How una see this mata?
You gat a kind heart...keep it up.
Thank you so much bro and I hope say we go imbibe this culture of giving especially from our hearts.
I may not have enough but I always make sure atleast 5k from my campaign money I dey give out to persons but I dey mostly buy some provision and toiletries and even most times I dey release upto 10k but I no fit post pictures or even take pictures because I no want am seem like say I dey anything I dey do for show but on the other hand I don rethink am say showing picture go also be the best way to also encourage people around here and now I go show pictures from next week atleast to show probes of my works and to also use am encourage other people to do same in every little way them fit and I go also encourage say anybody wey give out any relief materials make him snap and drop pictures over here to help encourage others over here.
We also get one small project wey dey our hand now on behalf of my charity foundation and we dey hope say by the end of March we go do one of our official outreach and na the link to the preliminary meeting and hearing with some persons in my local church Here