Pages:
Author

Topic: Nigeria and the new government (Read 187 times)

member
Activity: 406
Merit: 84
Eloncoin.org - Mars, here we come!
June 05, 2023, 01:01:33 PM
#24
Sometimes tinubu government fit be the best shall, though I no support tinubu right from start, but as e be now make we just accept the new government and stay in peace to avoid Crisis and war,  with all wetin tinubu dey talk for manifestos, if na wetin en go really do, then I believe say Nigeria will be better...
Make Nigerians, mostly the youth, make we embrace peace because if we say we no go gree e go cause war and if the war start, na we wey be citizens go still suffer am because e no go affect the politicians (Tinubu, Peter obi,Atiku etc). So make we stay calm and give peace a chance...
newbie
Activity: 57
Merit: 0
June 05, 2023, 10:41:26 AM
#23
The new government finally come onboard on this day. To all who have thought their would be war or evil, God took control. Whether the sworn in is your preferred candidate or not, let us unite as one Nigeria and move the country forward leaving aside the pearcing dagger of tribalism.

I look forward to seeing a better government, a greate investment on food and agriculture, Technology, education, employment , greater support for Blockchain technology and infrastructural development.

Put yourself together and work with a vision to be somewhat in this new government, personal determination is a reason to any outcome of your life, don't blame any government for your negligence.

Welcome to a new era of Tunubu government. Nigeria, different culture,  different languages , one people.


I don't think anything good will come out of this administration, and is also very early to start celebrating.
sr. member
Activity: 714
Merit: 358
Underestimate- nothing
June 04, 2023, 04:49:25 PM
#22
The new government finally come onboard on this day. To all who have thought their would be war or evil, God took control. Whether the sworn in is your preferred candidate or not, let us unite as one Nigeria and move the country forward leaving aside the pearcing dagger of tribalism.

I look forward to seeing a better government, a greater investment on food and agriculture, Technology, education, employment , greater support for Blockchain technology and infrastructural development.

Put yourself together and work with a vision to be somewhat in this new government, personal determination is a reason to any outcome of your life, don't blame any government for your negligence.

Welcome to a new era of Tunubu government. Nigeria, different culture,  different languages , one people.

If the new administration comes in with something new, we should hope for the better. If not, it's not going to be easy at all. Even the issue of this subsidy is going to need a lot of implementation before it can be declared which they did not consider.
When the price of gasoline rises, it affects everything we can think of, and if the government does nothing about it, many people may even find it impossible to feed.
Therefore, if the government doesn't boost the minimum wage and offer other forms of transportation, we still have a very long way to go. I simply want for a better government. Looking from the streets you see how scanty it is become because of the price of transportation.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
June 04, 2023, 01:42:59 PM
#21
All I can sey is dat we're in for a disastrous ride. My people talk sey na d smell (odour) of mess dem dey take know the taste of shit. We don see how e dey go now wit just one day in office. Baba Blue–laba don begin show us renewed shege.
Oga why you dey talk like this, because person were get the interest of thos country for heart go know say true true the new government have not to sign any single penny from the federation account or have tempered with any federation money, so people that ascribe the current challenges to the new government be like people that blame the current network congestion that result into high fees on bitcoin scalabilities.

So let's get things straight and as educated people let's try to enlighten our people in the right way and with the right information.

Fuel subsidy no concerned tinubu in any ways and at that we must braze up for the task ahead to reclaiming our nation from the muster call subsidy in any form.

As them remove subsidy from gas over a year ago we die?


So this time also it for long term benefits of this nation economy, so we have to cooperate with the government.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
June 04, 2023, 09:34:41 AM
#20
All I can sey is dat we're in for a disastrous ride. My people talk sey na d smell (odour) of mess dem dey take know the taste of shit. We don see how e dey go now wit just one day in office. Baba Blue–laba don begin show us renewed shege.
If we can survive Buhari 8 years tenure as the president of Nigeria, I believe we can all survive anything wey Tinubu government go bring come to the table as em the rule us for the country.

Em d very unfortunate sae our rightful candidate no win the election but still yet Tinubu don become our president and we gat to accept am with good fate until the tribunal give their final verdict about the presidential election of who win or not.

You no wetin the give me concerns of late be sae how our electoral voting system go be in the future if finally Tinubu succeeds running us in his first tenure and nothing happens via tribunal making a proper judgment towards the election rigging brought before them. You go know sae anything like voting during the election period don end for millions of Nigerians side. People no go get mind to come out to vote ever again. Peoples mind go be, after wasting time to vote, INEC go now select who d want to win the election. So no need of voting since peso vote no d count again for Nigeria election
full member
Activity: 504
Merit: 198
My privacy, my right.
June 03, 2023, 06:48:51 PM
#19
All I can sey is dat we're in for a disastrous ride. My people talk sey na d smell (odour) of mess dem dey take know the taste of shit. We don see how e dey go now wit just one day in office. Baba Blue–laba don begin show us renewed shege.
The shege is somethng that came so fast than when when we had expected it. The truth is that a house built on lies and coercion and rigging can not stand, so make we no dey deceive our self. As long as there are some aggregations yet unsettled and issues still left unattended to in a supposed democratic system then there would always be a recurrent decimal of how things has always been. I don't wish for the worse but from all indication from religion to ethnicity down to tribalism and statism e are no living like a one people. If I dey lie den check as the sharing of appointments formula go be nah.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
June 02, 2023, 08:22:34 PM
#18
😂 You funny die oh. You dey ask question sey e b like small area dey shake for their bodi like sey you nor know sey Tinubu im sef dey shake. Abi you nor watch the inauguration on May 29?

Senior man no mind me oh😅, if you follow the way things be for this contri you self fit shake pass your newly elected president.
I watch that video and to delete am no even hungry me, that alone go let you believe say this contri nah autopilot e dy as I been talk...
The play go soon start oh...
hero member
Activity: 812
Merit: 675
June 02, 2023, 04:28:31 PM
#17
All I can sey is dat we're in for a disastrous ride. My people talk sey na d smell (odour) of mess dem dey take know the taste of shit. We don see how e dey go now wit just one day in office. Baba Blue–laba don begin show us renewed shege.

As him don talk say renewed hope, na the hope be dis? Na so we go take start am with dis new government? One tin I know be say and I believe in wella na him be say dis Naija go better whether na through difficulty or no. Dis kind shege, we neva see am before but make we just dey believe say better days dey ahead for us. As we no say, every good tin no dey come easy, we gatz pass through dis vigorous process to make tinz right. I been vex before, but na only the word wey say, “there’ll be light at the end of the tunnel” still dey keep my hope alive for dis renewed hope.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 02, 2023, 09:49:57 AM
#16
~
even if you live in denial for the next 4 years, e no go change anything...
By inference, no wan is living in denial. My point is dis, as you talk about supporting him; how do you do it? By saying his excellency to his name or referring to him as "our president" "my president", knowing sey na stolen mandate? I get ur point small but you nor supposed give up easily and begin show pessimism. My people sey wen dem carry anoda persin corpse wey nor dey related to us pass, e dey by like sey na firewood dem carry pass. We supposed still dey in solidarity wit the people's will. Again, make you also reason am sey Tinubu fit knack ban on crypto transactions oh. Na their way. Those old men nor get joy at all.
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
June 02, 2023, 09:18:01 AM
#15
My brodas, shey una sabi sey na dis type of belief make us dey like dis for dis naija so? You see a man wey rob you of your votes and right to vote you still sey you nor get any orda choice than to support am? What happens to rejecting him?
What do you mean by rejecting him? The reality be say na Tinubu be the president of the federal republic of Nigeria, even if you live in denial for the next 4 years, e no go change anything; the election is over, the election process is being challenged in court, so imo the only thing wey person fit do now na to support the new government and wait for the courts verdict. Me i dey vex say my candidate wey be Peter Obi no win, but there's nothing i can do as things stand, i did my own part by casting my vote for him and defending it as well.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 02, 2023, 07:57:41 AM
#14
I no support Tinubu, neither did i want him to win, but as e be so election don finish, so i just have to support the new president and the new government, wishing them evil no go help me, so i have to wish this new administration success and to pray for them to make Nigeria proud.

Whether we vote for the new government or not no matter now wey dem don swear them in. The only thing to do now na to join hand with dem in our own small ways to make the country better, by being law abiding and to do our work diligently.
My brodas, shey una sabi sey na dis type of belief make us dey like dis for dis naija so? You see a man wey rob you of your votes and right to vote you still sey you nor get any orda choice than to support am? What happens to rejecting him? I don even begin hear people wey condemned Tinubu before begin talk now sey maybe na d will of God for im to be there as president. All dis wan na wash because nothing concern God and politics. I follow ordas too reject Tinubu and this wicked government. I want a country where things will work.

We dy pray make we land well oh, this government is like e get small areas wey dy shake for their body so.
😂 You funny die oh. You dey ask question sey e b like small area dey shake for their bodi like sey you nor know sey Tinubu im sef dey shake. Abi you nor watch the inauguration on May 29?
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
June 02, 2023, 07:30:21 AM
#13
All I can sey is dat we're in for a disastrous ride. My people talk sey na d smell (odour) of mess dem dey take know the taste of shit. We don see how e dey go now wit just one day in office. Baba Blue–laba don begin show us renewed shege.

My senior man you say we're in for a disastrous wetin😂😂😂?
No be now e begin oh, this contri nah autopilot e dy since oh.
We dy pray make we land well oh, this government is like e get small areas wey dy shake for their body so.
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
June 02, 2023, 01:58:30 AM
#12
But sha, this fuel subsidy removal by the new president, at dis time no de favourable to the masses at all, long queues for filling stations with high prices, the effect go be inflation because e go cause prices of everything to go up, thereby devaluing the naira. Even though say we no need de subsidy, the president for first put measures in place so the people no go de suffer like this.
E no get anytime wey dem go remove fuel subsidy wey people no go complain, na so e be, and removal of fuel subsidy must cause hike in the price of fuel, but that one na just for the short term, we have to look at the long term benefit. Nigeria they budget trillions of Naira to pay for fuel subsidy, me and you know say no be all that money dey go into paying for the subsidy, plenty still dey enter some people pocket, the money wey Naija dey budget for subsidy too much, and e dy affect the budget for other sectors of the economy.

Having said that, the downstream sector dey somehow decentralized now, private companies go fit come in and competition go come dey, i am in support of this deregulation, but that is if the government do everything right, and make sure say dem concentrate on other sectors of the economy, wey go increase minimum wage and create more jobs.
full member
Activity: 364
Merit: 220
Eloncoin.org - Mars, here we come!
June 01, 2023, 05:52:05 PM
#11
Whether we vote for the new government or not no matter now wey dem don swear them in. The only thing to do now na to join hand with dem in our own small ways to make the country better, by being law abiding and to do our work diligently. But sha, this fuel subsidy removal by the new president, at dis time no de favourable to the masses at all, long queues for filling stations with high prices, the effect go be inflation because e go cause prices of everything to go up, thereby devaluing the naira. Even though say we no need de subsidy, the president for first put measures in place so the people no go de suffer like this.
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
June 01, 2023, 03:02:53 PM
#10
I no support Tinubu, neither did i want him to win, but as e be so election don finish, so i just have to support the new president and the new government, wishing them evil no go help me, so i have to wish this new administration success and to pray for them to make Nigeria proud.

Having said that, the removal of fuel subsidy isn't a bad thing, no be today wey we don dey hear talks of removal of fuel subsidy, the upper class they use subsidy chop money and to centralize the downstream sector, as them remove so, the government go fit use the funds for other sectors of the economy, wey go lead to economic growth and increase in minimum wage (that is if the government do the right thing). Subsidy removal go also create free market in the downstream sector, competition go dey and in the long run the price of fuel go come down and scarcity no go dey like before.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 01, 2023, 02:06:47 PM
#9
Make we still dey pray say make God still dey take control because e never end. The end go justify the means.
By now we supposed don realize sey God nor dey interested in politics. Countries wey things dey work well nor be religious countries dem sef, you fit check dem out. Na citizens dem dey take the bull by the horns. They don't call on God to do it for dem. Make I even play you d reality. Wit years of experience, I don com realize there are two areas in man's life wey God nor dey like put mouth – Politics and Wife selection. God only comes into marriage wen you don already settle down, carry d woman enta house in d right way.

~
Apart from our government, e be like we dey do ourselves wicked well well.
My guy, na hat-trick you score at once wit dis comment. Make I nor too talk put there. BTW, double congrats, my guy! E good as you don com join us for up. Wen you go host us wit taati butas of fuwel oh 🤔

Quote
Our new president should not have been quick to announce subsidy removal like that
Una sure sey Tinubu even know wen im take talk dat thin. Shebi dem dey teleprompt am on wetin to talk.
sr. member
Activity: 378
Merit: 259
June 01, 2023, 01:26:13 PM
#8
Day one he hit the ground running without any direction and plan. For physics that year, Dem been teach us about scalar and vector quantity.  Dem talk say scalar quantity no get direction but vector quantity get direction and magnitude. Tinubu na scalar quantity and Obi na vector quantity. From wetin I understand about the removal of subsidy eh, e nor bad at all. Even Obi, talk say him go remove subsidy but at least he tell us how him go take do am but this one now just open mouth waaw, without any plan first. See were him don put us now. Even NNPC nor like am but Dem gats play along.
Me i no dey support the removal of subsidy, because every country in the world subsidies one or tings to make life easier for their citizens. Instead wey be say Nigeria Wan remove subsidy why we no fit repair our refineries? And the big fear now is dat if we finally remove subsidy say e dey go back to proper channels?
We are Nigeria where everybody make use of any slice opportunities.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
June 01, 2023, 12:07:00 PM
#7
All I can sey is dat we're in for a disastrous ride. My people talk sey na d smell (odour) of mess dem dey take know the taste of shit. We don see how e dey go now wit just one day in office. Baba Blue–laba don begin show us renewed shege.
Apart from our government, e be like we dey do ourselves wicked well well. You remember during that time wey money dey scarce too, how POS people been dey use us dey cash out with their very high withdrawal charges, na so fueling station owners dey do right now. Our new president should not have been quick to announce subsidy removal like that, it has made fueling station owners to start hoarding the product and selling at ridiculous cost for a litre.

We nor fit just cun dey blame Tinubu now now, na just talk e talk, people wey we suppose carry eye face na the people wey decide to immediately begin to sell their old products at new price, na dem dey cause all this problems.

hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
June 01, 2023, 10:05:25 AM
#6
To all who have thought their would be war or evil, God took control.


Make we still dey pray say make God still dey take control because e never end. The end go justify the means.


Whether the sworn in is your preferred candidate or not, let us unite as one Nigeria and move the country forward leaving aside the pearcing dagger of tribalism.


This election self no too dey about tribalism because even strong hold of Tinubu, many no support him. To move the country forward go hard with the high level of rigging wey every person know. Is not like in the past wey people no too dey put eyes down and now the margin for rigging and mode of it na slap on the masses.

Who e even be you like say win the presidential election?


Before we can see a better government we need to be a better people, we have to be the change that we want first before we can be able to see thigs change around us, people there in government position are just common beings like us, who can make mistakes any time and yet be corrected, we have to also love one another, learn to live in peace with all men, be a patriotic citizens and contribute to the growth and development of the country.

Lol... my brother you dey talk about love one another, you don see love without money for pocket? Hunger dey everywhere, no be home video. For the other hand, me I no believe say change go start from the people oo, no. Na people in government go begin change. Them go begin change by enforcing the right thing. If them begin call bad thing to be bad thing and punish even their family members and friends wey do bad thing then change don begin be that na and every other person go fear to do wrong. The theory of social contract don carry power and authority give the people elected or selected (any how them enter there ) to lead followed by the authority to command obedience through even guns. So change start with people in authority and even for Nigerian system, change start from the number 1 person be it the president or governor because Nigeria be like country wey dey practice unitary system of government mbok.

From wetin I understand about the removal of subsidy eh, e nor bad at all. Even Obi, talk say him go remove subsidy but at least he tell us how him go take do am but this one now just open mouth waaw, without any plan first. See were him don put us now. Even NNPC nor like am but Dem gats play along.

My brother you see that subsidy, if them go remove am time never reach. Like NLC dey follow government in the past talk say make dem repair refinery but dem leave that one go allegedly support dangote own wey obviously dey out for profit. Now NLC and TUC through their presidents, come. Joe Ajaero and Mr Festus Osifo respectively don dey remind them on Aburi we stand lol. Meanwhile, that subsidy na the cost wey dem dey take carry crude go abroad, refine and bring am back. So na who cause am wey make dem dey carry crude go abroad? Na the question be that wey NLC dey ask.

The spokes person to Tinubu, Dele Alake don already start the talk talk and lie lie wey dey inside. We still dey where we dey if not worse off. God help us.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
May 31, 2023, 07:50:10 PM
#5
Day one he hit the ground running without any direction and plan. For physics that year, Dem been teach us about scalar and vector quantity.  Dem talk say scalar quantity no get direction but vector quantity get direction and magnitude. Tinubu na scalar quantity and Obi na vector quantity. From wetin I understand about the removal of subsidy eh, e nor bad at all. Even Obi, talk say him go remove subsidy but at least he tell us how him go take do am but this one now just open mouth waaw, without any plan first. See were him don put us now. Even NNPC nor like am but Dem gats play along.
Pages:
Jump to: