Pages:
Author

Topic: [Rules] Unofficial General Guidelines For Posting( Na de koko dem) - page 2. (Read 546 times)

sr. member
Activity: 714
Merit: 353
E make sense as rules they for the forum and you still put pidgin make we understand more about each other post and other things
sr. member
Activity: 714
Merit: 353
I like the rules hope we going follow the rules to avoid other things.
legendary
Activity: 2184
Merit: 1302
Then lastly, before you or we go consider any new pesin as a valid member we go see him stability and contribution towards our 9ja board and to the forum at large this one go make us very serious.
No be older users here they decide/consider new users to be valid member, as long as say you be Nigerian, you are eligible to post here, even non-Nigerians sev they free to comment for here or anywhere else (local boards included) as long as you sabi the language of communication for the board (without using GT or plagiarising), thus we would appreciate it if we have more quality users and less spammers, but this board is open for all. If users spam here, you can basically report their posts.
So make we put am for rules as well so that if dem report anybody wey be 9ja we go straight request for parma ban to reduce bad names so that we too go dey protected as I believe say many of us bele dey here and e no good make one common person come remove all our hands for table wey we dey carry chop.
We no go fit add that one to the unofficial guidelines/rules for here, no be naija users go tell moderators wetin them go do for forum, them they handle issues on a case by case basis, thus na moderators they decide wetin them go do about any user wey break rules (whether na Nigerian or not). Mind you say Nigerians they do well for forum, and na only very few times wey i don see say Naija person break rules or got banned, thus we suppose only tell new users about the forum rules and teach them wetin them suppose know. We no suppose put any extra effort to protect ourselves or to tell people say Naija people they good and industrious, if them no wan believe, na them they lose.
full member
Activity: 798
Merit: 134
Brodaly una try I know say e no easy at all to struggle to this extents in achieving the so desired local board, in as much we dey put fire we go try as well to make sure everything pure and legit. Secondly wetin I go also tell new pipo be say make them no carry street eyes fall enter inside this our lovable forum b4 dem go spoil our images bicus sometimes if I dey negotiate some deal ones dem noticed say me na omo 9ja the discussion no dey too get head at all. So make we put am for rules as well so that if dem report anybody wey be 9ja we go straight request for parma ban to reduce bad names so that we too go dey protected as I believe say many of us bele dey here and e no good make one common person come remove all our hands for table wey we dey carry chop.
Then lastly, before you or we go consider any new pesin as a valid member we go see him stability and contribution towards our 9ja board and to the forum at large this one go make us very serious.

Abeg I still get plenty thing to yan but make I rest small as no be only me dey here.
As e dey play e dey show
Thank you all.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
So far so good, we dey progress and one thing I use Sabi Naija be say we no dey ever carry last and e dey show even for this forum and I just wan say una too much.
To our selfless bosses them @Brainboss@Igehhh una too much for all the effort una dey put for this forum to make sure say everybody dey survive here and the fact say una no dey relent, una reward dey here on earth even before una reach to enjoy the one for heaven.

And just as @Agbe my one Senior man wey I dey see him handiwork for the forum been don suggest say this introduction and rules wey OP post for rather dey in pigin than plain English as na we something and na pigin we know no be oyibo Grammer.

With that been said I want to thank everyone who has contributed immensely in one way or the other to bring this to manifestation, I say thank you and I want to encourage everyone that no matter how heated the board turns out, we should always look out for each other and be our brother's keeper.
Thanks once again.
~OBARI.
hero member
Activity: 1120
Merit: 887
Livecasino.io
Well done Igehhh. You have done well. I have no doubt that this is serve as a very good intro to newbies in the future. I would like to make a suggestion. I don't know if this can be added to the rules. Make we dye try search the board first before we make any post to avoid repetition of topics and redundancy. For example creating several topics to discus the new CBN policy with the bank note redesign when there is no new idea or analysis in it.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
Your rules of engagement dey ok OP. As the matter be like this nobody go do anyhow for the our platform here. Make the rules wey dey govern this board be our guidelines for the interim until we settle down Wella. As e be now ehn, rules na wetin dey hold platforms, organizations, nation's, associations etc for them to dey together make no Yama Yama come out wey go bus cata cata because if e happen na every O man on your own o wey no go make sense at all.
 Like as you talk, say the rules go dey but as time goes on say amendment and changes go dry, new ones go dey added while some existing ones go dey modified e better that way so as you talk make we take am like that.
hero member
Activity: 826
Merit: 641
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
This is a good effort that is commendable @igehhh, kudos to you. Rules are important in a community like this and I believe we are good to go with these ones. We are used to communicating under the Naija subforum, much more might not be needed pretty soon. But there would be moments where reasons might later present themselves to add to the ones posted above.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
This rules them really makes sense and for every well meaning naija person for inside the forum go understand say keeping to the rules no supposed be big issue but him own best interest it is needful and necessary so that everyone go get space for himself here especially when it comes to spamming.

Another tin I just want suggest, na say, it for good we also add an for the rules say make every new brother or sister wey just join the forum and wan make comment for the naija board for the first time make sure to introduce himself so we go fit know am. How una see am nah?
its not necessary as i stated in the rules;  "Do not post any sensitive or personal information about yourself or others" we made that mistake in the past we will not make the same mistake again. we were not supposed to expose our personal information on a public domain in the first place for our own safety.. omoh tins dey sup for here make everybodi just dey him dey hustle, even you wan know person you fit vinto am via PM
hero member
Activity: 938
Merit: 605
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
This rules them really makes sense and for every well meaning naija person for inside the forum go understand say keeping to the rules no supposed be big issue but him own best interest it is needful and necessary so that everyone go get space for himself here especially when it comes to spamming.

Another tin I just want suggest, na say, it for good we also add an for the rules say make every new brother or sister wey just join the forum and wan make comment for the naija board for the first time make sure to introduce himself so we go fit know am. How una see am nah?
legendary
Activity: 2408
Merit: 4282
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
U dun try for this one, I believe we go dey update the thread and as time goes on we go request for am to be pinned, maybe after we dun get posts wey full everywhere wey e come dey hard for newbies to find this thread. Igehhh I go also suggest you qoute that whole thread wey you link under the ur post. Make we no dey carry traffic dey commot this board. Instead linking just say make them read am below. Anything wey we dey find make we make am available here as na so I see for other places so person fit spend him whole dey here without going out.

Also do the thread like a welcome thread where you welcome everyone to the board (you understand wetin I dey try talk so). Like make them know how the hustle start and them not destroying it with their spamming, I believe time go come when spamming go wan kill here but we go survive am and abeg make no body dey rush anything, with requstujyfor specific things like subbaords etc with time when we see a need we go contact theymos, make we just make here active and that's all.
hero member
Activity: 994
Merit: 701
The rules dey okay and good to go for now. They are very straightforward, concise and easy to understand by anyone. Any other thing that is necessary to add can follow up after this. As you’ve also suggested, this thread should be pinned to the top so that newbies on the local board can easily see it and read through before joining other activities here. Welldone Igehhh.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Dem dey good 2 go. But di no 2, u 4 change am 2 Pidgin instead of Naija. Naija no be language but na di kwantri bibdat. Thanks 4 di rules. I really like am well well. But time goes we go still change some of dem. U go find way pin am so im go dey on top always.

Good points.

U go find way pin am so im go dey on top always.
Only the administrator, and global moderator (if i remember correctly) can pin threads, but this isn't a problem, the thread doesn't have to be pinned right now, we can all see it the way it is, and please let nobody make any request to them about pinning this for now, either through PM or a thread in meta, because it is somewhat irrelevant and unncessary for now. (i they talk because you fit close eye open am, see new thread for meta wey Naija person make say make them pin our unofficial guidelines. Abeg oh Grin). We gats take things somewhat easy, once we don gain full ground, then we go fit they make more requests.

To avoid daily bumping and spamming under the topic, I will lock it after taking in suggestions and when everyone is satisfied with the rules (based on the votes thus far), and then we/I would kindly request it to be pinned via PM because it will serve a valuable purpose on the local board. It only takes a few seconds to pin a thread, so it's not a big deal.

sr. member
Activity: 658
Merit: 441
Dem dey good 2 go. But di no 2, u 4 change am 2 Pidgin instead of Naija. Naija no be language but na di kwantri bibdat.
I saw that too... Him fit just change am to naija pigin, it is still cool that way. Nice job Igehhh ah dey see all of una doings, make una keep the good job.
legendary
Activity: 2184
Merit: 1302
U go find way pin am so im go dey on top always.
Only the administrator, and global moderator (if i remember correctly) can pin threads, but this isn't a problem, the thread doesn't have to be pinned right now, we can all see it the way it is, and please let nobody make any request to them about pinning this for now, either through PM or a thread in meta, because it is somewhat irrelevant and unncessary for now. (i they talk because you fit close eye open am, see new thread for meta wey Naija person make say make them pin our unofficial guidelines. Abeg oh Grin). We gats take things somewhat easy, once we don gain full ground, then we go fit they make more requests.
hero member
Activity: 952
Merit: 555
The rules are good and linient enough to abide with and as time goes on there may be room for improvement for additional rules that will also contribute towards the required guide needed on how every member of this locale to behave, i will in addition suggest the rules to be pinned and locked with time for everyone to see or better still, this can be a general rules discussion thread for the board while there will be another thread created and pinned only for the rules and regulations, i must commend you guys to be doing well in bringing things together for good and benefit of all.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Dem dey good 2 go. But di no 2, u 4 change am 2 Pidgin instead of Naija. Naija no be language but na di kwantri bibdat. Thanks 4 di rules. I really like am well well. But time goes we go still change some of dem. U go find way pin am so im go dey on top always.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Welcome to Naija local board, the OGBONGE online community for discussions about Bitcoin, politices and other cryptocurrencies! We are glad to have you as a member of our community and look forward to your participation.

As a new member, you may have many questions about Bitcoin and other cryptocurrencies. We encourage you to take a look around the forum and browse through the various threads and discussions. You can also use the search function to find specific topics that you are interested in.

If you have any questions or need help with anything, please don't hesitate to ask. There are many knowledgeable and helpful members of our community who will be happy to assist you.

We hope you enjoy your time on BitcoinTalk and look forward to your contributions to the community. Ur face show, Ur shoe shine.  Grin


These are some of the unofficial guidelines we must implement/follow in order to combat spam and keep this board as clean as snow (I know it's impossible to achieve a clean board without a bit of spam), but it can be reduced if we stick to the following rules, which, as I previously stated, are unofficial and subject to change and improvement over time). I'll leave the thread open for comments.

RULES

  • Follow the rules and guidelines of the forum.
  • 1. Only Naija Pidgin and English is allowed
  • 2. Be respectful and polite towards others. Avoid using offensive language or making personal attacks.
  • 3. Stay on topic and avoid hijacking threads with unrelated discussions.
  • 4. Use clear and concise language and try to keep your posts brief and to the point.
  • 5. Check your spelling and grammar before posting.
  • 6. Avoid spamming or posting repetitive or off-topic messages.
  • 7. Do not post any sensitive or personal information about yourself or others.
  • 8. Respect the privacy of others and do not disclose any personal information without their permission.
  • 9. Do not post content that is illegal, or copyrighted/plagiarism.
  • 10. No duplicate thread/Topic is allowed.
  • 11. Be mindful of the tone of your posts and try to contribute constructively to the conversation.

Do not TRUST, always VERIFY before dealing, i will serve as escrow in local fiat/crypto dealings on legal digital/physical goods off/on the forum for FREE
Pages:
Jump to: