Pages:
Author

Topic: Person wey get money no fit spray the money again? (Read 244 times)

hero member
Activity: 1050
Merit: 501
Without being told, spraying money is an offense given under the country's law. No be because for long, our country government don been d overlook this and not putting eyes into it, we come think na normal thing for one to spray money at any event he or she pleases without knowing the fact na their country's currency dem d abuse like that. Nevertheless, this law wey FG put in place for naira abuse na to curtail the abuse of naira, so that Nigeria's go get regard for it. No be to be spraying money anyhow like it is worth nothing. At least there supposed to be a manner of respect when holding a naira. Em go better to give peso money in bundles than spraying it one after the other just to show off. I believe na wetin our government want us to be doing "give out money in bundles for occasions than spraying it"
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
I think they are three now. Recently it was Bobrisky. Now it is Cubana Chief Priest.
But there is nothing that will stop naira note abuse. Those seen on video were arrested. Or maybe the EFCC has just started.

Edit: He has been granted bail for ₦10 million with two sureties in like sum
https://punchng.com/breaking-naira-abuse-court-grants-cubana-chief-priest-n10m-bail/
One thing for this country be say make person just dey do legit business wey no get anything to do with money theft because when your hand dey clean justice go speak for you no matter say for this our country the judiciary system too dey poor to carry out cases.
Cubana Chief Priest nah tight business man wey dey popular for ye country and em get influence even outside this country so the arrest wey them arrest am nah just because of money. Although, me I no too they reason that one sha but my own be say where all those money wey pipo dey use bail them sef dey enter? Watin them dey carry am do? Even those good wey customs done size even after them collect bribes, were those money and goods dey enter? Well if we start to dey talk about this country this page go full. So as e done be say if person spend em money sef nah problem nai be say the bets thing to do nah to just dey spend am jejely, instead of to spray for occasion e better make the person just send the celebrant any amount wey em feel say go dey okay for ram...
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
Nobody Dey above the law, and if them catch any obvious person, not just yahoo boys, them go arrest and sanction such a person.
Normally I know say, everybody Dey para for government and anything wey government do outside of reducing the cost of things an rubbish  for now as long as Nigeria is concern but sincerely these men Dey abuse the currency and you need to Dey were men Dey para with fundz then you go agree with government say, then need to put law but these men for wait make I first do my wedding before all these regulations and I don talk am say, these country no like me, as e reach my turn to start life, everything just Dey change for the worst.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
~
Before now di federal government don dey warn about naira abuse and mutilation but pipo no dey take am seriously, so naim dem decide to go afta high profile persons wey dey commit dis crimes so dat everybodi go take di mata seriously. But dis is Nigeria, and everly e get some persons wey go get a free pass. I believe small small dem go begin go afta yahoo boys wey dey also mutilate naira.

Na true wey you talk, i no think say e make sense as dem send Bobrisky to 6 months in prison, e dey very harsh. Naira mutilation don dey happen for Naija for a very long time now, e get better ways wey dem go fit take create the awareness say na crime, rather than going after only celebrities.
How me I dey reason dat bobrisky mata be say him don offend a very strong politician or businessman wey wan teach am a lesson because of di way dem handle him own mata, him lawyer bin ask for bail which dem even turn down.
full member
Activity: 224
Merit: 151
As part of our fundamental human right I believe person wey own property or wealth fit use am the way e want because man get liberty to do anything as long as the thing no go worry another person negatively. I come Dy wonder why EFCC come Dy attack people way they use their money the way dem want.
No b say the person na politician or get appointment to say the money na government money. Man struggle for him own money and anything wey en use am do wey go give am joy  nay e go do. Today I just come stumble over this news d thing come taya me.
Ok make I ask question, what of those yahoo boys wey Dy spray money like this, some Dy even deliberately destroy properties worth millions just for dem to pay for the destruction as a way of show up.
https://cdn-af.feednews.com/news/detail/e06f6c2736523e06eb5f2c01b43b9a28-push?features=2114219&uid=5d83310483f9004e9419146d9b02332210255284&like_count=0&client=mini
The money you are spraying or you think it's your is a property of the central bank of Nigeria and at such the government has the  responsibility of making sure that the Naira note is not defaced. You only own the legal right to have those money in your account because you worked it, and not to destroy it or defaced it.

That's why there is a law against the act of destroying or defacing the currency. In as much as you have the right to spend your money, you don't have the right to destroy it or cause damage to it. Nobody is stopping you from exercising your right, but you must do it in a lawful way. So people that the efcc are going after committed a crime and there are evidence against them that's why they are being arrested. That you rent someone house doesnt mean you should destroy the property. Use it the way the person asked you to use, anything outside that is not advisable, you will pay for any consequences that may arise.
full member
Activity: 1134
Merit: 154
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
I wonder o, I no know wetin be Naija people problem for this our country, if u do like this na war, do like this na still problem, person no come know wetin dem really want, for money wey u suffer get, na we no get right to spray or spend am as we like without going to prison or queried about, sometimes I dey ask myself say which kind country wey dey so, for ur own property o, na person go tell us how we go use our properties them, now people don dey mind the way dem dey do things especially that money side, everybody just dey hide their true identity just not to get involved with EFCC dem, even for occasions dem, people just dey do things on a low, to avoid problem, for  money wey I suffer get o, like say I dey beg them to give me money, just imagine how bobrisky matter be, e just end up to stay for prison for 6 months , for which crime kwanu, just because say e spray plenty money o, this country people just funny ehn, till we discover say na we be the cause how crime still dey increase for this country, our country no go still dey better.
full member
Activity: 462
Merit: 145
The Nigeria government is reinforcing every solidable means to ensure the currency remained stable when traded towards other developed countries currency, like the exchange rate will be balance just as the dollar. I think they're doing a good job to maintain this new regulated order. As for one of the richest bar man for nigeria, Cubana Chief Priest, he is different from Bob risky wey EFCC sentenced to 6 months for the abuse of the Nigeria naira currency. Na this thing I de make reference to, level de this game. Cubana na 30 GB and we know say dem no de carry last when it comes to handling matters before e go escalates.
It is true that Cubana Chief Priest is more influential but this has nothing to do with naira exchange rate. It is about naira abuse.
It has nothing to do with exchange rate nor does it affect the value of Naira in a positive way.
This law has been active since before the late mother's burial ceremony of Obi Cubana and although nothing happened much then, except he being invited to explain the source of his wealth, the current administration has a lot to do with influencing the enforcement of many policies that were left rather ignored, by the past government.
newbie
Activity: 22
Merit: 0
As part of our fundamental human right I believe person wey own property or wealth fit use am the way e want because man get liberty to do anything as long as the thing no go worry another person negatively. I come Dy wonder why EFCC come Dy attack people way they use their money the way dem want.
No b say the person na politician or get appointment to say the money na government money. Man struggle for him own money and anything wey en use am do wey go give am joy  nay e go do. Today I just come stumble over this news d thing come taya me.
Ok make I ask question, what of those yahoo boys wey Dy spray money like this, some Dy even deliberately destroy properties worth millions just for dem to pay for the destruction as a way of show up.
https://cdn-af.feednews.com/news/detail/e06f6c2736523e06eb5f2c01b43b9a28-push?features=2114219&uid=5d83310483f9004e9419146d9b02332210255284&like_count=0&client=mini

Ignorance of the law is not am bcos it is against Nigeria Constitution to be spraying money up and down this was the reason why bobrisky and cubana chief was arrested though cubana chief priest pleaded not guilty and was granted while bobrisky pleaded guilty and still in detention. Now the fact de money belong to u dose nt mean u can use in whatever manner u feel like .in Africa especially in Nigeria we do things without being conscious of the law.
sr. member
Activity: 1316
Merit: 379
#SWGT PRE-SALE IS LIVE

Naira mutilation is an offence in Nigeria, i know say for a very long time dem don dey overlook am, but right now government wan create the awareness say e get as you go use the Nigerian Naira wey e go be offence. Things such as spraying, hawking, squeezing, writing on the notes, etc, na offence and the punishment be say the offender go spend 6 months in jail or the option of N50k. So this matter no be violation of human rights, Naira mutilation na offence, but plenty people no know before, but now dem know.
I believe say this new law go help call people to order, especially those our Nigerian police wey dey stand for road collect 100 Naira, squeeze am put inside pocket. But come to think of the whole thing, a police man go arrest em follow police man if em see say eh squeeze money put for pocket? I no talk say make them no punish people for violation of country laws oo, but then charity begins at home. Make people wey dey implement all these laws checkmate themselves properly and I dey pretty sure say na them go even violate the laws pass and still go scutt free. Una go see am say very soon videos go come out where politicians or some law makers dey spray money or violate same laws but still no law go hold them, the case no go even reach anywhere but when common men violate laws them go dey maltreat them like animals. My advice to our country people na say make una dey extremely careful with this new money policy and avoid anything wey go make you get charges of violation of the new law, be it squeezing or spraying at occasions.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
The Nigeria government is reinforcing every solidable means to ensure the currency remained stable when traded towards other developed countries currency, like the exchange rate will be balance just as the dollar. I think they're doing a good job to maintain this new regulated order. As for one of the richest bar man for nigeria, Cubana Chief Priest, he is different from Bob risky wey EFCC sentenced to 6 months for the abuse of the Nigeria naira currency. Na this thing I de make reference to, level de this game. Cubana na 30 GB and we know say dem no de carry last when it comes to handling matters before e go escalates.
It is true that Cubana Chief Priest is more influential but this has nothing to do with naira exchange rate. It is about naira abuse.
member
Activity: 378
Merit: 76
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Do not mind them. Cubana Chief Priest is not going to prison is all what I can see. Sending Bobrisky to 6 month in prison is unfair and not called for.

I can see Cubana Chief Priest and Davido together very well. Davido Uncle which is the governor of Osun state now and Davido's father are very powerful and influential people. Also the guy will know a lot more of people but those two people are enough.
The Nigeria government is reinforcing every solidable means to ensure the currency remained stable when traded towards other developed countries currency, like the exchange rate will be balance just as the dollar. I think they're doing a good job to maintain this new regulated order. As for one of the richest bar man for nigeria, Cubana Chief Priest, he is different from Bob risky wey EFCC sentenced to 6 months for the abuse of the Nigeria naira currency. Na this thing I de make reference to, level de this game. Cubana na 30 GB and we know say dem no de carry last when it comes to handling matters before e go escalates.
full member
Activity: 378
Merit: 182
Play Bitcoin PVP Prediction Game
As part of our fundamental human right I believe person wey own property or wealth fit use am the way e want because man get liberty to do anything as long as the thing no go worry another person negatively. I come Dy wonder why EFCC come Dy attack people way they use their money the way dem want.
No b say the person na politician or get appointment to say the money na government money. Man struggle for him own money and anything wey en use am do wey go give am joy  nay e go do. Today I just come stumble over this news d thing come taya me.
Ok make I ask question, what of those yahoo boys wey Dy spray money like this, some Dy even deliberately destroy properties worth millions just for dem to pay for the destruction as a way of show up.
https://cdn-af.feednews.com/news/detail/e06f6c2736523e06eb5f2c01b43b9a28-push?features=2114219&uid=5d83310483f9004e9419146d9b02332210255284&like_count=0&client=mini

Nigeria is not a serious country you should know that by now, they know our pressing needs and they busy chasing shadow, it is bet sad that we found ourselves in this kind of ugly situation, using your wealth to help people in the society is now crime, so If am wealthy I don't have the right to help celebrants with my money again, I think our law makers are not doing their job very well, this is the best time legislation should be taken serious , this right of the masses has been tampered and the executive has to be cautioned for this reckless way of using power, they have abused power a lot and something has to be done about it, Nigerians are facing hard time, this kind of news should not be making news again, how would a serious government reason in such a shallow manner, there are looters of public funds in this government why not face them instead doing otherwise.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Lol, yes, i think the whole bail conditions is stringent to make sure say the defendant go return to court when it is time for the next hearing. Dem also make sure say the defendant submit him international passport, i just think say all these na part of the process.
Do not mind them. Cubana Chief Priest is not going to prison is all what I can see. Sending Bobrisky to 6 month in prison is unfair and not called for.

I can see Cubana Chief Priest and Davido together very well. Davido Uncle which is the governor of Osun state now and Davido's father are very powerful and influential people. Also the guy will know a lot more of people but those two people are enough.
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
Cubana Chief Priest was bailed with ₦10 million with 2 sureties. A court case that will lead to ₦5000 fine supposed not to lead to ₦10 million bail I think. This is Nigeria.
Lol, yes, i think the whole bail conditions is stringent to make sure say the defendant go return to court when it is time for the next hearing. Dem also make sure say the defendant submit him international passport, i just think say all these na part of the process.
This is just part of what is happening in Nigeria that only awareness and some strict actions can be effective against but they are not doing anything than going to celebrities. It has no sense because this can not stop naira mutilation.
Na true wey you talk, i no think say e make sense as dem send Bobrisky to 6 months in prison, e dey very harsh. Naira mutilation don dey happen for Naija for a very long time now, e get better ways wey dem go fit take create the awareness say na crime, rather than going after only celebrities.
sr. member
Activity: 294
Merit: 267
I like how Central bank was been serious about this Naira mutilation of a thing, it has sent a message to many ignorants people who don't know law, with two victims that were arrested within the few days even someone who is not active on the internet will have gotten the message by now because arresting a person like Obi Cubana chief priest is one of the reason why they took him in despite knowing he is not the only person who is guilty of this act.

Atleast people that love to oppress friends that the have money will all stop now and even if they did spray money in parties and ceremonies, they will make sure no phone is allow to avoid people from making videos because I'm very confident that nobody want to be victim in the hands of the government.
sr. member
Activity: 574
Merit: 387
As part of our fundamental human right I believe person wey own property or wealth fit use am the way e want because man get liberty to do anything as long as the thing no go worry another person negatively.
Your money na your thing now, and nobody talk say make you know use am do anything wey you like, but e no mean say you go come Dey rough handle money now, if you Dey spray naira make people Dey step on am e mean say you no Dey respect the currency be that now, if you see Wetin some people Dey use money do, you self go shake head say e no make sense now, but if they start to Dey arrest people now, then plenty people go get sense.

I know say current Nigeria problem pass that one now, but I still like d idea, if you spray money or you do anyhow with naira, then make dem arrest you, make you go face judgement.

Ok make I ask question, what of those yahoo boys wey Dy spray money like this, some Dy even deliberately destroy properties worth millions just for dem to pay for the destruction as a way of show up.
The once wey Dey spray money, or the once wey Dey destroy money, if hand touch them, Dey will surely be punished, and na double punishment they go even get self, because na yahoo boys dem be again. If you destroy your property, then no wahala, but na Nigeria currency Dey no want make u misuse or destroy.
hero member
Activity: 658
Merit: 519
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
So how we dey sure say if one top politician spray money for event EFCC go arrest am. For Nigeria na only you wey no dey connected and government dey envy your source of income, na him law dey hold, including poor and average man.

I think that there are better thing to look for solution to, especially this high rate of inflation, and not arresting people enjoy the fun of spraying money in occasions. However, if the law will apply to everyone I support am. So why Bobrisky own different wey make government no grant am bail, abi he no get 10m.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
Man struggle for him own money and anything wey en use am do wey go give am joy  nay e go do. Today I just come stumble over this news d thing come taya me.
Ok make I ask question, what of those yahoo boys wey Dy spray money like this, some Dy even deliberately destroy properties worth millions just for dem to pay for the destruction as a way of show up.
Na the Yahoo boys dem sef go dey very easy to pick. But I guess government wan start with popular faces first. You sabi sey death wey kill Alhaji, if e catch ordinary Mallam na to tear am into pieces na. First na Bobrisky wey buy bobi and yansh. Now, dem don move to Chief Priest. Na small small, make all dis madness with naira mutilation stop. Nor be recent law sha but na dis administration get balls to act on am. I applaud dem for dat.

Make we reason the thing well sef, spraying na unnecessary show off e bi. Nothing else. If you wan support person for event, send am cash for hand or transfer am give am, na the same value dem get.
full member
Activity: 504
Merit: 151
As part of our fundamental human right I believe person wey own property or wealth fit use am the way e want because man get liberty to do anything as long as the thing no go worry another person negatively. I come Dy wonder why EFCC come Dy attack people way they use their money the way dem want.
No b say the person na politician or get appointment to say the money na government money. Man struggle for him own money and anything wey en use am do wey go give am joy  nay e go do. Today I just come stumble over this news d thing come taya me.
Ok make I ask question, what of those yahoo boys wey Dy spray money like this, some Dy even deliberately destroy properties worth millions just for dem to pay for the destruction as a way of show up.
https://cdn-af.feednews.com/news/detail/e06f6c2736523e06eb5f2c01b43b9a28-push?features=2114219&uid=5d83310483f9004e9419146d9b02332210255284&like_count=0&client=mini
Omo I feel say government wan really take the law seriously this time around, because according to watin I see the law don dey into existence since 2007 but we no dey recognise am or obey the law.
If the sentence of bobrisky or the arraignment of cubana chief priest go stop people from spraying money for occasions go stop, no be these arrest go do am. They also need to some orientation in our towns and villages to enlighten more people. Because as we speak this weekend, people are going to still spray more money and the EFCC cannot get to them at once, however this has been a cultural that has entered into the fabrics of Nigerians, so it is something EFCC will use the carrot and the stick approach to resolve overtime and not overnight.
full member
Activity: 238
Merit: 161
The great city of God 🔥
Spraying of money na Nigeria tradition, E go dey very hard for them to stop people from spraying money because Nigerians don dey use to am. Although Nigeria law dey against or prohibits people from spraying of money, trading of money, tearing of money and many other 
Types of abuse of the naira note. I think oga Charles tim don shear the link. I get another one too, you fit click here the only reason this thing even affect these people na because them be celebrity and influencers. FG no say if dem hold dem say something go come out Naim make law hold them. Because I know how many weddings/traditional marriage or burial ceremony dey go on for we country Naija everyday, wey dem dey spray money, but since dem own no dey obvious Naim make dem no worry them. But for sure that matter no go go anyway people must continue but no be say I dey encourage them o, na just weting I no. Because we 9ja we too storbon.
Pages:
Jump to: