Pages:
Author

Topic: We suppose use pidgin English de post for our local board. (Read 217 times)

full member
Activity: 364
Merit: 220
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Of course nah true, mk e easy for everybody especially as they say no  AI because no be everytime e dey dey person body to speak correct English, mk person no write wetin e no fit explain but as local board dey like this, person fit dey speak pidgin as person, e good to free urself in a way we can because e dey reduce mental stress for us, so for us to express ourselves and all that mk we just dey use pidgin language foe here wey be local board so that person no go get unnecessary headache and e dey also help person to understand more about this forum too and also e dey help to aquire more knowledge from other people and here be like update station.
Because of dis pidgin English, wey de allowed for dis our local board, na im de make me to de look forward to de come here to make posts and free myself, freestyle with di language wey I de very proud of. But dat one no mean say I beta pass our members wey de flow with only correct English for our board, because no be everybody sabi flow in writing pidgin English, or some fit no like di idea of writing in pidgin, di important thing be say we de understand each oda. I de feel at home for dis our board because na we we de for here, one love to dis our naija board.
jr. member
Activity: 0
Merit: 0

I observe say other local boards, na dem local language dem de use, even di ones wey get dem own alphabets na im dem de take post too. So I see am say e get as e be, when we use normal or standard English, post for di main boards, we go come use di same English, post for our local board.

This thing wey you talk na the real matters, I be person wey no dey too like expose the bad bad thing wey dey we country and if we dey continue to dey write with normal English all this oyibo Dem wey dey here go dey read am dey think say na our country wey bad pass, e go really dey good if na only we we dey understand wetin we dey post for our local board concerning our country because even us too no dey understand wetin other country people dey talk about and I dey see am say Dem no really they gbedu us because Dem dey think say all of us na scammers so e no good for Dem to dey read and understand our posts make e no make matters worst.
E dey pain me as I dey see post wey dey condemn us and the writing go come be for normal English, I understand say no be everybody for we country Sabi use pidgin but at least as Dem dey post make e no dey paint us black/bad to other country eye. Las Las I dey in support of pidgin English for our local board make e dey in favor of everybody.
full member
Activity: 1134
Merit: 154
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Of course nah true, mk e easy for everybody especially as they say no  AI because no be everytime e dey dey person body to speak correct English, mk person no write wetin e no fit explain but as local board dey like this, person fit dey speak pidgin as person, e good to free urself in a way we can because e dey reduce mental stress for us, so for us to express ourselves and all that mk we just dey use pidgin language foe here wey be local board so that person no go get unnecessary headache and e dey also help person to understand more about this forum too and also e dey help to aquire more knowledge from other people and here be like update station.
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
Normally them call am say nah local board, so I no see any sense way we go use English for here, because even other local boards self we no go fit read watin Dem they right without transactors and e no make sense at all say nah only us they share our own thing with English although pidgin self no be our own language but that one better pass as all of us way be 9ja they understand am, oyiles fit come our local board come make comments and I no sure say we fit make comments for their own local board, them understand watin we they talk all because we they use English. As e dey hard for other local boards to write with English I know no why e come dey too easy for we 9ja (aje-pako) to write broken bottles (pidgin), if we check my local board posts I dey always use pidgin write because e too easy to flow, even if English dey e no go pass one, imagine say as you dey write with pidgin you dey get more lines.
full member
Activity: 364
Merit: 220
Eloncoin.org - Mars, here we come!


Thank you Kelward for the suggestion and we value your input. But I go like me leave pidgin and English as di two accepted languages for our local board. E get Nigerian people wey no dey too flow very well in pidgin and some people sef e dey hard dem to comprehend text written in pidgin, so if we dey use only pidgin here e go dey hard dose set of persons to identify themselves with our local board because dem go feel secluded. Weda na pidgin or English any person feel comfortable to express himself or herself, make de person go on with it. If there's need to revisit dis mata in di future and vote on it just as oga Brainboss talk, we go run am but for now make we dey enjoy both of dem. This is my own thought sha.

I agree with wetin you talk, because you really capture di essence of di thread, because evendo say e de better to de post for pidgin English, no be all of us fit to flow for inside. Aldo I feel say part of di reasons wey bitcointalk forum, take create local boards, na to make di forum to de more dynamic, and to accommodate oda languages wey de different from English. Diafo dem go de expect to de see oda languages, slangs or alphabets for local boards, to confirm say true true na locals be dis.

Wetin sweet me pass for dis discussion be say at least everybody for dis our local board fit to read and understand posts for pidgin English, even if dem no fit to flow to speak or to write am. And e no affect our knowledge of bitcoin and cryptocurrencies at large.

Last last, i agree say if there is need to make changes over a period of time or vote on any matter wey go make our board to de  better, me I support am. Because only change na im de constant for life.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Na my little contribution be that for this matter.

U self ehh see the date wey you dey bring back wetin dun dey die, better repair your phone and data oh (joking) make you no go dey open matta wey dun die. The truth be say me I still stand for the pidgin language matta but dat one no mean say I no accept the pidgin and English language wey we pass into law. Law dey change and in future if we change am, we go accept am too. We fit still change am to only english too I no go opposed, the issue na say nothing is constant when it comes to rules and regulations. For the forum self before when you do plagiarism na straight ban but now (if dem ban you you fit come back take small punishment depending on your reputation) or moderator delete your thread free you when reported (as we have seen in some cases). Things dey change and that's why humans are the most evolving creatures.

I never wanted to be a moderator, the good wey I dun do this board and forum alone nobody dun pay me back (although I no say make person pay me). Wait una think say I wan carry more load for head lol. Only me know wetin been identify as a Nigerian dun cost me for here and the benefits no be wetin I fit see my yansh with because wetin I dun get i do still get am been identified as a Nigerian or not. Make e no dey belike person dey get any specific treatment. When time come for we to get subboard we fit throw in small request for a moderator (although I never see any reason for one) and we no go even nominate anybody because theymos no dey like nomination self him dey like do wetin him want and so far e dey work for am so we go leave am like dat until dat time come. No too reason small disagreement, it's needed in every organization.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
This type of mindset no go lead us anywhere. It is not good to say you deh happy as theymos never agree to give us a moderator.
The way you see some sentences may not be what it means. Read the post again.
 
Or maybe you will understand it better below in another direction entirely.

We supposed to have all this for our board like other local board get them.
Not all local boards have moderator(s).

Croatian, Greeks, Hebrew, Indian, Japanese, Dutch, Korean and Skandinavisk local boards do not have moderators. If you do not have a member that has been a moderator from the main board, it will not be easy to have new moderator on a local board.

I was not surprised as we did not have a moderator.
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
I like that theymos did not choose a moderator for this board. If someone will be a moderator, I have finally which wish Igebotz to be our moderator or anyone that is not biased but see Nigerians posting in both English and Pidgin that we all understand here on this forum. Or we should not have a moderator.

We all understand both languages.

This type of mindset no go lead us anywhere. It is not good to say you deh happy as theymos never agree to give us a moderator. Everything we do here supposed by for the good of us all. And also we need more merit sources to join boss CryptopreneurBrainboss so that merit go deh go round. We supposed to have all this for our board like other local board get them. This thing no supposed bring quarrel among reputable names for this place. Make I add also say na person weh no go deh partial we want no be just any name. I deh see many senior men here weh no deh like help newbies and low ranked members. I no go like make somebody like that enter as moderator or as merit source. That one go kill our board.

Charles–Tim and CryptopreneurBrainboss, una be hefty men for here. Abeg make una no quarrel over this type of thing so that the grass no go suffer. At the right time everything go fall in place and we go get wetin we wish from theymos.

Na my little contribution be that for this matter.
sr. member
Activity: 406
Merit: 360
The fact be say na Naija we dey and I don see so many people wey no go eva speak pidgin for their life. This no be say them no go fit speak but them no like am and na only English them dey speak. If you like speak pidgin na English them go use reply you and vice versa. Na e make both language good because na these two language na e be the commonly use for Naija. Myself, I like both of them because there is a time that you will need to speak one of them to use relate well with people to understand you based on the environment.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
No, make una ask di Op, which language do im think sae we dey use here. Is it Fulani, Igbo Yoruba or Ijaw language? Op supposed know sae na di normal naija language we dey knack for here since. Abi op Kno no sae naija Pidgin English na do combination of local languages with standard British English? Abi op just dey come 9ja? Op supposed know sae no bi everybody go fit use di Pidgin English to write fluently like other people dem so pure English too is allow to be used here. Because even before di creation of the board dis mata we don deliberate am for di defunct social media platform (wtp) and we come to do agreement sae both p/s English is allowed to use be used so to some extent I no blame di Op because im na newbie for here and e no bad for him to ask. But make im know sae e no bad to use di two languages.
hero member
Activity: 1050
Merit: 501
If to sae you don stay for the forum for so long, you for understand sae this issue of using English or pidgin has been talked about and agreed on sae, peso fit use English or pidgin for our local board as far as the message wey em d pass d pass for the forum d understandable for peso wey d read am.

As Charles-Tim don talk, na English and pidgin na em be the language wey unify us all as Nigerians. Whether you decide make your post for English or pidgin all join as far as you go make your post to be understandable and follow for wetin the post the talk about, we are good to go with it(English or pidgin)
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
I de reason say di word "local board" suppose mean say bitcointalk forum, de expect say we suppose de post for our local language. But as e be say na different ethnic groups, wey de speak different languages na im make up di country, and di whole Nigeria, no adopt one single indigenous language, so na dis pidgin English, na im be di language wey unify us, both di rich and poor, literate and illiterate sabi am. Na im make I de reason say posting on our local board go de more original if we de use dis our pidgin English de do am.

All respect to di members wey de use normal English de post for here, na to pass di message of your post na im de important pass, but unless say di person no too sabi make conversation with pidgin English, e for de better to de change style and de use dis our special English de post.

I observe say other local boards, na dem local language dem de use, even di ones wey get dem own alphabets na im dem de take post too. So I see am say e get as e be, when we use normal or standard English, post for di main boards, we go come use di same English, post for our local board.

All di same nothing spoil, na just my own small opinion na im I say make I sama for here..
Thank you Kelward for the suggestion and we value your input. But I go like me leave pidgin and English as di two accepted languages for our local board. E get Nigerian people wey no dey too flow very well in pidgin and some people sef e dey hard dem to comprehend text written in pidgin, so if we dey use only pidgin here e go dey hard dose set of persons to identify themselves with our local board because dem go feel secluded. Weda na pidgin or English any person feel comfortable to express himself or herself, make de person go on with it. If there's need to revisit dis mata in di future and vote on it just as oga Brainboss talk, we go run am but for now make we dey enjoy both of dem. This is my own thought sha.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
I like that theymos did not choose a moderator for this board. If someone will be a moderator, I have finally which wish Igebotz to be our moderator or anyone that is not biased but see Nigerians posting in both English and Pidgin that we all understand here on this forum. Or we should not have a moderator.

We all understand both languages.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I have a friend on this forum, he also was posting in English, Brainboss sent him merits several times (to quality posts). Brainboss have more influence. This guy is one of the people that was even encouraging me at the time saying English is also the official language in Nigeria. He suddenly changed one day that Brainboss messaged him to be posting in Pidgin. I do not care if anyone believe this or not.

I still want the board to be in pidgin and I'm not hiding that fact (but the community has the final say that's why pidgin and English got my vote), they were many people that wanted pidgin as well but the main reason we considered English was because many people wrote me about you not been able to speak pidgin very well and it's mostly because of you that many people finally accept English if not we were all okay with Pidgin. They gave me reasons and I so sense because then you were one of the most active user and only pidgin means you'll lose interest in the board. If you're not been a dictator now (like you accused me of been when I insisted of pidgin been the official language to make us unique then), you'll let people air their opinion when the time comes.

Me meriting dat ur friend just shows that even though I wasn't in support of English I still merited his quality contributions when I saw them. As I have said there's nothing constant on the board, when the need for a change comes in the future we'll not suppress that voice and we'll let it to a vote any opinions that wins that time between the three options will get implemented. You're quick to call someone a dictator when the decision doesn't favor you but feeling like you're not one when you don't want people to air their opinion.

We shouldn't shut anybody from airing their opinion, just dat nothing is changing now but in the future things might depending on the community feedback (but we wait until then).

I like that theymos did not choose a moderator for this board. If someone will be a moderator, I have finally which Igebotz to be our moderator or anyone that is not biased but see Nigerians posting in both English and Pidgin that we all understand here on this forum. Or we should not have a moderator.

We all understand both languages.

I never wanted that and glad we agree on something, and neither will it be you and if we need a merit source appointed to the board it has to be him and now I guess he can go ahead with the application he was preparing for months but stopped when urs came out.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
I have a friend on this forum, he also was posting in English, Brainboss sent him merits several times (to quality posts). Brainboss have more influence. This guy was one of the people that was even encouraging me at the time saying English is also the official language in Nigeria. He suddenly changed one day that Brainboss messaged him to be posting in Pidgin. I do not care if anyone believe this or not.

@CryptopreneurBrainboss
Before the vote, you wanted to make Pidgin mandatory. Why? Because people post more in English. Why? Because you thought theymos will not give us local board. While I said that what we needed are activities and more people. I supported both English and Pidgin.

Before the vote, you even deleted my English post on Nigeria local thread which totally pointed to what is happening in Nigeria.
You have been the dictator on this issue of English not to be included or not.

I will appreciate you to discourage what you supposed to discourage. This board is going on good. Why Pidgin or English/Pidgin discussion necessary. You merited the rules of the local board which means you are satisfied, then point to it in time like this.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
The people that are coming should respect what other people have rules for before, not to come with their own ideas that we have discussed before. You even send our board rules 2 merits.

You apply to be a merit source, first thing you have to understand is that you don't send merit just because you agree with a post, I might have agreed to the post or not but the meriting is done to highlight a quality posts. How many where we when we got the local board, just few people shouldn't expect to make a law that govern everybody and expect them to accept it. Even the constitution get adjusted when deem fits. You can't silence the new members because you feel they should respect decision that was made when they didn't have a voice and just few people came together  to make it at the time when there wasn't a big representation of the people.

In the future if a change in rules is deem fit a vote will be recall because at a point people will want to write in their local language that isn't english or pidgin and you can't deny then that privilege because it's a local board. In the future we might have other subboard that isn't in English (strictly for other dialects). You can't stamp on we not needing other vote and neither can the people present today say that because tomorrow things might change. I voted English and Pidgin as well because that's what the board needed back then but it mightn't be want we need in future (but we can't say that until it's the future). The rules isn't changing now but nobody can say it won't in the future, change is constant and as humans we have to be reasonable to accept change.

This is off-topic to merit source application.
This is not silencing anyone.

One of the things you don't do as to opposing been a dictator is to force people to accept what you feel is best for them. And secondly, meriting a posts doesn't mean you agree to what the post is saying as an aspiring merit source for the local board, you should take note of that and not use it in an argument to validate your point.

PS: The forum is centralized and not decentralized like Bitcoin that you think should maintain its 21 million supply.

Dictatorship?

Remember you have once deleted my post in English on local thread before we cast the vote. You are more inclined to Pidgin which what many people went against.

You sounding like one while calling me one, then we had an agreement that post should be only pidgin but you opposed it and now you don't want others to opposed your opinion?
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
A vote was passed before and we accepted English and Pidgin even though me personally no value English for the board but the community has the final say, maybe in the far far future we can also have another vote but obviously it won't be now.
I remembered that I chose both Pidgin and English. But I would have preferred it more in only English. I knew most people will choose both at the time and I also went for what people would have chosen.

I do not think we need any other vote, the local board has been created already and we accepted both English and Pidgin. I see those that will come up with only Pdgin suggestion to be biased or to be newbies because we all know how things are in Nigeria. I can give more evidences that Nigeria supoort more English officially. It is English that unified us. If not English, we would not be here.

The people that are coming should respect what other people have rules for before, not to come with their own ideas that we have discussed before. You even send our board rules 2 merits.

1. Only Naija Pidgin and English is allowed

For newbies that have such questions, it is not bad to point to that number 1 rule instead of thinking of looking again in the future into what we have discussed before.

This should just be like the 21 million bitcoin supply while there have been some improvement proposals for bitcoin. The languages should not be changed.

We are all good as we have understood our differences before.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
All di same nothing spoil, na just my own small opinion na im I say make I sama for here..

Well said but as you talk na your opinion be that (e dey valid as others support your opinion) but since pidgin no be the official language language, e no go make sense to imposed am on others but you as a person fit dey write am steadily and people wey buy into your idea dem follow you up. Both English and Pidgin dey welcomed here. Na only our local dialects wey we no too welcome for here because if we say make each language get their own local thread for here we go begin dey create division among ourselves and e no go bring united wey we need to carry this board ahead ahead. You know say ethnic division is a problem already in our nation so to avoid am moving into the forum make we just stay with pidgin and English.

Normally but them we gats understand say some people dey here wey nor fit write in pidgin except their mama language. All still join. And for Charles, it doesn't matter whether our ATMs are in English or news is being broadcasted in English. May I remind you that you can actually choose your preferred language ? Even when you call the network providers. May I also remind you that there are news channels - TV and Radio that broadcast and have their programs strictly in Pidgin, zero English. But then to each man him own...nor be rule say we must write in pidgin but na just based on your preferred choice.

A vote was passed before and we accepted English and Pidgin even though me personally no value English for the board but the community has the final say, maybe in the far far future we can also have another vote but obviously it won't be now. For the time being you fit write am in anyway wey make sense to you like only pidgin, only english or you mix them together (dat's you write in English and Pidgin together) make we no bring other local dialect yet even though they're already becoming a normality in our everyday life as you talk am in regards to we having the choice to choose which language we want
to listen to via call centers, radio and television stations and ATM operations etc. If we star language war now e no go make sense instead e go scatter wetin we dun build.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Normally but them we gats understand say some people dey here wey nor fit write in pidgin except their mama language. All still join. And for Charles, it doesn't matter whether our ATMs are in English or news is being broadcasted in English. May I remind you that you can actually choose your preferred language ? Even when you call the network providers. May I also remind you that there are news channels - TV and Radio that broadcast and have their programs strictly in Pidgin, zero English. But then to each man him own...nor be rule say we must write in pidgin but na just based on your preferred choice.

Ur clarification make sense. Well apart from say English too enta us unto say the lingua franca tin wey take so much of our mother tongue away, some sabi write pidgin but dem no just want to write wit am. Me even lik 2 even flow with pidgin, e dey sweet and away 2 code ourselves here. If we dey yarn english all d tim, anybody 4m oda board go dey follow us bumper 2 bumper & no all d tin wey dey sup here, e no too make sense. Although d issue start 4m top as we no get one unifying native language as we see for oda board. Except say pesin sabi french, german, u no fit jus enta dose board 2 no wetin dey sup dere except u wan translate.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
Normally but them we gats understand say some people dey here wey nor fit write in pidgin except their mama language. All still join. And for Charles, it doesn't matter whether our ATMs are in English or news is being broadcasted in English. May I remind you that you can actually choose your preferred language ? Even when you call the network providers. May I also remind you that there are news channels - TV and Radio that broadcast and have their programs strictly in Pidgin, zero English. But then to each man him own...nor be rule say we must write in pidgin but na just based on your preferred choice.
Pages:
Jump to: