Pages:
Author

Topic: Over use of opportunity (Read 173 times)

full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
December 17, 2023, 01:41:14 AM
#24
Naim be your country for you, any small thing wey dem manage get opportunity DRM go use am to the fullest, then latter we go come for y blame government for their failures and corruption when the corruption start from us dey go, make I even gist una wattin bring this banning of keke driving for night make una dee how human being wicked, based on say aboki dem many wey dey do this keke business for we state, one day one aboki come carry passenger matured youth wey don serve NYSC finish, do him and the guy come dey get small misunderstandings with N50 aboki day the guy go give am N50 while the guy say na 100 e dey pay ever since, naim the aboki carry daga go stab the boy, and the come die. So just imagine because of N50 naira person kill em fellow human being, very nonsense story.
full member
Activity: 182
Merit: 120
Cashback 15%
December 14, 2023, 04:11:18 PM
#23
That one na common problem for everywhere and people like that always claim to be smart cause they love what they're doing by punishing others, why Nigeria still dey suffer from common problem an because some people dey greedy and e dey affect the citizens, just like the keke and taxi issue you mentioned those taxi driver fit use the price of fuel cover up and people go still believe, for example we dey suffer for transportation issue just because some people are just too greedy and selfish, during president Tinubu speech and he made a speech about fuel subsidy removal I no know if some people observe just after the speech the price of fuel surplus that day till date, I don't know what's their motive and intention but the citizens are really suffering in terms of transportation, still on the gas generation now the price of gas don increase, same thing for market and customers dey face the consequence when that particular product no dey market and na only one person get that product the price go increase, I will judge them as greedy people.
full member
Activity: 224
Merit: 195
December 13, 2023, 02:58:39 AM
#22
You see for this country so, Na man dey do man and e no go better if we continue like this. Every body just dey shine him eye as any slight opportunity wey we get, gbam we go make use of am excessively and we go then complain about the government do this and that when be say e suppose start from the single building block which is between ourselves.

Transportation na one major area wey dey hit am, as normally everybody go make movement, u fit just wake one morning u go hear say price of fuel don go up, for something wey all of us sleep wake up and na so u go see all the transport people in togetherness as dey don discuss and agree together. Another sector na food stuffs, everyday na so the price dey increase for goods wey dey store since for shop, like we Nigerians na him dey do ourselves.
full member
Activity: 1190
Merit: 126
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
December 12, 2023, 01:42:10 PM
#21
This kind opportunity is everywhere and is not the fault of the people using the opportunity to collect money from the passenger but because the government refuse to carry out their responsibility to make life easy for the citizens. If am in their shoes, I will do the same thing to use the opportunity to make money from the passenger because, government suppose consider the situation first before banned Keke from the area because there are some places the taxes cannot reach right now which is causing a lot of robbery in the society.

I heard that local government chairman and some of the house of assembly has presented the issue before the governor about what the society is going through at the moment which they have promised the society that thing will return back to normal before the end of this week.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
December 12, 2023, 12:55:35 PM
#20
Na Bayelsa State this thing happened. Na because of change of #50 Aboki man used knife stabbed the Ijaw boy to dead at the middle of this year. The boy just came from Abuja and and he was paying #50 a drop at Abuja so when he came to Yenagoa, according him, before he was stabbed to dead and when the argument was going on, the place he entered the Keke was not even reached the placed he entered the Keke at Abuja. And the Aboki said he would not give him the change so, they argued till Aboki brought out the knife from the Keke and stabbed him to dead. So with that anger the Ijaw youth burnt down the Keke instant and all the Abokis at the area ran away. And the governor heard the news so curfew was used to ban the Keke driving for Night so taxes took over the night movement.

And according to taxi drivers the way Keke used to drink fuel is not the same way for Keke so they have to charge high to meet up the expenses. Because where Keke is using 2Ltrs of fuel the taxi can use 5 ltrs of fuel therefore if they charge the same with Keke then they would drive at lost. And that is why they are charging higher in the night.

Op this has nothing to do with the forum activities and if this matter dey bother you then you have carry it to your social media handles to air it out there and users would have discussed with you there. I am making comment to clear the story. Bring cryptocurrency related discussions so that we can discuss well.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
December 12, 2023, 12:28:53 PM
#19
For my state something happen wey lead to stopping of Keke driving in the night and no much taxi,,buses so now the rate of transport fare at night no be here..where you go pay 150 normally for day time,,,now na 300 because say the few driver's wey dey available don see so many passengers on the road so now them don see opportunity to bill people anyhow they like without considering say this one na my fellow human being...all their own if you like you enter...if you like stay...
I Dey familiar with this situation from a time and it’s not only when these no movement within a time range Dey imposed, even when it rains in the evenings and people are in a hurry to get home, you will find drivers monetizing the situation with a demand and supply scale.
If na the curfew situation, I no go too blame the transport agents because, both themselves and you are breaking a law to be out in times where you’ve been remanded to be indoors as a form of regulation. In the events that your found outside, the transport agent is likely to be more punished than you the passengers. In most cases, these passengers will just leave the driver to carry his/her cross.

In the case where e Dey due to the weather, Omo, the focus should be in the number of turns you can do but no, these guys no Dey reason that one. Na less turns and more profit be their focus thereby, allowing the population to suffer through exploitation. Na there the thing spoil. The funny truth be say, what goes around comes around. Money way you get by unjustified means, e Dey also find means way no Dey justifiable to use commot. When e happen, no be devil work, na your work.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
December 12, 2023, 12:00:27 PM
#18
Firstly, op you should know that there's no humanity anymore in the world. Almost all humans have lost the touch of a feeling of humanity in them, we have all bind our conscience so bond that the conscience have died to repelling us from doing immoral and inhumane things and actions towards fellow human.

The things op mentioned and talked about in the post is something me as a Nigerian goes through everyday stepping out of  house for to go work for our daily bread and it's so adverse that I have gotten used to the situation that It doesn't bother me anymore neither do I get surprised when I see people taking advantage of such opportunities in abusive ways.

I keep on telling people that in this country the poor are the problem of the poor even before the rich politicians that we abuse and blame for our sufferings and economical harshness we face in our  society. It's only when humans stop taking advantage of situations in an inhumane and without conscience that's when live can get better as we wish it to be.

We all know and  remember the issue of cash scarcity that happened early this year... Imagine how Nigerians were suffering fellow Nigerians, I don't want to even mention about  POS operators you all know the rest stories.
sr. member
Activity: 378
Merit: 259
December 12, 2023, 10:46:33 AM
#17
This word opportunity eeeh e dey cause wahala for we society oh...most people wen opportunity reach their hand them dey take am do and undo their fellow human..wetin make I dey talk this thing..
For my state something happen wey lead to stopping of Keke driving in the night and no much taxi,,buses so now the rate of transport fare at night no be here..where you go pay 150 normally for day time,,,now na 300 because say the few driver's wey dey available don see so many passengers on the road so now them don see opportunity to bill people anyhow they like without considering say this one na my fellow human being...all their own if you like you enter...if you like stay...
Although no be only transportation,,so many other sectors too na the same over using of opportunity nai still dey go on...and we dey cry for change
The thing dey border🤦 me I say make I share am with una



When we get opportunity for naija everybody they become thief, everybody will like to use the opportunity and make money, all this things na from our governments e take start, because when we vote them finish immediately they get to that seat all they will be thinking is to steal money they don't care about us anymore, now you want to blame the bus driver for increasing their fees because they have stop Keke driving in the night, i did not blame them all it is their turn, for this country God just dey favor everybody when it's their turn let them use it, no be say the opportunity go last forever nothing should be new to you in this country, if there's no transport money to dey spend if it's not necessary for you to going out in the night, i think you should stop it for now to avoid spending money anyhow.

If to say na for another country I will be like the matter shock me but as far say na naija nothing is like a surprise to me, we naija dey always carry every opportunities like say we Don make am for life, as you dey talk about this Buse own you no remember that time wey cashless policy dey? That time na the time wey nobody fit forget am, those POS people show us shege by that time oh, if you want to withdraw money wey you get na big problem, in fact na you get your money that time but na you and the POS go share the money because 10k charges be 4k or 5k, that time if you want to withdraw they will still be saying if you don't want to withdraw make you dey go, so this your own no be new thing for naija.

We no fit forget waiting our eyes take see during the cash scarcity, most of this POS use the opportunity to buy car some build house with the way they take suffer us for this country, they too over use the opportunity and we no get choice than to withdraw with the any charges they collected, all this busses issues no suppose surprised am because we don face waiting pass that one.
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
December 12, 2023, 09:27:27 AM
#16
This word opportunity eeeh e dey cause wahala for we society oh...most people wen opportunity reach their hand them dey take am do and undo their fellow human..wetin make I dey talk this thing..
For my state something happen wey lead to stopping of Keke driving in the night and no much taxi,,buses so now the rate of transport fare at night no be here..where you go pay 150 normally for day time,,,now na 300 because say the few driver's wey dey available don see so many passengers on the road so now them don see opportunity to bill people anyhow they like without considering say this one na my fellow human being...all their own if you like you enter...if you like stay...
Although no be only transportation,,so many other sectors too na the same over using of opportunity nai still dey go on...and we dey cry for change
The thing dey border🤦 me I say make I share am with una



If to say na for another country I will be like the matter shock me but as far say na naija nothing is like a surprise to me, we naija dey always carry every opportunities like say we Don make am for life, as you dey talk about this Buse own you no remember that time wey cashless policy dey? That time na the time wey nobody fit forget am, those POS people show us shege by that time oh, if you want to withdraw money wey you get na big problem, in fact na you get your money that time but na you and the POS go share the money because 10k charges be 4k or 5k, that time if you want to withdraw they will still be saying if you don't want to withdraw make you dey go, so this your own no be new thing for naija.

Na our government dey cause all this thing's because if them they do the right thing nothing will be like this, commercial Bus driver they do shakara dey tell passengers say if them no wan enter make them go, na their time na make them dey enjoy, after thing's become normal now their eyes go clear, because every opportunity no dey last if you no manage am well.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December 12, 2023, 09:19:00 AM
#15

Although no be only transportation,,so many other sectors too na the same over using of opportunity nai still dey go on...and we dey cry for change
The thing dey border🤦 me I say make I share am with una


Like you say no be only transportation. The thing cut across all the sectors of Nigerian economy. If we look into fuel now abi kerosene or diesel. We no go even talk of people wey dey sell goods self because them too follow dey take advantage that na why I talk say the thing spread for everywhere. For example now if filling stations hear now say government want increase price dem go stop to sell and wait for the new price and before you know am dem go begin sell old cheaper price for new costly price. But if government say price drop, dem go still continue to sell old fuel for that price wey e dey before government announce price reduction.

So na government matter be this. Government suppose put price regulation to dey active and checkmate some of these extortions.
no be lie...but the thing there be say even those government go put in charge to checkmate the extortioners sef go still like collect bribe from them cause they too will see it as an opportunity

Na all those circles of bribe collection still keep Nigeria for this level wey we dey. If to say the system dey cleansed up all these ones wey we dey talk no go be issue. No society dey perfect actually but a country wey dey corrupt is always found with the commonest kinds of ills. Price control system suppose be something wey go make the common person on the street enjoy live but who go bail the cat...If you rig election enter then you no go expect say things go begin work as expected. We no need to dey fool ourselves.
full member
Activity: 266
Merit: 113
December 12, 2023, 01:20:00 AM
#14
Na so the matter de be on a normal. People no de joke with opportunities because them no say e no de last forever. Today for be your turn and tomorrow everything don shift face, na how you take follow am up as e de hot na him go give you joy latter or make you tell just mere stories at the end of the day.

Wetin De pain me for matters like this when involve a sudden increase in the price of things na say the price of tp for we country no de always go back to normal ones e climb up, e de always be forward ever, backward never.

And about people when de make the decision of banning the use of keke without making proper plans as to providing an alternative means to it, na them know wetin be their problem.  How you go just wake up hear say them don scrap a particular thing for the society when the average man de use but you no go hear of the replacement when de on ground for to use tidy the matters? God de sha.
jr. member
Activity: 76
Merit: 3
December 11, 2023, 06:43:35 PM
#13
This word opportunity eeeh e dey cause wahala for we society oh...most people wen opportunity reach their hand them dey take am do and undo their fellow human..wetin make I dey talk this thing..
For my state something happen wey lead to stopping of Keke driving in the night and no much taxi,,buses so now the rate of transport fare at night no be here..where you go pay 150 normally for day time,,,now na 300 because say the few driver's wey dey available don see so many passengers on the road so now them don see opportunity to bill people anyhow they like without considering say this one na my fellow human being...all their own if you like you enter...if you like stay...
Although no be only transportation,,so many other sectors too na the same over using of opportunity nai still dey go on...and we dey cry for change
The thing dey border🤦 me I say make I share am with una
To be sincere we Nigeria's we always put all the blame on our gov't which is not always right because we self are to be blamed at times. There are many things which we do most especially about this uncontrol price of a thing. na we dea kill each other sometimes. Abeg this money racing dea much if Una no forget if you do good you go see good.
member
Activity: 103
Merit: 36
December 11, 2023, 06:21:37 PM
#12
This word opportunity eeeh e dey cause wahala for we society oh...most people wen opportunity reach their hand them dey take am do and undo their fellow human..wetin make I dey talk this thing..
For my state something happen wey lead to stopping of Keke driving in the night and no much taxi,,buses so now the rate of transport fare at night no be here..where you go pay 150 normally for day time,,,now na 300 because say the few driver's wey dey available don see so many passengers on the road so now them don see opportunity to bill people anyhow they like without considering say this one na my fellow human being...all their own if you like you enter...if you like stay...
Although no be only transportation,,so many other sectors too na the same over using of opportunity nai still dey go on...and we dey cry for change
The thing dey border🤦 me I say make I share am with una


Normal the billing no suppose be the same
You have to first understand that working at night is riskier than working during the day, particularly in this country.Do you know the number of bike and taxi drivers that have gone missing while working at night?  I have no doubt that you won't feel at ease strolling at night either and not that I'm happy with the prices some of them requir but there is nothing we can do about it.
 
member
Activity: 168
Merit: 50
Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
December 10, 2023, 09:11:46 PM
#11
Even here where I am if rain just fall transport will increase. that the major problem with 🇳🇬  they over use opportunities even when is not necessary because they know at that point you really need that thing so it it choices they won?t beg you. Who still remember laser fever time bath salt, salt was very cost , Covid 19 nosemask too we over do in this country
newbie
Activity: 29
Merit: 2
December 10, 2023, 03:50:34 PM
#10
Hmmm as I dy read wetin you write I just feel tired because e don come become normal thing for we country naija, we they complain say government do this, government do that, but we, we don check ourselves? We dy most times undo ourselves instead of us to dy show that brotherly and sisterly love to each other.
Just enter market to buy mostly foods stuff nai you go know say some people worse pass government, once dem hear rumour say na only dem get that commodity or products, automatically that goods don add price for no just better reason.

Make we try to dy help each other,  people have fail to understand that we came too this world with nothing, and we will go back with nothing, make we just try our possible best to dy spread love .

So many non know that one say we go..go back with nothing nai make we dey very self centered... always looking for chance to take from the other person to add to his own without minding the damage it would cause to that person




Although no be only transportation,,so many other sectors too na the same over using of opportunity nai still dey go on...and we dey cry for change
The thing dey border🤦 me I say make I share am with una


Like you say no be only transportation. The thing cut across all the sectors of Nigerian economy. If we look into fuel now abi kerosene or diesel. We no go even talk of people wey dey sell goods self because them too follow dey take advantage that na why I talk say the thing spread for everywhere. For example now if filling stations hear now say government want increase price dem go stop to sell and wait for the new price and before you know am dem go begin sell old cheaper price for new costly price. But if government say price drop, dem go still continue to sell old fuel for that price wey e dey before government announce price reduction.

So na government matter be this. Government suppose put price regulation to dey active and checkmate some of these extortions.
no be lie...but the thing there be say even those government go put in charge to checkmate the extortioners sef go still like collect bribe from them cause they too will see it as an opportunity
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December 10, 2023, 12:14:24 PM
#9

Although no be only transportation,,so many other sectors too na the same over using of opportunity nai still dey go on...and we dey cry for change
The thing dey border🤦 me I say make I share am with una


Like you say no be only transportation. The thing cut across all the sectors of Nigerian economy. If we look into fuel now abi kerosene or diesel. We no go even talk of people wey dey sell goods self because them too follow dey take advantage that na why I talk say the thing spread for everywhere. For example now if filling stations hear now say government want increase price dem go stop to sell and wait for the new price and before you know am dem go begin sell old cheaper price for new costly price. But if government say price drop, dem go still continue to sell old fuel for that price wey e dey before government announce price reduction.

So na government matter be this. Government suppose put price regulation to dey active and checkmate some of these extortions.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
December 10, 2023, 11:04:51 AM
#8
The discussion is not about the over use of opportunity. Over use of opportunity because the state government do not allow the use of Keke driving as business anymore in your state? Like I said, it is not over use of opportunity. Also it will only be in the state capital. Or is the ban all over the towns in the state? This is common in a state that is becoming more well developed.
member
Activity: 154
Merit: 33
Eloncoin.org - Mars, here we come!
December 10, 2023, 10:25:35 AM
#7
Of course yes, too much power.that is realistically exercise is always a threat in the societies.
Some persons who are down only waits at their rising to inconvenience other people including those who were at the same down level with them from the roots of origin or placements.
That is one of the things the leaders those to the masses, they just forgets about the primary aim in their positions of leadership. All they cares about is the caucus and their families welfares while ignorantly snobbing to the masses welfares instead, they get the poor masses works like the elephants while earning the ants and the big treasures goes to them the leaders accounts with no Hunan sympathies and no conscience.
How was the policy of the law restricting means of mobilities suppstto be necessary or contributing to the good of the societies knowing that people are still out there that is to be convied back home or their respectable places with the mentioned conveyable means Keke (motor bike) even at their awareness that there are some areas motorcycles (Bikes) are restricted and not even the cars that running along some of the axis and yet the government ignorantly makes the situations hard for the masses on such notes.

I don't blame those Keke drivers for over charges of the transportation fees by the nights because they are operating in services of going against the laws of the authorities and orders.
So they have to charge the passengers higher on a high risk violating the last order. And they are believed to have some money saved aside for bribery of caught. We all knows how corrupted the country is and also, the risk of their lives and their Keke has them the reasons for such a high charge fees. This is not something that they are taking chances by over charging for their transportation services. @ OP, atleast you denoted it that they don't change such a high about of the nights during the day.
full member
Activity: 392
Merit: 236
Bitcoin in Niger State💯
December 10, 2023, 09:17:14 AM
#6
I no go blame anybody about the situation wey we they inside now. That could be an opportunity in the sight of the transportation guys and for them it's there opportunity to move the market prices upward at a particular time. But as it is an opportunity for the transportation guys , it will not be to the travelers or commuters since as a passenger you're always looking for what's favourable to you and within your budget.

This is where the government is supposed to come in, to ensure there is a proper checkmate of the rates and that such rates are standardised and monitored by the related regulatory bodies including that of private car owners. The same issue is what we face with commodities, because there's an increase in the exchange rate and fuel subsidy removal, prices of some commodities have skyrocketed and still increasing by the day and no government body is taking a leadership role towards salvaging the situation for the benefit of the average and poor Nigerians. We are indeed the architects of our own problems.
full member
Activity: 322
Merit: 166
December 10, 2023, 05:58:15 AM
#5
This word opportunity eeeh e dey cause wahala for we society oh...most people wen opportunity reach their hand them dey take am do and undo their fellow human..wetin make I dey talk this thing..
For my state something happen wey lead to stopping of Keke driving in the night and no much taxi,,buses so now the rate of transport fare at night no be here..where you go pay 150 normally for day time,,,now na 300 because say the few driver's wey dey available don see so many passengers on the road so now them don see opportunity to bill people anyhow they like without considering say this one na my fellow human being...all their own if you like you enter...if you like stay...
Although no be only transportation,,so many other sectors too na the same over using of opportunity nai still dey go on...and we dey cry for change
The thing dey border🤦 me I say make I share am with una

Dis wan no be something of surprise for dis country again, many of us don witness dis tin for other part of the country. The tin just dey like demand and supply, how the bitcoin functions wey dey lead to rise and fall in price depending on the way people need am and vice versa.

For situations like dis, na strict regulations government suppose put in place for dis people because without dat regulations, everybody go just dey put any price wey dem like and e go really affect the people wey dey live for dat region. Nigerians dey really take advantage of opportunities illegally and without imposing laws na so dem go still dey continue dey do.
Pages:
Jump to: