Pages:
Author

Topic: No need to change job due to low salary, just add another source. - page 3. (Read 488 times)

sr. member
Activity: 588
Merit: 338
I reason wetin you talk, unto say if the income for di job wey you de do no de reach you, instead to leave am, say make you find another hustle join am, afterall a bird at hand na im sure pass. But wetin I go add be say make person no de settle for less, you fit to de manage di job and at di same time de look for a better package elsewhere, instead of to sidon idle, because no food for lazy man. To add another side hustle good but what if di Job wey you de do no give you any chance to do side hustle? You see am say life no balance, because most employers dem go over work you and dem go like to pay you very small salary, if you continue for di job, no hope for a better life and if you leave di job, how you wan take care of your needs. Infact e be like say na crime to de poor, so to get out of dat kind rat race, na to stay for di job and try to learn one skill by fire by force, weda na tech or handwork, sabi am and find your way to an independent better life.
sr. member
Activity: 266
Merit: 205
My country people good evening inside this evening, today e get one issue wey I just dy reason with one of my guy, so I just say make I share this idea, if e go make sense to some people or not.

The issue na concerning one of my guy wey dy tell me say him dy find another work because the one him dy do, the money too small , say e no dy reach him and his family again, so I ask am how much dem dy pay am? Him say na 90k, i just weak as him tell me the amount, I tell am say, bro ur salary dy fair enough to dy complain like this na, just look for another thing to use double ur hustle, no need to dy look for big job wey no dy come, I even suggest Bitcoin and other business wey him fit add up with this his regular monthly salary.

So why I dy talk all this tins, na to let those people that need to hear this, that most times, no be only our job dy cos our financial difficulty, na  due to poor salary and inflation, na just lack of different sources of income dy cos am, see make I tell you, if you get like three different hustle wey dy pay you the least, weekly or monthly bro you go do well more than you go even expect, just reason wetin I just talk now and how you see am?
Pages:
Jump to: