey yab us like say we no be human being, anywhere e pain dem, make dem scratch am, bad belle pipo. Abeg my men dem, make una no 4kup as dem dey find small mistake wey we go do. Shine ur eye and dey on clear road.
Mona fagi dis Xmas.
Na so e be right from time them no dey ever take Africans serious, them dey feel like say na only them deserve the good life, but las las no be so, anyhow e be make we just dey push dey go, "na just time e go take stamerer go call him papa name".
Merry Christmas my people, make una stay safe oh, this one I dey hear say another lockdown wan happen from January, na true?