The question is " must everyone venture into cryptocurrency"?
No, this is purely no because not everyone could have that interest or patient to venture into digital world, our old parents can't venture into trading or investment because they may not have the time and energy to seat and watch the market.
Na true you talk sey nor be everybodi go like involve for dis owa type of hustle. Na the same way nor be everibodi go lawyer, doctor or even politicians. We gat to find wetin suit us to do. The koko na to do legit biz and gather kishi. Again, I nor believe sey age get anything to do with learnin cryptos. Na just laziness dey make some of owa old people not to venture into it. The time to read and learn, dem feel sey dem nor get am again. You know how many above 60 years olds wey dey here. For we naija sef, 60yrs don begin enter old people.
I knew lots of people who would have gotten balance or stabilized through bitcoin and this forum but not, rather they need instant job and payment.
Honestly, I get the same experience too. I fit count how of them wey I register here and paid the registration evil fee for but dem run leave dis place later. It's not encouraging at all.
My brother i no even reason am to carry anybody come here again because if you carry them come dem go think say you get all power to make them become within you be instantly without them knowing that this place is stage, you must start first before counting level 1 or 2 but few people way me try show road here run.
Oya what about to buy bitcoin and hold, maybe when the price increase them sell but see wetin dem come do, fear no gree dem buy when the price cheap about 5 of them immediately them see say price wan leave them pump na so them just jump enter market price just do back reverse turned down by force na so dem carry lose money because dem no gree follow instructions. for that reason them come hate anything about bitcoin the more, wetin come make me vex be say when e go reach time for them to buy e go hard them to enter buy but as soon as market change dem run go buy.
For we country we no too dey expose to digitalization unlike the oyibo people, correct me if i am wrong you no fit compare white wey be 60 years old and black wey be 60 year old, owa own go feel like say him don too old to venture into such tin, but white feels is the right time for them venture into it.