Abeg make we no call d economy situation on ground inflation.
Wetin me I know na hardship
This place na im I want talk about and leave all those funny questions wey you dey ask. The thing dey funny, make dem reset the country afresh
Anyway, my brother the country hard no be inflation. This one don pass inflation. The thing don dey unbearable but the challenge be say no way forward as I dey see the present administration. In fact NLC self no help matter, how you go begin strike one day when you don wait for government tire and the next day Dem say make you come make una talk again. The whole people wey dey involved for Nigerian governance na corrupt people. You remove subsidy wey average and poor people dey take still feel government, increase fees for schools,which one persin want talk.
The current NLC chairman, I no know wetin I go call am as. Whether na weakly or na peso wey over like money. How peso go call for nationwide strike today, the next day you don see am for Aso-Rock d laugh with the President, telling Nigerians sae the nationwide strike no go work again. The purpose wey you take go see the president sae, make em increase the minimum wage of civil servant to 100k naira due to hardship and the high cost of things, you no actualize am. You lock up for the whole matter till date.
The stupid display wey the NLC chairman show to Nigerians makes me to remember Adams Oshimole when em NLC chairman during Obasanjo tenure. If na person like him for seat as NLC chairman, there would have been an immediate nationwide strike d day wey Tinubu announce the removal of fuel subsidy.
What do you expect from a corrupt system? nothing. Almost everyone wey d on top of big positions for the country d corrupt. Wetin them sabi na for their pocket. Once wey big money don enter their pockets, anything we d masses like make them pass through for the country is non of their business. It's well sha for us all. We Nigerians are survival of whatever hardship the leaders of our country throw at us