Pages:
Author

Topic: Wetin dey sweet your belle for this crypto journey since you start (Read 150 times)

hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
My people, since everybody dons dey join crypto for our country, e sure for me say many of them no understand how e be, na just profit and money dey enter their eye. Una wey una don tey for this investment, abeg make una yarn us things wey dey sweet una belle for this journey. Make una tell us wetin una don experience wey also spoil una belle make we learn from una wealth of experience. Newbie for crypto make una come hear from senior men
Cryptocurrency is a journey and at that, if anyone tells you that you are in for a get-rich-quick scheme then you may be talking about altcoin which is a pour gamble.

But if you talking about Bitcoin, one of the things we're. Deysweet me with bitcoin be say, bitcoin gives us the opportunity to. Grow and learn at the same time, such that, knowledge about Bitcoin and the entire cryptocurrency industry as a while is very important because no one can survive without adequate knkwladdsge.
hero member
Activity: 812
Merit: 675
My people, since everybody don dey join crypto for our country, e sure for me say many of them no understand how e be, na just profit and money dey enter their eye. Una wey una don tey for this investment, abeg make una yarn us things wey dey sweet una belle for this journey. Make una tell us wetin una don experience wey also spoil una belle make we learn from una wealth of experience. Newbie for crypto make una come hear from senior men

Since I join this forum ba, I don learn many things but still, I dey feel say I never learn to the point wey I go fit burst out say I don sabi finish and fit face anything about crypto. My exposure here don teach me many things for my everyday lives wey I don inculcate with the teaching from here. I know say at least now, I don sabi some kind things online wey be say I no fit call for scammers and again and I can easily tell when someone is posing red flags too.

Investment for crypto good, not just anyhow crypto but for bitcoin in particular. As far say you don invest for bitcoin, it is  assured that you go get benefit from am but na for those wey get patient to wait for it at the right time. If you don chop bele full, try buy some bitcoins keep and you go enjoy dis decision later.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
My own bi sae na the unity we we get for here nai dey sweet me pass. We dey gbolo one another nd di thing dey sweet me 4 bele and stomach. And anoda thing be sae everybody dey carry everybody along. But make we no forget sae forum no bi ur classmates, or your padiman, if u do pim ehn forum go do sege 2 ur account so make everyone dey melo down. Naso I sae make I add am for u ooo.
full member
Activity: 364
Merit: 220
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Wetin sweet me pass for this crypto journey so far especially for this bitcointalk be the friendliness, because people wey you never meet for your life, dey interact with you. If you bring topic for forum, even if you be newbie, senior members go post for the topic, without discrimination.

Members wey don get experience for bitcoin, no dey hesitate to answer questions wey oda members no understand. For me na show of true love, no competition at all.

Last last, I been they reason how I wan learn bitcoin, because of the complex terms wey full am, but people for this forum really make am easy for me to learn, because dem dey ready to guide me through.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
I’m grateful for this forum because this place exposed me to many concepts which ordinarily wouldn’t have come easy to me. Knowledge is power, and with the knowledge I have, nobody can deceive me to invest in Ponzi schemes or scam crypto projects. I know how to research new projects and manage risks. The most beautiful part of being a part of a bitcoin community is that you get current information on bitcoin trends and everything happening in the bitcoin ecosystem, the disadvantage however is that when you’re in a bitcoin forum such as this, most people are biased and only discuss bitcoin, you can miss out on other profitable projects in the crypto space because you’re fixated on bitcoin.
member
Activity: 130
Merit: 10
My people, since everybody don dey join crypto for our country, e sure for me say many of them no understand how e be, na just profit and money dey enter their eye. Una wey una don tey for this investment, abeg make una yarn us things wey dey sweet una belle for this journey. Make una tell us wetin una don experience wey also spoil una belle make we learn from una wealth of experience. Newbie for crypto make una come hear from senior men

Seeing how the industry dun mature na wetin dey sweet me pass and the rate at which new new technology dey join dey impress me as well. When I join nothing like staking, Metaverse , Defi etc but today e dey possible. And na so e go dey increase as I dey hear say AI category go soon enter the market abi e dun already enter self. All this na better money making opportunity as if person fit catch one or two coins for this category, put am better money na major cashing out dat person go get like this.

I no dey advocate for this strategy oh as e dey very risky although e no go bad to put small money for this altcoins dem instead of going to buy that beer or hard drugs (on colos lol) with the money, abstain from this things and save that money to invest. Who knows you fit get better return to use hold body. The profits wey full this market dey give me joy. I dun survive on cryptocurrency for more than 6 years now and no be lie. The forum dey help too but money wey person dey make from investing na him dey sweet me pass.
My senior brozzay u make waaw for dis one wey I drop. I follow u reason on how d cryptocurrency industry dey grow and d new technology wey dem dey introduce. E dey important make we keep our Irene 👀 and earrings 👂 on d latest trends nd opportunities we we fit use make money. However, e no dey advisable make person invest all em savings for any risky investment, including cryptocurrency. Na why I dey always hammer-on say e dey important to always do ur own research nd dey really convinced bfor u for fit invest ur money. Abeg make we no forget say, investment get risks oo, so make we invest wisely nd no go put all our eggs for one basket.
sr. member
Activity: 630
Merit: 420
My people, since everybody don dey join crypto for our country, e sure for me say many of them no understand how e be, na just profit and money dey enter their eye. Una wey una don tey for this investment, abeg make una yarn us things wey dey sweet una belle for this journey. Make una tell us wetin una don experience wey also spoil una belle make we learn from una wealth of experience. Newbie for crypto make una come hear from senior men
Despite  the journey  of doing crypto for naija no easy at first to extent wey them be they lock people  account wey they deal with crypto and even police  be then arrest  boiz but that one na because  say yahoo boiz they disguise has crypto investors, and waiting they sweet me pass na when bull run start every were they make sence but my brother before he sweet you for body, body go first pain you that how crypto is you lose you gain, normal normal  all of us they the game together. Even if government they show us shege  crypto they put smile small small.
full member
Activity: 364
Merit: 220
Eloncoin.org - Mars, here we come!
My people, since everybody don dey join crypto for our country, e sure for me say many of them no understand how e be, na just profit and money dey enter their eye. Una wey una don tey for this investment, abeg make una yarn us things wey dey sweet una belle for this journey. Make una tell us wetin una don experience wey also spoil una belle make we learn from una wealth of experience. Newbie for crypto make una come hear from senior men

I just dey happy say I dey learn the technical aspects of this Bitcoin thing. The terminologies, the new friendships and network wey e don open for me. If nor be for this my crypto journey I for nor Sabi some fantastic guys wey dey here wey I never see with my two eyes. I dey happy say I dey environmentally aware about wetin dey happen with Bitcoin all over the world. This one na class wey Dem nor force you attend but you dey sure of correct grade A if na exam. You fit talk about Bitcoin even if them wake you from sleep, anytime, any day, anywhere.

Bros, your talk give me joy and hope, because the terminologies no be here. So I de understand say no be because my brain no too sharp or e block make me i never fully understand everything about bitcoin for this short period. So the learning na gradual process, even una wey be our Oga, de still learn one or two things

So the thing wey de sweet my belle so far be say i don understand say the business of bitcoin de profitable, and people for this forum dey friendly and also de ready to share and discuss wetin go benefit us to grow for bitcoin business. Also this forum give room to discuss other interesting topics wey no too relate to crytocurrency.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
My people, since everybody don dey join crypto for our country, e sure for me say many of them no understand how e be, na just profit and money dey enter their eye. Una wey una don tey for this investment, abeg make una yarn us things wey dey sweet una belle for this journey. Make una tell us wetin una don experience wey also spoil una belle make we learn from una wealth of experience. Newbie for crypto make una come hear from senior men

Seeing how the industry dun mature na wetin dey sweet me pass and the rate at which new new technology dey join dey impress me as well. When I join nothing like staking, Metaverse , Defi etc but today e dey possible. And na so e go dey increase as I dey hear say AI category go soon enter the market abi e dun already enter self. All this na better money making opportunity as if person fit catch one or two coins for this category, put am better money na major cashing out dat person go get like this.

I no dey advocate for this strategy oh as e dey very risky although e no go bad to put small money for this altcoins dem instead of going to buy that beer or hard drugs (on colos lol) with the money, abstain from this things and save that money to invest. Who knows you fit get better return to use hold body. The profits wey full this market dey give me joy. I dun survive on cryptocurrency for more than 6 years now and no be lie. The forum dey help too but money wey person dey make from investing na him dey sweet me pass.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
My people, since everybody don dey join crypto for our country,
Where did you carry dis kind tori come here? 4 we country if piple don join crypto sef e never reach everybody. Though Nigeria nai be di highest crypto users in di African continent yet e every reach where everyone e don join oo.

e sure for me say many of them no understand how e be, na just profit and money dey enter their eye. Una wey una don tey for this investment, abeg make una yarn us things wey dey sweet una belle for this journey. Make una tell us wetin una don experience wey also spoil una belle make we learn from una wealth of experience. Newbie for crypto make una come hear from senior men
u no supposed blame oda piple bcos na weti carry u go bitcoin trading and investment. And weti been dey sweet me 4 bele na di low fee rate for transactions but dis days di fee won kill peraon. So no way 2 chop again. Since nai I dey do fasting.lol Grin
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
My crypto journey no be today e start sha... And I don get some ups and downs alone de way. As much as I like Bitcoin, I dey also like to invest in altcoins. One thing wey like about cryptocurrency be say anything fit happen, your small investment fit change your story and make you a millionaire and at the same time one thing wey I no like na de issue of scam projects and one wrong move fit run you down. Na im make e dey good make we dey always do due diligence before we invest in any project. I no go like begin to mention some of the projects wey I don invest wey bring back some good returns and some wey cast due to personal reasons but in all my crypto journey has been beautiful.
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
As for me I go say I still be newbie for the crypto journey because na last year October I come start to learn about crypto for this forum. You know say forum go always tell you the truth about crypto say na btc sure pass. I go say I start my own crypto journey as e dey hot when everything don dey sweet. Wetin dey sweet me be say, the crypto con give me small confidence base on say when I reason about my small btc and the bull run wey go come up for 2025. I don also learn so many things wey I no for ever know for this forum,on top say I don still meet different people from different part of the world wey dey take life simple. New friends and new pattern of income.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
The ups and down wey I don experience for my crypto journey no be here. If I open mouth tell you how my investment money gone wrong for crypto, you go begin to imagine how I take survive am but thank God sae em don become thing of the past now.

My journey for crypto don also taught me never to rush investing into any altcoin based on FOMO except bitcoin. And secondly, peso no fit make am alone for crypto without the directions of others to help am build emself as a better investor for crypto.

One thing am glad about towards my crypto journey be sae, it has brought some fantastic people around me wey don turn to brothers and sisters for my side. Now we do analyze the crypto market together and help each other grow in exposure of crypto knowledge
hero member
Activity: 896
Merit: 645
D crypto journey no b 2day o nd I go say, e no b vry eazi one kwa jst say, d waka way we waka am, e nevr fail us still.
D journey na 1 way mak persn realise say, somtin dey d corner nd na onli 4 u 2 open eye look, open ur head 2 learn somtin new nd do watin dey needed mak u 4 see better.

Watin really swt me na wen I look my wallet nd hw far way I din waka, e dey giv me joy nd I nevr stp stil, I stil dey waka d road nd d mor I waka ram, d more my eye dey open 2 new tins nd ways 2 view tins. Na awakening e he 2 my thinking mind. So, I go as well njoy am as e be. E swt 2 knw somtin abt dis somtin way many pple nevr dey open 2.
hero member
Activity: 574
Merit: 627
If nah our story u really wan hear how we carry get both good and bad energy for the crypto industry, If I start my story this entire page fit just full. Me nah from airdrop I carry come inside crypto, I park rubbish tokens full for my wallet, from their I come start to be my own mentor, I they carry money buy anything way resemble coin way them just list newly for coin gecko and coinmarketcap, some of them really give me heart attack bcuz some of them I go dy fit even sell am again, nah so I play they lose lose money till I come start to they advise my self.

1 thing way I learn from the past way I carry they sustain myself from to dy run inside lose, nah to mind watin I buy from the market, no be anything way we see way we go carry our money buy some coins/tokens no worth to spend our money on. Advice way I go give any body way they come inside the industry newly nah to they careful of watin in wan buy if in must buy make in better fine any of the top 100 coin/token way they listed for the open market use am hold body. Make in remove sharp sharp profit from in mind bcuz nah dat kind thing they make people run enter token way them they carry scam them.
member
Activity: 212
Merit: 12
My people, since everybody don dey join crypto for our country, e sure for me say many of them no understand how e be, na just profit and money dey enter their eye. Una wey una don tey for this investment, abeg make una yarn us things wey dey sweet una belle for this journey. Make una tell us wetin una don experience wey also spoil una belle make we learn from una wealth of experience. Newbie for crypto make una come hear from senior men
My dear,the joy no be here, since I begin here about the crypto currency exchange my mind dey always dey happy and all my believe be say I must make through crypto currency and na e dey always dey sweet my Belle,
And another thing be say e make me get more friends and so many of them I don't know them in person but if I ask questions them dey answer me well,and again the site wey I no no before I don know them small small i dey enter different websites dey find better crypto currency make I invest,i no say me i be new comer but e dey sweet me and I dey get the believe say I go make am one day..so I dey encourage my brother and sister who never dey do am make e start am ooh e good and e dey work..
member
Activity: 130
Merit: 10
My people, since everybody don dey join crypto for our country, e sure for me say many of them no understand how e be, na just profit and money dey enter their eye. Una wey una don tey for this investment, abeg make una yarn us things wey dey sweet una belle for this journey. Make una tell us wetin una don experience wey also spoil una belle make we learn from una wealth of experience. Newbie for crypto make una come hear from senior men
Experiences in crypto can vary, but it's important to educate yourself by making vast research and not just focus on the potential profits.
member
Activity: 714
Merit: 30
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
My people, since everybody don dey join crypto for our country, e sure for me say many of them no understand how e be, na just profit and money dey enter their eye. Una wey una don tey for this investment, abeg make una yarn us things wey dey sweet una belle for this journey. Make una tell us wetin una don experience wey also spoil una belle make we learn from una wealth of experience. Newbie for crypto make una come hear from senior men
The crypto needs dedication oo, and person need to take him eye off quick profit because na wetting de our new investors mind be that, "make dem just buy now as dem talk say bull run na next year, so dat dem go cash out and that's all". Sometimes we need passion for d business because if you de enjoy your crypto life, you no go fit leave am even during bear market, especially as dis forum de give us live updates and a lot of encouragement not to give up.
sr. member
Activity: 1316
Merit: 379
#SWGT PRE-SALE IS LIVE
My dear there's nothing bad about cryptocurrency at large, the only thing I noticed wrong is when you try to apply greed in the industry because let say for instance, you invested in an altcoin and it happens to pump 10x or maybe 50x instead of you to sell and take profit you will be expecting the market to give you 100x of which to me is a greed why because the opportunity was there for you to utilize but you didn't make any efforts rather you seat and watch the opportunity passed you bye.

Again if you want to invest for long time do not consider invest in altcoin because they may not have this long term increase since we often encountered bear market. At this point either it may dump on your head or you are being left with nothing from your investment so I suggest you should look and consider bitcoin as the ultimate over here and can withstand long term investment.

If you can understand all this correctly then cryptocurrency is very sweet especially when you don't involve yourself with a borrowed money or a family money other than your spare money.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io

Jump to: