Pages:
Author

Topic: Newbies make una stop those off topic posts ASAP (Read 390 times)

full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
Newbies abeg if una no get any useful post to create make una just try dey make comments instead of to go create new topic. The things wey I dey see this period dey make me dey vex, and as e stand now, I no go take likely with anybody wey dey deliberately they make all this useless and off topic post. E get as person go make off topic post but the thread go dey interesting because e carry enough useful information, but when you read something for social Media or news come carry am come here say na thread you wan create when you know standard of wattin we need here, THAT PERSON MUST CHOP TAG.

posts wey I dey see this few days dey make me vex. How person of 42 post a jr member go dey make multiple errors at the same time, only you create off topic wey no get head, and only you still make 3 thread under 2 hours as in, person wey bring you come no tell you how things dey play for here. We no come here to play oo, if you dey here make you know say we mean business.

Unless say you no know the value of this forum naim go make you mess up the place anyhow
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
I gave you my last merits because your OP thread is also what makes us to know that we aren't here to play as this is not a medium for fun or making trashy posts.
I have seen this post more like 5 times but hasn't read whole article but when I come across bit today I just feel to read the whole writings and I get to know that what you are saying are what is making our local board divide into various parts whereby some are posting trashy posts and many are posting quality post with good contents on it.
Whit this post a newbie can know that he should improve their posting patterns from low quality to higher and higher qualities and that will make the person grow in any ranks of his/her choice.
@igebotz just did a wonderful job by creating the spam reporting thread and since then there have been a very big change in our local board,, thanks @igebotz.

Some persons dey forget say this forum no be like other regular social media platforms wey you fit talk anything wey your brain just think. We no come here to play oo, na why we must key into wattin the forum wants from us, now the new trend of shitpost wey dey reign naim be this inflation talk about Dollar gaining value over the Naira. Wattin dey bad if una just make all the comments for one thread? Some person dey act smart to create catching topic for this same matter but the body of the thread na just desame thing. I just wan remind una say, eyes dey watch una oo, after we don agree to make the board a better place una still dey go ahead to dey post rubbish, wattin pain me pass na say some full members sef still join wey dey this things and this na people wey don stay the forum pass 6 months. Truth of the matter na be say, you just dey reduce the reputation of your account.

You wey know the value of this forum, you no suppose let person advice you before you do the right thing
full member
Activity: 182
Merit: 152
Never give up
I think if we get moderators for this our board wey go put eyes on the kind of post wey dey come in here it will reduce the number and rate at which people spam. Since this board is free for people to post what ever they feel like to post people will always post whatever they feel like to post but if we get some people wey deu monitor the board the board will free from spammers and it will be a product of quality posters. Things can only work fine if we get people monitory the board just like every other board that we have in this forum.

Though we never get moderator and we dey pray to get one, but boss igebotz don shook hand for this spamming matter and now e come create thread wey we go fit dey report spammers and AI content to that Dem go either lock the thread or dash the person tag so that e go know wattin e dey do. That na very good update wey dey like this and the board look like wattin don dey clean from excessive off topic and spam posters.
Big thanks to all the person wey dey put body to make this local board a better place I appreciate una effort.
I gave you my last merits because your OP thread is also what makes us to know that we aren't here to play as this is not a medium for fun or making trashy posts.
I have seen this post more like 5 times but hasn't read whole article but when I come across bit today I just feel to read the whole writings and I get to know that what you are saying are what is making our local board divide into various parts whereby some are posting trashy posts and many are posting quality post with good contents on it.
Whit this post a newbie can know that he should improve their posting patterns from low quality to higher and higher qualities and that will make the person grow in any ranks of his/her choice.
@igebotz just did a wonderful job by creating the spam reporting thread and since then there have been a very big change in our local board,, thanks @igebotz.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
I think if we get moderators for this our board wey go put eyes on the kind of post wey dey come in here it will reduce the number and rate at which people spam. Since this board is free for people to post what ever they feel like to post people will always post whatever they feel like to post but if we get some people wey deu monitor the board the board will free from spammers and it will be a product of quality posters. Things can only work fine if we get people monitory the board just like every other board that we have in this forum.

Though we never get moderator and we dey pray to get one, but boss igebotz don shook hand for this spamming matter and now e come create thread wey we go fit dey report spammers and AI content to that Dem go either lock the thread or dash the person tag so that e go know wattin e dey do. That na very good update wey dey like this and the board look like wattin don dey clean from excessive off topic and spam posters.
Big thanks to all the person wey dey put body to make this local board a better place I appreciate una effort.
full member
Activity: 560
Merit: 161
Me I don advice them tire about the way them they post, but em just dey be like say na fuel person dey pour for fire. flie wey no gree hear advice dey follow dead man enter grave. I just like the way the cordination dey Cary come slow by slow we go reach our destination proper.

E just dey sweet me for body say the forum don dey organise again. Because of this attitude don pursue most of our senior men dem comot. Em just be like when a boss leave house for him servant come travel thhinking say the hose dey co-ordinated only to come back home come discover say the house don dey messed up. Wetting you think the boss go do? Na to fire him worker na.
I think if we get moderators for this our board wey go put eyes on the kind of post wey dey come in here it will reduce the number and rate at which people spam. Since this board is free for people to post what ever they feel like to post people will always post whatever they feel like to post but if we get some people wey deu monitor the board the board will free from spammers and it will be a product of quality posters. Things can only work fine if we get people monitory the board just like every other board that we have in this forum.
full member
Activity: 1176
Merit: 118
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Well, I no too blame d newbies for d off topic OP, I blame d people dat is bringing or introducing dem to Bitcointalk.org and to d local board without giving dem proper orientation
about cryptocurrency because, once u give dem little orientation about some of d things dat related to crypto and BTC and were to focus to learn how to improve in quality post, I believe we for no dey see all those off topic in d forum.

 I was told that they are still searching for moderator for us in the Naija local board, I pray the moderator should be home based and also a legendary or Hero members in d Naija local board who know everything about the Bitcointalk.org  and, it will totally eliminate all those off topic and add more value in the Naija local board.
full member
Activity: 140
Merit: 63
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
Me I don advice them tire about the way them they post, but em just dey be like say na fuel person dey pour for fire. flie wey no gree hear advice dey follow dead man enter grave. I just like the way the cordination dey Cary come slow by slow we go reach our destination proper.

E just dey sweet me for body say the forum don dey organise again. Because of this attitude don pursue most of our senior men dem comot. Em just be like when a boss leave house for him servant come travel thhinking say the hose dey co-ordinated only to come back home come discover say the house don dey messed up. Wetting you think the boss go do? Na to fire him worker na.
hero member
Activity: 602
Merit: 504
Top Crypto Casino
But for now I for sudjest make you lock this thread to avoid spamming, since Igebotz own still dey active. Make every shit post matter enter there thank you.


Baba I appreciate you concern and how this off topic matter sef dey pain you but, my thread they entirely different from the one wey boss igebotz create. That na thread wey we go take dey report spammers or Ai post, e just wan be like the one wey dey for meta board. E no dey related to wattin I this thread dey all about. For this thread we dey advise newbie to stop off topic so that Dem fit increase the quality of their post. Having said that, I fit even dey bump this thread on a stead so that newbie go dey feel the heat and know say the matter serious like that.
Welldone brother we dey see all of una efforts and even. If you just dey advise or dey give them small tap to wake up on their shit posting all of them na still for the growth of this our board, abi I no talk inline with the idea? The issue is now being handle and as igebotz don start that him thread I dey very sure must newbie way no wan listen to advise go soon get am clear Wella for him hand as dem don start tag you.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
But for now I for sudjest make you lock this thread to avoid spamming, since Igebotz own still dey active. Make every shit post matter enter there thank you.


Baba I appreciate you concern and how this off topic matter sef dey pain you but, my thread they entirely different from the one wey boss igebotz create. That na thread wey we go take dey report spammers or Ai post, e just wan be like the one wey dey for meta board. E no dey related to wattin I this thread dey all about. For this thread we dey advise newbie to stop off topic so that Dem fit increase the quality of their post. Having said that, I fit even dey bump this thread on a stead so that newbie go dey feel the heat and know say the matter serious like that.
full member
Activity: 238
Merit: 161
The great city of God 🔥
I sudjest the thread created by igebotz  Report Spammers, Spambots and AI Posts Here.
 Naim go help moderate the board even though E dey harsh but I believe say na that pattern go fit help us achieve quality post for here. Although Sometimes too I no go blame most of them. na just ignorant and most of them no get guardian so them believe say every post na post provided say person talk sometime. But for now I for sudjest make you lock this thread to avoid spamming, since Igebotz own still dey active. Make every shit post matter enter there thank you.
member
Activity: 182
Merit: 24
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
I know say post like this been don dey exist, forgive me, but this one too pain me to express my thoughts for old thread.

Newbie abeg I use God take beg una, make una try dey increase the quality of post. This forum no be where you go just wake up from sleep then anything wey you jam for social media you go carry am come dey talk for board. With the little time wey I don dey this forum and this board to be precise, I know how many of our boss at the top they work effortlessly to try make the local board for dey better and outstanding. But all these una off topic post Dem wey no get head don dey too much. Last year we deliberate on this matter, e come be like say the off topic  come reduce but now e don dey come up again.

Make I clear una say, as this our board be first 4 for the entire local boards na so eye Dem dey enter our body, to observe wattin dey happen. And when Dem see say na rubbish post plenty pass the main Bitcoin post, e go come be like say we no serious and we don they compromise. Off topic post get level, e get how you go create off topic but e go dey helpful for us as members of the forum or for our normal lives outside the forum. And e get some kind off topic wey go come even bring Bitcoin discussion for the thread later on, all those na creativity you go take do am. I no go lie you be like we go go back to the time wey Dem been dey report off topic post wey Dem go move to achieve oo. At least that go help our reputation.

Another one again na when we go see people dey go talk rubbish for out side board, guy afa make una use una head pan. Which one go dey go talk like say na Nigeria own naim bad pass for this life, if you wan blab the country come talk for where men go understand come relate with you, no be to dey go sell your own self for outside local board just because you wan try impress outsiders. Omor una wey dey do this thing dey fuck up big time. Una better repent oo, e no good. Why u no use pidgin talk am for local board instead of to dey betray us, they back stab us.
Op is like me and you they reason one thing before you talk this matter enter board, I know say all work without play make John or jack dull for I can say is not in most cases even if it let us balance the table. With some off topic I don't think we are achieving the learning why the board exist, what we need is helpful facts information that brings growth, motivational work and past experience others, the trend ,nature of the market and current news . Where this purpose is not know the abuse is inevitable. Please as newbie is not mandatory you must create topic you can still write useful idea and information on existing topic and get your rewards or merrit, some topics has not comment because nothing to write home or any knowledge to be derived, let's try and help ourself so that the growth will be more efficient because you can be in the board some sometime without gaining better knowledge of off topics become the other if the day.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
Now sef e come be like na newbie outsiders naim don dey come dey post rubbish scam airdrops them, assuming say we get DT member now we for just dey knack them tag on a stead, since to create account no dey tire them. But I appreciate the person wey waka make them for lock all those thread, my brother God bless your efforts, and e go reward you openly. With this actions before you go know the local board go come dey free from rubbish posts. If to say we fit pin some of these kind of thread for up so that any newbie wey come go fit see read, e for better. Then when the post go dey down and newbies wey just come go come start to post rubbish again.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
 Naturally, I for waka pass this thread since I don see many of these but with the Op add ASAP, e mean say mata don pass gari. Make I tell these newbies one thing them no know; this local board be the only place we get o, I no know whether them fit close boards if e no dey give beta contribution o but this no make sense. E no good to fill this place with junk and unnecessary posts wey no get anything of value to the forum. Some of them wan turn here to another Google search engine as every news wey shele, them go wan drop am for here and e no good.
 Truth be told, so many of us don loud this mata but w be like say nothing dey really happen, but good tin say some threads don dey moved. The more these off topic posts are being made, e come dey make here boring to enter because as you open, na wan yeye post wey no get head or tail go fes greet you.

 Nah true say if we check statistics on local boards, nah we go come out first, but that no be avenue to begin post rubbish just so that e go look like say the board dey busy. Abeg make we try dey post things wey get quality and not just quantity.
full member
Activity: 378
Merit: 182
Play Bitcoin PVP Prediction Game
I know say post like this been don dey exist, forgive me, but this one too pain me to express my thoughts for old thread.

Newbie abeg I use God take beg una, make una try dey increase the quality of post. This forum no be where you go just wake up from sleep then anything wey you jam for social media you go carry am come dey talk for board. With the little time wey I don dey this forum and this board to be precise, I know how many of our boss at the top they work effortlessly to try make the local board for dey better and outstanding. But all these una off topic post Dem wey no get head don dey too much. Last year we deliberate on this matter, e come be like say the off topic  come reduce but now e don dey come up again.

Make I clear una say, as this our board be first 4 for the entire local boards na so eye Dem dey enter our body, to observe wattin dey happen. And when Dem see say na rubbish post plenty pass the main Bitcoin post, e go come be like say we no serious and we don they compromise. Off topic post get level, e get how you go create off topic but e go dey helpful for us as members of the forum or for our normal lives outside the forum. And e get some kind off topic wey go come even bring Bitcoin discussion for the thread later on, all those na creativity you go take do am. I no go lie you be like we go go back to the time wey Dem been dey report off topic post wey Dem go move to achieve oo. At least that go help our reputation.

Another one again na when we go see people dey go talk rubbish for out side board, guy afa make una use una head pan. Which one go dey go talk like say na Nigeria own naim bad pass for this life, if you wan blab the country come talk for where men go understand come relate with you, no be to dey go sell your own self for outside local board just because you wan try impress outsiders. Omor una wey dey do this thing dey fuck up big time. Una better repent oo, e no good. Why u no use pidgin talk am for local board instead of to dey betray us, they back stab us.

Bro you have said it all, newbies here are not after quality again they just post anything they like because they see this board as there board, how would tell the outside world what you are made of, it is important for newbies to change from this attitude, most thread here is just like a reply not a topic because most of them does not possess the standard of thread, some people get tired of than local board because of the newbies attitude, everything should not be a post, for me, I think what a newbie should be doing here is to concentrate on asking more question, making more research to know how it works here, if things continue this way, many will be ignored.
newbie
Activity: 36
Merit: 0
Snr man watin you talk no be lie oo me sef I be for this forum I been no really understand at first because I been feel say as na Nigeria board you fit talk anything related to Nigeria but seeing this your thread now I calm down go through ahm con see say watin you dey talk na true. If we no talk anything about this off topic e go take over for this forum and the snr men them wey fight to bring up this local board go be like say we don disappoint them

So I like watin you talk though me sef na newbie for here too wey dey still learn about this forum. I go say threads like this na some newbies need as they just start
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
Tankz,u tok wella, even miself mek de mistek bcs I no undastan de forum then,I tank u for de brodaly advice.Mi I be newbie mek Una also give mi som help in al direction dat will  mek mi grow.

As newbie wey you be, the advise wey I get to give you na be say, make you do enough reading rather than postings. You fit dey post one or two, but make your major work for now be reading, try they read quality informative threads especially the ones talking about Bitcoin, you go see say in no time you go get quality knowledge to fit dey contribute and that go eventually give you merit.

Almost everybody start from newbie, na only few person wey as Dem come the forum Dem don already get knowledge about Bitcoin, so their post from day one dey make sense with quality. But me I start with zero knowledge but I come go find material online dey read, plus the one wey I see for this forum. Before you know I don dey get small knowledge wey I take dey contribute for as comments. And one thing na be say make you make more of comment than posting thread. From Commenting on other people thread e go help you learn to build constructive post.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
E be like say I don dey see some moved topics, great action. Na like this small small we go take dey clean the local board from original off topic post. Any post wey you know say off topic well well, abeg una fit even report am to the moderator make e for move am to off topic. But this action go really work faster when the account wey dey report get reputation. That is, if na higher rank the moderator go reason am pass when na just newbie, jr member or member rank. Let's work hand in hand to help our local board.
full member
Activity: 280
Merit: 151
God is All
Me I feel say na because of the OT wey dem get because most newbie dey on the orientation say if dem create topic then e go dey easier for them to get merit which dem no know say na big lie

The most annoying part is that they don't even actually see the topic and check if they can relate with it properly before posting it to the general topic. And the worse part of it is that they hardly stick to correction because some of them after being guided still tend to post and continue with the spamming of the LB.
full member
Activity: 182
Merit: 120
Cashback 15%
I will speak concerning this matter but me self no dey perfect na learn I dey learn but if I do anything wrong for this forum and person correct me I go feel remorse, but now you talk today, you complain tomorrow them go still flood the board with this topic very funny, as everybody don agree say the team na no gree lol. The one wey really surprise me na I see one interesting topic to share my idea concerning wetin the op talk but at that time I dey really busy and no way to comment so I drop my phone, within 2hrs I come back online looking for the topic I no see and to my surprise new topics don full board I gat search for this topic before I see am, the first time things no be dey like this so why things dey change now, now wey be new year na now we suppose take the seriousness to another level rather na the other way round.
full member
Activity: 182
Merit: 152
Never give up
The worst part of it all be those our fellow Nigerians wey dey post trashy posts for general boards like Bitcoin discussion board.
Just few days ago, I come across one trashy posts from one guy wey register for forum since 1 year ago and em no get any merit. But firstly I dey really blame some pipo wey dey carry them come because when you no lecture your apprentice e no go gain any knowledge of watin em dey see.

How some body go go Bitcoin discussion board go dey talk say people dey suffer from Nigerian scammers hand, and the person already know say the Nigerian board dey for here. And how the poster of that post go want make the other people way dey this forum take dey see the Nigerians way dey inside the Nigerian local board, and still the poster na still Nigerian.
E better make person make any mistakes for e local board than to carry am outside. Now it em done go tannish the Nigerians image for the general boards, tomorrow if anything happens to the say guy, na who go get straight speak for am?

Anyhow wen e be, as a person way dey think outside the box you suppose to know say this thing wen you won post go make sense then you post am and anyone way you know say no go make sense you live am instead of to go dey post something wen people go take out you for ignoring list.

If person make mistakes for em local board, others go contact am through pm or post am for the thread tell you watin you go do, na make I talk say e better make person make mistakes for e local board than to carry am outside, for others to think say everybody way dey the board na one and get the same characters.
Pages:
Jump to: