Pages:
Author

Topic: Some challenges of the newbies in the forum - page 2. (Read 321 times)

sr. member
Activity: 658
Merit: 441
February 18, 2024, 04:58:06 PM
#7
When you park enter a new environment or neighborhood, e dey wise for you to observe the environment, kno wetin dey sup, so dat you go kno as you dey waka for the area. Naso e be for here, as a newbie, you need to first read the rules and guidelines, observe how people dey post and learn. But some newbies no dey take their time learn while odas dey feel intimidated by the senior members, which no suppose be so and for that reason dem dey fear to post for some certain boards wia dis men gallant.

I just want talk say, as a newbie you fit chuck mouth for discussion wey dey go on for any wia for the forum and give your own contribution as long as you kno wetin you dey talk and you no dey spam, nothing do you. But e still dey advisable make you start your journey for the beginners and help board and make you dey read more dan you dey post.
hero member
Activity: 1176
Merit: 785
February 18, 2024, 02:46:08 PM
#6
The truth about this forum be say eh no be rocket science, wey if you put in much effort you no go understand how things dey work for this place, because the fact say others don come here and make an should be a motivating factor to others say if they do the right tin, they too go still make an for the forum. Because all that is needed here na just patience, hardwork and obedience to forum rules, and nothing much, wey if only you can abile to them all, you dey rest assured to succeed just as I did, Nwada001, Agbe, Franctoshi and many others did.

So my dear friend, I no say eh no easy, but just try and don't give up.
member
Activity: 168
Merit: 77
February 18, 2024, 11:57:50 AM
#5
Honestly, if all the newbies wey dey enter the forum dey take their time to familiarize with the forum the way you do, then the rate of spam and meaningless post go really reduce. You go see person just register account today today, e jump enter Bitcoin Discussion board go as "What is Bitcoin and how can we make money from Bitcoin". Anytime I see those kyn things, e dey really pepper me for mind because I go come dey wonder wetin these people dey really thing wey them dey do this kyn thing. Normally when you go where you no know, you gats first chill make you for observe wetin dey happen there and how people for their dey do things, you no go just come where you no know, you don start to dey ask people careless questions. Na true say here na learning environment and high ranked members supposed dey carry newbies along, but no be to come forum as a newbie come ask question wey be say u fit just easily ask Google make Google for give you better answer, you go ask question wey people don already tire to answer for the forum and you expect make them answer you, after you go say people here na bully, wey be say you never even do wetin you supposed do. Abeg make we dey try do the right thing.
member
Activity: 364
Merit: 44
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
February 17, 2024, 07:09:47 AM
#4
Your advice may look simple but is the truth about this forum and newbie behavior, one think they must know is that posting without knowing what your posting is waste of time. Everything thing has it methodology, and for this forum the first methodology is to study, read and understand before any action of making post. Some may say what is there to read, any who ask such have not prepared it's mind to learn in the forum because allot of pin post of beginners and others helpful article and write concerning crypto and Bitcoin full the board which I don't want to repeat to avoid spanning. I first avoid posting just as you do and read,that help me allot because the two post I made when I started gave me merrit, orientation to Newbie should go beyond posting on the thread but how to acquire the required knowledge just as you have started, because failure to learn can make you a failure because without knowledge one can't make progress on the thread.
sr. member
Activity: 266
Merit: 205
February 17, 2024, 03:00:52 AM
#3
Lol🤣🤣 this guy no go kill me for laugh oo, you funny aswr, the way you take dy explain ur movement around the forum Just be like most of this movie wey we dy watch, wey one village guy go enter city  for the first time, come dy do funny things base on say everything dy really strange for him eye, but na normal sha, such is life.

Na good tin say you take ur time learn, even though you no get anybody to guide you, because na wetin most newbies for this our local board lack, so if most newbies dem been get person to guide dem, e go dy much easier for you, as for me, my own start no dy too hard for me sha because I get person wey dy guide me and draw my ear make I no do some tins and tins.

Sometimes na him go dy worry me to make post, but see me now, na me dy post on my own without anybody telling me, but na part of the leaning process sha
member
Activity: 66
Merit: 5
Eloncoin.org - Mars, here we come!
February 14, 2024, 10:22:58 AM
#2
Firstly, I really enjoyed reading this post, I don't have enough spare smerit to spend I would have shown a little love since we are in a season of love (valentine's day).

The fact that you took some time to back off from some certain discussions to understand first before sharing your thought shows some similarities between us. I created my account some time ago but I was kind of busy with university stress so I backed of instead of spamming the forum and I literally learnt alot before I start engaging in discussions, if only some newbies can find this thoughts and use them here in local board, I guess Igebot wouldn't tag them at all.

Well now that you have some level of knowledge here its good for you, for me I'm still stuck trying to divide attention to learn some things too and contribute and also take my studies serious at the same time making my rank up a bit slower but with time we will get over all of the learning stages.

For the terminologies that seems hard to understand you can use the following links to understand them.
[1] https://bitcointalksearch.org/topic/terminology-126798
[2] https://coinmarketcap.com/academy/glossary

I believe they can help you understand better, have a good time here brother.
member
Activity: 225
Merit: 64
February 14, 2024, 09:37:54 AM
#1
For the first time when I join this forum I just dey stagnant dey observe like fowl wen go new place. Then I come decide to Waka for the forum small make I know how things dey but yet I no know wetin dey happen for the place.
wetin I do?.
First first I start to find where help dey, successfully I come see am quick because e no hide at all be like this forum design this sight mainly for newbies to help ease their stress of finding help, then I see many options wen I no even understand as a newbie plenty grammar both the ones I know and the ones I Neva hear before then those words I tap them e carry me show google then I tap am immediately I see the meaning of some of these big grammar and many more, some Bitcoin related talks I Neva hear before.

Then I still get some places where I still fear to enter or post something after my first and second week in the forum e.g
The economic board.
The Bitcoin discussion board.
And so many more but I still decide say I no go enter that area say nothing concern me because I think say na for people wen Dom arrive dey for there because of the big big grammar wen I see like the Alt coin and many more of them for this board wen I see as senior men board. Wen I come enter this board one day come see one write up wey say ( not all kind of post are accepted in this board na where I for totally back off but I come decide to enter instead of posting I carry one week read these big post them and make research of this big words and now I think I fit post anywhere regardless of the quality. I think say most of these my highlights na major challenge to the newbies, so my advice here na say make nobody rush to post take time understand very well.
Pages:
Jump to: