Wetin I de try talk be say make we no de write anything off like that on the first appearance, make we continue to de learn anything when de reasonable and useful to learn. you never can tell which one will end up paying you very well in this life.
All dis tin wey you pass through na part of struggle wey everybody dey pass through first before making it in life. The process just different, but everybody get him story to tell on how dem take make am reach d stage where dem dey so. Your person wey show you way really like you and you suppose show big appreciation to am for dat because no be everybody dey help others dis days. As you don find dis forum you come dey benefit from am, no relent to go find oda means of making money too. Your knowledge for here no fit go but d oda benefits wet you dey get for here fit stop, end or pause at anytime. So try look for anoda means outside d forum to compensate yourself with. One way no be way now for naija.
That is why e no good make you get negative impressions or vibes of person if you no really know the truth of the matter. Dis tin don take many people down than bringing dem up. When you see someone making achievements on something, make we no just look am like say him don dey into illegal activity online just like dat, e fit be your destiny helper wey go lead you to your own success too. If you get privilege to near dos kind people, ask dem politely to show you d way and if dem no gree no force dem and no go cast their matter outside. Just humbly leave and look for anoda means to try oda legit means of fending for yourself. Because him no help you no mean say anoda person no go dey to help you.
If you they look how things they, plenty opportunities still they the country but the hard part nah to find am or find person wey go fit link you up. Normally ah no go blame person wey they lock up to show people in way of success cos ah done see where person help person nah the person wey he help nah him wan con spoil in business for ma. Nah why people no they people be tha. The heart of man at times e they desperately wicked and deceitful.