This is the reason I don't listen to fud anymore because that is also a strategy by them to confuse people who are weak hands and they end up selling low and the whales buy them all at low prices and hold them to take big profit.
Di drop really panic me, unto say me na new person for bitcoin matter. I just hold small bitcoin for my wallet as I just de learn about di market speculation. From time to time e go just appreciate, di thing just de sweet me, before I know di btc just start to de deprecate for my wallet, now e de lower dan wen I get am. I even fear say make I no wake up one day see say di wallet don empty.
I agree with your explanation, Helving dey around di corner and di whales dem fit to manipulate di market by selling dem bitcoin, wey fit likely cause dis price dump, so people go panic and sell dem bitcoin, wen di price come down finish dem go come de buy am back. So di best thing wey person fit to do now na to hold im bitcoin, till bull run, wey im go sell and make profit. I also agree with members wey say now na di best time to buy bitcoin.
Actually, e don be like tradition wey be say anytime wey halving dey around the corner, price fluctuations dey strong very well because people go dey manipulate the market very much to see how people go take rush sell their Bitcoin at give away price make dem buy all then after the halving, the price go come sky rocket very high pass the initial and in some cases e dey high pass the last all time high wey Bitcoin don reach before.
Make you no fear about the up and down of the Bitcoin price I know say as Na newbie wey you be for the system, the price fluctuations go fear you because the price wey you buy the Bitcoin don diminish but as a long term holder wey you be, you no need to panic because e g ok bounce back to normal and do much better than the previous price. Na so the market be.