But I don notice say many newbies wey I know for Bitcoin matter no get knowledge about how e de work, dem de buy Bitcoin with money wey dem wan use on the short term because dem hear say e de profitable. I believe say na only wen we enter bull run proper wey Bitcoin price go de surge steadily na im investors fit to take chances to invest money for short term profits.
Misconception say wetin dey happen here na only gambling and ponzi scheme na wetin make people dey believe say dem fit invest money today and become dangote tomorrow. We dey believe everything wey we dey see for internet say this person make like this amount and like that and we go just think say na so e be. Sometimes self I no dey blame the newbies again because na the lies wey dem tell them to make dem use their referral code register for some of this exchange na wetin make them dey believe say the industry na where to not take am serious and just behave like say dem dey play bet9ja.
True true, no be today this general misconception don dey, especially for most of these newbies wey just dey lap the crypto space, them go just hear or see where them talk say Bitcoin investment na e sure pass because you go just put your money inside, then wait small, Bitcoin go rise, gbagam, you cash out big time, lol.
Although na true say na like that e supposed be, but them fail to realize say for every business e get things and things wey dey involved, people wey dey enjoy for the Bitcoin matter today no be clear eye, wetin I mean be say their eyes don see many many things and as e be like that, them don Sabi how to take dey manage dey navigate the market make them no for go loose guard, so e no possible for newbie to enter today (without doing the due diligence) burst everywhere tomorrow, na only for film those ones dey happen.
Make we for dey try use our head dey reason well.
preferably do DCA method and no plan to sale am on the short term. Na my advice to newbie investors.
You no fit dey wrong with this method, e sweet pass when you get work and you dey get salary. Even though you no get salary work self but if you dey receive money and you fit plan yourself well on how you go dey run the monthly investment, before you know you dun put better money for the market than to they wait make you get better block to use buy one time.
DCA makes investing in Bitcoin simple and more profiting, just know that one and sha only dey invest money wey no go too much for you if you lose am.
Wetin you talk na true talk walahi...
Ever since I learnt about Bitcoin matter, and the potential wey e carry, na so I tell myself say na here I suppose dey, salary work no be for me, although my holding never reach where e supposed reach due to say my income level no really high like that, but with the small small DCA I dey do every week, iffa look my portfolio i dey smile because assuming say i been dey wait make the money for plenty make i lump-sum or I been dey reason my small income flow, i for no fit do anything, but like my teacher talk when i dey secondary school, say na small small them dey catch monkey, and with DCA i dey catch the BTC small small.