Pages:
Author

Topic: The Journey So Far - page 2. (Read 295 times)

hero member
Activity: 966
Merit: 701
May 25, 2023, 03:28:57 AM
#3
E shock me say I no too sabi your username till today. E sweet my belle to see our women dey involve for bitcoin and this forum, those way identify as female for the forum generally no too plenty. E good as you no give up, as you take reach full member na so you go take reach the next rank but you go need to know more things about bitcoin. Sometimes na where person know reach nai e rank dey reach. Congratulations on your new rank, I no fit wait to see you reap the benefits of your dedication.
hero member
Activity: 602
Merit: 638
May 25, 2023, 02:59:51 AM
#2
You don try, now u don see say if u allow the forum collect small time from u, the forum go also give u small thing in return, which that one nah promotion. Congratulations 👏🎉 for d new rank way you don unlock, I just see am say nah yesterday dem help carry u enter diz new rank. Now way u don reach here so, diz full member no be the last so I go advice make you still carry that ur same energy way u use reach here even if nah to borrow small from ur husband carry dy support ur self, eh go help, so that u go also collect more rank for here way u go celebrate 4 time way dy front, I know say female dem dy the forum way from our side but nah just few we sabi with dre name and others.. Eh good to see our sister dy also push am hard to reach next level.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
May 25, 2023, 02:48:17 AM
#1
I hail una my pipo i know say e no too good to post this one here but, e good to start from home before we move go do am outside meaning say the gratitude suppose go to people wey dey home than any other person even though i no post there again i dey okay with here.
My Husband began to tell me about this forum for long but i never put am interest and him dey tell me say my fellow we women dey here as well say why me no go put interest to dey move around the forum to dey explore things, but due to my kind of woman and my belief i just feel like say na lazy man work to dey seat down place dey press phone or laptop.

The matta con dey worry me for sometimes so i give am space small dey expect work towards my field of study but ones ones i dey reach here, since him help me teach me how to create account i con manage get am then 2021 but i anoda thing wey me no know say person dey increase for rank. I no even too take am serious but after i put to birth i come get small chance to dey focus here, even self my daughter no allow me press phone or to dey use my pc becus we dey drag who go operate am pass. But of all this i still put mind onto say i come dey lonely and nothing much to dey do, na so i bring mind to explore here finally i come dey receive small small merits wey carry me enter full member, i know say the story long sha bicus no be everything i fit remember post here again.
But the bottom line be say i come thank people wey help me enter Full Member, The Cryptovator, CryptopreneurBrainboss, JayJuanGee, CryptoHeadlineNews, LogitechMouse, Igebotz and Nwada001. Others way help me too join but no be everybody i fit list here so i truly appreciate una for the help.
We rise by lifting others!
Pages:
Jump to: