I had a privilege to have a conversation with a doctor his revelation send shivers to my spine,he talking about how many patients come to the hospital needing dialysis and majority of them na young guys..omo I fear,he also emphasised on the fact that to get liver failure is more dangerous.In his word,"If kidney wan fail,him go give you sign,if you notice am you fit package am before e breakdown finally,but liver no dey give any sign..it will just breakdown and before you know belle don dey swell up".And largely liver failure are also caused by excessive alcohol intake.in general let our alcohol intake be in moderate,too much drink no be enjoyment o,check originality of drink before you drink,there are so many fake product out there make person no go carry wetin him no know.
Best advise now, na to stop or avoid the practice of the act. Intake of some kain substances no good for us. For alcohol, Dem go say drink responsibly but we go wan show who fit resist highness pass, we no go know say we don dey drink irresponsibly. Alcohol right from time no good for the body, then too much of it go come worsen the situation, the same thing with the weed abi cigarettes abi tobacco we dey consume. Asides those two, salt on e own dey risky when too much of an dey consumed. Everything for the world get advantages and disadvantages, we just gats dey responsible with all of them.