Pages:
Author

Topic: The Journey So Far (Read 295 times)

hero member
Activity: 784
Merit: 589
June 05, 2023, 03:33:04 AM
#23
Congratulations @SmartGold. This your success story no go end here and just like wetin @Satoprincess tok, I folo put mouth hapi to see our felo women dey push, preserve and excel for tins wey on a norm na men sopoz dey do.
 I believe say this milestone you don reach, e no go end for here. Good job and we all look forward to seeing you achieve more heights...
hero member
Activity: 742
Merit: 529
June 03, 2023, 06:26:51 PM
#22
Na this kind beautiful successful stories we want to the see, this stand as a challenge to those single young youths wey go come forum after maybe one person for forum introduced them to the forum then later you go start to the hear say forum hard to grow, forum na this na that. Everything for life if you don dey determined and ready to do the extraordinary, the rest na story cause las las you fo achieve success. So OP, congratulations to your new rank and we look forward to see you higher and higher in rank. No dulling!
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
May 30, 2023, 06:55:42 PM
#21

Na full woman perspective you carry narrate this one o. As in eh... I know say we get some kind string woman for here, woman like SatoPrincess and few others but, e sweet me to dey see say, some women dey way dey try put body and take up the task to follow man dey do watin them dey do make innovation no pass us by. Make we no con dey come second when the opportunity to come first dey.
You dey do well gor yourself and I sure say, gradually, you don dey see reasons with your plus one why, you need take here serious. Still, I go advise say make you no dull yor course o both na study and yiu fot carry them join body dey go. You dey try, kwantinue.

Hehe no be play, I know say many of una no go notice me because my level never higher like una but, I thank God today say people like una don come see me and as well discover say woman like us dey exist. We no fit grow if we no lift each others and I don see am say na wetin dey happen here like this.
Make e no be like say I dey yan too much but as you see am you too go understand. This post don come connect me to people wey balance for the industry.
Thank you
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
May 30, 2023, 06:15:39 PM
#20

Na full woman perspective you carry narrate this one o. As in eh... I know say we get some kind string woman for here, woman like SatoPrincess and few others but, e sweet me to dey see say, some women dey way dey try put body and take up the task to follow man dey do watin them dey do make innovation no pass us by. Make we no con dey come second when the opportunity to come first dey.
You dey do well gor yourself and I sure say, gradually, you don dey see reasons with your plus one why, you need take here serious. Still, I go advise say make you no dull yor course o both na study and yiu fot carry them join body dey go. You dey try, kwantinue.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
May 29, 2023, 11:33:06 AM
#19
But the bottom line be say i come thank people wey help me enter Full Member, The Cryptovator, CryptopreneurBrainboss, JayJuanGee, CryptoHeadlineNews, LogitechMouse, Igebotz and Nwada001. Others way help me too join but no be everybody i fit list here so i truly appreciate una for the help.
We rise by lifting others!
Congratulations to you my dear, because at least i'm happy say our Naija women no dey take last in this crypto stuff & eh dey give me joy, because first, I go say thank you for believing in your husband and also in Bitcoin & this forum, because na only we wey don arrive go fit understand wetin you passed through in your journey from "Brand New" to "Full Member" that you currently are, and I will like to encourage you not to give up, as on this forum, there are whole lots of opportunities you can tap from, ranging from the normal forum signature campaigns, contests and prediction challenges, wey if you dey lucky you could possibly earn or win a good decent amount.
member
Activity: 406
Merit: 84
Eloncoin.org - Mars, here we come!
May 29, 2023, 11:11:51 AM
#18
Congratulations my sister, you don really try, your ranks and merits really shows hard work, e really show and na motivation to us all wey really wish to get to the rank wey you dey now, thank you for sharing this story as e don serve as motivation to us, God bless you..
Also a great thanks to your husband too for helping you out, na real man en be
hero member
Activity: 700
Merit: 523
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
May 27, 2023, 02:04:26 PM
#17
Life na seriousness and consistency on whatever man dey do and before you know am you don dey learn small small and before you know am,you too go fit dey talk for where senior men dey talk base on your knowledge.

Now na you don dey enjoy the forum because you don realize say you need to join the moving train towards ranking up and other necessary things wey go make you happy for the forum. Next time make you check if similar thread dey like this so that you go also post your achievement there too.
Congrats.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
May 27, 2023, 07:15:17 AM
#16
If not for the sake of privacy, i could have ask to know your husband, because i can understand the level of efforts he may have put in to get you to this level, just as it is hard for a husband to teach his wife how to drive a care same it is with teaching your spouse cryptocurrency, Bitcoin and the bitcoin talk forum in general.

But then it feels so good to see you making some progress even though your little angel wants to get you distracted, but then never give up on your dream since you already understand how the Bitcoin talk forum works as a full member.
member
Activity: 93
Merit: 52
May 27, 2023, 01:59:21 AM
#15
Wow this is a great news, very happy seeing another female king from we country. I no know say women dey here like this o, like this we go try identify ourselves very well so that we go know total women from we country wey dey forum. Congratulations I hope to be there soon.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
May 26, 2023, 05:19:34 PM
#14
You dey welcome to di forum, me I never see dis user account in dis place before, na di first time. Ur Bobo really love u, and make u no take play. Im want ur progress and expansion of knowledge from your jurisdiction of study na make im tell u to come here dey learn bitcoin and invest in it so dat u can make something out of the investment. And u too, u dey try e no dey easy for nursing moda dey come here dey make small research dey post. As u tok am sae ur baby sef dey drag phone with u to use am and na so di mata dey always. Mostly wen dem like to watch cartoon den your own na to give her di phone and relax  Grin. Welcome.
sr. member
Activity: 1316
Merit: 379
#SWGT PRE-SALE IS LIVE
May 26, 2023, 01:25:00 PM
#13
This is amazing 😍
Congratulations our sister, at least we have another satoshi princess from we community.
Isn't that too smooth with women putting much interest posting here and to dedicate time to available even to reach this rank because they always come up with one or two complain about husband and children but seeing going this higher coupled with your baby is a thing of joy and happiness.
Again congratulations madam. Abeg Igebotz try update her for our monthly stat so that she go dey recognized and known as well.
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
May 26, 2023, 01:16:36 PM
#12

Madam SmartGold01 I congratulate you big one. It is not easy for women to follow rub minds here as una no plenty for this type of thing. To learn cryptocurrency and know am well no be easy thing and na him make I deh congratulate you for this new step up weh happen for your account. Continue to deh post and rank up.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
May 25, 2023, 03:40:38 PM
#11
I must greet you specially on your new level. Na good example you dey set for the other people way dey your back, as them see say you don make am e go motivate them to still try their best to increase their rank. I want make you see this your accomplishment as reason to increase your contribution because now the forum done recognize as part of its core. Congratulations SmartGold01
hero member
Activity: 812
Merit: 560
May 25, 2023, 12:24:40 PM
#10
Congratulations to you mate and welcome to a new era, i want you to continue the good works and never relent, because you will always have the results of every of your efforts in due time, also know that it's also another challenge for you to face the next phase on the forum and in life as a whole, you're no more a kid that needs milk for growth, now you can chew meat and the higher you go the higher the level of expectations required from you to meet up with, never forget to maintain a steady and constant learning on the forum each day.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
May 25, 2023, 10:32:57 AM
#9
Congratulations to you SmartGold01... I dey happy for you for this new feat and I wish you many bars for your shoulder. Na SatoPrincess be de only established and high ranking female from our local board wey I know wey dey do very well for de forum and I go dey more than happy to see you work in her shoes, better her records and also set some marks for others to follow. The journey is just starting, enjoy you new rank it is well deserved.

Na true me dey see her everywhere because I know say as woman e no easy to stand in the midst of men most especially e come be say no woman to follow encourage you join or even see fellow women to compete with.
Anyhow sha I dey happy for her because na she be my sole motivator wey make me still get the energy to dey still hoover round here if not my dear brothers e no easy at all.
But nevertheless, make we see how we go move.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
May 25, 2023, 08:13:28 AM
#8
Madam smartgold  kudos to you for this achievement o. You really don try for this height wey you reach like this. As r be now ehn I dey really happy say our women then wey dey for this platform don dey do well to dey active like this. I hail you for this one as e dey make me happy well well.

Atleast make you dey try  come show face here so that all of us go dey contribute to the growth of our very own board so that other country people go dey envy am as e better pas their own.

You don try for this rank wey you reach so. I go say make you out more efforts so that you go continue to Dey  grow for this platform.

Congratulations to you again.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
May 25, 2023, 07:22:41 AM
#7
Congratulations to you SmartGold01... I dey happy for you for this new feat and I wish you many bars for your shoulder. Na SatoPrincess be de only established and high ranking female from our local board wey I know wey dey do very well for de forum and I go dey more than happy to see you work in her shoes, better her records and also set some marks for others to follow. The journey is just starting, enjoy you new rank it is well deserved.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
May 25, 2023, 06:53:38 AM
#6
You don try, now u don see say if u allow the forum collect small time from u, the forum go also give u small thing in return, which that one nah promotion. Congratulations 👏🎉 for d new rank way you don unlock, I just see am say nah yesterday dem help carry u enter diz new rank. Now way u don reach here so, diz full member no be the last so I go advice make you still carry that ur same energy way u use reach here even if nah to borrow small from ur husband carry dy support ur self, eh go help, so that u go also collect more rank for here way u go celebrate 4 time way dy front, I know say female dem dy the forum way from our side but nah just few we sabi with dre name and others.. Eh good to see our sister dy also push am hard to reach next level.

No be small thing at all but I believe say I go still make am to another level since I don dey already scale around the forum and as well getting more knowledge about things wey dey happen here.
Sincerely speaking e no really easy at all but one thing for sure say, no matter how person cry due to hunger person no go fit cry out blood for eyes 👀. So I go still dey here see the next level, only thing e go take me na just time.

E shock me say I no too sabi your username till today. E sweet my belle to see our women dey involve for bitcoin and this forum, those way identify as female for the forum generally no too plenty. E good as you no give up, as you take reach full member na so you go take reach the next rank but you go need to know more things about bitcoin. Sometimes na where person know reach nai e rank dey reach. Congratulations on your new rank, I no fit wait to see you reap the benefits of your dedication.

Sometimes na so e dey be sha, e be like say as my rank never high e no too attract your attention but thank God say as I shift small like this you don come sabi me. Na wetin make our pipo say "Who get person na'im pass who get money" na so e be. Me self dey notice you well well even self I don follow shuck mouth with you for same thread them self but as then my face no show and my shoe never shine 😂.
From the name I believe say you too na my gender so e go better for me well well say I get fellow.
full member
Activity: 448
Merit: 117
May 25, 2023, 04:59:38 AM
#5
Congratulations to our very own sister. You don really try for this achievement as e no easy to attain this height for this platform o. Hard work really pays o. So i go encourage you to keep up  with your good work wey you dey do and also, make you for try dey always show face here so that we all go dey tori and dey jolly here too to dey know wetin dey sup for we country board if na wetin go require our input too make we for do so that all of us go fly high for this platform so make nobody dey left behind as you talk say we rise by lifting others. Na good talk you talk be that o.
once again, congratulations to you.
hero member
Activity: 616
Merit: 509
Top Crypto Casino
May 25, 2023, 03:30:52 AM
#4
Well-done my sister, I go take your word for am because you don clear us say you be the feminine gender if not na man I for refer you as but that being said you don try well well and also you for try post this your rank up for this thread wey one of our senior man don already create so that people like you wey just rank up fit post am there. I go drop the link to the actual thread so that you go fit update am there.
Here is the link:: https://bitcointalksearch.org/topic/makeannounce-ur-rank-up-nd-weti-u-don-achieve-plus-merit-here-5436898
Pages:
Jump to: