I have a questions? what are the things newbies should do to earn more merit, and what is the advantages of merit, also and also what should encourage the newbies to get more post.we are new in the forum so we still need, some guide so that we can meet up with our daily post.
E no get anything like "daily post", as a newbie wey no even dey campaign, no be must say you go dey steadily make posts, as a newbie reading better pass posting, because the more you read, the more you go dey learn wetin to post from what you read. E get wetin i notice say e dey affect newbies, and the thing is, dem dey rush, dem wan grab everything in a day, no go dey look some users wey still dey new but dem get penty merits, mind you that knowledge dey different and e get people wey dey understand things faster than others.
Having said that, the best way to take get merits na if you get to learn about Bitcoin and the forum too, e go help you to dey make high quality posts, and na posts like that they give merits. The advantage of merit be say you go use am rank up, and as you rank up dey enjoy yourself for forum, you go fit join signature campaign they earn incentives from your contribution to the forum.
Na true, di best way for newbies to take get merits and rank up na to learn about bitcoin, follow forum rules and di most important na to try to focus on making quality posts. Di only thing wey i go fit add from my small experience for di forum na for dem to get patience, because as a newbie or member, you fit to de try make quality posts, but merits no de come like dat. So for me, na just to de continue learning and making quality posts, gradually merits go come, because if new members focus more on merit and e no de forthcoming, na big discouragement be dat.
E go also de good if our senior members go de encourage di low ranked members for our local board with merits from time to time, if dem see quality posts from di upcoming ones. Except for a few members like Oga Brainboss, most ranked up members for dis our Nigeria board no de encourage and support new members with merits. Na my own experience and opinion be dat.