Normally, I no dy like to talk about religious matter because we wey be Nigerians, we come carry religion for head like dadar, we come even serious pass isreal and Saudi Arabia wey both of them originate from, just imagine how person go dy sick seriously, base on say no money to go to hospital, instead of the church members to contribute and take that of their member to hospital after prayers, Dem go carry grounfnut oil, in the name of anointing oil, give person mama to drink, last last the sickness go still dy, but when them wey be men of God sick, Dem go go hospital.
Some women dy even respect their pastors more than their husbands, Dem no know say, every body get their role in someone's life, and each of Dem get their own level of respect, no go carry respect you surpose give ur husband use give ur pastor, if not peace no go rain, as e be so, na only God go help us for we country, because for we country our holiness don pass God own, but na we wicked pass.
Baba in as much as medicine na the cure to sickness, if you no believe in healing then just leave am rather than to dey talk generally without being specific. I know say we don get so many scam wey dey pretend to stand by God, but that no mean say you go talk am like say na general thing. With my own self I don witness healing without taking drugs, but from prayer.
The fact say Nigeria carry religion for head na good thing because, we no know wattin the future holds, serving our creator with joy and dedication na very sweet thing wey you your self go confirm the benefits korokoro, so no talk like that.
Then for the case of woman and their husbands, even the bible talk am clear say the husband naim be the head of a woman no be anybody, so women Dem supposed to dey give their husband that maximum
I no know why them go even bring religion matter come board sef, una they forget say this na general board all religion dey inside, una go just open mouth they talk wattin una brain just just think, they cast una self. No be only our own bad pass so make una stop am. Na so una take dey cast una house matter for outside? Tomorrow una go call una self christians yet una dey here dey talk una believe down. I am ashamed of people posts wey I read for here.