Pages:
Author

Topic: Quick money wahala - page 5. (Read 949 times)

sr. member
Activity: 476
Merit: 337
October 25, 2023, 03:59:29 AM
#3
Me I go like talk am say the government nah very greedy people, them no wan help others way need the help but them they give to those way already get enough money and fams, anyway I just dey imagine am now say whether nah so every big men and women dey for this our country, but me I no go fit believe so, 1 of the things way they make this country no dey move forward nah because then the government no dey do as them promise when dem don already enter office.
Pipo way they follow the footsteps of the government those same pipo nai dey help put hand together spoil this good country way we dey so, people go just dey work harder to earn a liven with salaries of 30k a month and some pipo go just dey their house dey collect millions a month without working anything, this situation make me they feels as if those way they work hard just dey waste their time, good strategy to make money nai be the main Koko.... Me as I dey so I no dey blame anybody way dey go borrow money just to make another money because those set of pipos nah pipo way get the mindset of risk just to make money.
sr. member
Activity: 350
Merit: 335
October 24, 2023, 05:47:38 PM
#2
Every body wan make quick quick Cash .Gone are the days when youths work hard to earn a living,them no send how the money take come..nai make now scammers full everywhere...nobody is safe . Government too is to be blamed Sha cuz if you go all these government offices no workers yet they won't  employ fresh graduates .Na only God go help us
The rot start from the top down to the bottom... everybody dey hustle to make am against all odds. Check how far our politicians are ready to go just to be in power. That is what is propelling the youths to do both legal and illegal just to make am. Many people dey even before them make am but the hustle continues.

I no really dey against working hard to make am, I no dey against fast hustle... wetin I dey against na quick money through illegal. Any money wey no give us rest or wey we get at the expense of other people blood or tears no really make brain.

Best na to remain clean dey push life small small dey go. If you find anything wey genuine, come dey put food for your table, abeg give am your best.
newbie
Activity: 29
Merit: 2
October 24, 2023, 03:02:33 PM
#1
Every body wan make quick quick Cash .Gone are the days when youths work hard to earn a living,them no send how the money take come..nai make now scammers full everywhere...nobody is safe . Government too is to be blamed Sha cuz if you go all these government offices no workers yet they won't  employ fresh graduates .Na only God go help us
Pages:
Jump to: