Pages:
Author

Topic: We dey give ourselves bad names everywhere. (Read 332 times)

member
Activity: 212
Merit: 12
April 21, 2023, 03:33:12 PM
#30
My brother na better thing you talk, please make we try help ourselves because if you use because of the bad government wey we get go do bad thing if they catch you them go kill you oooh because we wey poor mases them no take us as anything ooh so please help yourself and save your life too,

But make I tell you the truth, this government no they try at all, because wetin make them no won do this our obodo naija make e be like obodo oyibo so that our brothers go stay here and hustle, because some of them go there and they no get wetin them go do for there because them no go school and hungry won kill them and they start to the thief,and e no good..
And another thing be say e get people wey thief they their blood so no matter what them get them go still thief,so no matter what the government do they can still go on and do fruad so make we the youth help to stop this,

Again Nigeria name don stain long time ago by our politicians wey they carry our money dey go obodo oyibo go keep,so oyibo people don know us with thief, fraud,so no be today na e the name stain ok..
full member
Activity: 840
Merit: 137
Op no be say I dey support fraudulent acts o, but if you really look into this matter eh, na naija name nai just dey echo when it comes to fraud, but believe me, e get other countries wey dey do this fraud past Nigerians, una no go tell me say na Nigeria be the most corrupt county na, no na it's not possible, other countries dey wey do worst than naija, but Dem dey always carry naija put for front when e comes to fraudulent acts and other illegal activities I no like am abeg, if you check and investigate this arrest for fraud matter now, you go see say some China citizens go dey involved too, but Dem no go gree arrest Dem too, na only naija citizens Dem go arrest, just to paint us black always....
Our Matta don cast every where na,our name Naija echo past anything wey I know.The moment oyibo people see say na Naija you from,them don already dey tag and label you thief and scam.Na wetin them dey tag us be dat,but we no go kill ourselves,normally,our government no dey do us well,people gat do anything wey dem fit do to survive.We just gat stop castigating ourselves,if other people,like outsiders dey talk say we bad,we no gat follow them dey reason thesame thing,work no dey,and wetin people see say e dey pay dem nai dem dey do.I no dey support fraud oh,but I dey talk base on how the our country be.
hero member
Activity: 1008
Merit: 715
Its sad say our contri is only known for all the fraud stuff and not the good ones, which true true, I go talk say our govt get a major role to play in the increase of scamming activities in our contri, because there is a popular saying that "an idle man is the devil's workshop", and yet instead of our politicians/govt to create an avenue to engage & empower the youths at all levels, all they care about is how to embezzle funds that their 10th generation will likely use when they finally come to earth, which is quite very bad and not good for any developing contri like ours.

But despite what here are some of the goods things Nigerians are doing around the world that never go viral unlike the negative ones

1. Emmanuel Ikechukwu Umeonyiora has become the first official Igbo Language lecturer at the University of Oxford. This will be the first time that the Igbo language will be taught in an Ivy League school in the diaspora.

2. In 2016, Dr Oluyinka Olutoye and his partner led a team of 21 doctors and performed a surgery never done before. This surgery saw them remove the fetus from the womb placing it back for the period left to be delivered. After its success, he was appointed the Surgeon-In-Chief at the Nationwide Children’s Hospital in the U.S.

3. Mojisola Christianah Adeyeye is the first African Fellow of the American Association of Pharmaceutical Scientists Fellow. For twenty one years she taught at Duquesne University in Pittsburgh, PA, USA.

Source:
https://guardian.ng/life/epitomic-nigerians-making-worldwide-impact/
jr. member
Activity: 70
Merit: 5
Bet2Dream.com
Nigeria is the most popular country that is well known with fraud and all this scam activity and still the issue is not burder most of leaders and seriously the issue is damaging our country images, although we know say many of youth's be unemployed but we get hand to work like labour work and still get money but now a days many of Nigeria youth's no want to work with their hands again everybody wants to enjoy free money and from those fraud activities that lead some to spiritual activities and end with mental illnesses and some lead to death.



Actually, if we all remember that proverbs wey talk say train a child the way he should grow.we go notice say na our leaders they do this fraudulent activities pass. Na the one wey them dey do na e big pass. The only way this fruad and thiefy thiefy go fit stop for we country na if the government of this country lead by example. Them go con set law, employ better genue people for efcc, no be all these ones wey dey follow orders from people wey dey thief. With this ehhnn the country will start having a good names.
     And also, no be only the government our parents too. These days parents dey encourage their children to do fruad. Them no care how them take run am just Sha the pikin bring big moto come hux make them sit down for front sit.. like it doesn't even make any sense. Why would a parent want to give their children bad name? I'm really tired of this generation.
full member
Activity: 448
Merit: 94
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Op no be say I dey support fraudulent acts o, but if you really look into this matter eh, na naija name nai just dey echo when it comes to fraud, but believe me, e get other countries wey dey do this fraud past Nigerians, una no go tell me say na Nigeria be the most corrupt county na, no na it's not possible, other countries dey wey do worst than naija, but Dem dey always carry naija put for front when e comes to fraudulent acts and other illegal activities I no like am abeg, if you check and investigate this arrest for fraud matter now, you go see say some China citizens go dey involved too, but Dem no go gree arrest Dem too, na only naija citizens Dem go arrest, just to paint us black always....
member
Activity: 322
Merit: 10
In as much that there alot of Nigerians giving this country a bad name everywhere they go there are others who are also changing people's view of Nigerians positively even in that same place but though they are few but with time and the growth of the good ones, Nigerians will not be seen as scammers

We have very decent people flying the flag for the country's intelligent, hard work and craftsmanship, we have people in sport making us proud and we have those in the entertainment industry doing the same. Nigeria isn't as bad as we're been painted. Just a few are getting caught for their evil deals and they make it look like everybody in Nigeria is guilty of that crime. The crime wey dem dey associates with us say na we get am, no be us even dey do am pass and sometimes the people wey dem catch dey commit d crime just dey claim Nigerian since na there popular pa for people from this side, the thing they balance himself.

I get your point Sha,. No be lie my brother. Naija pipu na some of the hardest working peeps around the globe. From childhood na so d odds go dey pack against us, from bad government, to no basic amenities provided, to parochial profiling from the west, yet naija pipu Dem dey grind on. One day God go hear our prayers and give us leaders that will tink of us first.
member
Activity: 322
Merit: 10
Nna I dey feels your pains, I dey tells you, Im kinda person that always sees good in person but I don fall mugu too much for our kind that it's hard to see a brightness in this midst of the dark.

Well we can do for now is be the change u want to see and don't be discouraged.

Even from dis forum wet we dey we can make a difference as a community, dat is reliable and helpful. Thank you all my people.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Many at times I d seat down the reason how our country go be in 10 years time because the way I d see this our country, em no d go well at all. Checkout many of youths(male and female) wan quick money, them they ready to go any length to actualize am, if na to cut their life short, they are ready to risk am all to make sure they belong for the people wey don make am for life.

This our country, nobody d ready to serve or work for others. All men wan be their own boss, drive the latest car and show off on what grounds actually? To impress girls or wetin fa? Their village people I guess.

Something urgent needs to be done to all this new find job called fraud wey many Nigeria citizens don get involve into as job because d way I see am, em go affect the upcoming generation in the sense that na curse give people wey d dupe people of their fraud and that curse go affect their coming generation. The bible don talk am ready sae em go carry sins of the father, place am for   their first to third generation. Em better make them repent and amend their ways, to save their upcoming generation
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
In as much that there alot of Nigerians giving this country a bad name everywhere they go there are others who are also changing people's view of Nigerians positively even in that same place but though they are few but with time and the growth of the good ones, Nigerians will not be seen as scammers

We have very decent people flying the flag for the country's intelligent, hard work and craftsmanship, we have people in sport making us proud and we have those in the entertainment industry doing the same. Nigeria isn't as bad as we're been painted. Just a few are getting caught for their evil deals and they make it look like everybody in Nigeria is guilty of that crime. The crime wey dem dey associates with us say na we get am, no be us even dey do am pass and sometimes the people wey dem catch dey commit d crime just dey claim Nigerian since na there popular pass.

As for the jobs wey you dey talk, no be say boys no know say jobs like dat dey but dem they find quick money and na wetin dey make those kind job hard them to do besides if then dey learn dat job, wetin dem go dey chop for the time being and that kind job no fit give money wey this boys dey expect. You dun see the lavishing lifestyles wey dem dey live? One good thing about all this things be say, as people dey wey dey spoil our name na so we get better people dem wey dey make people cut cap for people from this side, the thing they balance himself.
member
Activity: 64
Merit: 17
In as much that there alot of Nigerians giving this country a bad name everywhere they go there are others who are also changing people's view of Nigerians positively even in that same place but though they are few but with time and the growth of the good ones, Nigerians will not be seen as scammers
jr. member
Activity: 44
Merit: 1
I nor dey try invalidate the message wey you dey pass o, but you see that India eh, na dem do fraud pass. Na just say na Naija own dem dey blow out of proportion. Back to your message - Some Nigerians don believe say without fraud them nor fit make am. The problem now come be say it is more than just getting a job in Affiliate marketing, copywriting, web developer, security analyst, these boys and girls nor dey patient again. They want the blink blink now. They want the pomp and pageantry now.. Dem want make dem sing dorime for them. And they want to hit it big. 100k, 200k  and even 500k nor fit do anything for them. To commot for fraud na mind thing first before getting a job.
No be lie bro many of them really wan get name for club and shows make them just they hype hype them and as you see those hype men ba they really know watin them dy do if they see say you get na you they go hype pass and other guys go they jealous to just work hard to get same money make they hype them too so I really go with you when you say to leave am na mind e no easy at all because were person they collect in block intact to get a job no go worry you because you will see the pay small government fit the pay 80k plus and you get client way they give $500 weekly na just mind bro i really get that point
jr. member
Activity: 86
Merit: 2
Ranging from our politicians down to our primary school children  , there are few people who place value or importance on the Nigerian image,  we post nonsense to display our short comings on the internet and the global community has viewed us to be overly corrupt,  there are still honest people living in Nigeria  ,
We should stop ruining the image of this blessed country Nigeria  , it starts with us, it's not every of our short comings we should post online, 
No country is a saint filled country, they know how to protect the image of their country in the eyes of the international community  ,

We should protect ours because no-one will do it for us.  Thanks
member
Activity: 308
Merit: 26
One thing wey I don know Nigeria for be say,anything wey dem don decide to do,dem dey doam too much,and that too much nai dey make people of the world feel and talk say dem bad.When Niger people start to dey do scam,dem doam to the extend wey be say the thing don dey too common for street,and e don dey become our way of living.
I no fit talk say we dey give ourselves bad news because say everybody know say e no easy to survive,and if e be say na dat one go work for them,dem dey doam fully.
I swear bro and e no make sense, for the bad aspect of am, we done give ourselves bad name among other countries and our leaders no even care o, their own to to borrow money, you go turn on ur television you go here all manner of bad stuffs Nigerias dey do for another country.
Na why some countries they tighten there travel requirements when it comes to Nigerians,

If care is not take someday traveling our of this country to another go be very big problem oo.. becos them no go allow us,
We need to repair our reputation o, and make Nigeria great again.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
Abeg make we leave this mata for who the matter concern  because this country no follow and just incase you no know, make I also remind you say yahoo money dey sweet die and na less hassle but nothing dey easy if we go fit admit the truth. This yahoo matter don even tire me and despite say I no support am, atleast I know say this yahoo on the other hand don deliver people but that one no be excuse Sha.
We suppose know say the country don already hard and even graduate no fit see work because companies dey look for people with minimum of two to three years working experience and yahoo na the only work wey person fit easily think of because if you go agree with me say no legit work dey easy not even the little ones we dey get for the forum because before you go grow account reach this height you go understand say e no easy at all.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
Due to the high rate of poverty in Nigeria😩😩😩😩, it's citizens tends to immigrate to other neighboring countries around them. ☑️Some Nigerians takes their bad behaviors along side them😞😞, thereby creating a bad image for their own country.😞😞 I recently watched a video of Nigerian cult clash which happened some years ago in dubia. In the video you can see how these Nigerian youths who were armed, harassing and chasing people from the street. With these behaviors, the government of other countries can decide to ban Nigerians from immigrating into their countries so as to prevent loss of life.
With the forthcoming election, we all pray that Nigeria gets a good President who can restore Nigerians economy back to it's fullest.🙏🙏🙌🙌🙌☑️
I no even know say you be naija, nai you dey worry technical board with plagiarism and smileys, them don report your account I no know wether moderators go pity you. If you get second chance abeg nor make this kind error again. Try reduce the smiley for text bitcointalk different from fb, ig and other Plato forms you dey used to, with time you go understand. If you never know wetin to write, you fit dey write for our local board here things go dey easy for you.
full member
Activity: 840
Merit: 137
One thing wey I don know Nigeria for be say,anything wey dem don decide to do,dem dey doam too much,and that too much nai dey make people of the world feel and talk say dem bad.When Niger people start to dey do scam,dem doam to the extend wey be say the thing don dey too common for street,and e don dey become our way of living.
I no fit talk say we dey give ourselves bad news because say everybody know say e no easy to survive,and if e be say na dat one go work for them,dem dey doam fully.
sr. member
Activity: 588
Merit: 440
God go samma you triplets for dis ogbenge yarn wey you dish here. My broda, d thing dey scatter my head too wen I look at peeps wey I drag com here but dem later run comot as dem not fit endure reading, posting and waiting to rank up. Some of dem na me even pay dat evil IP fees for dem sef, just wasted my cash for nothing. E dey pain enta bone. Even yesterday sef, I dey with person wey I supposed bring here but I nor need dat stress for now. Him go still run comot.
Many people dey look for the easy way but dem fail to understand say something wey dey worthwhile takes time. Patience is a virtue, as you dey contribute to the forum naso you go dey rank up and naso your reward go long. But keep the rewards aside, being here and interacting with people from different backgrounds, works of life, ethnicity, religion and races you get to learn new things, see things from different perspective and you fit get one information wey go just change your life forever. But some people no dey see am so.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
there are some boys you would called to join you here and learn free skills and build their accounts on this forum they won't Instead they can't endure after joining this platform for 1 to 3 months without any good cash flow to their hands they will leave here and look for another alt means of making money instead for them to focused here they decides to join internet frauds. I basically have introduced about 15 boys to this forum here but few of them said they don't have all time to seat and be reading things around this forum.
God go samma you triplets for dis ogbenge yarn wey you dish here. My broda, d thing dey scatter my head too wen I look at peeps wey I drag com here but dem later run comot as dem not fit endure reading, posting and waiting to rank up. Some of dem na me even pay dat evil IP fees for dem sef, just wasted my cash for nothing. E dey pain enta bone. Even yesterday sef, I dey with person wey I supposed bring here but I nor need dat stress for now. Him go still run comot.

By the way, OP shey you don hear of "Call Centre" for India? Check dat up and you nor go eva pity anything India. Dem be kura too.
hero member
Activity: 854
Merit: 597
I just believe say everything na about choice. Doz guys choose the path to quick moni and now police don nab dem. Wetin dey appalling na the rate at which diz guys dey quick to join this kain tin as if nah the only source of wealth be dat. @Adbitco, I reason wetin you talk so. Sometimes, our youths dey too lazy to involve in somtin profitable and as such, e dey worry even the good ones wey wan use dia life do beta tin abroad becos diz oda ones don go spoil am.

 In such a situation, nah who we wan blame? Lack of job opportunities, laziness or the devil's handwork??
hero member
Activity: 532
Merit: 508
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Nigerian youths are complaining about lack of jobs, but even when they travel outside of their country, they don't still find something useful to involve themselves in but rather go on implicating themselves and causing bad name for their nation. It's so bad for a country's citizen to travel to another country and do some shite that ends up giving his or her country a bad name.

@Adbitco, Just keep extending helping hands to those you feel need them; most will realize the value and rippe the benefits, and they will thank you for it. Those who don't value it because they need quick cash, should feel free to do as they please. In this economy of our time, every person has what is favorable to them, but illegalities are what I don't support. 

Let the youth learn from the mistakes of others who have run amok; some are now into trouble they can't excape, and some are now severely derailed.
Pages:
Jump to: