Pages:
Author

Topic: Who is to be blamed ? (Read 299 times)

sr. member
Activity: 378
Merit: 259
September 06, 2023, 09:07:33 AM
#26
I beg my pipu,I dey vex for the way things just dey scatter and inflation dey high everyday by day. Tinubu wey some people say na him dem want, say him go fit change things for the country to make am better,come join dey make am worst the more. Imagine three months never reach Baba remove fuel subsidy,remove education subsidy and still go apply for loan say him wan use am pay poor Nigerians 8k for 6 months. Yesterday,I dey watch news come discover say fuel wey them say no more subsidy price from 530 run reach 630,I ask myself say how come. This make me dey wonder say make I ask this question since na all of us dey the country together dey see as things don dey  go ever since. My question be say for Naija na who dey make things dey spoil the more,shey na our Nigeria police or Politicians or we the citizens. I beg give me your reason.
As for me na we the citizens they make things worst for ourselves, we know say this person if he get to this position things will not go well the way we want am and at the end of election we go still vote am based on their fake promises say them go make things better. If no be say we want things to get worst for us we go look Tinubu and think say him go make things better for our country, na part of believes wey we have on him they makes things worst to this extent from fuel subsidy just for 3 weeks see where we are now, since yesterday our country dey on strike for two days, Buhari don kill us in this country before Tinubu take over, they are still from the same party, and some people still come and believe them still vote for the same party we are facing a lot in this country.

To travel now is also a big problem as fuel don cost no be waiting we dey pay before we dey pay now, since we still dey this same party hand we no sure this our country fit better again.
sr. member
Activity: 560
Merit: 408
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
September 06, 2023, 03:02:38 AM
#25
Being a politician is not a problem but na the selfishness in our politicians na him be our major problem, they ones with good mind when they got into office them too will get corrupted, and no one cares about anyone and as well care for we country, Anybody who enters office or holds any position na him stomach him go dey find, thereby leaving the major reason why they were elected in that position in the first place and forgetting say our country don good today na our hand e dey.
This issue dey complicated because di mistake come from all of us, during election periods we di mass always go for di person wey fit dey give money forgetting person wey get good reputation, is only 2% among over 300 millions Nigerians that can spend their money for the poor mass with out requesting for anything. Naija wey we see like this wide in times of ruling because most of our leader wey we elect na pipo spend for them with the agreement say if the win dey go return so percentage to dem, that why dey always consider their sponsor and forgot their supporters that is why we dey suffer for their hand, we should not curse dem rather pray for them to change to better person.
hero member
Activity: 798
Merit: 546
September 03, 2023, 03:59:49 PM
#24
My question be say for Naija na who dey make things dey spoil the more,shey na our Nigeria police or Politicians or we the citizens. I beg give me your reason.
Looking at all the hardship wey dey this country, I can boldly say that the only problem and major primary problem we get for this country na our politicians them, while the rest such as "police & citizens" na secondary that can easily be resolved, because if I'm to follow this small illustration wey you just give, I go like ask you @ O.P, who comot this fuel subsidy wey dey make the price of goods and everything skyrocket high? Is it a police man, politicians or fellow citizen? Because if you can know the answer to that question, then that means you already know the answer to our major problem wey we get for this country.
Being a politician is not a problem but na the selfishness in our politicians na him be our major problem, they ones with good mind when they got into office them too will get corrupted, and no one cares about anyone and as well care for we country, Anybody who enters office or holds any position na him stomach him go dey find, thereby leaving the major reason why they were elected in that position in the first place and forgetting say our country don good today na our hand e dey.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
September 02, 2023, 04:22:29 PM
#23
My question be say for Naija na who dey make things dey spoil the more,shey na our Nigeria police or Politicians or we the citizens. I beg give me your reason.
Looking at all the hardship wey dey this country, I can boldly say that the only problem and major primary problem we get for this country na our politicians them, while the rest such as "police & citizens" na secondary that can easily be resolved, because if I'm to follow this small illustration wey you just give, I go like ask you @ O.P, who comot this fuel subsidy wey dey make the price of goods and everything skyrocket high? Is it a police man, politicians or fellow citizen? Because if you can know the answer to that question, then that means you already know the answer to our major problem wey we get for this country.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 02, 2023, 04:19:16 PM
#22

If na to blame, we all know who to blame which is the government and at this point, I think we no suppose vote for the sake of political parties bjt we should rather vote for candidates we deam fit for a public position because we'll suffer it if anything bad happen as e dey already happen now.

My brother we vote for the person wey we suppose vote for but we see say the gang ups dey too much and one man say na im turn and no body fit talk. Even Buhari no support tinubu but whether Dem don drink something together wey make Dem no fit turn back . We all sharp our PVC and use an well and only youth votes for the country both north, east, west and south push APC out but today dem still rig am. So the wahala no be here.

On top of the police matter, hmmm. Police, Army, Custom and all other agencies na function of wetin dey happen for the country. For country to dey better, it must start from the president himself because na him get the say unto how the government dey, no institution wey no be government.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
September 02, 2023, 04:08:56 PM
#21
My G. This matter wey you bring here na very long matter o. Government naim be our challenge oh[/b], according to my analysis Nigerians dey hardworking, talented and educated. Nigeria matter just be like family were eldest son get driving job and instead of him to give his younger brother wey Sabi drive him go force himself to do the driving job were ass him no get the skill. wetting you think ft happen? If care is not taken him go get accident to distroy the future of his employer.

Make I make you understand say na the bad governments dey make us dey hard working and talented and most of our talents are been learnt and no be say we dey born with am. The learning process fit no dey intentional but na wetin dey happen to us be dat. Look at other parts of the world wey their government get better responsibility, dem no get our level of hustle (wey we dey call hardwok) and dat one na because say the government dun provide everything for dem finish. If Nigeria governments was better we no go dey get the hardworking traits wey we get for the country but dat one no be excuse for the surfer wey dem dey surfer us and they thief our money for their personal needs them.
We Nigerians just be lik iron steel in a furnace under the craftsmanship of a goldsmith such kind of steel dey com out strong and well carved  e dey even hardly rust or bend and this goldsmith for this analogy na hardship aka Sapa/Shege.

And if luk down well we go see say for Africa and most parts of the world Nigerians nah get the best brains despite how hard the country we com from dey on us. Like if you fit survive for this naija inno get anywer wey you no fit survive. Na just unfortunate tin say we get bad leaders wey no get sympathy for the people dem claim to lead in guvonment.

The country don turn evrybodi  to risk taker and if you sit down say you no wan take de necessary risk you go just in ur sleep like that cos nobody dey com to your saving if you never try to first save yourself by taking risk.

 Since we no get de privillage to com from country wey de government don provide every essential social amenities keep to make life sweet, we den no get choice but to take the risk wey dey available.
If you survive you survive, if you die all die nah die.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
September 02, 2023, 08:54:50 AM
#20
My G. This matter wey you bring here na very long matter o. Government naim be our challenge oh[/b], according to my analysis Nigerians dey hardworking, talented and educated. Nigeria matter just be like family were eldest son get driving job and instead of him to give his younger brother wey Sabi drive him go force himself to do the driving job were ass him no get the skill. wetting you think ft happen? If care is not taken him go get accident to distroy the future of his employer.

Make I make you understand say na the bad governments dey make us dey hard working and talented and most of our talents are been learnt and no be say we dey born with am. The learning process fit no dey intentional but na wetin dey happen to us be dat. Look at other parts of the world wey their government get better responsibility, dem no get our level of hustle (wey we dey call hardwok) and dat one na because say the government dun provide everything for dem finish. If Nigeria governments was better we no go dey get the hardworking traits wey we get for the country but dat one no be excuse for the surfer wey dem dey surfer us and they thief our money for their personal needs them.

Many of our young girls are dying by the day all in the name of hookup(olossho promax). Dey don't even care how or whether it will take there life. Yahoo boys has use them for rituals countless times. Wasting there destiny. The solution is to empower the youth in government. So that some parastatas will be changed. If dey don't want the youth at least dey should create employment opportunity and start production instead of consumption.

UK, Canada & United states wey belike heaven to many of us for this side still get high rate of prostitution and our own self dey learn work for where their own dey, scams and all sorts of internet scams dey popular dat side yet dem still get a better economy and are doing well for their own self. Country better, job dey and everything dey go well no mean say boys and girls go stop wetin dem dey do. Even now self we still get people wey dey put head together hustle and we still get those wey dey do this things wey you talk, people go always lazy and dem go dey find the easy way out. Dat one no be government fault, now our longer throat they cause am.
full member
Activity: 322
Merit: 185
September 02, 2023, 05:00:02 AM
#19
Dis Naija matter plenty and e long like epistle to talk about. We no know who to blame again, na ourselves ahbi the leaders wey we put for those positions to lead us? The matter just get as e be now like this. Na to just go meet prayers and make person find something to dey do and no relent for government work or any intervention for now if not you go just old without achieving anything for dis world. Dey say for good thing to come, one must have to pass through hardship, I just pray ours no go pass like dis before things go come begin better for us for Naija.

I no think say even if they wan Write book about naija omo he go take years before they complete the book and he no go end self because problems they increase every blessed day, both the leaders and the followers  get there own role to play and both parties they fuck up, but sometimes prayer is good but we need to start taking responsibility, if you no do well we vote the person out because people and getting tired and true true make we all find something to do the thing go really help. Naija need serious reformation and transformation. And make we they pray has you talk to.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
August 31, 2023, 11:29:56 PM
#18
I beg my pipu,I dey vex for the way things just dey scatter and inflation dey high everyday by day. Tinubu wey some people say na him dem want, say him go fit change things for the country to make am better,come join dey make am worst the more. Imagine three months never reach Baba remove fuel subsidy,remove education subsidy and still go apply for loan say him wan use am pay poor Nigerians 8k for 6 months. Yesterday,I dey watch news come discover say fuel wey them say no more subsidy price from 530 run reach 630,I ask myself say how come. This make me dey wonder say make I ask this question since na all of us dey the country together dey see as things don dey  go ever since. My question be say for Naija na who dey make things dey spoil the more,shey na our Nigeria police or Politicians or we the citizens. I beg give me your reason.

My G. This matter wey you bring here na very long matter o. Government naim be our challenge oh, according to my analysis Nigerians dey hardworking, talented and educated. Nigeria matter just be like family were eldest son get driving job and instead of him to give his younger brother wey Sabi drive him go force himself to do the driving job were ass him no get the skill. wetting you think ft happen? If care is not taken him go get accident to distroy the future of his employer.

Our leader has make Nigeria leadership a family heritage.
Emagine tinibu saying publicly that the presidency is his turn. As big as Nigeria someone bits his chest that he must be the president and he became it. Despite all our efforts but still to no avail. Democracy wey Dem teach us for school. Say "it's the government of the people by the people and for de people"now "government of the people of the people and of the people"

Them say the youth are the leaders of tomorrow. I wonder if tomorrow never still reach. ABI na parable because Dem say tomorrow never ends. Student are graduating from different institution every year with better grade dey end up riding okada,Keke,danfo/taxi, hucking pure water doing all manner of things just to earn a living. Most people graduated as first class in software programing some software developers doctors, layers, bankers, engineer in different field. When dey sick for employment the boss will think employing such personnel is a treat to his work. So employment becomes a problem.

Now even odimary cleaning job, dey will ask you who send you? Whereass
O you saw a poster clearly stated cleaner job needed. So the politicians has made the country a living hell for the youth to survive. They only become friendly to the poor when it's time for election after wining. the next time you see them, is when dey come for another campeign.

After all this political oppression and humiliation, the youth became angressive and started illigal activities. There is a saying that "if you can't beat them you join them" there brings us into curruption i.e

1) kidnapping
2) Armrobbery
3) cyber crime e.g Yahoo Yahoo/hacking
4) hire killers
5) child trafficking
6) fake churches everywhere
7) cultism and terrorism
8 ) bandit and militancy etc.

So in every sector of Nigeria, corruption is growing drastically. as a matter of fact corruption has been a means of survival in this country. Many people can not survive without crime.

They said police is your friend. Only when you have the money. Innocent persons are rotten in jail for the crime dey know nothing about. Some just because you are just dating a rich mans daughter dey jail you for life. Rich men are the law them self's. If a poor man driving without his papers complete it's a crime but a rich man without car papers can travel anywhere in Nigeria without police even checking his boot.

You apprehend a critical and send to the cell, dey realise him just some few minutes of ditention. If you are riding on road just make sure you have your offering to give police otherwise dey will detaine you. Even when you have not even carried any passenger.

you will come to withdraw money in the bank. If dey see you are a rich man you are above the law. The take you through the back door and give you what you need and others will be left with no choice Dan to wait through out the whole day with their number on it. Sometimes security on bank will take people's atm card to withdraw money for new commer while others are still on que.

Many of our young girls are dying by the day all in the name of hookup(olossho promax). Dey don't even care how or whether it will take there life. Yahoo boys has use them for rituals countless times. Wasting there destiny.

The solution is to empower the youth in government. So that some parastatas will be changed. If dey don't want the youth at least dey should creat employment opportunity and start production instead of consumption. One other important this is bringing down fuel price because petrol price has a great funtion in all sector of Nigeria.

Thank you.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
August 31, 2023, 06:09:46 PM
#17
Wetin nigeria police get to do with this whole matter now na?
I no blame anybody wey go drag the Nigeria police into any of this stories because na them use their hand spoil their name and things for themselves. But the truth be say nigeria police no get any say fir this matter because them just gats dance to any tune played for them and most times them dey always dey very submissive to any government  because na from there, their own chopping fit come out from.

If na to blame, we all know who to blame which is the government and at this point, I think we no suppose vote for the sake of political parties but we should rather vote for candidates we deam fit for a public position because we'll suffer it if anything bad happen as e dey already happen now.
full member
Activity: 392
Merit: 185
Play Bitcoin PVP Prediction Game
August 31, 2023, 07:31:26 AM
#16
When it comes to Nigeria problem, the government should be held responsible, do you know that after the second upward review of pms in Nigeria, so many private depot's and filling stations, have been selling the product lower than the  so called NNPC approved price, this has been happening uptil this moment, that's to say that, there is a foul play somewhere that needs to be checked, the government controls everything so if their are new policies or price inflation, there are agencies and commissions that are assigned to to function in that capacity.

Our leaders are not sincere to us, so it is high time they begin to accept responsibilities as they are, the country will only work, when all the arms of government comes in synergy and function according to the constitution of the country.

sr. member
Activity: 392
Merit: 269
July 22, 2023, 06:38:49 PM
#15
I beg my pipu,I dey vex for the way things just dey scatter and inflation dey high everyday by day. Tinubu wey some people say na him dem want, say him go fit change things for the country to make am better,come join dey make am worst the more. Imagine three months never reach Baba remove fuel subsidy,remove education subsidy and still go apply for loan say him wan use am pay poor Nigerians 8k for 6 months. Yesterday,I dey watch news come discover say fuel wey them say no more subsidy price from 530 run reach 630,I ask myself say how come. This make me dey wonder say make I ask this question since na all of us dey the country together dey see as things don dey  go ever since. My question be say for Naija na who dey make things dey spoil the more,shey na our Nigeria police or Politicians or we the citizens. I beg give me your reason.

My brother the country tire person ooo, the cost of living in Nigeria is too high, they don't even care about unemployment youths, thousands and millions of people graduating every year, no job. The one way they pain me pass na this fuel matter, people never recover from 511 naira, them come increase am to 630 naira, well anyhow they want am we go survive, after all we are use to it.
full member
Activity: 518
Merit: 156
July 22, 2023, 02:38:31 PM
#14
I beg my pipu,I dey vex for the way things just dey scatter and inflation dey high everyday by day. Tinubu wey some people say na him dem want, say him go fit change things for the country to make am better,come join dey make am worst the more. Imagine three months never reach Baba remove fuel subsidy,remove education subsidy and still go apply for loan say him wan use am pay poor Nigerians 8k for 6 months. Yesterday,I dey watch news come discover say fuel wey them say no more subsidy price from 530 run reach 630,I ask myself say how come. This make me dey wonder say make I ask this question since na all of us dey the country together dey see as things don dey  go ever since. My question be say for Naija na who dey make things dey spoil the more,shey na our Nigeria police or Politicians or we the citizens. I beg give me your reason.

The problem of our country is multidimensional, it ranges from class war, political, ethnic, religious and other intra complex issues.
A lot of people argue that, this are some of the issues faced with a Developing Democracy, but ours is Fused with lots of sentiment and revengeful bitterness.
A country must have thinkers and idealist at the helm of affairs to steer the wheels of Development.

First, our leaders should be discussing about housing schemes affordable for people to live, a water system in our houses, affordable healthcare services, electricity and food security.

Once the above mentioned is reached, things will begin to fall into place, hence the institution's will begin to get strong, ranging from the judiciary, the police, the civil service etc.
But then, if our political class are not discussing these, and they are hell bent in just occupying political offices without purpose, then we all begin to suffer the effect of hyper inflation, insecurity and other social vices like we are currently experiencing. It's a long ride we've entered.


hero member
Activity: 1064
Merit: 501
July 22, 2023, 01:23:35 PM
#13
The kind of hardship wey d for our country peso no fit talk how em go take escape am. Even the rich and the poor don see weehnnn for the country. Everybody the feel am, even those wey voted for Tinubu and those wey no vote for am the feel the high cost of things.

Would I say, we don pass the first stage wey be shege for fuel price of 530naira, we don enter another level wey be shege banza for fuel price of 630naira, peso no know another level wey em go enter again for this country. Whether na 1000naira for fuel price.

Em do become a norm sae, every new week na em peso the receive disheartening news for this country wey no go favor am but to  increase more  hardship give am.

The question of whom to blame for this our matter no go be here to give answers to, because all of us the guilty of how our country don spoil reach.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
July 21, 2023, 07:19:33 PM
#12
I beg my pipu,I dey vex for the way things just dey scatter and inflation dey high everyday by day. Tinubu wey some people say na him dem want, say him go fit change things for the country to make am better,come join dey make am worst the more. Imagine three months never reach Baba remove fuel subsidy,remove education subsidy and still go apply for loan say him wan use am pay poor Nigerians 8k for 6 months.
Believe me, I no been dey against the fuel subsidy issue o. I been ready say, after a great suffering would come a greater good but, this kind suffering no be like say e get light at the end of the tunnel with the way Baba dey reason.

Like, watin be the point in trying to take loan and pay people while you hike the price of watin for make almost everything to dey affordable for we nation. E cast like that na!
We shah know say, cost of transportation na one thing way dey make things cost for we country before we go con reason scarcity matter. Why jot redirect this loan to making our refinery work rather than dey plan pay families 8k for 6momths.

E no just make sense to me.
sr. member
Activity: 630
Merit: 420
July 21, 2023, 06:55:05 PM
#11
I beg my pipu,I dey vex for the way things just dey scatter and inflation dey high everyday by day. Tinubu wey some people say na him dem want, say him go fit change things for the country to make am better,come join dey make am worst the more.
I no sabi d plans wey tinubu get for Nigeria, but I know say anybody wey wan come change Nigeria, all of us wey dey d country go first see shege first, because Nigeria don spoil pass the level wey be say person go just come fix am easily. And the way things be now self, e be like say even d tinubu wey wan come change Nigeria don confuse already, Nigeria don spoil pass Wetin one person go just come change within 3 months, anybody wey wan change Nigeria no fit do am within even 4 years.

I dey watch news come discover say fuel wey them say no more subsidy price from 530 run reach 630,I ask myself say how come.
Na Wetin e mean say dem commot fuel subsidy be that now, government no go dey pay any part payment, and the price won’t be regulated again, d price no go stay one place again and every filling station go fit sell petrol any price wey dem like. No dey surprise say petrol fit dey 600 today, by tomorrow make e go 1000, next tomorrow make e drop come 500 again, d price no go stable again.

My question be say for Naija na who dey make things dey spoil the more,shey na our Nigeria police or Politicians or we the citizens. I beg give me your reason.
Wetin dey happen now na everybody get fault, both politicians, police and we d citizens. All of use contribute to d failure of dis country, but everybody go dey blame our politicians, but even we wey be citizens get things wey we dey do to spoil d country.
member
Activity: 406
Merit: 84
Eloncoin.org - Mars, here we come!
July 21, 2023, 02:23:11 AM
#10
To me na everybody be the problem, both police, Politicians and we wey be citizens, the day wey tinubu do en swearing it into office as president, the man made a statement say subsidy will be removed, en never even implement am that time sef, fuel stations start to increase the price of fuel then, and this fuel was their old stock oo.

People wey do road transport Dem kuku increase the price of transportation, people wey even still dey use their old fuel wey Dem been buy when the price never increase still follow increase price for transportation, and anytime wey price of transportation increase for Nigeria because of the cost of fuel, even if the cost of fuel come down, the price of transportation no go come down again.

Okay see as the fuel price increase from 530 to 617, plenty fuel stations for my side here wey get old stock( fuel) no gree sale again oo, Dem close their stations, Dem dey wait make the 617 circulate everywhere then Dem go come dey sale their old fuel wey suppose be 530 for 617, in order to make more profit.

Is that one not wickedness?

If government and police no dey reason and help us, we wey be citizens suppose reason and help ourselves, but we dey follow dey show ourselves wickedness, and e no good
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
July 20, 2023, 05:56:14 PM
#9
I beg my pipu,I dey vex for the way things just dey scatter and inflation dey high everyday by day. Tinubu wey some people say na him dem want, say him go fit change things for the country to make am better,come join dey make am worst the more. Imagine three months never reach Baba remove fuel subsidy,remove education subsidy and still go apply for loan say him wan use am pay poor Nigerians 8k for 6 months. Yesterday,I dey watch news come discover say fuel wey them say no more subsidy price from 530 run reach 630,I ask myself say how come. This make me dey wonder say make I ask this question since na all of us dey the country together dey see as things don dey  go ever since. My question be say for Naija na who dey make things dey spoil the more,shey na our Nigeria police or Politicians or we the citizens. I beg give me your reason.
If you are living in Nigeria and you earnd your money in Niara then you are in to faced alot of this inflation and even if you dont earn naira whatever currency tou hold by the time you want ro purchase goods and services the impact of this bad economy in our daily business and prices will still eat up the money and touat the end will end un the same cycle.

But still it is better to earn in foreign currencies in this economy since the exchange rate is high you will be able to make out big amount that you can use to pay off the inflated goods in the system, when I mean holding foreign currency what I mean is e.g Bitcoin,  dollars and Eauro this is the money exchange currencies and for that, their value against the Naira is still with a big difference.

So work hard and get paid in those coins that have greater value than your traditional currency.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
July 20, 2023, 12:54:31 PM
#8
My question be say for Naija na who dey make things dey spoil the more,shey na our Nigeria police or Politicians or we the citizens. I beg give me your reason.

This question dey straight to answer oo. The thing na as e dey play e dey show, we all sabi say politicians don show us shege. I don't know the people wey dey advise the people in power, their brain need to be examined. The thing be say even the advisers na part of game of selfishness and personal gain. Wetin additional 8k want do for a family in one month while Dem dey share billions as allowance. The Nigerian politicians matter pass wetin pesin fit understand.
sr. member
Activity: 462
Merit: 414
July 20, 2023, 11:49:40 AM
#7
The worst part of it is we don't have strong christians. If to say we get better pastors and religious leaders for nija, them for don call God, come solve our problem but no. Them dey use Christianity take purse politics and fame.
Well  My brother I no sure weather Dem go fit fix nija oo make we just dey manage am the way we see am
My broda,Nigerians don pray tire, but heaven help those who help themselves. As you talk na only God fit help for this country because we as citizens don try vote person wey who want but INEC na them dey put is for all these problem wey we dey face presently. Our government na them dey spoil this country because them no care about how to do things wey go bring job employment for the youths, instead them dey use their office dey thief all the money wey them suppose to use lessen poverty for the country. I just believe say one day na one day Nigerians ho stand on their feet to say enough is enough.
Pages:
Jump to: