Pages:
Author

Topic: No save money inside Bitcoin for short term use because of price dip - page 3. (Read 621 times)

jr. member
Activity: 62
Merit: 4
E dey good say when u get interest for something try find out how de thing dey work, so u sef go get brain on how e dey take dey work. Before we put our monie inside any investment, make we ask questions get information for our sef first before we go put our monie so that our monie no go loss inside. I don see am say some of all this bad bad talks wey people dey talk about bitcoin na result of people wey no understand how Bitcoin investment dey, dem no get Knowledge dere mind think say if u put ur money u go get profit instantly but ee no dey work like that. Our money dey important to us well well so ee better make we put am for investment wey we understand so ee go balance with our expectations.

If u dey put money for Bitcoin, dey expect say u go get profit or take am back for short time ur calculation dey wrong. Unless u dey trade bitcoin, and trading no dey advisable for newbie. If u wan invest money for Bitcoin make u get understanding say Bitcoin price no dey steady ee dey move up and down that's y dem dey advice to invest for long time with good plan like DCA so that benefit go come.
member
Activity: 224
Merit: 33
Bitcoin no be short term investment,even if most newbies wan invest their fund into Bitcoin dem dey get the thought say when dem don invest their fund the price go increase the next week or month,dat one na just deceive dem dey deceive themselves.Every newbies suppose do their own research know say Bitcoin no be get quick rich scheme,and so Bitcoin no be stable currency, Bitcoin dey fluctuate you fit buy Bitcoin when the price dey $67k just to wake only to see sey the price don drop to $63k.E dey important to note say make no newbie go save e moni put for Bitcoin dey think say the moni go dey increase every seconds that one na big lie.Many people don see the reality,I dey hear of cases wey student dey invest their school fees for the short term with the mindset say the coins go profit dem for the short term and when price continue to decline for the short term na expectation=regret dem go see.
sr. member
Activity: 224
Merit: 195
I always object newbies to first understand and grab quite a good amount of valuable knowledge about Bitcoin. Depends on how people might see it, but personally Bitcoin is an investment and it should be treated as such. We don't invest and in the run get to tamper with what we worked to put together. Before investing there should have been enough readiness to solve every financial need that may arise that is were the emergency/reserved funds comes in. The market could be red aswell be green but rest assured we often get to see investors make good fortunes from their holdings.

OP no really vexs ohh I no no if this thread na the correct places to ask this question which one be DCA what the meaning of it in terms of crypto.
@Obari is not the OP. OP means the original poster, the owner of the topic thread.
member
Activity: 126
Merit: 12
Investing in Bitcoin for short term is a wrong move , in order for you to be more profitable in Bitcoin investment, it has to be for long-term within 5 years to 10 year or even more, with sure mindset,you have to plan your other aspect of life too ,so that it will not affect you during your investment period .

 As a newbie rushing into investment is wrong, and that is why you rush out ,you need to get yourself prepared by having alternative source of income in other for you to be stable while investing.As a newbie,you need to start with DCA Strategy which is the best for newbies, where you buy and accumulate gradually, until you have understood the processes and various strategy that you will decide the one that will be convenient for you.
member
Activity: 10
Merit: 0
Op you don try for this your thread and I sincerely appreciate your effort to bring something like this but I wan also let you know say, irrespective of wether investor wan do long term or short term, wetin really master be say, you Dey make profit and you Dey only invest the amount wey you fit afford to lose.
A lot of newbies Dey enter the cryptocurrency industry with the very wrong mindset of ponzi where they expect to make profit as soon as they invest a little amount but the reverse is always the case as they at some point even get liquidated.

As a newbie, the best approach is using DCA so you wouldn’t have to get stressed trying to invest.
OP no really vexs ohh I no no if this thread na the correct places to ask this question which one be DCA what the meaning of it in terms of crypto.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
Op you don try for this your thread and I sincerely appreciate your effort to bring something like this but I wan also let you know say, irrespective of wether investor wan do long term or short term, wetin really master be say, you Dey make profit and you Dey only invest the amount wey you fit afford to lose.
A lot of newbies Dey enter the cryptocurrency industry with the very wrong mindset of ponzi where they expect to make profit as soon as they invest a little amount but the reverse is always the case as they at some point even get liquidated.

As a newbie, the best approach is using DCA so you wouldn’t have to get stressed trying to invest.
full member
Activity: 434
Merit: 227
God is All
Bitcoin na one of di best investments wey anybody fit to enter but many newbies no know say e de better to hodl am for long term. Unto say Bitcoin de volatile dat na why e de advisable to hodl am for long term because na store of value wey de take long term to reach new ATH price and give better ROI.

But I don notice say many newbies wey I know for Bitcoin matter no get knowledge about how e de work, dem de buy Bitcoin with money wey dem wan use on the short term because dem hear say e de profitable. I believe say na only wen we enter bull run proper wey Bitcoin price go de surge steadily na im investors fit to take chances to invest money for short term profits.

Nobody know exactly wetin Bitcoin price go be in di next 24 hours, weda e go pump or dump, na only speculations and predictions we fit to do. Dat na why newbies need to understand say e no de advisable to invest in Bitcoin on a short timeframe because di price fit to dip wen dem wan use di money. Invest di amount wey you fit to put aside, preferably do DCA method and no plan to sale am on the short term. Na my advice to newbie investors.
If anybody wan really get better thing for their investment in Bitcoin then having the mentality of saving your coins for long term na the way forward because if na because of watin you hear na make you come rush use your money put hoping say you go get profit with short period dem you are likely going to lose because Bitcoin is an investment that worth better and done safely if it is done on a long term basis. Just forget about any quick quick money idea wey you get because the volatility of Bitcoin fit fuck you up especially when you don already put target say na so so time you go actually get the profit.
sr. member
Activity: 546
Merit: 342
Bitcoin na one of di best investments wey anybody fit to enter but many newbies no know say e de better to hodl am for long term. Unto say Bitcoin de volatile dat na why e de advisable to hodl am for long term because na store of value wey de take long term to reach new ATH price and give better ROI.

But I don notice say many newbies wey I know for Bitcoin matter no get knowledge about how e de work, dem de buy Bitcoin with money wey dem wan use on the short term because dem hear say e de profitable. I believe say na only wen we enter bull run proper wey Bitcoin price go de surge steadily na im investors fit to take chances to invest money for short term profits.

Nobody know exactly wetin Bitcoin price go be in di next 24 hours, weda e go pump or dump, na only speculations and predictions we fit to do. Dat na why newbies need to understand say e no de advisable to invest in Bitcoin on a short timeframe because di price fit to dip wen dem wan use di money. Invest di amount wey you fit to put aside, preferably do DCA method and no plan to sale am on the short term. Na my advice to newbie investors.
Well sometimes you no go blame these newbies sef because na lack of orientation or if at all you wan blame dem e go be on the aspect say dem no really get the patience to actually research about watin dem dey get involved in and the reason why I say this na because say many of them sef don actually place Bitcoin investment as something wey you fit just cash out now now now (GET-RICH-SCHEME) which na very big lie. If anybody really wan get better profits or promising growth for their Bitcoin investment then the person go gats know say him gat hold am for long term.
member
Activity: 10
Merit: 0
Wetin you Yan na true, person wey wan invest for bitcoin no sopos use Moni wey e wan use do something wey dey temporary come put am for bitcoin. Because if na money you wan use for important something and E come drop, you go dey put Bitcoin for your prayer point make E just go back to the price you carry buy am make you recover the amount wey you don lose for the short period of time. I get friend wey wan use him money do business, but base on how E dey hear as people dey Yan too much about bitcoin him come carry him business money go am for bitcoin, for that time bitcoin dey $70k bitcoin fall to $60k naso him business money fall, naso E no dey sleep. every day na to check if bitcoin don manage reach $68k but E no gree. When bitcoin manage reach $70k, out of greediness him dey wait make E climb above $70k to maybe $72k, before him know btc don drop again since that time him never gree to sell the bitcoin because If E sell am now E don lose. So as you talked Naim be the koko. Who no say E no go fit bear to invest for long time no sopos use him business money or any urgent money go gamble for bitcoin for short time. Though the person fit gain sha but the risk dey high too.
My OP I agree with wetin u yan ohh most newbie dey always think say bitcoin na something wey u fit invest in today and then com back tomorrow com cash out, but I gist there's is more to it ohh, that your friend just be like me years back too, when I been no no anything about bitcoin all my through be say I go just drop money then e go pump then I cash out but far from it, in just this little words I go Express bitcoin investments to the newbies" The patient dog go eat the fattest done one day" this dey try tell you say if you no dey patient you can not invest in bitcoin.
full member
Activity: 308
Merit: 203
Nobody know exactly wetin Bitcoin price go be in di next 24 hours, weda e go pump or dump, na only speculations and predictions we fit to do. Dat na why newbies need to understand say e no de advisable to invest in Bitcoin on a short timeframe because di price fit to dip wen dem wan use di money.
the thing is that within an interval of 24 hours, it's less likely that Bitcoin will go as high as 5× or 10× of its present value which would have placed an average newbie in a massive profit for the short term. At the early phase, Bitcoin experienced those kind of bull and although we hope and speculate such kind of things playing out, in the real sense it might not play out that way and what we might likely witness will be a gradual bull that would most likely not happen too sudden.

Once you're investing your money for the short term purpose your expectation wouldn't give you rest of mind and any thing that appears like a bull will seams like a perfect moment to sell while the bears that are supposed to be moments of buying more Bitcoin could tense you up.

Invest di amount wey you fit to put aside, preferably do DCA method and no plan to sale am on the short term. Na my advice to newbie investors.
this isn't just for newbies and sometimes when we talk about newbies, we paint the picture as though they are the only ones that don't know how to do things the right way. Regardless of how long you've stayed in the forum or the general Bitcoin sphere, if you aren't investing the right way and using the right strategies, you're going to face the same fate that's peculiar to the newbies.
sr. member
Activity: 658
Merit: 429
Hope Jeremiah 17vs7
Many people dey miss this thing, dat why even if aggressive buying dey good somehow, na who get where to fallback to wen market nor move as he/she plan go enjoy bcos dem fit HODL till bitcoin price raise again while  others way dey buy without no place to fallback to, wen need be go sell for even lost just to survive even if they know say the price go still raise with time.

This na one reason why them always dey talk say nor invest all your money for bitcoin, inside  2021 people speculate say bitcoin go reach $100k 2022 but external factors cor affect the price market cor dip well well, people sell for lost but nor be all sell bcos them nor know the truth but bcos dey invest too much (aggressive buying) and then Market nor cor go as they plan so they go sell for loss just to cover expenses while we know those wey buy even at the ATH 2021 and HODL don even gain m this year while if they continue to buy the dip join watin they get before them go for gain m well well.
sr. member
Activity: 406
Merit: 303
The great city of God 🔥
Wetin you Yan na true, person wey wan invest for bitcoin no sopos use Moni wey e wan use do something wey dey temporary come put am for bitcoin. Because if na money you wan use for important something and E come drop, you go dey put Bitcoin for your prayer point make E just go back to the price you carry buy am make you recover the amount wey you don lose for the short period of time. I get friend wey wan use him money do business, but base on how E dey hear as people dey Yan too much about bitcoin him come carry him business money go am for bitcoin, for that time bitcoin dey $70k bitcoin fall to $60k naso him business money fall, naso E no dey sleep. every day na to check if bitcoin don manage reach $68k but E no gree. When bitcoin manage reach $70k, out of greediness him dey wait make E climb above $70k to maybe $72k, before him know btc don drop again since that time him never gree to sell the bitcoin because If E sell am now E don lose. So as you talked Naim be the koko. Who no say E no go fit bear to invest for long time no sopos use him business money or any urgent money go gamble for bitcoin for short time. Though the person fit gain sha but the risk dey high too.
sr. member
Activity: 518
Merit: 317

Jump to: