Pages:
Author

Topic: Scam alert,,,,, Confirm before doing anything. - page 2. (Read 286 times)

sr. member
Activity: 224
Merit: 195
We get to dey on guard as this na festive season all this fraudster dey in a haunt for who go fall victim but normally our God big pass dem.
See the kind extent wey all this people dey go just to fraud person for this kind hard economy wey everybody dey find way to survive. Dey come use mother base on say they no say nobody dey joke with em mama so make we try dey careful, make we dey shine our eyes wella so we no go fall victim.

I go advise say make we use this Truecaller app as e dey easily detect scammers attack as na wetin me I dey use so when i see their call I no dey pick.
sr. member
Activity: 476
Merit: 337
My pipo, Una good evening oo, e get one kind of thing way scammers them take they scam people this days, and I know say some of us here go done they aware of am and many people too done fall victim for those kind things them.
The thing be say, them go call you con tell you say somebody for una or a member of your family dey sick seriously and em done rush am go hospital and the doctor say if Una no deposit money first em no go start the operation.

And the way them go call you, tension self go hold you, if you no be person way get mind you fit still collapse instantly (e done happen to me and them say nah my mother but God forbid nah their mama no be my lovely mother).
The way e take start be say, I just dey one hot afternoon dey reason how I go take flex this Christmas season, nai call enter my phone and the person dey cry seriously say em be my mama friend for our village (and really really my mother dey village) and the guy say appendix done bos for my mama belle say them done rush her go hospital, say the doctor say em no go start work if we no drop deposit of 90k, so me self tension enter my body, that time that time, I done start to dey find were I go get 90k to send and i done already tell them to send account number so them con send me paga account.
After I find the money finish, something con enter my mind say make I call one of my uncle way dey close to our house and I call am ask am about my mama, em con talk say she dey find but I no tell am anything at all.
Then letter the scammers call me back say make I do fast deposit the money.... ASAP na I tell am say NA EM MAMA GO DIE, at first em no talk then em end the call, then I call my mother and she pick the call, we talk wella but I no still tell her watin happen.
And today this same thing happened to one of my close friend too, em no tell me even when I ask her until when we done reach POS shop nah she tell me, then i tell her make she no send the money say nah scam and i still tell her make she make call her family person first ask questions, and so she did,,, finally finally, all nah scam.

So all this long story be say make we dey careful as scammers done enter streets with another formula.
Pages:
Jump to: