Pages:
Author

Topic: Where you been dey when your mate they mine bitcoin? (Read 273 times)

hero member
Activity: 700
Merit: 577
Bitcoin na new thing to me and it was when I came to the city dat I even understand it very well though I heard it in the rural community but the uses was not as strong in the city area. And when bitcoin came, not everyone accept at the first sight so everyone no go dey equal for the industry.

So if I go say or answer your question I go say I been dey village dey fish and do farming work. Because dat one nai be the necessary labour for human life to survive. Until I came out. Wen my mate tell me bitcoin sef I no gree invest because the thing been dey one kind but later when I come understand the thing nai I come join am.
sr. member
Activity: 854
Merit: 451
Your topic sounds somehow to me, e should like say na insult you dey insult people, but as I come read the post I come see say no be say u dey insult na u no just get the appropriate topic for am.

So shear your story here, since wey ona want make we dey run our matter for foregn way like this. Make ona dey add bitcoin for everything wey we dey do here make people wey dey come check us here think say na serious thing wey We dey discuss. Oyibo man say all work without play make Jack a dull boy.

Just dey busy for nothing, no ask me who bring me hare o😂

I no go lie u I no sabi anything about bitcoin that year, I no even sabi say bitcoin dey exist or I fit even know anything like bitcoin, me I no go lie I rank up account for 2go that time, sometimes if I wan sleep I go login keep dey rank up my account, if to say I sabi Wetin be bitcoin that time i for no dey waste my time on 2go now. But even if I mine bitcoin that time, I dey sure say I go don lose access to the bitcoin because no be say na better phone I dey use that time, na all dis android phone’s wey before u know e don cash virus, u go need go format am.

But even as I no see bitcoin mine, I no blame myself because I no sabi about am, if to say I sabi about bitcoin and I no mine that time na that one for pain me pass, but as I no mine, atleast I dey invest small small money wey I dey get for bitcoin now which I see as a nice idea.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
Op this your yarning fit dey funny to some people but na something wey be say if person reason am well na a call to wake up from our slumber. E get many things wey we dey spend a lot of my time and energy on, wey no really make sense, but if we fit channel same energy to something else wey dey productive, e go really help us. Social media whether 2go, Facebook, Twitter etc. good but excessive use of it dey bad. Make we use our time wisely, make we use am learn skills wey go add value to our lives.

Bitcoin mining no be your mate oh, the cost no be here... So no compare am with 2go  Grin
sr. member
Activity: 504
Merit: 389
The great city of God 🔥
I want you to understand that many people here today have no or little knowledge of how this mining of a thing is been done, Bitcoin mining is a very complex part of Bitcoin, it requires much knowledge and electricity for this process to a successful, OP, over to you how many people in this country can run a mining farm, where is the electricity, the financial aspect is on a high side, you now see that your thread is baseless to many people here, I now concur to the comment of one of us here, that you brought this thread here to catch a cruise, this not fair at all, this doesn't tell well about your growth here, despite the there is freedom of speech in this forum, there are threads that you should bring here, thanks, I hope you desist from this act.
I was even thinking that bitcoin mining was don by phone. Just like this web 3coin. Had it been it was mined by phone I think many people would have gotten alot of it. But since it was not possible for mining, what about accumulating? Or was there no bitcoin wallet? Maybe had it been people bought much bitcoin Witt lesser amount it will still have been good thou.
sr. member
Activity: 434
Merit: 254
DAKE.GG - CASINO AND SLOTS | UP TO 230% BONUS
I want you to understand that many people here today have no or little knowledge of how this mining of a thing is been done, Bitcoin mining is a very complex part of Bitcoin, it requires much knowledge and electricity for this process to a successful, OP, over to you how many people in this country can run a mining farm, where is the electricity, the financial aspect is on a high side, you now see that your thread is baseless to many people here, I now concur to the comment of one of us here, that you brought this thread here to catch a cruise, this not fair at all, this doesn't tell well about your growth here, despite the there is freedom of speech in this forum, there are threads that you should bring here, thanks, I hope you desist from this act.
sr. member
Activity: 490
Merit: 325
My people I great o. Abeg make ona no kill me for this talk wey I wan talk for here, I no say I never talk before for this  we local board, and the first time I dey talk come be rubish like this. But I no go do am again🙏 the question be say where ona dey when people dey mine bitcoin and how old wey you dey then?

Even if I'm healthy and old enough to do whatever I want, age doesn't mean anything. You can be under 18 and could have still been able to mine bitcoin because in those days, people use PC and some small computers to mine bitcoin then when the network was not this extra secure but now, you need millions of Naira converted to dollar to mine bitcoin in Nigeria and looking at the situation of Nigeria, businesses are folding up due to bad economy state.

Quote
Sorry create thread instead

As for me na 2go I been dey fire down dey find rank from novice to legendary wey nothing come out self nawao.
I finally reach master but I no benefits anything and I been they 14 to 15 years then.

So shear your story here, since wey ona want make we dey run our matter for foregn way like this. Make ona dey add bitcoin for everything wey we dey do here make people wey dey come check us here think say na serious thing wey We dey discuss. Oyibo man say all work without play make Jack a dull boy.

Just dey busy for nothing, no ask me who bring me hare o😂


I remember doing 2go back then but I wasn't too focus on that, I had good browsing phone then and my friends will even laugh me for not able to make use of my device for what people do then but I was less interested. If I had know about bitcoin mining then, I will have give it a try and who knows.

However, if I'm to back in time with knowledge I have gain about bitcoin, I will not only be mining but will be buying all the coins from miners but who says they will sell when they all know how precious it is from the future.Grin
hero member
Activity: 756
Merit: 508
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID

So shear your story here, since wey ona want make we dey run our matter for foregn way like this. Make ona dey add bitcoin for everything wey we dey do here make people wey dey come check us here think say na serious thing wey We dey discuss. Oyibo man say all work without play make Jack a dull boy.

Just dey busy for nothing, no ask me who bring me hare o😂

My tori be say na 2016 I no say Bitcoin they exist with a friend of mine in school, during that period he been dey tell me the important of bitcoin but since I no sabi am well well and again I consider my friend as a rough guy who don't take anything serious rather than spending time on is phone which than I consider as waste of time. Where I was when people are mining bitcoin truly I don't even know how to operate a mobile phone because I came from a poor background were I don't have access to mobile phone, then is only my father and mother that was using mobile phone because my father is not always at home he travelled a lot and get my mother a phone so that he can be communicating with us through the phone.
newbie
Activity: 50
Merit: 0
I really don't know where I was. I wish I turn back the hands of time. I knew about bitcoin earlier, used it for MMM ponzi but never stored or keep $1 worth for future
sr. member
Activity: 532
Merit: 250
So shear your story here, since wey ona want make we dey run our matter for foregn way like this. Make ona dey add bitcoin for everything wey we dey do here make people wey dey come check us here think say na serious thing wey We dey discuss. Oyibo man say all work without play make Jack a dull boy.

Just dey busy for nothing, no ask me who bring me hare o😂


I no too find dis your post offensive sha, but na d manner wey you take publish the body of the post na him make people think say you no serious and you just dey catch cruise with people for here. Back to d topic of your post because na him b d genesis of all dis your talk for the thread. Back then when dem dey mine bitcoin ba, I no know wey I dey sef because I no fit recall wetin dey really sup for my life dem, I just know say I dey go school and dey come back house come chop. I no really get any idea about computer stuffs that much. Looking back dat time, to even afford the mining tools for mining go dey very expensive and na little people fit afford am then. Even now sef, no be everybody fit still mine but prefer to buy bitcoin because of difficult it is to own a mining machine and own a bitcoin through it.
sr. member
Activity: 546
Merit: 265
Sense dey ur nonsense and e worth sharing amongst.
The Truth be say Bitcoin don com many of us table but with that granted we take am, we seriously non know the real potentials so we chosed fun and social activities such as the 2go, Facebook and others than that of it.
Though all that platform no waste total to some person's because some benefited from the social sites then before things cast.
I remember when one oyibo woman dey write me for Facebook then dey call me on video call dey tell me say like me as at 2010 - 2012 na so I dey get such sceneros but I no send them bcos I no one day think am say oyibo na get wetin to offer to blacks so as most of us believe say nothing Bitcoin get to offer us then.
But now, we dey pursue the oyibos not easy to catching up with and also chasing the Bitcoin not still easy to catch-up with.
That na just life.
My tell us something, Bitcoin of nonsense before and Bitcoin of senses today make me believe say whatever that is firstly produces even if people never dey rush am go be hot cake in just a matter of time and there also being an origin of the product before similar products are invented is where the original product is layed. This na the crypto industry where Bitcoin becomes the grassroot of cryptocurrencies and til date it takes the leads of the originality potentials.
This also thought me not to take the paths of the crowd bcos na say people around me no follow Bitcoin as at then na em make me no follow am to but now even village people don dey folo Bitcoin na em make me too followed up cus my eyes don clear.
member
Activity: 75
Merit: 16
While this topic isn't exactly what many people wanted but atleast it has a message to pass. This goes deep to show information is power, imagine what would have been of us if we knew about mining Bitcoin then. But wait oh, how many of us would have actually embrace the opportunity considering mining Bitcoin wasn't profitable back then. This also goes to tell us we should always be in look out for information because alot of things are going on that would have been life impactful for us but we don't have that information. Make we no do like na our fault say we no sabi about Bitcoin back then because none of us been get the opportunity to sabi am but immediately we do we no waste time take advantage of the opportunity.

You really spoke like a legend that you are, in this life there is need to always take risk no matter the outcome if you will win or not already anything one is doing in life two things are always involved, is either you win or you lose, disadvantages and advantages. Had it been say those first people wey been know about bitcoin then took it serious at least by now almost all of us here for be legends in this bitcointalk forum but because the awareness know reach us on time come make us still dey struggle for the industry. Okay take a look at Indonesia board you will see almost all of them are legends because the awareness reach them on time.

What am really trying to say is that we should learn to follow things as it is hot. Even if it fails then we move, there are some businesses we even do physically yet it still fails us. Everything is what giving a trial though I know that due to frauds and lots of scams has made lots of person to lose interest whenever something new are being introduced to them but we should try as possible to remove the spirit of doubt in our life and always look for ways by which we can find solutions within ourselves.

The 2go experience almost dey like this platform in the aspect of the ranks but it's more of a chat platform unlike this bitcointalk forum where lots of things are being discussed and analyzed and people's views and opinion are also taken into account.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
My people I great o. Abeg make ona no kill me for this talk wey I wan talk for here, I no say I never talk before for this  we local board, and the first time I dey talk come be rubish like this. But I no go do am again🙏 the question be say where ona dey when people dey mine bitcoin and how old wey you dey then?

While this topic isn't exactly what many people wanted but atleast it has a message to pass. This goes deep to show information is power, imagine what would have been of us if we knew about mining Bitcoin then. But wait oh, how many of us would have actually embrace the opportunity considering mining Bitcoin wasn't profitable back then. This also goes to tell us we should always be in look out for information because alot of things are going on that would have been life impactful for us but we don't have that information. Make we no do like na our fault say we no sabi about Bitcoin back then because none of us been get the opportunity to sabi am but immediately we do we no waste time take advantage of the opportunity.

As Bitcoin enter Nigeria through MMM we no waste time begin embrace am and na wetin matters be that, we fit dun miss the start of the whole journey but the bus (Bitcoin) never go far, we still fit follow Bitcoin reach e destination (global adoption) and make profits. Wetin go matter in years to come go be whether we Invest when we hear about Bitcoin and no be if we start the journey dey mine Bitcoin when the currency was launched. Many of us were not independent when Bitcoin started and even though we dun dey independent we weren't yet financially sound so all this one for make us not been aware about mining Bitcoin but now wey we still get the opportunity to invest, make we no miss am. Dem talk say the best time to invest for inside Bitcoin was in 2009 but the next best time na today so make we no miss the opportunity.
newbie
Activity: 15
Merit: 0
I been no no about anything called bitcoin or anything way them they even call technology self, cuz where me I dey those can things you no fit hear am from anybody oo.. Waiting you go dey hear na oboy com excut me go farm, com make we go river side go swim. So if to say me I don hear about technology or bitcoin mining for those early ages way them they do bitcoin mining. Ah ah ah by now self my life and mentality for don change sence if I no say things go con dey as e dey now way technology dey everywhere for this world way we day so.
sr. member
Activity: 546
Merit: 450
Fine by Time
My brother wen Bitcoin come out and some people start to they mine am, me ah no even they aware. At least you u get phone me ah no even get phone talkless to get any account.  The thing be say were i dey nah for my village , technological knowledge no they, the only wey me ah know that time nah to chop food then go play ball. This life sha. E they pain me well well say everybody wey they aroung me that time just get this local mentality. If to say they get small knowledge of waiting they happen for the world. Me ah for done join Bitcoin since because no be today ah done get this love for anything tech and digital something. Nah why up till now me ah still they into tech.
sr. member
Activity: 686
Merit: 398
Me I really know no where I they when my mate they mine bitcoin and I no even dy aware of any of my mate way get bitcoin minning machine for anywhere at least for this our country, eh be like nah because you miss out for the bitcoin minning and to make am big true their nah why you also follow the people way they mine pia coin now.

Sometimes people way get the information about this bitcoin for the past years when minning been theycheaper and easier been really no value am, and me I been no even hey information about anything way them they call crypto currency at least I no fit remember if anything like that been they exist, maybe nah when I been they struggle to write weac nah when my mate been they make good use of their own time.

Omoh diz your question don remind me of one movie way I watch way person pikin they ask him papa where him been they when him age mate and class mate them been they make money way him no follow them make the money, doz kind question no they really get straight up answer because we no no say nah so eh go be.
legendary
Activity: 1106
Merit: 1372
I no fit remember when last I login to 2go. Day one na years back. And for di mining, no be everybodi sabi mining and no be everybodi go mine.  Grin when my mate dey mine, I been no get money and mining equipments  dey very much expenses plus light wey I no get steady. Those my mate dem been get plenty money to start di mining business so dem start am day time. And as I said, everybodi e no go enter mining some of us need to enter investment and others fit join mining, some dem go enter trading. In the cryptocurrency ecosystem industry everybodi dey enter where good for am. So me na investment good for me so I dey day side but sometimes I dey visit trading.
sr. member
Activity: 476
Merit: 337
This your topic and the discussion them no aline at all because you no like talk watin they in line with the topic, any way sha make I just talk watin I won talk based on the topic,,,
This mining stuffs about Bitcoin sha you know say to buy things way you go fit use dey mine Bitcoin no be come chop as of then,, anyway you go fit talk say thing been good before now but bro make I tell you,,. Now every were hard and to afford the necessary things for this Bitcoin mining,,, you go must get steady electricity and strong network speed..
Without this thing you no go fit mine Bitcoin, more especially that aspect of light, that one nah one of the challenge way we as a Nigerians dey get.. and lastly, Bitcoin mining mo be con chop matter, you go must dey focus.
full member
Activity: 160
Merit: 84
E don tey way I hear about bitcoin. The problem wey I been get that time na patience to learn about bitcoin because bitcoin it's self is a complex topic. With the knowledge wey I don get now,  e dey vex me say I no invest in it years ago wey my friend introduce it to me.
It's better late than never, bitcoin is here to stay forever.
It's  good to educate and ask questions about things you are not too knowledgeable about, this will help to guide you to make the right decision so you won't miss out on opportunities.
sr. member
Activity: 434
Merit: 275
Enjoy 500% bonus + 70 FS
My people I great o. Abeg make ona no kill me for this talk wey I wan talk for here, I no say I never talk before for this  we local board, and the first time I dey talk come be rubish like this.
imagine say all of us de for the same hall de talk important matter when fit make your life change for the better, and you come decide say make you choke mouth for the matter come start your speech like the way you just did now, if person shout on you make you sit down you go take am as bad thing?

I know say possibly na cruise you wan catch but make you try know say first impression matters a lot. Make your destiny helper no come take you as one unserious person come de ignore any conversation when involve you.

Now concerning your post, you to know say everybody get as there lives de structured and most of the things when we de do na based on wetin de relevant to the time, our environment and the things we de exposed to. The fact say some persons start to de accumulate bitcoin at an earlier stage no make others unserious people. E just mean say de possibly never too know much about bitcoin and that one fit be because de know de close to anybody when de mine bitcoin.

😂Lolz no mind me! like say I sabi anything? Sometimes first impression no dey matter like that but if person come dey talk Rubbish frequently naim e go come be problem. Who wants help go help. Oyibo say make we no Judge book by it's cover. Even as wey dey learn make our life for change no mean say cracking jokes na one kind taboo. Make we no come over serious for some certain things wey no to dey nessesary. Here don become a place were most of us they always visit. is just like our second home. Sometimes we just catch cruise and e no change anything from who we be. Thanks

sr. member
Activity: 504
Merit: 389
The great city of God 🔥
My people I great o. Abeg make ona no kill me for this talk wey I wan talk for here, I no say I never talk before for this  we local board, and the first time I dey talk come be rubish like this. But I no go do am again🙏 the question be say where ona dey when people dey mine bitcoin and how old wey you dey then?

Sometimes I dey think am say how come this kind opportunity dey sice wey person never get the information earlier but never the less no time too dey late, anytime you wake up na your morning.

As for me na 2go I been dey fire down dey find rank from novice to legendary wey nothing come out self nawao.
I finally reach master but I no benefits anything and I been they 14 to 15 years then.

No knowledge is lost everything in life has it's own time no matter how serious we dey, there is always time for us to have fun. Even as say Sometimes e dey do me like every talk wey I dey talk for house  make e enter forum turn to write-up, go comment people thread or post for forum. No mean say e dey possible. but just to pick up from where you meet others.


So shear your story here, since wey ona want make we dey run our matter for foregn way like this. Make ona dey add bitcoin for everything wey we dey do here make people wey dey come check us here think say na serious thing wey We dey discuss. Oyibo man say all work without play make Jack a dull boy.

The thing I go tell you now say bitcoin that time self na only few people even dey awear about bitcoin.  And bitcoin that time self never get value, so na of recent time wey bitcoin come pump. E come drag people attention so even that time self I doubt if most of us even don hear am on 2009 when the price of each one be $0.0009 that time e really dey worthless. In come futher grow again to $0.01 for 2010. The price come rise  from $0.1 to $0.2 for Oct 26, 2010 before you know e reach $0.3 for 2011 naso e continue to grow till 2016–2020 when in come reach $19345 . I no ft give you the statistical data analysis of the growth,but wetting I wan try tell you be say na gradually bitcoin adoption Cary spread if them even tell you that time you go still doubt because Naija dey always want to see results first.
Pages:
Jump to: