Pages:
Author

Topic: Who is to be blamed ? - page 2. (Read 330 times)

full member
Activity: 1358
Merit: 207
Catalog Websites
July 20, 2023, 10:03:45 AM
#6
Quote from: Sim_card
My question be say for Naija na who dey make things dey spoil the more,shey na our Nigeria police or Politicians or we the citizens. I beg give me your reason.
I think na politicians dey spoil d country, becos d politicians no say if d country better like other developed countries their big men level don end be that. You saw what happened in d concluded general elections how politicians used money to bribe professors to rigged election for their favour which dey did, and those are d professors who made many students to withdraw from school because of exam malpractice form dey received from the school. Police and citizens cannot control politicians becos dey have all d tool to use to punish any of Dem, either d police man or woman is sack from his or her job, likewise citizens too, d politicians can form fake allegations on his or her head that will make such person to die in prison.
sr. member
Activity: 798
Merit: 364
July 20, 2023, 05:29:06 AM
#5
I beg my pipu,I dey vex for the way things just dey scatter and inflation dey high everyday by day. Tinubu wey some people say na him dem want, say him go fit change things for the country to make am better,come join dey make am worst the more. Imagine three months never reach Baba remove fuel subsidy,remove education subsidy and still go apply for loan say him wan use am pay poor Nigerians 8k for 6 months. Yesterday,I dey watch news come discover say fuel wey them say no more subsidy price from 530 run reach 630,I ask myself say how come. This make me dey wonder say make I ask this question since na all of us dey the country together dey see as things don dey  go ever since. My question be say for Naija na who dey make things dey spoil the more,shey na our Nigeria police or Politicians or we the citizens. I beg give me your reason.

Wetin make stray bullet hit police for this matter now? Grin well, na citizens be the police, na citizens be the politicians so the answer to your question is na we the citizens be the problem. To make 9ja better na everybody work but e go hard because as you dey shout na that time another person dey laugh. People wey dey place to make am better no want am to be better because na our shege dey open way for them.

All those politicians na for our midst dem comot from but wetin we dey tell them? Absolutely nothing because dem dey use money close our mouth and we go continue to hail them and defend their wickedness. Na we the citizens not up to our responsibility jare. Imagine a father tell him son wey be politician say if you no do better for people no bother calling your father again because I go disown you. Wetin go happen? All of them get people wey go follow them talk and they go obey but unfortunately no one is talking.

Again, Nigeria problem big pass the world itself. Na division go sure pass for this country now. The peace and unity we dey sing day and night na just pretence and illusion because no trust among us. Another group dey hope for downfall of the country if they're not in power. We can still live in coexistence but abeg make dem free anybody wey no wan do again and we go experience some development.
sr. member
Activity: 504
Merit: 254
July 19, 2023, 05:42:46 PM
#4
Monetary policies and d rate of economy dey govt hand.
Na dem b d decision makers.

D price of Petrol way dey engine movments & T.P na 1 majo determinate way dey determine cost price of anytin abt moni

Yes, pipo vote BAT but dem no elect am. Na chuse dem chuse am oda wise e 4 no dey dia & n desperateness 2 mch.
Dou no blame dose way vote am cuz any hw e be 4 competition, who dey contest go stil gt 1 or 2 pipo to vote am.
D main tin b say him dey lead us all so anytin we face, d comon pipo  2 way get trust in am say e go do well go stil face dsame tin with evry odas.

As 4 comotin d fuel subsidy, him BAT don alredy tok am sins him campaign say nomata hw we protest say dem go stil remov subsidy.
Is like dat 1 na n num.1 aim cus na same day dem do handova him comot subsidy  afta earlier sound warming den.

Com to who dey responsible on d way tins dey go, my felo, e no dey we d masses hand, e no dey military or paramilitary hand, nobody hand oda dan d politicians/govt

If d govt bring, keep maintain and activate laws way go guide us with active system way go exacise  equal abidment,  d contry go beta.

& d oly way d govt go meet up with a better economy na if dem stand to compit wit oda advans & betqa economic grot contries & if dem win, make dem compit a higher 1.

D govt jst be like dem dey ok settling with less.

D trut be say, dis so govt dey feed on public funds & d right constitution giv d masses na fake. E no dey work if not dem suposedey hia pipo cries

Diz pipo really don sell dia conscience to Zero Conscience on the masses.

Insecurities mata dey do us, inflations dey do us, No quality education & huspitalities.
0 shameless govt we gt 4 9ja
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
July 19, 2023, 04:10:38 PM
#3
 If we start blaming anyone today, e no go fit finish. The whole things happening today is not the work of just one person but everyone. For inside the country, we get those wey want progress and those wey no want. E no fit be the police, because them too dey receive order, e no fit be the politicians because na people put them there. If you say make I blame anyone like dis so na we be d problem of this county. Nigerians we are the threat. I'm just tired of the country and with d way things are going, I see more people suffering.
The worst part of it is we don't have strong christians. If to say we get better pastors and religious leaders for nija, them for don call God, come solve our problem but no. Them dey use Christianity take purse politics and fame.
Well  My brother I no sure weather Dem go fit fix nija oo make we just dey manage am the way we see am
hero member
Activity: 1008
Merit: 702
July 19, 2023, 03:30:20 PM
#2
Dis Naija matter plenty and e long like epistle to talk about. We no know who to blame again, na ourselves ahbi the leaders wey we put for those positions to lead us? The matter just get as e be now like this. Na to just go meet prayers and make person find something to dey do and no relent for government work or any intervention for now if not you go just old without achieving anything for dis world. Dey say for good thing to come, one must have to pass through hardship, I just pray ours no go pass like dis before things go come begin better for us for Naija.
hero member
Activity: 560
Merit: 511
July 19, 2023, 07:07:36 AM
#1
I beg my pipu,I dey vex for the way things just dey scatter and inflation dey high everyday by day. Tinubu wey some people say na him dem want, say him go fit change things for the country to make am better,come join dey make am worst the more. Imagine three months never reach Baba remove fuel subsidy,remove education subsidy and still go apply for loan say him wan use am pay poor Nigerians 8k for 6 months. Yesterday,I dey watch news come discover say fuel wey them say no more subsidy price from 530 run reach 630,I ask myself say how come. This make me dey wonder say make I ask this question since na all of us dey the country together dey see as things don dey  go ever since. My question be say for Naija na who dey make things dey spoil the more,shey na our Nigeria police or Politicians or we the citizens. I beg give me your reason.
Pages:
Jump to: