Pages:
Author

Topic: Newbies make una stop those off topic posts ASAP - page 2. (Read 390 times)

hero member
Activity: 854
Merit: 1246
I gave you di merit when I see di topic without reading the content because only the topic has don justice to di body of di thread. Your thread really make sense. For now dis na one of the best posts in di local board. And you have tok well. And for me I no go blame di users wey dey post and creating those trashes but I blame those who brought dem here. You one thing in life, a father also produces his kind, a good lecturer produces his kind. Like example, di person dat introduced you to do forum will never regret because you are good and doing well. Some people introduce people to di forum because of signature campaign and nothing more. They themselves don't even know what is bitcoin and probably because merit is flowing in the local board they were opportune to rank up and enter campaign so they tell their friends and family members to join and those are di people dat producing the trashes in di local board. Let see what we can do again. And I thank God that you brought di issue. When I created a thread to shortlist some of them, someone was saying he would message those users but I don't know how far him don go and do with dem in the pm section. Well dis will wake me up again and I will put into very serious action dis time around.
We have been saying dat if you dey bring person to di forum make sure you tell di person to what to do and don't just abandon di person. Give di person home trading. I think when some users will become victims di others go learn from am.
full member
Activity: 560
Merit: 161
This na bitcoin forum wey wetin we suppose to discuss must be bitcoin and it related but most times wetin I dey see here is very different , and have nothing to do with bitcoin. Wetin we suppose to dey see here na things wey suppose concern money , wey fit help to grow financially and things wey fit make us not to fall into the trap of scammers. Newbies just needs to understand the aim and the purpose of the forum,  and to bring good discussions wey go fit into here that will be of benefit to other members.
hero member
Activity: 602
Merit: 504
Top Crypto Casino
I know say post like this been don dey exist, forgive me, but this one too pain me to express my thoughts for old thread.

Newbie abeg I use God take beg una, make una try dey increase the quality of post. This forum no be where you go just wake up from sleep then anything wey you jam for social media you go carry am come dey talk for board. With the little time wey I don dey this forum and this board to be precise, I know how many of our boss at the top they work effortlessly to try make the local board for dey better and outstanding. But all these una off topic post Dem wey no get head don dey too much. Last year we deliberate on this matter, e come be like say the off topic  come reduce but now e don dey come up again.


Well as far as new members  dey come the forum this kind of things no go stop so the best you and everyone of us can do is to keep the word flying so that eventually things might turn around with this newbies because most of them are really confused on how to go about things and I believe with good orientation they might actually turn up which I have seen several cases of users do.
member
Activity: 112
Merit: 78
I don't know why my fellow newbies are flooding this place with posts which are off topics. I don't really know if they where not properly oriented or they are the ones who have refused to learn from the people who brought them to this forum. My humble appeal is that my fellow newbies should learn from people who has been here before us and are setting the pace for us to follow. Let's learn something good and avoid something that will make us be on the bad book of the forum.
full member
Activity: 224
Merit: 195
At the very beginning of me joining this forum, there has been some sudden changes, poor posting style and thread.
This Newbies are all up creating threads up and down, not even creating something meaningful just some random shit posting. I don't think this will help us grow further, the sooner they realize that the Nigerian Local Board Is having enough spammers in it then they disregard all our efforts. Currently the Nigerian Local Board is one of the top boards in the forum and we need to maintain our standards without falling out. We require more hands on deck, every body creating threads just to earn merit, it is very improper and should be be stopped.
full member
Activity: 280
Merit: 159
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Since our senior men for the forum addressed the issue of shit posts for the local board, the thing has been reduced. But the newbies, wey they enter the forum, no fit dey aware of the issue, so I suggest make newbies, wey dey enter the forum for the first time, read that thread wey we take address the issue of shitposting so that they go know wey thing be shit post and know what type of post to make for our local board. Secondly, make we stop to dey bring up wey thing we dey pass through for life come local board
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
To me I go add say since you know say topic like this they exist, eh for better make u just add this your thread like comment for the thread way already they exist than for you to create another thread


Just as @ever-young cap, eh for good day you been just add this your thread as a reply to the already existing thread wey the talk on this same issue of misbehaviour and off topic wey done the be like a recurring challenge for our board.

That na why I apologize for the first place , I know say e dey wrong, na why I beg in the first place. Make una no vex for breaking rule just this one time. Wattin my eye dey see dey bitter my heart, just go look the local board like this now, na soso off topic don full everywhere. If na one one we dey see we go pain person, but this one wey naim come many pass soo, naim dey pepe me so.
hero member
Activity: 728
Merit: 512
@Makus nah as eh the pain you nah so eh the pain every well meaning Naija person for inside this community on how this new fresh dudes the behave just to colet merit abi recognition from oyinbo men them wey no even get their fvckin time. Just as @ever-young cap, eh for good day you been just add this your thread as a reply to the already existing thread wey the talk on this same issue of misbehaviour and off topic wey done the be like a recurring challenge for our board.

If only these newbies knew how men them struggle, the mental energy wey men them put together in unity agitating every now and then just for us to get this our local board eh, just if only them know them for don stop some of these rubbish them the do for both inside the LB and other general boards as Nigerians. If this way wey most of these newbies we the get nowadays the misbehave, say nah so the men wey been dey here before them come been the also behave like that I no sure say them for come jam this prestige them the enjoy inside the community as a Nigerian.

Na people build the reputation wey una newbies the enjoy today, so abeg make una also ensure with all sense of reasoning to maintain and build further on that repute in good hands because all these complains done the too much. And as for old people wey the bring in newbies into the forum, make unah try the orientate them about the kinds of topics to bring here, if possible which I know it is, make unah the ask to review any topic them create and intend to drop for the forum before them drop am. In that way most of this low quality, off topics and those others way the about tarnishing our country image go dey very reduced.
full member
Activity: 182
Merit: 109
My snr man @makus you don talk well, no be only you dy see am, me self wey they new here dy observe am, but too me It still boils down to wetin dem tell the person, before him even enter the forum,  the lack of proper orientation nai be the major issue wey they cause this tins, secondly, some people expecially newbies, if them no get anything to write or talk about dem no go just rest, dem go wan force something out of their system, wey no go make sense base on say dem lack enough creativity then, abeg as a person e dy very good to learn how to do the right thing, even when no one is watching.

Concerning those people wey dy go rubbish our country for English board, I dy use God name beg ona, make ona stop that nonsense, Nigerian get a very good reputation for this forum, no go rub everybody oil because of ur selfish interest, you think say na only Nigeria bad? You don see any day for this forum wey American citizen don come out come dy rubbish their country, you think say them no get their own bad side? those people wey dy do that thing make ona stop abeg, ona no go use am achieve anything.
full member
Activity: 1134
Merit: 154
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
To me I go add say since you know say topic like this they exist, eh for better make u just add this your thread like comment for the thread way already they exist than for you to create another thread, another thing too nah say those topics them way you consider to they off topic you for try make you quote some of them or even drop link to am make people way they create those off topic post also take note if possible dem go work on there self or better still avoid to create thread.

Some newbies just feel like say nah to create thread full everywhere be the thing to do them know no say eh get how dem go create some kind thread reach even people way suppose give them merit go add them for there ignore list.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
I know say post like this been don dey exist, forgive me, but this one too pain me to express my thoughts for old thread.

Newbie abeg I use God take beg una, make una try dey increase the quality of post. This forum no be where you go just wake up from sleep then anything wey you jam for social media you go carry am come dey talk for board. With the little time wey I don dey this forum and this board to be precise, I know how many of our boss at the top they work effortlessly to try make the local board for dey better and outstanding. But all these una off topic post Dem wey no get head don dey too much. Last year we deliberate on this matter, e come be like say the off topic  come reduce but now e don dey come up again.

Make I clear una say, as this our board be first 4 for the entire local boards na so eye Dem dey enter our body, to observe wattin dey happen. And when Dem see say na rubbish post plenty pass the main Bitcoin post, e go come be like say we no serious and we don they compromise. Off topic post get level, e get how you go create off topic but e go dey helpful for us as members of the forum or for our normal lives outside the forum. And e get some kind off topic wey go come even bring Bitcoin discussion for the thread later on, all those na creativity you go take do am. I no go lie you be like we go go back to the time wey Dem been dey report off topic post wey Dem go move to achieve oo. At least that go help our reputation.

Another one again na when we go see people dey go talk rubbish for out side board, guy afa make una use una head pan. Which one go dey go talk like say na Nigeria own naim bad pass for this life, if you wan blab the country come talk for where men go understand come relate with you, no be to dey go sell your own self for outside local board just because you wan try impress outsiders. Omor una wey dey do this thing dey fuck up big time. Una better repent oo, e no good. Why u no use pidgin talk am for local board instead of to dey betray us, they back stab us.
Pages:
Jump to: