The rate at which young people dey get diabetis and hypertension these days is alarming.
The rate at wish young boys dey consume beer with no moderation is increasing everyday. Some go take five to ten bottle of beers dey call am enjoyment. That kind life no be enjoyment. You dey only destroy your body system.
Excess consumption of alcohol fit cause diabetes.
E get wetin dey regulate our sugar intake , them dey call am INSULIN. When you take too much beer, e go make the insulin no dey work well again, this will then cause increase blood sugar level. Excess beer dey destroy won organ for our body wey them dey call Pancreas. This pancreas dey produce Insulin wey dey regulate sugar as I mentioned earlier. Imagine say that organ is destroyed, that's the worst type of diabetes
Do you also know that excess beer consumption dey cause Obesity which is a risk factor for diabetes?
Diabetes is also link with hypertension, e mean say person wey his or her sugar level dey high fit get hypertension too which is dangerous to you heart, if e affect heart, na Cardiac arrest, if e affect kidney, na kidney failure and if e affect brain, na stroke be that.
Some young guys now dey complain say their manhood no dey stand well( Poor Erection) some of them na due to excess sugar for body. So if you get this kind issue and you know say you dey drink alcohol well well, go check your sugar level.
Diabetes no get cure, you can only manage it with life style changes till you go old die.
I say make I bring this thread here because I get person wey get this diabetes for young age and I know wetin the person they pass through.
Please drink in moderation if you choose to drink, and do not make it a daily lifestyle
I hope this message help someone here.
Alcohol ordinarily na poison for the body system, that's why dem advice say make we take am moderately, it can lead to kidney failure, e dey capable of doing a lot of harm for the body system. Especially when you don reach the age of 40, so e better say u stop taking too much alcohol or reduce it. Especially for this we country way fake drinks full market, the other day, e get the kind brand of beer way I dey normally drink, Omo recently I don notice say the taste of this brand don change oh, so it then means adulterated (fake) don also enter the market. Omo I just stop to dey drink that brand of beer entirely. So we gat to dey careful watin we dey drink oh