Pages:
Author

Topic: We dey give ourselves bad names everywhere. - page 2. (Read 442 times)

hero member
Activity: 952
Merit: 742
Nigeria matter don tire me on fraud oo nah so you go see news all the time about fraud wey guys they do even outside the country. I just dey read news for nairaland na him I see say they arrest 2 of our guys in India for fraud. Dey dupe doctor in India for N6.6m

https://www.nairaland.com/7521381/two-nigerian-fraudsters-arrested-duping

Abeg make we dey encourage ourselves whenever we dey gathering to stop all this act. We know say work no dey de country at least make we try create one for ourselves. They get all this online work wey they give money without dupe we can learn digital skills like Affiliate marketing, copywriting, web developer, security analyst and even dis forum they give money when you participate in all this signature campaign. You can call your friends that are jobless and give them the legit. All this work they legit people go pay you well when you do work for them.And again if there is any legit, wey we no say money dey come out make we tell our people, to reduce and eradicate this bad names wey we dey give ourselves.

How una think am?
My brother, the Problem be say, no be every body wan suffer create work for im self, especially as dem see say people wey de do dis kind fraud de make am quickly.

Na better advice u bring but persin need to de convince him friends because me and u know say some people regard all these online jobs as scam, and you no fit force person to do wetting him/her no wan do, your own na just to try your best.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
casinosblockchain.io
January 15, 2023, 05:54:12 PM
#9
Na two things dey cause dis kind matta of fraud among we naija people, which is:
 • unemployment and,
• laziness ( seeking for quick success).
 The height of unemployment for we con3 dey too alarming and even di government no dey do anytin hep curb d situation. Instead of Dem to tink of initiative wey go create employment for the timid population Dem go rather the tink of how to di loot from the country porse and now many of the youths don mk up their mind say anyway na way. So why fraud no go envelope us as a pipo everywer.

Another issue wey be laziness ,some pipo no wan pop it energy n time run sometin wey go pay Dem in time to com ,Dem d find d one wey go bring moni now now. Imagine say I tk time introduce to my friends for street about Bitcointalk and how to tk go about it for the growth process, this boys rejected di project, Dem say Dem no need anything wey go stress Dem n no go even bring money sharp sharp. Say Dem no go fit di crack der head di write write tins everytime. But dis na same guys wey day and night na inside bet9ja shop Dem dey playing virtual sport betting. From day day Dem reject d offer I stop to dey datch Dem moni wen Dem beg for my hep.

hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
January 14, 2023, 08:20:24 PM
#8
Look lemme tell you one thing you don't know about our Nigerian boys, let us forget the fact that we here on this forum trying to reason out good things, there are some boys you would called to join you here and learn free skills and build their accounts on this forum they won't Instead they can't endure after joining this platform for 1 to 3 months without any good cash flow to their hands they will leave here and look for another alt means of making money instead for them to focused here they decides to join internet frauds. I basically have introduced about 15 boys to this forum here but few of them said they don't have all time to seat and be reading things around this forum.

Somehow i began to digest what our president says about our youth that " We are lazy" yes this purely truth, because only few youths i noticed that are working hard to make out clean money instead of joining internet frauds. I believe we that are here have a very big seperate mentality. Then moved down to governments, they aren't trying in any case to help the youths at all, if there were to be work would there be any way youths would go involved in any malactivity?
No! because they aren't talking responsibility.

That is why i used to beg our brothers here to please be patient while you are here, little time your shoe go shine and your face go show and as e day you go dey see am live!
hero member
Activity: 798
Merit: 570
January 14, 2023, 05:26:57 PM
#7

Dis Mata dey always give me headache all d time bcus this bad guys Don spoil tins for ground. Now many countries no trust naija pipu again due to this bad fraud activities wen this naija guys carry for hands. Nowadays no white man dey trust us for any deal again except u have powerful connections. e go dey hard now to see beta deal done with white man especially online bcus they believe naija is fully of fraud pipu.

Op I see sai u dey talk about make we dey teach guys way where money go they commot, Dat one no be problem my bro, But make I clear u with one tin,all those guys involve in fraud activities na lazy guys dey be, even u try give them Link for where small small money go dey come and dey go dey use their energy and brain dey no do bcus they no b serious type before. Make u hear, I Don introduce this forum to one of  my lodge guy B4 due to Dat make e dey get  little little change for hand, but last last he no do oo  bcus it is lazy type and it looking for easy money, which we no it no possible expect fraud, now na yahoo yahoo d guy b now oo.
hero member
Activity: 1120
Merit: 887
Livecasino.io
January 14, 2023, 08:00:40 AM
#6
I nor dey try invalidate the message wey you dey pass o, but you see that India eh, na dem do fraud pass. Na just say na Naija own dem dey blow out of proportion. Back to your message - Some Nigerians don believe say without fraud them nor fit make am. The problem now come be say it is more than just getting a job in Affiliate marketing, copywriting, web developer, security analyst, these boys and girls nor dey patient again. They want the blink blink now. They want the pomp and pageantry now.. Dem want make dem sing dorime for them. And they want to hit it big. 100k, 200k  and even 500k nor fit do anything for them. To commot for fraud na mind thing first before getting a job.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
January 14, 2023, 04:30:36 AM
#5
Two people na won give country of over 160 million people bad name? Some kind talk de taya me he don tay the country cast for Oyibo people ear. Nigerian Prince dey Wikipedia as ”a cheat who seeks to obtain money through advance fee scams quotations ▼ I fell for a Nigerian prince scam.” The case na yeye case, the Indian doctor shock me, how person way dey educated go dey find love potion and charm to use for man nor be crime be that or the laws dey different for their own people.
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
Lohamor Family
January 12, 2023, 05:09:36 PM
#4
Na wetin dey happen for the country na e naija boiz cari go India,our leaders don keep the country carelessly wey make majority of Nigerians start to do so many lie lie things. We don cast everywhere because of our corrupt life. We forum members no dey like that because for here na trust sure pass,so we no go fit be scammers. Boiz now no won calm down use their head learn one or two,instead na sharp sharp money dem dey find. We need proper orientation to commot this corrupt mindset
sr. member
Activity: 644
Merit: 350
January 12, 2023, 04:32:49 PM
#3
Sure these fruad activities don too much e they everywhere but naija own worse pass.. Wetin they course these thing be say na naija government be the main course of fraud for the country if na the way people get knowledge to use in fraud the government now use the opportunity to create a way for them make they, they use that knowledge chop food e go better pass, but how person go suffer for almost 18yrs going to school since e deh small Las Las we finish school we no get job..
No be everybody get that mind of staying without job atleast men go Chop na they're using the knowledge wey they get on illegal things which na government be the main source of these
sr. member
Activity: 644
Merit: 335
January 12, 2023, 01:06:33 PM
#2
Nigeria is the most popular country that is well known with fraud and all this scam activity and still the issue is not burder most of leaders and seriously the issue is damaging our country images, although we know say many of youth's be unemployed but we get hand to work like labour work and still get money but now a days many of Nigeria youth's no want to work with their hands again everybody wants to enjoy free money and from those fraud activities that lead some to spiritual activities and end with mental illnesses and some lead to death.
member
Activity: 71
Merit: 21
January 12, 2023, 08:26:31 AM
#1
Nigeria matter don tire me on fraud oo nah so you go see news all the time about fraud wey guys they do even outside the country. I just dey read news for nairaland na him I see say they arrest 2 of our guys in India for fraud. Dey dupe doctor in India for N6.6m

https://www.nairaland.com/7521381/two-nigerian-fraudsters-arrested-duping

Abeg make we dey encourage ourselves whenever we dey gathering to stop all this act. We know say work no dey de country at least make we try create one for ourselves. They get all this online work wey they give money without dupe we can learn digital skills like Affiliate marketing, copywriting, web developer, security analyst and even dis forum they give money when you participate in all this signature campaign. You can call your friends that are jobless and give them the legit. All this work they legit people go pay you well when you do work for them.And again if there is any legit, wey we no say money dey come out make we tell our people, to reduce and eradicate this bad names wey we dey give ourselves.

How una think am?
Pages:
Jump to: