Pages:
Author

Topic: Wetin you for do as a Nigerian? - page 2. (Read 326 times)

sr. member
Activity: 462
Merit: 414
July 30, 2023, 11:55:02 PM
#8
Bros as long as na thief no cause for alarm,since if police come around,he dey clear say people go say na thief. Remember for Nigeria wey we dey people dey kill thief and nothing police dey do about the matter. If your conscience dey judge you,then know say you no get any power to change wetin don happen. For the state wey I grow up,if bad boys won kill you,them go start to dey beat you dey shout thief for your head because them no say na only wetin go make them get free access to kill you and nobody go talk,instead them go join hand beat you. Na only police go fit come to your rescue then,so to cut all the long story short. You are not part of the killers.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
July 29, 2023, 06:52:51 PM
#7
You don talk am finish say, you no confirm am if the person don die or not, you only think say e dey possible via say, you observe say them don knack the thief strong thing way fit make am kick bucket.
It's not in your place to take any action. You no fit take action based on suspicion as you never confirm say the thief don die, the thief no be your person, e no die for your hand, 3 no thief for your shop and the closest thing way bring you for the matter be say, you observe a part of watin happen.

So watin you go do be say, you go wait make you get confirmation if the guy kick bucket and na base on the hit way you think say that guy hit am.  If e tur case way them require weakness and you dey called upon, you go talk the past way you see. If them no con give you, Jejely remain your house, no be your matter!
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
July 29, 2023, 09:00:00 AM
#6
my broda with all the information wey you give if at all say the person come kpeme from the knack wey dem knack am, civilised police go interrogate people wey dey the street especially those wey dey around the scene and dem go arrest the people wey take laws into their own hands but just as I been talk "civilised police", my broda kpokpo for we country go first do mass arrest for the whole street before dem even watch the video to catch the people wey beat the thief and if you nor dey careful dem fit catch you join.
if the matter na death case you nor dey free oo because dem no go stop until dem get all the people wey face show for the camera but las las na money go solve the problem except for the people wey use hand touch the thief.
for your case sha, the only thing wey I fit advise na for you to put this matter for God hand, e no get any thing wey e nor fit do.
newbie
Activity: 2
Merit: 0
July 29, 2023, 08:54:27 AM
#5
This is a fact that you can easily find in any search engine. In our Mumbai Escorts, girls get recruited based on their ability and field of interest. You can trust that the girl you choose will be your friend and make your dreams come true.
newbie
Activity: 1
Merit: 0
July 29, 2023, 07:57:55 AM
#4
Our Goa Call Girl girls are not only beautiful and perfect but also honest and Goa Escort will give you genuine love and satisfaction. This Call Girl Agency Goa can help you have the most romantic time of your life.
full member
Activity: 322
Merit: 146
July 28, 2023, 04:37:13 AM
#3
Along d line, I no reach dia finally so na to make my Waka like I jst dey pass by & if by means u gt to b queried, d way u talk na so camera dey catch am too. If e too much e take ur questioners to d pipo way beat of kill am dia shop or houses cuz as u dey house relax b4 dem com query u, na so others too go dey dia shops & houses since u say jungle justice don b com normal tin 4 dem dia so dem go vomit tins by dem self say u no folo

Otherwise... U dey free
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
July 27, 2023, 09:51:13 PM
#2
According to your story, you no really reach the crime scene  fully so no need to fear.
Along as you no follow beat the thief,
You no follow shout make them beat the thief and you no really reach the crime scene, then nothinh to fear about because this na Nigeria and the truth be say l, except say that thief get person wey fit fight for am which I no sure, then the matter as long as na theft related and if the owner of the shop get better compass, then nothing dey to fear as our police force na one of the most easiest to influence as long as you fit pay.

If this matter wey you bring so, dey directly related to you, then I wan assure you say you no need to fear at all because nothing dey happen and normally you no follow especially  since camera  dey wey capture people we gather beat the guy.
sr. member
Activity: 350
Merit: 335
July 27, 2023, 09:09:23 PM
#1
My fellow country people, make una follow me reason this tory wey I carry come maybe one or two person fit learn how to be safe as a Nigerian.

One day you come outside make you for feed your eyes small for wetin street dey talk, you come see say two people dey pursue one guy man say him na thief. True true the guy na thief and na expensive item him steal for one store. As him dey run, luck no too follow am, so them come catch am and na so him start to beg. You dey one corner dey observe as them start to beat am, the guy dey beg but them no gree. You come start to dey go closer make you for observe everything better and see weda na person wey you know and if you fit put mouth beg too; other people too don dey face that side as e dey be na when people hear noise. But as you don dey near there, one of the people wey catch am wey happen to be the owner of the shop come carry something hit the thief, na so the thief voice loss... him no dey move or talk again! By this time, you don dey very close to them when you observe say them don knack the thief something wey strong wey fit mean say the guy don kpeme, but you never confirm sha o. Immediately, you come match break, come reverse and begin to discharge for the area, as a Nigeria make wetin you no know no put you for wahala.

If e  happen say true true the guy die and camera dey somewhere wey capture everything and all the people wey dey near the area as e happen... and e come be say you comot for the area run go your house, base on Nigeria system, you dey free or you no dey free? If the person no dey free, wetin be the right thing wey the person suppose do? Remember o, them never confirm say the person don die... you just observe as they knack am and as him no dey move or talk again, and you take off immediately. 
Pages:
Jump to: