Pages:
Author

Topic: Over use of opportunity - page 2. (Read 180 times)

full member
Activity: 560
Merit: 161
December 10, 2023, 04:43:01 AM
#4
One thing about Nigerians dem sabi abuse opportunity let's just lookat when dollars price been dey go up steady against the naira business sees it as opportunity everything for market go up, even things wey no get to do anything with dollar the price go up and since naira gain value the prices of all this things never come down. This thing Nigerians are good in doing this, always we complain that the government is bad but we wey be common people we no dey try at all.
full member
Activity: 224
Merit: 175
December 10, 2023, 01:05:01 AM
#3
Hmmm as I dy read wetin you write I just feel tired because e don come become normal thing for we country naija, we they complain say government do this, government do that, but we, we don check ourselves? We dy most times undo ourselves instead of us to dy show that brotherly and sisterly love to each other.
Just enter market to buy mostly foods stuff nai you go know say some people worse pass government, once dem hear rumour say na only dem get that commodity or products, automatically that goods don add price for no just better reason.

Make we try to dy help each other,  people have fail to understand that we came too this world with nothing, and we will go back with nothing, make we just try our possible best to dy spread love .
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
December 09, 2023, 07:27:52 PM
#2
That one don be Normal thing  For my country Naija. we dey always take advantage of any problem wey the economy dey face. Just like during the scacity of momey, you no see wetting happened to banks? The money wey CBN bring make them shear people from different banks the bank managers keep the money, dey shear am among POS Marchants. E  come make the naira dey scars that time. we go go bank to collect money na problem. Highest Dem fit give you na 3k. Dem dey sell the note to only POS people. This na no tell you say the curruption dey everywhere because if financial institution no ft maintain there dignity by making everything equalibrum, that is to tell you say if the common man do desame I no go too blame them.

the government wey we dey look up to don fail us naim they cause all this things. had it been the government dey produce public transportation with better price tag of transportation fee before them they put all this law e for better. But Dem dey put law without providing proffer solution to it. If you know the cost of 1 keke and how the youth dey manage to make money from am, you go know say e no easy for them too.  No be say I dey support them, but I dey talk base on putting myself in their shoes, you go also know wetting dey make them do those things. Me I bellieve say wetting go cause that price hyke na that ban wey Dem place on tryciclis. And anywhere such thing they, e be like a forbidden zone, and anybody wey dey run am dey at risk and the price of the risk them take naim be the price increase.
newbie
Activity: 29
Merit: 2
December 09, 2023, 06:52:12 PM
#1
This word opportunity eeeh e dey cause wahala for we society oh...most people wen opportunity reach their hand them dey take am do and undo their fellow human..wetin make I dey talk this thing..
For my state something happen wey lead to stopping of Keke driving in the night and no much taxi,,buses so now the rate of transport fare at night no be here..where you go pay 150 normally for day time,,,now na 300 because say the few driver's wey dey available don see so many passengers on the road so now them don see opportunity to bill people anyhow they like without considering say this one na my fellow human being...all their own if you like you enter...if you like stay...
Although no be only transportation,,so many other sectors too na the same over using of opportunity nai still dey go on...and we dey cry for change
The thing dey border🤦 me I say make I share am with una

Pages:
Jump to: