Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 260. (Read 1332014 times)

staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
U see dat thread so we go dey bump am till thou kingdom com till dem giv us wetin we dey find cos dis time around na so so positive reaction dey de thread. All De abino dem know say we deserve am dey don see our activities nobe lie. Almost all de crypto forum get 9ja board cus dem sabi our force. 2secs wi fit shut down.
If u be naija and all dis while u dey hide cus of fear wen dem giv us board no cum ooo drag space cus de kind juju I go do bend person prick ehh no wahala.

@Mpanmaegbu dis ur ogoni name nobi dsame app u delete put porn hub?
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
E go get reason theymos never give us local board, as we dey increase the activity for here, and for other Nigeria matter, the chances they increase. theymos will later consider wetin we dey ask.
Una know sey theymos nor dey quick react to issues. I nor think sey e get any reason pass dat one. The guy dey like draw like ogbolo wey dey cold. Im dey like guage reactions on things from others before im go react and that na why e dey always look like im dey too slow. Make una nor reason am sey im don collect gala from Bubu not to give us greenlight for owa localboard creation.

Igeh, you and your troubles be like Lai Mohammed and lies or Mallams and their kettles. Kontinue oh. Me wey don dey on discord since 2017 sef.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
But as de thread dey go, we just need more of our pepuls 2 join dis race 2 be given our board. Abeg som of us wey dey outside dis place shuld help tel odars about dis matta becus we need more hands and leg now.
If the matter bin end for people joining this our small corner, i sure say e for be small something, e no for be watin go keep us for that small place on the chat but then, na say, people way don even find their road come here cef dey act like say, e hard to speak pigin abi na waste of time... My people, i dey slam my language anyhow when i jam my tribe men o, talk more of on a foreign soil way we don try get corner and na to hustle make we for get board way remain. Na to loud am be that na! But our people no dey even wan touch leg for the ground or shuck mouth for the tori way dey the town. Na there e tire me. E no go go-hard say, you talk finish con dey reply yourself. Na to spam the board be that na... people need dey respond make e be proper discussion. I sure say most of us dey whatsapp groups way be say, na so 321 messages we dey see when we say make we just view watin sup for that way. Na that spirit we fit carry boost for here. Anytime person dey online, na to just branch make we for see wtain we fit shuck mouth.

Still on the matter eh, e go shock you say, non of us, even me inclusive never throw-way anything to anybody for the board since o. Except Brainboss, the only G way don dey try for us since. Na all this thing we need to change from make we too dey enjoy watin forum get to give us.
legendary
Activity: 1652
Merit: 1208
Gamble responsibly
Baba I dey suspect u oo u be like person wey go uninstalled bible download porn...na also every day African queen porn pages dey increase in number......

Make un try oo
Everybody na Jesus boy na. No way to holiness than serving Jesus na. How you know African queen porn pages? Me never hear that before oh. Wink

Dat thread wey Charley create na awereness, we go come in full force and na Brainboss go lead dat time, anywr wey theymos hide we go worry am.,dey kpor wetin go happen.
E go get reason theymos never give us local board, as we dey increase the activity for here, and for other Nigeria matter, the chances they increase. theymos will later consider wetin we dey ask.
full member
Activity: 756
Merit: 231

Dat thread wey Charley create na awereness, we go come in full force and na Brainboss go lead dat time, anywr wey theymos hide we go worry am.,dey kpor wetin go happen.
I tink sey dem oyibo lik progrex, na now de tin dey convince me say dem no lik am at all, de record shown sey atleast we need am but dem wey no dey talk maybe dem hav dia reservasion. But as de thread dey go, we just need more of our pepuls 2 join dis race 2 be given our board. Abeg som of us wey dey outside dis place shuld help tel odars about dis matta becus we need more hands and leg now.

Sickness na bad tin and God go continue saving us all, Iseh.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
Abeg we 4 cari d same energy go Bitcointalk discord:( na der we fit get Cyrus attention well na him be 2nd in command anytin wey him tell thymos na sure copy..
No b lie you yarn 4 yarn, you wey your face don show for the discord group, you fit run am for us e no bad keh.

As for the local board mata, wetin we just need na to make this page enter about 1000+ pages, Lol, I no say e no go easy shah, but we go run am. Ona never notice sey we beta pass oyibo dem, for oda local board dem still dey struggle like, e.g Vietnam, becos of Brainboss arrange dis hangout, nae mak dat statistic man(no wan cal name) run go create him own 4 him kontri pipo, check am, howfar dem don reach, our papa born us wit pressure.

Dat thread wey Charley create na awereness, we go come in full force and na Brainboss go lead dat time, anywr wey theymos hide we go worry am.,dey kpor wetin go happen.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Take https://discord.gg/ahgHyku mak u try put de energei der I don share did link tire I no kwn why to download app dey hard us but una get space and data 4 porn
Cool How you know?  Roll Eyes
Baba I dey suspect u oo u be like person wey go uninstalled bible download porn...na also every day African queen porn pages dey increase in number......

Make un try oo
legendary
Activity: 1652
Merit: 1208
Gamble responsibly
Take https://discord.gg/ahgHyku mak u try put de energei der I don share did link tire I no kwn why to download app dey hard us but una get space and data 4 porn
Cool How you know?  Roll Eyes
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Throw the link for the discord here na. Abi the link go chop your data ni?
Take https://discord.gg/ahgHyku mak u try put de energei der I don share did link tire I no kwn why to download app dey hard us but una get space and data 4 porn
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
mak nobodi yarn 4 oyibo language here again cus edey on investigation so pipo eyes full here...
Na true you talk but nor be today their eyes don dey enter here na. You sabi sey anything wey we Naija peeps dey do dey draw attention na  Grin. Another matter be sey as we dey hustle for we local board one of their arguments be sey Naija na still oyibo language dem dey take yarn and sey we nor get single local yarn. But we don dey try reason dem sey pidgin na one unifying yarn for we Naija people. So, from now onwards any persin wey come here yarn oyibo language we go investigate am to know whether na sabour wey wan infiltrate us. Abeg, in case you never put mouth for owa matta on top local board parole, make you rush go Meta now and follow dat CharlesTim thread.

For the merit chart, we no too dey chest merit like water for here base on say na only one source we get, if to say source plenty kperere, we for don reach far for the chart, no be lie.
Na true yarn be dat. If to sey we get another persin join Brainboss for that way owa blessings unto that level for dey highly kajaed!

Abeg we 4 cari d same energy go Bitcointalk discord abi una no get data? Sad na der we fit get Cyrus attention well na him be 2nd in command anytin wey him tell thymos na sure copy.. I dey beg una my broda man my sista woman mak una try borrow join na...
Throw the link for the discord here na. Abi the link go chop your data ni?
legendary
Activity: 1652
Merit: 1208
Gamble responsibly
For the merit chart, we no too dey chest merit like water for here base on say na only one source we get, if to say source plenty kperere, we for don reach far for the chart, no be lie.
No be only on source dey cause the low merit activity for our local thread, if to say we don get local board na, you go see how posts and activities for our side go increase, quality topics and posts go dey, this go make our board more active than before. Na waiting go make the merit increase. Make we dey hope for better tomorrow as some other Nigerians go apply for merit source, na guess oh but waiting I believe go later happen.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Abeg we 4 cari d same energy go Bitcointalk discord abi una no get data? Sad na der we fit get Cyrus attention well na him be 2nd in command anytin wey him tell thymos na sure copy.. I dey beg una my broda man my sista woman mak una try borrow join na...  Angry  . if u get moni 4 Luno go comot am oo p2p no dey
 I knw say we dey campaigns but mak we try dey show 4 here once or twice a week mak here dey busy lik Aba market
sr. member
Activity: 2842
Merit: 326
Vave.com - Crypto Casino
My people, make una just relax on top the crypto ban matta for we cowtry. Una even see the errors wey dey the letter sef for such a big office? E good like that make dem continue to dey disgrace dem gene everywhere dem go. Employ people wey sabi work, sem say no. Na just to chook all their people into offices wey dey pay better money na im dem sabi.

Make I even tell una the truth, this ban go even create more openings for crypto lovers. Make una just watch and see. When coronavirus gbege happened last year we think sey everybody go die and every businesses go collapse. You see dat thing wey dem dey talk about if one way close another one go open. As coronavirus enter town, POS services come increase everywhere. I believe una go don notice this thing wey I talk now sef. So, this Bitcoin ban surprisingly go create many other opportunities for us. The first business wey go boom now na p2p for Naija and across the world. Make we utilize this opportunity well.
Na bad belle people dem bi for that CBN, dey no get sense at all, dem don create FUD for some of my kontri people wey started to dump their coins dey don  spoil show kpatakpata for some people as for me I standa gidigba no shaking bitcointalk don teach me lesson say make I no dey fear for any useless news talkless of this one wey come from my own kontri.
P2P na him be the surest way e dey full berekete for binance where bi say na binance dey escrew any trade sef. I know say many people go find a way out as you talk am, why I go dey go save my moni on top of one useless bank wey go give me shikini interest for a long period of time where cryptos dey give me 5X I dey mad, I better put my moni for crypto and dey take one eye look am.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
My people, make una just relax on top the crypto ban matta for we cowtry. Una even see the errors wey dey the letter sef for such a big office? E good like that make dem continue to dey disgrace dem gene everywhere dem go. Employ people wey sabi work, sem say no. Na just to chook all their people into offices wey dey pay better money na im dem sabi.

Make I even tell una the truth, this ban go even create more openings for crypto lovers. Make una just watch and see. When coronavirus gbege happened last year we think sey everybody go die and every businesses go collapse. You see dat thing wey dem dey talk about if one way close another one go open. As coronavirus enter town, POS services come increase everywhere. I believe una go don notice this thing wey I talk now sef. So, this Bitcoin ban surprisingly go create many other opportunities for us. The first business wey go boom now na p2p for Naija and across the world. Make we utilize this opportunity well.
jr. member
Activity: 155
Merit: 7
The dream God is what I embody

Quote
Welcome bro, e no too tay b4 I Sabi say niaja follow dey this forum , any way na hustle bring us here and we go make am  , make you just follow the rules for here and avoid wahala ,
Me I be Igbo boy ,but I dey stay for akwa ibom too, maybe we fit jam one day na
 As for now the matter were dey ground be our govt were ban crypto without explanation , but as we all Sabi them go still unban am ,na just intial gra gra 😂

no be lie bros... na hustle carry me come hia, as for us to jam, me I de EKET oh, as you know EKET dry.... and as government ban crypto trading e no mean say u no KO fit hold your Bitcoin and crypto them, e only mean say na decentralized and peer to peer exchange u KO use....  one way or the other people wey use crypto KO increase pass before as them done ban the trading serf
member
Activity: 123
Merit: 25
Username: Morpheus
State: Akwa Ibom
Username:Murpheus
Gender: Male
State of resident: Akwa Ibom
Skills: Writer and Community Manager


Lemme add this... until now I no been sabi say my brothers and sisters de hia oh... I still be newbie shaa, my account done reach two years or so, but na just recently I begin de active, first time I been come here I been run Comot sha I no fit lie, the website been de confusing lol....

I no fit express joy finish as I come see dis place, and some of us de hold beta position, at least that shows that my people still de get mouth, with good reputation....
Make Una show me place make I keep my bags....
Welcome bro, e no too tay b4 I Sabi say niaja follow dey this forum , any way na hustle bring us here and we go make am  , make you just follow the rules for here and avoid wahala ,
Me I be Igbo boy ,but I dey stay for akwa ibom too, maybe we fit jam one day na
 As for now the matter were dey ground be our govt were ban crypto without explanation , but as we all Sabi them go still unban am ,na just intial gra gra 😂
jr. member
Activity: 155
Merit: 7
The dream God is what I embody
Username: Murpheus
State: Akwa Ibom
Username:Murpheus
Gender: Male
State of resident: Akwa Ibom
Skills: Writer and Community Manager


Lemme add this... until now I no been sabi say my brothers and sisters de hia oh... I still be newbie shaa, my account done reach two years or so, but na just recently I begin de active, first time I been come here I been run Comot sha I no fit lie, the website been de confusing lol....

I no fit express joy finish as I come see dis place, and some of us de hold beta position, at least that shows that my people still de get mouth, with good reputation....
Make Una show me place make I keep my bags....
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
From the two charts I go fit understand say we dey try well well for posting but we gat put am oil and grease, if we go comot shame come here yarn better talk, we for don reach far tey tey.
For the merit chart, we no too dey chest merit like water for here base on say na only one source we get, if to say source plenty kperere, we for don reach far for the chart, no be lie.
Base on the merit matter, na true talk you talk say, na just one source we get and that na Brainboss. People way don reach o apply, make them apply but na liver shah at least, Brainboss fit yarn una as e be so, nothing go spoil if una update am before una try. Na the matter.
From watin i dey see there, i believe say that statistics way dey there so na mainly based on the meriting way dey go on for this our small corner and the way we dey yarn kwa na em display there so. Na the matter we dey cry on be that. Here no dey sweet me the way e suppose dey sweet person, e con be like say, ns the same work we dey struggle to produce talk we dey do here. Na the bonus post place be this o, make we use am wella.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
<...>
From the two charts I go fit understand say we dey try well well for posting but we gat put am oil and grease, if we go comot shame come here yarn better talk, we for don reach far tey tey.
For the merit chart, we no too dey chest merit like water for here base on say na only one source we get, if to say source plenty kperere, we for don reach far for the chart, no be lie.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Please, make we na check this, we people go need to dey increase the way we dey post for here, this go later count towards us having local board.

https://bitcointalksearch.org/topic/m.55551963


Jump to: