Pages:
Author

Topic: Wetin you for do as a Nigerian? (Read 326 times)

sr. member
Activity: 266
Merit: 217
September 22, 2023, 05:35:17 PM
#28
Yes, I done hear your story and e clear well well, so if I encounter that kind of situation, I go just jeje reach my house then do like say nothing concern me and if you reason well, e no concern me because I never reach were the incident happen and if investigation take place and police ask me I go talk say I know know way thing happen because I no reach were then been they beat the thief.
Besides, thief matter na one kind thing way police they consider somehow, as law already quote am say make me no take laws into our own hands, but for some areas, government put laws say Jungle Justice and most of us for our local areas that kind of laws they, for those kind of places way get those laws even if people kill thief, no law go hole them because nah jungle justice.
member
Activity: 103
Merit: 36
September 22, 2023, 04:03:37 PM
#27
If e  happen say true true the guy die and camera dey somewhere wey capture everything and all the people wey dey near the area as e happen... and e come be say you comot for the area run go your house, base on Nigeria system, you dey free or you no dey free? If the person no dey free, wetin be the right thing wey the person suppose do? Remember o, them never confirm say the person don die... you just observe as they knack am and as him no dey move or talk again, and you take off immediately. 

Forget sey camera dey the area, you no join hand beat the thief or shout thief thief na, so why u no go dey free? and the camera sef no fit they work no be naija again Grin The matter dey simple so no worry yourself
Even if na for America wey camera dey full everywhere the matter take happen you are free they go just call you for some questioning since u no join hand for the matter except if you know sey you do something.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
September 22, 2023, 11:52:26 AM
#26
 Wetin I need fear for? No be my fault them use jungle justice judge the guy crime but as long as I no near the scene and plus no be only me stand there, even if the camera wan catch, no be only me e go catch na? No mata how crooked naija justice system dey, dem go gats need solid evidence nah.
Nah good mata you bring come here because for naija you fit no know wetin you do, them go just arrest you but this one clearly show say you no near dia.
member
Activity: 155
Merit: 79
September 22, 2023, 09:12:57 AM
#25
This matter wey you bring so just open person eye in case I meet this kind of thing, I go know what to do.
The thing be say, if the person die, the CCTV camera wey capture the thing go also see say you kno carry weapon which is enough to exonerate you. No be everybody wey dey there carry weapon, some are passerby.
sr. member
Activity: 560
Merit: 408
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
September 22, 2023, 01:27:33 AM
#24

for your case sha, the only thing wey I fit advise na for you to put this matter for God hand, e no get any thing wey e nor fit do.
In all dis kind matter make person they run away from all this kind matter becus e dey very dangerous, once something happened na the pipo wey dey surrounding be the victims. So before living the matter for God hand make sure you protect yourself by no going close to dat place, if not dey fit put any allegation on top your head, it dey no put say no u send dem come make dey come kill the guy or if the guy no die and e come see you an as the bitting the plenty the guy fit tell then say you dey among dem.
newbie
Activity: 28
Merit: 6
September 19, 2023, 11:07:07 AM
#23
This kind gist wey you drop so na serious one oh but for me nothing really concern you because you no near the particular place wey the thing dey happen and you no follow beat the person so wetin you no know no fit know you. But why human been go beat he fellow person to death just because of stealing his property in live no matter what death is never an option . Wetin happen to police station or SARS because na them fit handle this matter well in law and order but people these days carry law for their hand.
full member
Activity: 266
Merit: 140
September 11, 2023, 02:22:19 PM
#22
immediately, you come match break, come reverse and begin to discharge for the area, as a Nigeria make wetin you no know no put you for wahala.

E good like that as you know follow them beat the thief, and you lucky as you know get closer to that place, if not you don buy market for your self. why I said so is that if to said dey com raise case you know say police most be involved and everybody knows police wahala na, wether you follow them beat the thief or not their most Involved  you in the cases. So as waka go your house jeje na him better for you.
jr. member
Activity: 78
Merit: 6
September 11, 2023, 06:45:27 AM
#21
according to the story here, if na me I go first Run comote for the area first, because Nigeria matter tire me. because at that moment if police come, no body will know either you follow beat the guy or not. before you go talk say you no follow. you done reach station, if you reach station something must come out  from your pocket. even if I no reach we're the beating take place, I go still run, since na my area the beating take place.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
September 09, 2023, 06:32:41 PM
#20
Normally if police come the area that time as e dey hot them for arrest everybody them see for road weda you join or you nor join. For that cctv part, I nor sure say cctv dey for trenches o cos na for only trenches them dey do jungle justice. This kind matter na to avoid where e take dey hapun cause when e go burst na aproko people go call everybody name way dey involve.

Our Goa Call Girl girls are not only beautiful and perfect but also honest and Goa Escort will give you genuine love and satisfaction. This Call Girl Agency Goa can help you have the most romantic time of your life.

Who be this werey na here you won come advertise your ashawo business.
sr. member
Activity: 630
Merit: 420
September 09, 2023, 06:18:05 PM
#19
If e  happen say true true the guy die and camera dey somewhere wey capture everything and all the people wey dey near the area as e happen... and e come be say you comot for the area run go your house, base on Nigeria system, you dey free or you no dey free?
Dis story serious ooo, but if dis kin matter happen, and dey wan arrest people, u no dey free ooo, you self na eye witness, so police go carry you and u go drop statement about Wetin u see and how e take happen. Me I no dey like anywhere wey be say dem dey pursue thief or violence dey happen, because if police reach there, they no wan hear say u dey d place or not, dey no care if you dey among people wey kill d person or not, dem go arrest you. But dis ur own now if too say police wan truly do there work, even if dey arrest d person, dey suppose free d person since camera dey d place and e show people wey really kill d thief, ur own na just because you dey d area, but u no join hand beat d thief.

If the person no dey free, wetin be the right thing wey the person suppose do? Remember o, them never confirm say the person don die... you just observe as they knack am and as him no dey move or talk again, and you take off immediately. 
Since no be say anything don happen, na to just stay calm and dey look now, since camera dey d area and if dey check am dey go see Wetin everybody do, since u no join hand beat d thief, then I no dey sure say u go get any problem, but u know our country police, dey go wan use d opportunity chop money. just make sure say u dey low key for your house.
sr. member
Activity: 504
Merit: 323
September 08, 2023, 12:13:33 PM
#18
You dey one corner dey observe as them start to beat am, the guy dey beg but them no gree. You come start to dey go closer make you for observe everything better and see weda na person wey you know and if you fit put mouth beg too;

That place wey u no go na wetin favor you be that because why you go put mouth for wetin no concern you and you fit go there make e be another problem for you, because as they knack am that thing if him die the matter con be serious issue you fit enter problem.. however as you talk say weda you fit out mouth help the thief beg if na person wey you know, for me if you see person wey you know thief they con they beat am just pass as if you don’t even know wetin happen. How you wan follow thief beg people and they don confirm a say him thief. You know say e go be something wey you know con think bah if care is not taking they beat you for that place, because there is no way wey you go see say them they beat person wey be thief and they don confirm me I go con put mouth I no dey do am.


If e  happen say true true the guy die and camera dey somewhere wey capture everything and all the people wey dey near the area as e happen... and e come be say you comot for the area run go your house, base on Nigeria system, you dey free or you no dey free?

Why you fear? Even if you no run go your house they do am in your presence as far as you no put hand beat the thief or talk for there you just look them why you go con fear, if they come to you normal thing make you ask them they see you when you beat am? So as you no do anything no need to fear na.
newbie
Activity: 2
Merit: 0
September 08, 2023, 08:16:04 AM
#17
If your trip is scheduled for a long time then you must add these pilgrimages into the list of your visiting destinations. Lucknow Call Girls You can appoint an independent India escorts and explore the beauty of the town while accompanying a gorgeous girl. You don’t need to hesitate while calling us because we understand your needs perfectly.
sr. member
Activity: 350
Merit: 335
August 04, 2023, 09:23:12 AM
#16
If e  happen say true true the guy die and camera dey somewhere wey capture everything and all the people wey dey near the area as e happen... and e come be say you comot for the area run go your house, base on Nigeria system, you dey free or you no dey free? If the person no dey free, wetin be the right thing wey the person suppose do? Remember o, them never confirm say the person don die... you just observe as they knack am and as him no dey move or talk again, and you take off immediately. 
The thing be say, most times wey this jungle justice dey go on, the person wey dey receive am no dey guilty and everyone is innocent until proven guilty in the  court of law so no allow people carryon this kind devilish act for your presence and no wash your hands commot, put your hand you no know if you go fit saves a soul like that. For this particular matta so I go try see if I fit save this person before it's too late. Running is been a coward, you no follow them and you just need an evidence for that and you try to help the individual in need. This kind matter them na God wey go bless you.
This jungle justice of a thing is so common especially in the East and is fast spreading to the Southern and Western parts of Nigeria. It is totally wrong and uncivilised. For Aba, you no need steal or be caught with anything... make person just shout thief o and point your side, boom, fuel and fire don ckme out from no where.  Like you rightly said, majority of victims of jungle justice are innocent people; even setup can make them kill someone.
 
Well you will agree with me that our law enforcement agencies are not also trying... no forget mass arrest do happen where mostly innocent people are made to answer for and sometimes punished for crimes they know nothing about. I think these are some of the practices that discourage people from interfering whenever there is issue of jungle justice.  Instead of helping, people will flee to avoid getting into trouble.

In all of these, the love for humanity is seriously dying... people are becoming so self-cantred, not minding what happens to the next person. That is why people dey happy if light go everywhere and not only their own house.
member
Activity: 334
Merit: 27
August 02, 2023, 04:54:43 PM
#15
Actually, u no dey guilty of any crime committed base on the video coverage and your actions. As this matter still be so, e be like say jungle justice still dey brekete for some part of our naija. This thing na bad thing, person wey even dey throw stick and stone fit be ogbonge thief. Make we enlighten everybody for our area about the bad effect of jungle justice as it eliminate or cut short life over useless and non essential things . Life is more precious, we need to value life than anything else. The sin of jungle justice which is in most case death (murder) , is worse than stealing. Jungle justice is an act that is 1 million times worse than stealing.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
August 01, 2023, 07:58:32 PM
#14

Remember for Nigeria wey we dey people dey kill thief and nothing police dey do about the matter.

Bro, e be like you for try edit that your comment o. The kpai their idea no be my idea, na person I quote but, your editing done turn am like my words. I no buy the idea of to kpai thief just like that shah, make after story no con dey gor irreversible events like death. Try check am later shah.

legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
August 01, 2023, 06:49:58 PM
#13
If e  happen say true true the guy die and camera dey somewhere wey capture everything and all the people wey dey near the area as e happen... and e come be say you comot for the area run go your house, base on Nigeria system, you dey free or you no dey free? If the person no dey free, wetin be the right thing wey the person suppose do? Remember o, them never confirm say the person don die... you just observe as they knack am and as him no dey move or talk again, and you take off immediately. 

First shout say you go pay if you dey in this kind situation, nobody wey go hear that one wey no go calm down first. Make we no dey rheowawauface when we see jungle justice going on.. e fit be say e no concern you since you get any relation with the person wey dem dey beat bit Ike day e fit be someone wey you sabi (friend, brother, relative etc) so always help those experience in this type of treatment because e no good. Me I no happy as this  person dey commot so. Id you feel say dem go out and die your head oya used camera capture things as you dey go help the person in need.

The thing be say, most times wey this jungle justice dey go on, the person wey dey receive am no dey guilty and everyone is innocent until proven guilty in the  court of law so no allow people carryon this kind devilish act for your presence and no wash your hands commot, put your hand you no know if you go fit saves a soul like that. For this particular matta so I go try see if I fit save this person before it's too late. Running is been a coward, you no follow them and you just need an evidence for that and you try to help the individual in need. This kind matter them na God wey go bless you.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
July 31, 2023, 03:27:02 PM
#12
If e  happen say true true the guy die and camera dey somewhere wey capture everything and all the people wey dey near the area as e happen... and e come be say you comot for the area run go your house, base on Nigeria system, you dey free or you no dey free? If the person no dey free, wetin be the right thing wey the person suppose do? Remember o, them never confirm say the person don die... you just observe as they knack am and as him no dey move or talk again, and you take off immediately. 
For me, I go talk say for the fact say you no been dey the crime scene, but at a distance & yet no be you carry plank knack the suspected victim for head wey kpai am, as eh go show for camera we been dey video the whole event, me ah go talk say eh no get any business to do with you as per say you dey free. But however, that no mean say make you no comot for that environment for that moment wey that murder incident happen oh, because if police come to do mass arrest, they no go wan hear weather you been dey among or not until all of una don reach cell, and you know what that means, as to bail yourself go cost nothing less than 50k to 100k, since na murder case. So best thing when such happen na to just leave that environment since still yet no be you kill am.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
July 31, 2023, 12:13:14 PM
#11
Person wey d around the crime scene no mean sae em follow kpai the peso, if to sae the peso die. The peso d as free as the bird, if to sae the camera d around the crime scene and em capture the whole beating wey people give the thief. Since the peso hand no touch the thief, em conscience suppose the free, em no suppose worry for the matter.

I remember when I be young kid, I been witness this kind jungle justice for my area, I see as people take beat thief, wetin no d good commot em body until em die. When when em die, na when them come set am ablaze. I can't forget the incident up till date even though I observed the jungle justice from afar.

Na after when the jungle justice don happen finish, na when police come show. They begin to the do massive arrest for my area. They begin to the arrest every young guy or papa wey d my area weda the follow for the killing of the thief or not.

Wetin I wan talk be sae, anywhere wey peso see jungle justice happen, wey em avoid that area for the time being. You know why? When police show for the matter, I no follow no be wetin them go hear until you follow them reach station to bail and explain yourself out.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
July 31, 2023, 11:15:10 AM
#10
Op I no think say anything concern the person wey no reach crime scene na. Other people dey dere wey beat and kpai the thief. At least camera go show the footage.



Remember for Nigeria wey we dey people dey kill thief and nothing police dey do about the matter.

Bro we no say thief dey do people shege but that one no be the thing to take kpai person except say na on defense for your life but if na say mob catch the person wey thief, na to hand am over to person. However, we also know say if police see money, them eyes go dey shine so the thief fit bribe him way out but or a normal, if them catch one thief e suppose lead to catching of more of them from investigation and torture wey them go give the one in their custody, at least na one benefit of taking them to station even though say the legal system, police dey corrupt too much.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
July 31, 2023, 05:32:22 AM
#9
Bros as long as na thief no cause for alarm,since if police come around,he dey clear say people go say na thief. Remember for Nigeria wey we dey people dey kill thief and nothing police dey do about the matter.
Before you consider an as a thief, first consider say na human being. This person na person papa, Pikin, brother or sister. Yes, we know say this thieves them dey heartless and the nature of work way them dey do no be watin them dey pity person way go con make them require pity when them grab them like this but, killing person as e describe so, na jungle justice them dey call am and in the site of the law, that doesn’t make it right or the people way kill am to be less than a criminal. Na still murder be that o, make e clear.

You saying our arm forces and agencies no go do anything about am, that na lie o. No be for person way them catch and no be thief way get person. Na court dey talk am finish and you taking judgement and dishing out death penalty, that makes you the law which no suppose be so. Nigeria dey act like say we dey lawless but law dey.
Pages:
Jump to: