Pages:
Author

Topic: Scarcity of new naira notes.. POS charged me 9k to withdraw 30k... - page 3. (Read 385 times)

hero member
Activity: 784
Merit: 589
 This matter don serious pass wetin I expect oh, where I start to see reality na yesterday night when I transfer small 1k to lose #200 as charge nai them debt me go show declined for the POS paper up till now I never see my moni wey come back. That same night we find where to even do 5k but my contri piple, we no see, no moni to take buy kerosine or any soup things even to refill gas self na war while the POS person say moni wey dy nai wetin him wan take survive say moni no dy. My God, I no believe say I chop food wey no done well cos no moni and night don cover to even take credit something, see as to even sleep well dy hard cos of say I chop food wey no boil well...
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
Na delta state ughelli and warri self call anybody around there and verify, 3hundred naira for one thousand naira, guy just ask anyone wey you know wey dey around.
Okay chief... The issue just dey get tougher and worse everyday, my guy tell me say him babe collect 50k and dem charge her 10k for this same ph so e almost close to wetin you yan. Today dem charge me 1k for 10k withdrawal wey I make and the cash no even dey, I gats waka like 7- 8 places before I see cash. The way this cash scarsity dey go we go just revert to trade by barter make we no say we dey go back to stone age.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
This thing done get out of hand , na we dey make this country hard for ourselves small scarcity of naira note we done take advantage they suffer our fellow average citizens, those big men no dey suffer this scarcity we dey suffer but na same us wey supposed help each other dey make life hard for each other, I go say make I withdraw 30k and I was charged 9k how?? How did we get here? So when I remove 9k from 30k how much go come remain, things are getting from bad to worse and na the ordinary citizens they suffer am , let's not see every situation as an advantage to make money people dey hungry. You get money u no fit use am...wat a country.

Dem dey overdo am and everybody just wan cash out on the hype before everything dies down. I believe this scarcity no go last but make dem dey enjoy am while e dey on oh because na only God go judge this wickedness. I understand say Naira scarce and queue for banks long and to get Naira to run their pos business no dey but why dem go wicked their follow human being just because of that reason.

Sha to avoid all this wahala, just carry yourself go bank very early so you fit withdraw money keep for hand as if you come anything more than 7-8 AM, before you fit comot bank go be by mid afternoon oh. Also try making use of the cashless policy wey the government dey try reinforce as e goes well. This days na only 5k I dey withdraw while I dey use app dey run transfer for any other businesses of the day.

The only sad thing be say, bank wahala dun carry their own come. Every bank apps dun dey misbehave and na Kuda banks dey carry their own for head as if you check twitter, dem dey trend steadily due to their poor network that's causing the app to misbehave. I personally has been a victim so I understand how frustrated people are.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
This one nah wetin the head of command no suppose allow to happen since before them say make we change our moni to new one, see as we dy use our own cash dy buy abi exchange our own moni...
Like this this contri dy swim without control oh, infact this contri dy on autopilot.
member
Activity: 213
Merit: 12
My dear,it is not funny at all, but sometimes it is their fault, I don't really blame them rather I blame The present government, because in a civilized country when things go wrong and the government find out that things are the way it supposed to be,they order the law enforcement agency to tackle the issues before it spread out and become the order of the day,but we are in a country whereby Those in authority are the ones who sponsors what ever happens in the country, because what do you expect a POS Man or woman who went to the bank to withdraw his money he or she will use in running his or her private business,at a time like this the same bank which he or she has been using started charging a POS Man or woman, what do we expect from that person to do when he or she comes back home, so we need serious prayer in this country oooh..
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328

Wetin deh still surprise me be how nobody don teach any of the POS operators lesson till now. Their own don too much pass all the goofs weh Grandpa Blu Bulaba deh make. Someone should teach those operators or bank staff small lesson. But e come be like say the problem na people weh deh insist on collecting the new naira notes, why not collect the old ones and move on. At least from now till February 10th deadline na. Me na small cash I deh hold, the rest na through my bank app I deh take transact.
hero member
Activity: 798
Merit: 725
This thing done get out of hand , na we dey make this country hard for ourselves small scarcity of naira note we done take advantage they suffer our fellow average citizens, those big men no dey suffer this scarcity we dey suffer but na same us wey supposed help each other dey make life hard for each other, I go say make I withdraw 30k and I was charged 9k how?? How did we get here? So when I remove 9k from 30k how much go come remain, things are getting from bad to worse and na the ordinary citizens they suffer am , let's not see every situation as an advantage to make money people dey hungry. You get money u no fit use am...wat a country.
This one na normal situation wey we they do our selves. Nigerians they always take advantage what come their way if not how on earth person go charge you more than 20% of wetting u de withdraw?

Na we average Citizens they make things worse for ourselves, those POS guys now go they think of how them go use this opportunity to make their own bastard money instead of them to support their fellow citizens to make life easy for them as this cash policy come with hardship.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
My brother I feel your pain. The mata nah somtin wey if not handled quickly, e fit cause wahala. I face dis same issue when I go withdraw for POS after banks no gree dispense cash. E no go dey enof for CBN to order the release of new naira notes to be given OTC alone, but ensure say e go round. Imagine wetin I dey hear! Bandits get more access to the new naira notes pass the masses.
 Lai dis pesin hold moni but e no fit access am, and upon that, fuel still dey cost. Which way, naija??
member
Activity: 308
Merit: 26
Imagine person wey get access bank no fit access him money. No money for bank, no money for ATM, no money for POS, Buhari don give us an unforgettable parting gift.

Op, no vex ooo but I find this hard to believe because me no fit cough out this kind money give POS operator for just 30k transaction because na 10% dem dey charge for almost everywhere for my area wey be PH. Today sef I don perform 2 transactions using POS. I do 5k transaction at N400 and 6.5k at N600 and money wey dem charge me really pain me. The second person used my head, after agreeing that was going to do a transfer to him, las las the guy go call POS girl say make she collect the money, naso I come pay the charge. If to say na something wey I fit return I for just return am cuz the thing pain me.
Na delta state ughelli and warri self call anybody around there and verify, 3hundred naira for one thousand naira, guy just ask anyone wey you know wey dey around, even if you wan use transfer or POS buy something them go request for their charge and that's very strange compare to how it was done before, them dey sell money now, even the oos people dey buy money , the money dey use for there POS business

Jump to: