Pages:
Author

Topic: Where you been dey when your mate they mine bitcoin? - page 2. (Read 265 times)

sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
Op you funny well well, you don make me laugh scatter, which on be make we add bitcoin for our discussion make outsiders think say we serious, abi when you enter the local board e like say na play we dey play? Grin. Normally all work no play make Jack a dull boy na why e dey necessary say once once make we dey catch cruise like this. Though the topic fit look embarrassing to many people oo, but the truth na be say that time wey dem dey mine Bitcoin new our eyes been never open well, if to say person introduce am to us we for think say na scam, just imaging explaining bitcoin mining to completely ignorant person wey never get any knowledge about bitcoin, and as at that time our economy been dey bum and people been dey live well so for dem to stress their self mine Bitcoin for be like waste of time at that time, I no know if you day grab? That period men been dey on funds unlike now wey sapa dey everywhere, so I no lie you if to say person tell me about bitcoin mining that time I for no gree accept am. And apart from work that time I been serious well well with this Sega console game. Grin
sr. member
Activity: 476
Merit: 307
The topic of the post and the body no too blend wella as I been dey expect am. The topic make am sound say you wan tell us say we fall hands as we no join our mate them dey mine Bitcoin when them start... that kind talk wey mama and papa dey tell their children wey never meet up. But as I come read the body of the post, I come realise say you dey ask us to share wetin been take plenty of our time when we been dey grow up. Well since na tori you dey find, we go drop am as e dey hot.

Anything you go achieve for this life depend on the information wey reach you either from friends or family. If you no get the update, you fit dey inside water, soap dey enter your eye. As you dey build account for 2go when others dey build for forum, e mean say you no know say forum like this dey so you gat not blame yourself.

Me self been follow for 2go too and I know plenty of the people here also been do am. E get one statement wey my people dey take wey be say "na when person wake up from sleep be him morning". So now wey you know about the forum, give am your best and enjoy you catch fun while you build.
full member
Activity: 462
Merit: 196
My people I great o. Abeg make ona no kill me for this talk wey I wan talk for here, I no say I never talk before for this  we local board, and the first time I dey talk come be rubish like this.
imagine say all of us de for the same hall de talk important matter when fit make your life change for the better, and you come decide say make you choke mouth for the matter come start your speech like the way you just did now, if person shout on you make you sit down you go take am as bad thing?

I know say possibly na cruise you wan catch but make you try know say first impression matters a lot. Make your destiny helper no come take you as one unserious person come de ignore any conversation when involve you.
Now concerning your post, you to know say everybody get as there lives de structured and most of the things when we de do na based on wetin de relevant to the time, our environment and the things we de exposed to. The fact say some persons start to de accumulate bitcoin at an earlier stage no make others unserious people. E just mean say de possibly never too know much about bitcoin and that one fit be because de know de close to anybody when de mine bitcoin.

The 2go when you de talk about, na just social media when no go fit stop person from mining bitcoin. If like say you done know about bitcoin as at the time you say you de take focus on 2go, you for still de the forum still de do your 2go at the same time. Abi as you de this forum so, you know de active for Facebook and other social media platforms?

 The thing is just more of what you're exposed to, so no just try to make anybody feel bad say him de loose guard while him mate de hustle.
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
Well you are actually acting on the influence of kaikai,
He obviously dey under the influence of strong kiakia. I dey get e point sha but first of all, no body go kill you even though say you talk rubbish. The only thing be say e go dey affect your reputation for forum as other people Dem go see you as person wey e post no dey make sense.

So shear your story here, since wey ona want make we dey run our matter for foregn way like this. Make ona dey add bitcoin for everything wey we dey do here make people wey dey come check us here think say na serious thing wey We dey discuss. Oyibo man say all work without play make Jack a dull boy.

The truth be say Bitcoin was a new technology back then, and many of us no to dey familiar with the internet like that well well. During 2009/2008, I still remember the phone wey dey rain dat one na black berry. So d most thing wey we dey run with phone was normally na either call or yahoo.com. i know of Bitcoin recently around 2015, but based on bad thing wey some people Dem dey use am do I decided to stay off. U till 2019, I then started learning more about Bitcoin.


sr. member
Activity: 420
Merit: 253
Well you are actually acting on the influence of kaikai, but anyhow wey e b information na in be the key as if you ain't informed then you are deformed, all of us wey dey this forum na base on say person update us on wetin dey sup for here before we come enter then as time goes on we come understand the importance of being on this forum.

Talking about 2go, hmm I remember those days wey we dey chat on 2go and our stars go dey increase from Amateur, Novice, Master professional and all that but that's just a chatting platform as this forum is far from chats but rather interactions with members on how discuss about business that can possibly change the lives of individuals in the society.
However, you talk like a newbie that you are and I advise you rather watch and learn from the activities in the group before creating threads and replying threads.
sr. member
Activity: 350
Merit: 254
Enjoy 500% bonus + 70 FS
My people I great o. Abeg make ona no kill me for this talk wey I wan talk for here, I no say I never talk before for this  we local board, and the first time I dey talk come be rubish like this. But I no go do am again🙏 the question be say where ona dey when people dey mine bitcoin and how old wey you dey then?

Sorry create thread instead

As for me na 2go I been dey fire down dey find rank from novice to legendary wey nothing come out self nawao.
I finally reach master but I no benefits anything and I been they 14 to 15 years then.

So shear your story here, since wey ona want make we dey run our matter for foregn way like this. Make ona dey add bitcoin for everything wey we dey do here make people wey dey come check us here think say na serious thing wey We dey discuss. Oyibo man say all work without play make Jack a dull boy.

Just dey busy for nothing, no ask me who bring me hare o😂
Pages:
Jump to: