Pages:
Author

Topic: Nigeria’s new monetary policy cannot stop vote-buying. Discuss. - page 2. (Read 336 times)

member
Activity: 308
Merit: 32
New naira policy no fit stop vote buying for this country, ok now for Kaduna state the government say em know bank manager wey give one governorship aspirant 500million naira new notes , so even as the new naira they scarse so we people they collect am in bulk, na why the Naira scarse because our politicians done go do business with bank people to sell them the naira notes and come dey load small small money for ATM machine.
 Even the deadline wey dem been fix I been know say federal government put a this new naira policy in place just for the primary purpose of stopping vote buying but the supreme court done order the federal government not to ban the new naira notes so we never really know as e go be..but new naira policy no fit stop vote buying.
full member
Activity: 980
Merit: 237
I just sit-down for one corner dey laugh out loud, because this issue of vote buying is sure electoral practice. Though not legal, but we know how it is during such election times. I doubt there had been a time in this country when during election the prices of things become cheaper or cash flow become free.
The hardship and unavailable cash is more political than economic. The election is just some days away, and we would hear and see cases of vote buying more open and undisputed.
Let's vote wisely so we can from now secure the future of generations coming up.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Hire Bitcointalk Camp. Manager @ r7promotions.com
This year general election in Nigeria will be the worst election for vote buying. Okay look at it from this angle, now there is no money in circulation to the poor masses but nobody will tell me that no politician has enough cash in their houses for the forthcoming election. We know sae no politician and stand on the queue we stand. They only make calls and have their ways with millions. Ok now when di election kick start and in di polling unit APC or PDP gives you 10k with this hardship to get cash to vote for them won't you collect it? Time will tell, let us wait and see. I will be an election observant.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329

Wetin go make vote buying difficult na if those thieves weh be our politicians no see cash distribute and na the thing weh Emefiele deh try do. E no matter whether na dollar or naira them want to use. But some bank managers deh try sabotage Emefiele efforts by going through the back door to give those politicians cash. Na we deh do ourselves for Nigeria. We like to take shortcut and not follow due diligence. People no deh go prison for Nigeria for wrong things weh dem do once them show connection. Na all this things deh make many connected people to misbehave.
full member
Activity: 560
Merit: 100
Eloncoin.org - Mars, here we come!
This monetary policy no go stop vote buying oo, the way we dey complain of hardship and lack of money, e no dey affect politicians, this politicians too value power so Dem go do everything possible go collect power, and plenty citizens for naija too get this love for money, Dem prefer money pass our Nigeria to better, so they are ready to collect money from politicians to sale their vote, we dey Nigeria, this vote buying no go end...
hero member
Activity: 700
Merit: 673
Make I ask, which currency wey PDAPC(PDP and APC) been use during their presidential primaries to take buy key electoral officials, delegate electors, voters? Na Naira or na dollar?
Nah still the naira nah I mean the old naira way them change nia them carry buy the last vote. Lol.

Even if them succeed change this money finish the way them want change am, people way go buy vote go still buy vote, because people way them been they rush to change the money for, nah still the same people way don park the new money finish, when me and you they here they suffer to get am..

This vote buying of a thing no go end for this politicians, nah just us way be the voters nia go decide weather we go take the money vote for them or not .. me I no go advice anybody make in no take any money from any body oooh, because the money nah still our country own. Take the money agree to vote for their front, when you reach were to drop your vote you carry you hand vote who they your mind.. no be them go use ur card  do the vote nah still you.
hero member
Activity: 602
Merit: 442
A Proud Father of Twin Girls 👧 👧
No stress boss but weda we like am or not, this vote buying matter no go end anytime soon and even if e go end, I no really sure say na for our generation because so many things dey very wrong and most times even from our very tertiary institutions you go notice say this vote buying don dey paramount as students wey be leaders of tomorrow don already dey rig elections wey suppose dey free and fair and then we still dey expect them to dey free and fair when them enter politics proper?
I guess no and the only thing we dey pray for na positive change and that positive change go begin from is the citizens if we go fit refuse the money them go bring and vote in who we see fit to rule rather than selling our votes with believes that our votes don't count.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
This one na very interesting piece wey I read. The person wey write am try wella. Personally sef, I see say e make sense. Wetin e talk be say despite the new monetary policy wey oga Meffy don put for ground e nor go fit stop vote-buying during the election. Wetin be some of the new monetary policies? Una don already know that one Grin.

For this article, the writer talk say why this new policy nor go stop vote buying na becasue of the dollarization of the Nigeria economy. Wetin this one mean? See him summary
Quote
...the CBN’s monetary policy reforms are not expected to exert a fundamental change on the Nigerian dominant vote-buying culture. While it might minimise the use of the local currency for transactional politics of vote-buying, the policy is unlikely to stem the entire gamut of the thriving vote-buying “industry” in a heavily dollarised liberal democratic milieu as Nigeria.

To understand am better. Make I ask, which currency wey PDAPC(PDP and APC) been use during their presidential primaries to take buy key electoral officials, delegate electors, voters? Na Naira or na dollar?

Anyways, I hope say una don see small reason too. We fit still discuss am. Make una shook mouth as e dey hot?

Una doh o
Pages:
Jump to: